Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 278. (Read 628867 times)

legendary
Activity: 2716
Merit: 1221
Once a man, twice a child!
I beg make una keep this thread going so that we no go carry last here.
True talk wey you throwey here but the thing na all of us hand e dey. Make wey make this thread owa own Nairaland. BTW, my conspiracy theory be sey any username wey get number join body for here na Nigerian get am, abi una too nor think so?
Examples like...
gabbie2010
Maestro75
Nelson4lov
Becky666
Dem plenty o... 😁😁And dem need to come identify with other Naija peeps here.

@Brainboss, you come tell your people to increase that DGTX after you buy, ba? You for wait make I enter na 🤓
sr. member
Activity: 2590
Merit: 322
SOL.BIOKRIPT.COM
Na wah oh e get persin wey never fall mumu to dose scams before? Take God self for some of them because if no be MMM I no sure una for don see me for dis forum. Back in the early days I mumu die, na hyip, doublers, Ponzi abi matrix or wetin dem dey call am self, I no do? I do all but thank God today persin eye don open. All na experience and we don grab am major.

@Becky666 my eye still dey for that coin but small development been sure up so I get to sell sharp sharp to buy back my DGTX (thank God e don rise). I still go buy some of the ARPACHAIN before month end. This two coins na my major bags.

@Nelson4lov where you lost go, well thank God we don dey come back small small
I jam this thread and come explore am I dey gbadun una tory here well well na im I come pack here jejely make I make I dey learn how una dey buy all those coins wey una dey talk about, I no say you people na oga here in this forum CryptopreneurBrainboss and mpamaegbu una gramama na baba me wey bi say na science student I be learner.
Nigerians no dey dull themselves in these obodo oyinbo forum me self I don learn many things here and I don learn how to run commot for any Hyips and ponzi schemes MMM don teach many mumu lessons wey be unforgettable I no dey go near thing like that again.
I beg make una keep this thread going so that we no go carry last here.
hero member
Activity: 2100
Merit: 794
Top Crypto Casino
~
@Nelson4lov where you lost go, well thank God we don dey come back small small

Omo Brainboss, Your man just dey like dele. Remember say I dey learn web development na? I participate for one internship like that – HNG internship. The stress been dey too much so tey I stop after sickness kick in. But I reach the point to get IT placement wey I fit use next year for their office.

That aside, you see this matter una dey yarn so? About falling/participating in scam? mehn me sef get story to tell Oo. The road no dey ever dey straightforward. I remember some hyip I join then, 3.14%  daily. Most of my friends then chop, but immediately I put my cash wey I earn from faucets then, them go maintenance till today, maintenence never finish. No be only that one sha but I want keep my story short. Since then I vow never to enter a ponzi/hyip or any scheme wey dey too good to be true. Na why this new stuffs like Ethereum Money and forsage, I dey frown when people talk about them coz all na to rub peter to pay paul.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Na wah oh e get persin wey never fall mumu to dose scams before? Take God self for some of them because if no be MMM I no sure una for don see me for dis forum. Back in the early days I mumu die, na hyip, doublers, Ponzi abi matrix or wetin dem dey call am self, I no do? I do all but thank God today persin eye don open. All na experience and we don grab am major.

@Becky666 my eye still dey for that coin but small development been sure up so I get to sell sharp sharp to buy back my DGTX (thank God e don rise). I still go buy some of the ARPACHAIN before month end. This two coins na my major bags.

@Nelson4lov where you lost go, well thank God we don dey come back small small
hero member
Activity: 2100
Merit: 794
Top Crypto Casino
Kai kai. I don miss out on the fun already. Make I quickly join in.  First one of all,  make I welcome new members to the Africa/Nigeria Bitcoin and Crypto community.  I don set notifications now for this thread so I no go miss out again 😋


Username: Maestro75
Country and state of resident (optional) Nigeria
Skills: Student and school teacher, but I plan learning online stuff too

Welcome to the community bro. As usual, If you need anything, we're all here to support one another. This is our corner here on the forum made possible by chairman, CryptopreneurBrainboss.

Username: Alobo Realer
Country: Nigeria
State of resident: Benue
Skills: Web Developer in View.


