Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 274. (Read 595858 times)

hero member
Activity: 1400
Merit: 655
Bitcoin is achievement
Una thank you ooh for una support and advice for my new level wey i celebrate,are thank everybody wey encourage me and those wey no encourage me very well because is not easy oooh.
My brothers una do well very much, I don't really know how are go thank una again, but na God wey dey heaven go bless una very well to achieve una dreams.

I say God make bless everybody for me.

member
Activity: 127
Merit: 12
The trick na be say instead of to patronize the ponzi, I buy the coin. Ethereum get future oh make I just highlight am. If any coin fit reach bitcoin (four/five digit price) while bitcoin increase more na ethereum especially as this der upgrade dey come

The very day BrainBoss talk this thing I been no get much money to buy Ethereum, but I try my best convinced my friend with tangible reason why Ethereum go fit increase price soon, him see my reason legit come drop money take buy 1 eth, now him the smile with the price.
Na why I wan thank am personally and to every other person for una contribution and suggestions, our growth for this forum na the love we get for each other be the fertilizer. I throw Salute for all of una
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
Make I no lie you, you be my brother, you go need to make the English boards no tire you. The progress wey dey here na the results of our works for the English boards as we never get local board. The more we dey post the more the merit, the more the rank, make we Naija dey strong to the extent we go get our btt official local board.
My hands dey up for you Charli-boy. E be like you na guy man way know what's sup. E goes well. E dey give me joy say men like this dey the forum. Tuale for BrainBoss, at least, small-small we don dey know ourselve and e go surely help us see road wella.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
to keep up with English for the whole section of the forum no easy.
Make I no lie you, you be my brother, you go need to make the English boards no tire you. The progress wey dey here na the results of our works for the English boards as we never get local board. The more we dey post the more the merit, the more the rank, make we Naija dey strong to the extent we go get our btt official local board.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108

Came down, you meet us for this thread. We dey holam tight. Nothing mege. Onwe hu Ihe mega ayin. Nothing dey bite where you sleep.
[/quote]

Na the matter o, you na correct guy. You know how e dey be na
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Abeg, do-do men and women way group up for here I dey hail una o. Happy new  month and Sunday to all of una. How e dey be for una side na? Hope say everything dey go jejely. No wayo shah! Abeg, to keep up with English for the whole section of the forum no easy. Me I go like make we loosen up for here. I no say everybody no dey here pigin for here but, the plenty people way hear and understand am, make we promote am, pigin na our culture and that's what Africa is mostly about. Plus, promoting our unique African culture go bring us closer as per the unity. African culture way sweet wella!
Na our own small community be this o, na we dey here, so make we dey like say na our land be this. No plenty big big grammar for here. Loosen up, give me correct pigin way go make me laff. No be say, you no go make your point o, or pass message with better English for the rest way no understand pigin to follow up but, you go use your head and promote the vernacular abi mother tongue once-once. Abeg, if you sabi the pigin wella, make una follow me yan for here abeg, pigin-english sweet o. Abi the plenty comedy for we country no be when them use pigin direct am na em you dey enjoy am. Ah-ah! Too much English wan kill person for this forum. I dey see say some people dey run am already and I dey enjoy una, I no go lie. Na for people way still dey hide am to burst out o. Give me the wazobia, na so I like am, raw and original. Make we level up for here abeg.
I Preach One Africa,
I Rep Africa,
Ur Official 9Ja Guy.

Lol... Guy, you self ehn.
All these your epistle never pass those englishians own  Huh

sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
You dey right, but the thing dey under condition, some people for other countries dey even sell merit, I met a guy on cryptotalk wey tell me this. We Naija no dey like that, and the condition be say you go post quality and authentic posts, your brother go see the posts. But, if someone no post good, that na sorry o, no merit for such people, even if the person na from my state person, I no care.

Make we post good and make others know how important Naija dey for this forum and we go dey rank up step by step.
@Charles-Tim I swear down, this thing wey you talk even make sense pass, I don enter other board see how them play with merit like water. Wetin fear me be say post wey no reach 8 words get 4 merits, e con be say the racism too happen for here, na waya for Oyibo oh. Make we try sabi ourself at least I sabi every naija wey don show head for here.
@GeorgeJohn, the only condition na to make quality posts, as Charles Tim talk am. Congratulations on your new rank, e goes well as you celebrate with cartel roots. Keep it up.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
Please everybody join me am celebrate my membership in the forum because I never believe that I will become a member in bitcointalk community.
The thing sweet your belle come make you compose poem on top the matta sef 🤗. E reach, nor be small thing. Shebi I tell you sey na small small. Before you know wetin dey happen, you too don knack am enter the next one. Make you jollificate and continue to dey post well.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
@GeorgeJohn, I dey happy say you rank up, more power to your elbow.

My people make una dey help oooh make
Our brothers them dey grow well for here
Were we dey together.
Biko make una follow dey celebrate my
New rank today.
Omoh I salute everybody again.
You dey right, but the thing dey under condition, some people for other countries dey even sell merit, I met a guy on cryptotalk wey tell me this. We Naija no dey like that, and the condition be say you go post quality and authentic posts, your brother go see the posts. But, if someone no post good, that na sorry o, no merit for such people, even if the person na from my state person, I no care.

Make we post good and make others know how important Naija dey for this forum and we go dey rank up step by step.
hero member
Activity: 1400
Merit: 655
Bitcoin is achievement
Please everybody join me am celebrate my membership in the forum because I never believe that I will become a member in bitcointalk community.
Today I'm member and is a remarkable thing to me because I fined it difficult to get a membership merit that lead as a member.
Is now I realized the proverbs that says "a journey of thousands miles started with a step"
so therefore I need everyone support because  I'm proud of myself as a son of Africa

Una greetings ooh
Are dey celebrate today ooh
Because are done become member
For our forum wey everybody wey dey inside
Dey talkf for the betterment of bitcoin.

My people make una dey help oooh make
Our brothers them dey grow well for here
Were we dey together.
Biko make una follow dey celebrate my
New rank today.
Omoh I salute everybody again.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
imagine somebody telling me the only way person fit buy ethereum Na through FORSAGE, our knowledge fit save those way one be saved,
Good for bringing this up, but for here I no think anyone go fall for scam, btt don teach us how we go dey smart and avoid scammers. But for people wey no dey this forum, ignorance dey their body. I join one group for telegram, for less than 5 minutes, one idiot come add me telling me about trading, the scammers dey tell me say na 24 hours return, that one even dey beyond ignorance if falled for, na greed.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
As we day reason altcoin matter make we try day very careful, because this Na crytocurrency e fit good today come go somehow the next day. And pls make we advice those way one here, imagine somebody telling me the only way person fit buy ethereum Na through FORSAGE, our knowledge fit save those way one be saved,
I dey tell people sey Forsage na ponzi scheme because na pyramid e bi. Any scheme wey get to pay you only wen you bring person enter their cult without a product to sell na ponzi. E nor just be any MLM (Multi Level Marketing), na pure ponzi and e fit collapse at any time. But I sabi one big crypto and Forex trader for PHC wey dem dey call Jesam, (Brainboss fit sabi am as na im area) dey promote this Forsage.

Abeg, make una avoid that Forsage thing.
sr. member
Activity: 1176
Merit: 279
As we day reason altcoin matter make we try day very careful, because this Na crytocurrency e fit good today come go somehow the next day. And pls make we advice those way one here, imagine somebody telling me the only way person fit buy ethereum Na through FORSAGE, our knowledge fit save those way one be saved,

Those people wey dey carry Foresage matter put for head like gala and lacasera for traffic no too Sabi anything about cryptocurrencies. The only word wey dem dey use deceive dummies like themselves na Smarth contract. I dey laugh Thier mumu anytime I come across them sha. Dem recently introduce another one dey dey call Lionshare.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
As we day reason altcoin matter make we try day very careful, because this Na crytocurrency e fit good today come go somehow the next day. And pls make we advice those way one here, imagine somebody telling me the only way person fit buy ethereum Na through FORSAGE, our knowledge fit save those way one be saved,
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!

For those of una wey buy Cartesi, make una nor panic as e bi now sey e don drop shikini Satoshi. Na the effect of the last bounty distribution cause am wey dem distribute on July 23. Look for any angle to buy more. Na better coin be that.

Na how the matter the take play be that. As e fall like this many people go run go sell the small them get make all for no lost. Last last na who get that business oriented mind; patient and believe go laugh last, I see future for that coin too, e go raise as I de take eye see am so...
Na true. Like me now I bin sell that yesterday but I don rebuy am today with extra tokens to show for it. If you see any opening sey any utility coin wey you dey hold wan fall, na to sharperly sell am and then wait for the weak hands to follow dump. Una sabi sey some people go just begin run for streets once dem see other people dey run without knowing wetin dey pursue dem, ba? 😂😂 Then as a guyman wey you be, just smile and then quickly buy am back to add more to your hodlings. Na so the parole dey be oh but you gat to be very careful sha. Otherwise, you fit sell and not be able to buy back and then the cruise go leave you behind.
member
Activity: 127
Merit: 12

For those of una wey buy Cartesi, make una nor panic as e bi now sey e don drop shikini Satoshi. Na the effect of the last bounty distribution cause am wey dem distribute on July 23. Look for any angle to buy more. Na better coin be that.

Na how the matter the take play be that. As e fall like this many people go run go sell the small them get make all for no lost. Last last na who get that business oriented mind; patient and believe go laugh last, I see future for that coin too, e go raise as I de take eye see am so...
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Brother, you all dey good and helping, I dey thank for your contribution toward Africa bitcoin ATM I posted few minutes back.

https://bitcointalk.org/index.php?topic=5265432.new#new

Check it out, if deserved corrections, please do.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
The ATM dey lagos. Na one lounge and bar like that. Them even consider installing more ATMs across the country. But that fit be for 2020.
Guy, you confuse me for here. Shebi na 2020 wey dey already like this na abi na political 2020 you dey refer to here? 😏😏
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
But where the BTC ATM dey for Naija? Lagos or Abj?
Yes, @nelson4lov dey correct. I got included all details in the thread.

who see wetin that my darling Curio do a few hours ago?
Curio makes sense, since yesterday when he got to $1, the coin dey drop to $0.8 back to $1, that name good profit. But I dey fear because curio drop na big loss but it mainly $1 price.

About the minimum amount to hold to participate for staking, I believe say them go reduce am prior to the release and if them no release am, staking pools were go dey to cater for people wey no get up to the minimum.
I believe that, possibly staking pool go result.
Jump to: