It's a culture and I dey personally enjoy am. Although I no dey drag food but you see any occasion I enter, even though I dun belle full, I must chop.
I no sure say na culture thing e bi because while growing up na certain people for area weh we know say them no get shishi deh do am. But today na most people don enter that way, especially for village settings.
Well if there's an increase in dragging at events I guess we all know why, country hard. Bitcointallk dey bless us so we no go understand but if you go outside ehh you go pity people.
Boss no be lie you talk there. This place deh bless us well well. You go fear wetin those weh deh brag say them even get work deh receive as pay self. Most of the big boys like una deh even triple their pay. One day I go reach una level.
I fit remember one woman wey be dey my village when I small, we dey see her for every occasion on Saturdays and Sunday and normally anything wey she achieve na wetin her children go chop for the entire week until another occasion come board. I sure people still dey run this compass today self.
People like her deh every occasion. No be her type I deh talk about. Am talking of those people weh get jobs but still deh misbehave for events once them see food. Food weh person go poopoo in less than 48 hours later. Na big shame.