Alobo, Welcome Oo.  I be web developer too Oo. But mostly frontend for now. Happy to connect with you like this.

I been buy ARPA last night but I don sell off earlier this afternoon as profits enter coz now no be the kind of time to see profits and refuse to sell.
full member
Activity: 756
Merit: 231
How many were able to make this opportunity?
The coin don start im challenge nd if u dey among d lucky buyers in d dip den make we dance Atlanta becus we don harma. Dis market eh need patient  b4 tins go fall 4 gud, tank u Big Boss, am okay 4 d first stage of my sell, waiting for the next round around 350 or 400 SATs.   ARPA-CHAIN my folo-folo people, folo person wey know roads....@BrainBoss
legendary
Activity: 1414
Merit: 1118
...gambling responsibly. Do not be addicted.
About this.... I laugh because I also get that experience. I even buy coins they were already listed to be delisted from exchange (lol , how I want take know na. Person dey know wetin dem no sabi ?).
Na ignorance be that, na like disease self. Though, the kind scam are old before I sabi crypto not long ago, but I no dey invest on weting I no sabi. I see doubler too, I see many scam type but that Nigerian blood dey my body, no scam work if I no go lie. But, I no greedy nor dey impatient, life na step by step, these helped me especially when I see doubler site.

But weting dey pain me be sey people wet no know about these scams still fall victim.
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
@Brainboss, your agility dey totori me well. You sharperly rush go do buy back. You nor wan hear story story... Lol.

How far the saga for twitter any body don see am, all high reputed cryptocurrency related twitter profile and some top celebrities account na hushpuppy brothers in work run dem street and I hear say dey don scam like $115,000 already. You think this event go affect price? Positively or negatively.
D whole thing be like sey na Twitter dem completely hack o and then tamper with some popular handles. So, you think sey na Hush boys dem? 🤔. Anyway, I nor believe sey that hack go affect crypto price since nor be exchange wey dem nack. But wait o, those ones wey fall victims come begin send Bitcoin to addresses wey claim sey dem dey do give away with "send one get two" nor be greed dey do dem? Well, everybody dey learn at their own pace sha. I remember when some doublers dem wayo me too in 2017 wen I just enter crypto new. I learn since then.

I don dey read for forum on some fud speculation on the expectation say the hack fit affect the price of bitcoin but me I no dey think like that oo. Btc dey funny oo. Sometimes the thing wey you expect say go pull price down, you go surprise how buy candle go fly up lol  Grin Grin Roll Eyes And you go dey watch ya money floating for river Niger, chai.... Abeg make traders no just go dey sell btc oo, just watch well and be sure it is a trade decision wey you see and not just expectation wey dey your mind.


Quote
I remember when some doublers dem wayo me too in 2017 wen I just enter crypto new. I learn since then.

About this.... I laugh because I also get that experience. I even buy coins they were already listed to be delisted from exchange (lol , how I want take know na. Person dey know wetin dem no sabi ?).

But, I don't know if @brainboss also get this kind of experience.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1118
...gambling responsibly. Do not be addicted.
I welcome you wella wella with correct cool water for ya body. E good as you enter this house. We go dey roll the thing dey go together. But Bros, we nor sabi book here o na im make we dey use pidgin dey yarn here. Your English dey knack my head too much
I don go through some of una posts e make sense, to correct say you be all learned and understand English even pass me self, na me be your pikin and need correction and thank you. I never write or speak pigin like that before but I go dey try small. You welcome me good and e make sense.

Welcome @Oshosondy
I respect sey you get rank, I go(went) check your profile, you don work here. Thank you for the welcome.

How far the saga for twitter any body don see am, all high reputed cryptocurrency related twitter profile and some top celebrities account na hushpuppy brothers in work run dem street and I hear say dey don scam like $115,000 already. You think this event go affect price? Positively or negatively.
This na just social media scams, bitcoin price dey well, nothing fit affect ham. If unto say na exchange get fault now, wahala go dey, people can fear convert their bitcoin to fiat and withdraw but the scam na phishing. No exchange dey at fault, this type of scam common for banks self and banks never run down.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1221
Once a man, twice a child!
@Brainboss, your agility dey totori me well. You sharperly rush go do buy back. You nor wan hear story story... Lol.

How far the saga for twitter any body don see am, all high reputed cryptocurrency related twitter profile and some top celebrities account na hushpuppy brothers in work run dem street and I hear say dey don scam like $115,000 already. You think this event go affect price? Positively or negatively.
D whole thing be like sey na Twitter dem completely hack o and then tamper with some popular handles. So, you think sey na Hush boys dem? 🤔. Anyway, I nor believe sey that hack go affect crypto price since nor be exchange wey dem nack. But wait o, those ones wey fall victims come begin send Bitcoin to addresses wey claim sey dem dey do give away with "send one get two" nor be greed dey do dem? Well, everybody dey learn at their own pace sha. I remember when some doublers dem wayo me too in 2017 wen I just enter crypto new. I learn since then.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
DGTX too nor dey bad. I go try buy am by next week. Brainboss, e go good make you buy am back sharperly so you nor go ever regret not doing so now, the way I regret selling my 270 BNB coins @3 in 2017 or so before the thing go do $30 and then ATH of $40+ last year.

Na wah for you oh abi u no trust me, I don buy am back sharp sharp. First I buy ARPA for Binance come dey reason say make I just see how e go perform but after like some hours (later in the evening) I come view DGTX again for coinmarketcap, e don rise dey enta 7cents Broda I no think am twice go sell my ARPA (thank God I never withdraw am from Binance by then) then buy DGTX. For next 6months or so na the coin i go dey focus majority of my investment in. I believe the project die na just busy body make me go sell am.

How far the saga for twitter any body don see am, all high reputed cryptocurrency related twitter profile and some top celebrities account na hushpuppy brothers in work run dem street and I hear say dey don scam like $115,000 already. You think this event go affect price? Positively or negatively.

Welcome @Oshosondy
legendary
Activity: 2716
Merit: 1221
Once a man, twice a child!

I don already pack small ARPA keep on Binance. Since na Defi, e go suppose dey burn go down. Na around 1,450 billion e dey from the original 2billion. DGTX too nor dey bad. I go try buy am by next week. Brainboss, e go good make you buy am back sharperly so you nor go ever regret not doing so now, the way I regret selling my 270 BNB coins @3 in 2017 or so before the thing go do $30 and then ATH of $40+ last year.

The greatest risk for life as people wey sabi book dem dey talk, na to nor take risk at all.


Username: Oshosondy
Country: Nigeria
State of residence: Oyo
Skills: Trading
I welcome you wella wella with correct cool water for ya body. E good as you enter this house. We go dey roll the thing dey go together. But Bros, we nor sabi book here o na im make we dey use pidgin dey yarn here. Your English dey knack my head too much 🤡🤡
legendary
Activity: 1414
Merit: 1118
...gambling responsibly. Do not be addicted.
Username: Oshosondy
Country: Nigeria
State of residence: Oyo
Skills: Trading

It took me long to make my first post here, I joined few weeks ago but unknown to me about how this forum works, getting acquainted daily and knowing more. At least I know few people now that are Africans which makes me happy like I am not lonely here. I had a good start but I will like more of your help in term of encouragement, advise and many more and I hope you will not let me down.

I have made few topics...
https://bitcointalksearch.org/topic/m.54796274
https://bitcointalksearch.org/topic/m.54657290
https://bitcointalksearch.org/topic/m.54650180

...and I want to improve more, I hope you can advise me on that. Thank you all.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Username: Alobo Realer
Country: Nigeria
State of resident: Benue
Skills: Web Developer in View.

Samakpe for you, I get jolly for my Belle as I see my 9ja people interested in bitcoin, guy welcome.
I go advice make you reason wetin @upgrade don yarn e go help you for your stay here, baba the forum no hard Na many people soft, just do your thing in a right way.

Read rules if you never read am before
https://bitcointalk.org/index.php?topic=703657.860

Also read this one join
https://bitcointalksearch.org/topic/newbies-read-before-posting-1689727

Reading go help you for here well well.

Welcome my brother
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Welcomed @Maestro75 and @Alobo Realer
Make I go check all them altcoins wey una don recommend for here, my experiences with most of them don teach me say they no too dey reliable for the long-term, but better potential dey for the short period to hit better ROI.

