Pages:
Author

Topic: Youths Becoming Reluctant to Marry - page 2. (Read 266 times)

hero member
Activity: 1036
Merit: 674
July 12, 2023, 07:38:41 AM
#6
My country people. E get wetin I dey observe for we country wey I wan make una follow me put mouth. I notice say our young bobo them no dey too marry early again. My papa tell me say for their time, before you reach 25, you done already marry or about to. But today, 30 self never put marriage as priority. Plenty good reasons dey sha o but some their reasons no reason enough to be single at certain age.
On the contrary, I no dey observe d same tin way u dey observ. Watin Me I dey see b say, youths now dey marry quick. Persn cef way jst leave en papa house nd e hit any better money frm any means, na marriage go b d nxt tin on en mind. Dat no mean say, e no go stil dey carri olosho bt, 3 understnd watin olosho dey tak frm am nd him kwa need persn way go attend 2 en needs lik 2 dey wash cloth, prepare food, clean house nd d rest way concern wife 4 marriage following our African tradition. Especially wen pikin nevr join b4 e go start 2 dey need house help.

On top of dat, d idea say mak pikin follow papa nd mama dey grow dey very strong now dan in d 90s.

Mayb na ur area u dey observe dis one u dey talk ndi understnd say, man dey try avoid load way e nevr dey sure say e ft carry bt on top of dat one, pple way stil dey risk am dey kwa.
member
Activity: 388
Merit: 30
Reward: 10M Sheen (Approx. 5000 BNB) Bounty
July 12, 2023, 04:31:09 AM
#5
My brother , the mata weu you yearn hold weight but make I still clear you small. The problem in our society can be listed as follows:
 Money spent on marriage ceremony is enough for the new family business start up.
 The process of marriage enacted by some religious organization are far from reality and becomes more difficult for young people to follow it.
 The ladies of this generation are full of high expectations that can not be met and that has led some young guys to believe in making money first.
 Another issue encounter with delay marriage saga is that  some family have failed in their parenting and that has created another vacuum in successful marriage.
 Some are afraid of marriage not because they are not well to do but due to the history of failed relationship and other people's marriage.
 Some young people are afraid of what the future will be, considering the economy situation of the country.


My take on the whole thing , is that there should be a means of educating young singles and families about parenting, and living in love.

hero member
Activity: 560
Merit: 511
July 12, 2023, 03:38:38 AM
#4
The Confused Brothers aka Fine Boys: These na those fine bobo them wey women dey hardly say no to. Them fine die, so na girls dey rush them. Normally, them be ashawo because no type of woman them never harvest; from the ones them chase to the ones wey chase them. Unfortunately, them dey suffer to select wife. If care is not taken self, most of them dey marry girls wey no too catch attention and you go come dey wonder weda na brother solo the ladies spec marry this girl or na another person.
Fine boy wey no get money for pocket na palaza. Those fine boiz wey dey end up marrying ugly girl na because say them no get money. For Nigeria now na money girls dey marry. Ugly man wey get mad funds go marry miss world.

The Tasters Association of Nigeria : This group wan taste all the soup for this world... if you talk about marriage near them, them go use excuse frustrate you wey wan advice them.
These set of boiz just dey play before them go know an for old age them go marry and by then them no go get choice again.

Dangote Group: This group wan become Dangote first before them marry. You see this set, unless we plan for them, find one woman force her on them, them ready to reach 45 before them marry.  We know say money dey important for marriage but they no dey pursue money finish.
I pity for this set of boiz because them go end up not marrying if them no make money. OP, one thing wey I also want make you understand be say no be everybody God create say go marry and nobody everybody go marry at a particular age. The way wey all fingers are not equal,this apply for marriage side too. Some ready to marry but no see girl to marry them
hero member
Activity: 546
Merit: 516
July 11, 2023, 05:41:01 PM
#3
My papa tell me say for their time, before you reach 25, you done already marry or about to. But today, 30 self never put marriage as priority. Plenty good reasons dey sha o but some their reasons no reason enough to be single at certain age.
Maybe in Southern part. Go to North and see the difference. It has been estimated that by 2050, Nigeria population could surpass 1 billion if they continue to reproduce the way they are reproducing and nothing changed till now. More population are coming from the Northern part and they marry fast. Especially their females.

In the South, check those that just passed though senior secondary school and never go university, or those that did not go to secondary school at all. You will noticed they they marry fast.

In the North, as many of them get educated, many more do not get educated like people in the South.

Southerners do not marry and give birth fast again like the Northerners do.

Education is somehow related to this.

You are right, I no actually put the Norther Nigeria into consideration. Their custom and tradition actually makes early marriage easier. However, I no too cherish the pace they are going in terms of population that is not well taken care of... these are the outcome of their marriage system.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
July 11, 2023, 05:26:19 PM
#2
My papa tell me say for their time, before you reach 25, you done already marry or about to. But today, 30 self never put marriage as priority. Plenty good reasons dey sha o but some their reasons no reason enough to be single at certain age.
Maybe in Southern part. Go to North and see the difference. It has been estimated that by 2050, Nigeria population could surpass 1 billion if they continue to reproduce the way they are reproducing and nothing changed till now. More population are coming from the Northern part and they marry fast. Especially their females.

In the South, check those that just passed though senior secondary school and never go university, or those that did not go to secondary school at all. You will noticed they they marry fast.

In the North, as many of them get educated, many more do not get educated like people in the South.

Southerners do not marry and give birth fast again like the Northerners do.

Education is somehow related to this.
hero member
Activity: 546
Merit: 516
July 11, 2023, 04:56:27 PM
#1
My country people. E get wetin I dey observe for we country wey I wan make una follow me put mouth. I notice say our young bobo them no dey too marry early again. My papa tell me say for their time, before you reach 25, you done already marry or about to. But today, 30 self never put marriage as priority. Plenty good reasons dey sha o but some their reasons no reason enough to be single at certain age.

I don take one eye come observe plenty set of guy men them for this our time and they belong to some of these categories as e relate to man and woman something:

The Fear Fear Group: This na the group wey dey fear marriage like say tomorrow no dey. For their mind, marriage go tie them down and make them no get freedom again. If you wan scare person wey belong to this group, just tell am make him go marry Cheesy Cheesy Cheesy

The Confused Brothers aka Fine Boys: These na those fine bobo them wey women dey hardly say no to. Them fine die, so na girls dey rush them. Normally, them be ashawo because no type of woman them never harvest; from the ones them chase to the ones wey chase them. Unfortunately, them dey suffer to select wife. If care is not taken self, most of them dey marry girls wey no too catch attention and you go come dey wonder weda na brother solo the ladies spec marry this girl or na another person.

The Tasters Association of Nigeria : This group wan taste all the soup for this world... if you talk about marriage near them, them go use excuse frustrate you wey wan advice them.

Dangote Group: This group wan become Dangote first before them marry. You see this set, unless we plan for them, find one woman force her on them, them ready to reach 45 before them marry.  We know say money dey important for marriage but they no dey pursue money finish.

If you are still single and an eligible bachelor, oya take microphone and tell us the group you belong to or add your own if e no dey for the list.
Pages:
Jump to: