Pages:
Author

Topic: Why you might miss out on the bull run while holding - page 2. (Read 211 times)

full member
Activity: 196
Merit: 123
My country people good afternoon, today e get one impression wey most of our newbies get, wey I feel say Dem need to correct, if not, this coming bull run go pass Dem by even though say them prepare for am, but due to wrong preparation, the bull run fit pass Dem.

I know say as an investor wey we be, our main intentions na to make money, but dat one no mean say we no go use our head.

See eh, during the bull run, no be all coin dy rise oo, most of this alt and shit coin wey dy in your possession fit frustrate the haven day light out of you during the bull run, so to me if you wan dy sure say you self go benefit from this bull run, I suggest you accumulate like 95% more of Bitcoin, than park alt and shit coin wey fit disappoint you during the bull run,  abeg newbies like me make ona follow who know road so that ona no go lost.
Pages:
Jump to: