I think we have had a discussion similar to this although they aren't entirely the same because this is heading towards another direction but both threads are in relation to hardwork and smart work. The main thing wey make hardwork dun dey outdated na say e dey limit your earnings, hardwork wey be physical work go make am you no go fit dey make money from multiple sources and to survive for Nigeria you need multiple sources of income. Hardwork if you ask me na all dis 9-5 works wey be say e dey start by 9 and go end by 5 everyday without giving you the opportunity to do other things. E no matter whether you dey work for person or you dey do your own work, provided say na only hardwork wey you dey dey e go weigh you. Hardwork also include this labourer jobs dem. Even dem dangote get other soft hustle (smart work) wey dem dey do like investing in shares.
Share some other smart ways to make money.
- Investing in Bitcoin (this one na the koko because na the surest wey now to dey do smart work (me I dey like call am soft work)
- Trading cryptocurency (this one no be only Bitcoin but all cryptocurency, if you learn am well you fit dey make better money but make sure you learn am well before doing)
- Investing in foreign currency (e.g buying and holding dollars for it to increase and you take profits).
- Forex trading (this one dey self explanatory as na wetin people sabi pass)
- Real estate investments
- Social media influencing (This is the recent Gold mine as you fit influence multiple things at the same time from the comfort of your bed, you fit do TikTok, Instagram, twitter, YouTube etc influential different products from music, movies, restaurant, bars, clubs, normal everyday products, and so on).