Very true but sometimes the thing they go the other way. I if remember my 2017 experience with Binance tokens I get am like thousands but sell later after I noticed is no they rise again for sometime. Fast forward to today check prices see how far. Same with chainlink and most currently DGTX. This one own na him dey pain me pass. After all the patience I give am just sell am around 4cent and today e dey 6cent plus.

I dey reason buy am back as I believe in the project seriously but I dey fear correction anytime soon. That coin ARPACHAIN wey I suggest e don dey do me two two well the issue na my whole heart the bleed for my supposedly $DGTX lost, I fit pause by back my token anytime from now or wetin una think?

Person fit reason me how e see the project Digitex future exchange? and if na you among the two projects, which one you fit reason long term pass?
sr. member
Activity: 1890
Merit: 328
Important information: Nigeria Naira becomes first Fiat currencies to be listed on Binance.
Na dis thing make Binance exchange take dey pass other exchanges be dat. Once the CEO, CZ Binance, see anything wet go enhance im company, de guy no dey waste time to follow am up. Him realize dey so many Nigerian traders dey the Binance platform and to keep these people happy na im make am introduce naira enter Binance. Correct guy.

Abeg, make Una no reason am sey I be forget to introduce myself here even though e don tey wey I don dey this forum but I no too kukuma sabi this thread.

Username: Maestro75
Country and state of resident (optional) Nigeria
Skills: Student and school teacher, but I plan learning online stuff too
member
Activity: 127
Merit: 12
Becky666 and Mpamaegbu I gather courage take remove my Cap and shoe as I drop my chest for ground the take thank una for this ogbonge welcome. I pray say make the blessings Wei baba God don promise no go pass una by, and for this great opportunity una take give our dear people like this una reward go be for only heaven...

Mpamaegbu Hon Samuel Ortom dey very alright, Corona virus the only pass through him head but no the catch am, im the pay Salaries (im major achievement), im the travel and lots more...
legendary
Activity: 2030
Merit: 2174
Professional Community manager
Make I go check all them altcoins wey una don recommend for here, my experiences with most of them don teach me say they no too dey reliable for the long-term, but better potential dey for the short period to hit better ROI.

Welcome to all the new members dem wey don join the community, e go make sense if this thread stays active and those new members fit ask all their questions here and easily transition into the main forum.

• No copy any person work without source, and
• No engage in scam or share links wey fit steal person funds.
Asides this ones, just dey read and learn.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1221
Once a man, twice a child!
My eyes dey on that ARPA stuff, and now I don add the new one wey BB throw out to us — DGTX, I go try buy some units this week. I thank all my guys here for throwing these ones out. One love!

Alobo Realer, I throw cool water for body to take welcome you, bro. How Samuel Ortum dey na? Anyway, just relax and keep making better posts. The merits go come when you nor even expect am. I sabi how the thing dey be, especially when you never begin dey get campaigns to dey put food for your table and pay for your data.

My people, una fit put eye for this thread on Africa proverbs wey I start here African Proverbs in Pidgin
full member
Activity: 756
Merit: 231
Username: Alobo Realer
Country: Nigeria
State of resident: Benue
Skills: Web Developer in View.

My experience in the Forum: my experience in the forum is quite interesting and educative. I've learned so many things from this community, I joined as a novice to cryptocurrency, had no ideal what Bitcoin was before I joined the forum, but after due follow up and research I discover this is the best place fo me, and at a point i regreted for not knowing it before the time I knew it.lol..
Welcome broda, u are highly welcome to b part of dis movement nd hope 2 see u doing well, don't get urself into trouble, b respectful 2 forum members.
Quote
Everyone here is friendly and kind, but make I no lie, e hard to get merit for this forum, my struggle to get merit don land me into knowing plenty things about Bitcoin and other cryptocurrencies wey I don fall in love with. That one na like killing two birds with one stone, even I never too get merits I don know much about cryptocurrencies and I don know how and where to invest my money..

Merit go com wen u dey do d right things, kip up d gud work. Advise: don't post becus u want to; but present facts nd also convince members.
Jump to: