This is Nigeria were you see animals eat money, Nigeria is a place people do a lot of things bad roads and corruption has taking all over, but still on still as the matter be we all still dey believe on change of the country, come wetin u think?? u don ever think am
Yes, me na believer and I no go fit eva lose hope say my fatherland no go eva better as oda countries dey better. For every hardship, reward dey always dey follow am, even if no be now, make d next generation to come, our children dem, make dem enjoy the fruit of our labour now, seriously I no mind at all. If we keep blaming d country and ourselves, tings no go better. Everybody wan dey claim wiseness, d same position wey you dey complain say leaders no do well, dem give you a position and first tin wey come your mind na to steal money, which way na, how e wan take better na. Dis one na just one part of the disease wey Nigerians get, dey have the mindset say na national cake and make dem cut their own share to, and d repercussions na the next generations e go affect.
As Naija be now, you no need to dey wait for government to succeed or find way chop. Naija na one of the best place to run business smoothly without been affected by many things to slow your business down. I know say disadvantages dey but na d positive part you go look into more for you to succeed here. Look for business dat will for you and sell it out. Naija na stil better place wey I no go ever leave say I no go come back again. No matter how your house be, you go still manage sleep inside, na so our Naija be and I know say one day e go better for us all. But before e happen, make we ourselves start d change wey we want for d country. It begins with you and I.