Pages:
Author

Topic: Fake life in naija - page 3. (Read 329 times)

sr. member
Activity: 266
Merit: 217
November 21, 2023, 03:44:39 PM
#4
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.
The habits of borrow pose nah bad things because pesin dey do those things just to impress others, if nah man, I go say em dey try to impress girls but if nah woman I go say that nah just 0art of our life style.
But truth be told, borrow pose nah bad thing, but the real matter be say, no be we start this fake life of a thing,,,,, I dey try to talk say this nah part of many pipo life style. Sometimes, many pipo just win feel among, more especially when them see their fellow mate dey do the kind of things way them never do before. For instance, of your friends dey go night club and and you never go before, based on say them dey always bring some kind of goodies and some gist way them go dey yan you. One day you self go like follow them go and if you go go, you self go like look good,,,, if you no get good cloths, you go like borrow to pose.
But e no dey good,,, if you no get just try hustle to get.
sr. member
Activity: 266
Merit: 276
November 21, 2023, 03:27:53 PM
#3
Teenagers and youths of these days they more attracted to finesse thangs. ( Drugs, Sex and Money). Just as Burnaboy call am "trabaye". If you no they leave this kind life you no fit, get best  freind again for the country. everybody wan go club, party they want feel among. As long as dey dey benefit one or two things from you from all these angle nah so they dey call you blood. E hard to actually there around all this peer influence but if you go fit withstand am then you go far for life.

I feel like say people no care again, they just wan live the life untill death call their name. The life no easy and any money way dem get they want use am enjoy. But nah the wrong thing to do in my own opinion. The way i see life nah say as long as you they live make you they make plans just the same way you they enjoy yourself cos its a very big world and you need to prepare for the unexpected.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
November 21, 2023, 03:24:13 PM
#2
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.

make i shock you say some persons no be say dem dey form, na just their normal lifestyle to dey select food even though say them never eat anything, dem prefer to stay hungry than to eat wattin dem no like, but the one wey pain me pass na those people wey their ogah give them car to go wash but dem go come end up using the car go flex and most times this flexing dey sabi purge dem, maybe the car go come get issue or get scratch and before you go know dem don loss the job wey dem dey manage. then concerning the cloths own i get one friend wey sabi live this kind of fake life, em go fit borrow both top and trouser like 5 from different persons take do fine boy. but i wan still clear your doubt say no be only naija this kind of things dey go on, na every where e dey most especially for this part of Africa.
jr. member
Activity: 135
Merit: 6
November 21, 2023, 01:59:42 PM
#1

Jump to: