My country people good afternoon, today e get one impression wey most of our newbies get, wey I feel say Dem need to correct, if not, this coming bull run go pass Dem by even though say them prepare for am, but due to wrong preparation, the bull run fit pass Dem.
I know say as an investor wey we be, our main intentions na to make money, but dat one no mean say we no go use our head.
See eh, during the bull run, no be all coin dy rise oo, most of this alt and shit coin wey dy in your possession fit frustrate the haven day light out of you during the bull run, so to me if you wan dy sure say you self go benefit from this bull run, I suggest you accumulate like 95% more of Bitcoin, than park alt and shit coin wey fit disappoint you during the bull run, abeg newbies like me make ona follow who know road so that ona no go lost.
Person tell me say na Mumu dey HODL Altcoins, I been just laugh over am as the person talk am but if you look the statement well, truth dey there sha, Altcoins and shit coins be like time bomb, e fit explode anytime, so na to take am, trade am asap, because if you too HODL am, e fit explode for your hand and as e explode so, your funds don go, whether na Bull Run or na Cow Run, e no concern shit coins because those tokens only escort Bitcoin come and to benefit from am, na to just trade am that time wey e dey hot, because if you wait for too much, you fit dey disappointed. Most of those tokens na Pump and Dump, so if them pump am and you come dey greedy say you go HODL make we grow more, them come Dump am, your money don go be that.
Although e get some Altcoins wey get solid foundations, like Ethereum and a few other tokens, but if we go tell ourselves the truth, na only Bitcoin be the safest asset to HODL. Make nobody whyne you say e dey safe to HODL shit coins.