Pages:
Author

Topic: History of najia local board (how e Tay start) - page 2. (Read 8598 times)

legendary
Activity: 2408
Merit: 4282
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Although the thread wasn't necessary as we're barely a year old but I appreciate the effort put into creating the thread. Maybe if this thread been dey come out in our 5 years or 10 years anniversary na when I got see more importance to the thread but anyhow sha kudos for reminding us where we started from. This fight no start as Nigeria fight but as Africa and threads like this (No African local board) na wetin open our eyes to the struggle. Mpamaegbu come bring the appeal for a Nigerian board, dat time I dey full member and many of the OGs here still dey very lower rank. I remember because na when I reach Snr member wey I create that hangout thread and then we had a place to brings heads together and got what we have today.

If anybody here has to take credit na Mpamaegbu as na him open our eyes we come dey come together as one family and today we dun big like this. We still dey grow sha and small small we go get a bigger board wey go dey compete with the other boards but to do that we need more quality posters and as we dey post make we no only dey run am say we want complete weekly quota but to add quality to the board so anytime wey we request for anything them no go waste time approve am for us.

We dun try for ourselves and we go continue they push forward, all those bigger boards una dey see so, e take dem time to build am to where e dey so make we no dey rush our own. Small small we go get everything. Theymos get how him dey do e things, just requesting won't give us what we want but strategic planning go give us am.
hero member
Activity: 700
Merit: 673
~snip~

Thank u say u try recognize some of us for here, we they stand when necessary, well make I just talk for my self, if I see were person hand clean for my own view I they try with Watin I understand to put people for that area way dem fit see say the person no really they as bad as dem think say eh dy, but for case way be say the person don use him own hand scatter everything nah just to leave the case mke the person suffer him faith.

Watin I they try talk be say even if onah get who they help defend onah outside, eh no mean say onah no go bring head down nothing good pass were person fit just they avoid trouble any way possible way u fit avoid am no fall law, becuz if u break the forum law even your own lawyer fit they against you cuz eh get as eh go follow the case him own head fit enter and that law license dem fit take am from am, for here we love ourself no matter the attack nah just to put things for the local board in other eh no pass so.
sr. member
Activity: 420
Merit: 253
I commend all those our senior men them wey stand strong for us to achieve this our local board Una try well well o because I just dey wonder how the newbies them for do had it been say we no come get our own local board as in be say Dem never get any much experience like that but as we come get this local board, e come be like say e relief almost every body wey from Nigeria wey dey this forum because we dey interact with each other well and imagine some threads wey some of our members here carry come local board to advice us and also to correct some of us wey dey go wrong direction like for example the thread wey @adbitco create Abeg make we mind wetin we go talk for english board to avoid problems and also the one wey our senior man wey be @Agbe create U don Plagiarist ursef and Follow Instructions to Avoid Deleting of Application. and so many others so if we no get local board how we for take dey give ourselves advice Dem like dis and our local board really help to unite some of us outside this forum so to all of una wey make this our local board be like this we dey celebrate all of una and I also commend una doggedness to dey protect una brothers for reputation board, people like @legendary Charles-tim and Nwada001 and some other people wey I never recognize, I dey see una hand for reputation board na una be our lawyers wey we get for our local board make una still continue d good work o, together all of us go change the bad name wey some of our youths wey go involve themselves for things wey no good come give every body bad name but wit time you and I will change that narrative. Una well-done o
sr. member
Activity: 434
Merit: 265
Sibi Dabo,,,,,,, Teme Ini Na Sime
This na good start my guy, as e be say me na new person for this forum, I just come as Jonny just come, so I ne really get the full detail about this forum qnd the history of this forum bur thnaks to you as yiu come tell me/us small way you Sabi.
You try to update us th
is mata because no he everybody way dey here na Sabi part of the history for this place.
A very big shout-out to the heros on our local board for the good works they did to make sure that this our board is in existence today, it wasn't an easy mission to accomplish.
sr. member
Activity: 462
Merit: 355
The great city of God 🔥
Respect to our Heros who don make out there Time to make sure say this we naija local board stand today e no easy. Piking wey dem carry for back no no say journey far. And also Piking wey dem born to a wealthy family no no how much be bag of cement, or no even know how e Papa carry build Empire wey him dey enjoy.

Shout out to all of our naija Ninjas wey don fight for wetting we dey enjoy today. All My oga them @crytopreneurbrainboss @charls-Tim @Agbe @Mpamaegbu @Igebotz @Upgrade00 and to you @ satoprincess your donation or charity to people also bring attractions of Goodluck to us. may God bless you also to @brainboss for the covid19 disbursement of food, also to @Agbe for the introduction of bitcoin to students with laptop for study. Ona really try. if this forum they put calendar of the past Heros like Nigeria past Heros, we for don paste am here sothat any newbie wey dey come here sopos no the people wey dey dey follow chat say no be just any how people.

I respect ona, and the memory of wetting ona don do go always dey in our heart's. If not for ona how we fit dey enjoy benefits wey we dey get here? Now people dey push enter the forum almost every day dey creat thread up and down not knowing say the privilege na people bring the idea. once again I thank you all for your efforts. Thanks to you @Hatchy, for compiling this for people to know the origin of everything, because e dey give honour to those wey participate in making something a success. Thanks to @mia Chloe for bringing up the latest art contest too, because na those things go dey make here lovely and lively and with our talent we dey showcase for here go make the international people for the forum to change there perspective about us. and them go see a better part of us no be the negative side. I see say those men dey visit 9ja local board more often than other board that is to say them dey highly impressed with wetting we dey do. And our negative tag don dey comot. Ona Weldon.
hero member
Activity: 2212
Merit: 805
Top Crypto Casino
I got the notification about the mention in this thread. It's nostalgic and I like it. Kudos to you @Hatchy for a trip down to memory lane. The journey to getting this local board is a continuous one. Although only a few members started to journey, we now have a community backing the movement which is a big plus. A big thank you to members wey been go above and beyond to request and fight for the interest of the community. At this rate, we go soon get separate as per the request made in local board.


To all new members joining the community, you're welcome  Smiley
sr. member
Activity: 448
Merit: 560
Crypto Casino and Sportsbook
Wow!!! I am so pleased and surprised to have seen this thread. Although my little time on our Naija local board I didn't know so much about our board. However with the help of this thread I have been able to understand and know many new things about how Naija board really started.

I wan sti use dis medium take thank our bosses Dem 4 d effort way dem put to make sure say Naija board get head. I wan sti Thank Hatchy way e tay put dis thread together. Abeg ee shout out to Naija board we 2 much .Naija no de carry last true true.
sr. member
Activity: 700
Merit: 470
Hope Jeremiah 17vs7
So on d 08 February, 2019, our oga @ Mpamaegbu come create d first ever nija board request thread wey e title Nigeria Local Board: Theymos take Note.
Chai! I nearly typed disclaimer just now on top this thread sey you mis-tagged me instead of Brainboss for dat topic. I nor even remember startin dat topic again oh, at all. How time flies. You know dat thing dey sey about d internet not forgetting, ba? Dat's why e nor good to naked baff outside.

Na true, dat time nor be small gbege we face because naija been get serious bad image everywhere and d senior men before us nor too get d strength of disproving d bad image wey owa leaders dem put us into. Anyway, we thank God for where we don reach today for the LB matter.

Nice wan, OP. I for pour you beta colele wata but sadly na only wan bottle dey my fridge now.

Shout out to all men in da house! Happy New Year to all of una.
Mpamaegbu and CryptopreneurBrainboss God bless both of you and everyone who supported you guys especially those who supported in the Africa Bitcointalk community hangout signature campaign, Omo even our great grandfather Jet Cash supported us. Thanks to Charles Tim and Igebotz who later joined the fight God bless you all and every of our local members. May Becky666 continue to rest in peace.

Seeing all these donations by CryptopreneurBrainboss, Satoprincess and Agbe would have suggested we continue that Christmas donations especially now when economy are this bad.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
So on d 08 February, 2019, our oga @ Mpamaegbu come create d first ever nija board request thread wey e title Nigeria Local Board: Theymos take Note.
Chai! I nearly typed disclaimer just now on top this thread sey you mis-tagged me instead of Brainboss for dat topic. I nor even remember startin dat topic again oh, at all. How time flies. You know dat thing dey sey about d internet not forgetting, ba? Dat's why e nor good to naked baff outside.

Na true, dat time nor be small gbege we face because naija been get serious bad image everywhere and d senior men before us nor too get d strength of disproving d bad image wey owa leaders dem put us into. Anyway, we thank God for where we don reach today for the LB matter.

Nice wan, OP. I for pour you beta colele wata but sadly na only wan bottle dey my fridge now.

Shout out to all men in da house! Happy New Year to all of una.
sr. member
Activity: 336
Merit: 365
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
My People, Una weldone o. If una see the joy wey I dey get like dis so, una no go believe as I be like person wey don chop overfeeding. Well as Una see the title, history of nija local board. I just dey reason am say as many new naija board members dey enter forum, Dem suppose still know small history of how our oga Dem take fight their way till we finally got our own local board last year. Yes last year so we are actually just 1 year old. Hurray nija board members although I wasn't here at that time, but I'm grateful to be a member of this wonderful forum. And so far nija board has shown many impressive statistics in d past few months and we are happy to be amongst d most active local boards of d forum. Thanks to many of our new members and oga Dem wey dey do all their best to make sure say the local board dey clean and much more interesting than when it was just a single thread. Well enough of the talking, follow me through this short history of naija board and be amazed, just as I dey when I dey compildis thread. Like dis now, we don show say really, we Nigerians no dey carry last.



In d early days of the forum, when Bitcointalk nova dey popular as e dey now for we country, our old oga Dem find Dem way to dis ogbonge forum. And having being an African, a Nigerian, all of dey do very well here for BitcoinTalk. Dem really represent us d Africans very well, con create better reputations for inside dis forum. So far, some early men Come see say e go make more sense, if Nigeria get Dem own local board.

So on d 08 February, 2019, our oga @ Mpamaegbu come create d first ever nija board request thread wey e title Nigeria Local Board: Theymos take Note. Dis request was shocking and other men for naji wey see say d idea make sense come support d thread well. Dem hold ground with our oyibo men Dem. If you read through d thread you go see how many people Dem use mouth take finish our people Dem but Dem no gree. Sha Dem no grant d request dat time,but other many top oga con suggest say since na d first request, e go better make we first create something like a local language thread first. Dis idea na to calculate d amount of active members wey dey we country before Dem go fit reason to give us we Localboard.

With so many suggestions, on d 17 of march, 2019 oga CryptopreneurBrainboss come create de African bitcointalk community hangout thread. Dis name wey he give am, na to give way for other countries Dem wey dey Africa to tay take part for d discussion thread.

Images of old African community thread:




To bring awareness about d Africa Bitcointalk community hangout thread, @CryptopreneurBrainboss come reason am say e go make sense to start a signature campaign. Dis campaign na to take show other African people Dem wey no dey aware of d thread to no about am and join d discussion. Dis was how d Africa Bitcointalk community hangout signature campaign was created.D campaign dey for both paid and free volunteer signature dem. other members of d forum like and appreciate d idea wey brainboss boss bring and some con help create signatures and avatar even personnal text for dis campaign to take start.

Some of the early avatar : created by cabalism13




D signatures for d campaign: created by @ Heisenberg_Hunter

 
Quote
Member rank
▬▬▬▬▬      BITCOINS - AFRICA      ▬▬▬▬▬
There's a thread dedicated for Africans to hangout and discuss general issue and issue relating to blockchain development in Africa.
▬▬ Join Africa Bitcointalk signature campaign ▬▬


Full member
▬▬▬▬▬      BITCOINS - AFRICA     ▬▬▬▬▬
There's a thread dedicated for Africans to hangout and discuss general issue and issue relating to blockchain development in Africa.
▬▬ Join Africa Bitcointalk signature campaign ▬▬


Senior members and above

░░░░░░░▄▄▄▄▄▄
░░░░▄██████████▄
░░░██████████████
░░██████▐▌██████
█████░░░░░░░▀█████
██████▄▄░░▄▄░░██████
████████░░▀▀▄██████
████████░░▄▄▄░░█████
██████▀▀░░▀▀▀░░█████
█████░░░░░░░░█████
░░██████▐▌██████
░░░██████████████
░░░░▀██████████▀
░░░░░░░▀▀▀▀▀▀
░░░
Pages:
Jump to:
© 2020, Bitcointalksearch.org