Pages:
Author

Topic: Imagine wetin we fit use BITCOIN do (Read 422 times)

hero member
Activity: 798
Merit: 547
Leo is resting.
December 09, 2023, 05:29:05 PM
#43
I con imagine say we con dy use Bitcoin pay NEPA BILL, HOUSE RENT, TRANSPORT BILL (to pay conductor self) like do many things and the one wey make me talk about this one nah, we as Naija people con dy use Bitcoin dey pay Bride Prize for this contri?

How una see this one, to go marry then use Bitcoin pay the woman papa...
Wetin you talk na true. Bitcoin get many use cases for the abroad and we fit still replicate am here for Naija. From everything wey you list, I just want tell you say na only to use Bitcoin pay for transportation like local or inner city transport na that one go hard or dey almost impossible. Imagine say na Lagos, how you wan pay those danfon with Bitcoin.

I been wam talk about how to use Bitcoin pay transport go take worry us well well but as I see your contribution now, I say make i kuku support am sharp sharp. I been dey reason how you go take dey make the payment with Bitcoin to those conductors wey no dey hear abeg wait make i bring out money pay you na them go wam give you that kind time for you to make payments vis Bitcoin? E go dey very hard ooo

On the other hand, using Bitcoin to pay for transportation go only work if we fit dey enter pack to pay for any kind transport wey we wam take since e dey announced say na via Bitcoin wey people go dey make payments e no go dey too difficult again but e go work faster if say government support Bitcoin atleast people no go dey fear again to use am make payments.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
December 09, 2023, 03:26:18 AM
#42
Normally if we don reach that level to dey use Bitcoin take dey pay things like house rent and other stuff e go sweet well well, but e get wattin been dey go through my mind but I don get answer to am, the thing na be say, what if as you don receive Bitcoin for things wey you dey sell and e don reach to go market go buy another one, and as you reach the market, due to the volatility of Bitcoin the price come com down for that short interval, and the buyer come experience small loss for price how em go come do since e calculate emself before e reach the market? But wattin I get as answer na be say, if you wan dey accept Bitcoin for your business, you gats keep more than the amount so that should Incase the price come down for that short period of time to go still fit do wattin you wan do successfully. But Bitcoin na more of upward direction e dey face.
full member
Activity: 238
Merit: 152
Duelbits.com
December 09, 2023, 01:55:26 AM
#41
I con imagine say we con dy use Bitcoin pay NEPA BILL, HOUSE RENT, TRANSPORT BILL (to pay conductor self) like do many things and the one wey make me talk about this one nah, we as Naija people con dy use Bitcoin dey pay Bride Prize for this contri?

How una see this one, to go marry then use Bitcoin pay the woman papa...
Me sef I go like am if e reach make we dey use Bitcoin dey pay house rent nepa bill and other bills but the transport own go hard because normal transfer sef conductor dey hardly collect e com be when you tell am say na Bitcoin you wan use pay am, him go jus tink say u no get money to pay so you dey lie say na Bitcoin you get. For the house rent mata enh I feel say na just literacy of Bitcoin wey some pipo no get dats y dem never dey take Bitcoin for rent if not I don go boutique wey dem gree to take Bitcoin for payment but we waste small time for the man to confirm am, some persons don dey accept Bitcoin for their shops just dat dem dey very few so e go be like say pipo no dey do am.

Basically na just about awareness, most persons never Sabi how to use Bitcoin well well even amongst pipo wey get Bitcoin sef, some no still really Sabi use am do dia daily need transactions so na d only problem wey make e never happen, I sure say if some parents no go gree even if dem Sabi Bitcoin because dem go wan chop goat and dem go need give gods dry gin hahahahah, dem no go gree make btc replace all those traditional item if not e go dey very fun and easy, jus send btc once dey confirm you carry your wife go house asap.
sr. member
Activity: 504
Merit: 302
December 07, 2023, 10:35:52 AM
#40
Well e go good but no be now wey our networks never good finish.

Small cashless policy wey we do back then people enter problem because of lack of proper network to run transfer to people in the remote area of the country come to think of e go be if na Bitcoin we go send.

Before we can be able to reach this stage where people go they accept Bitcoin as means of payment, we need to have adequate knowledge about Bitcoin itself and how it works; if you do general survey in the country you go know the people that understand Bitcoin and people that did not even know about it not to talk of how it works.

Moreover, some people still did not believe Bitcoin because them they look as something we go die off soon.

This Imagination go take time before it comes to reality because even our government never accept Bitcoin so allowing people to accept it as a means of payment generally go hard.

The imagination no be small imagination sef, if na for another country now I fit talk say that kind thing fit happen but na naija we dey talk about o, naija na place where before make them believe on something E go take time, na for naija you go wan do transfer for some people and them go they talk say na fake transfer you wan do fir them, naija na place wey them no too dey trust online thing's if not be money them go see chop for that thing, although btc Don dey popular for naija and na because of it na him many people dey survive today.

And about paying the bride price with bitcoin wey him dey talk, him fit use bitcoin pay for any other things but I don't think paying with bitcoin will happen because na marriage we dey talk about here, marriage deserve to be Done the way of our culture and traditional, I no even show say the parents go even collect the btc because bride price na money wey be say them go use pray during wedding, although he fit favor the bride parents if they accept it but it will not make sense at all.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
December 07, 2023, 04:50:16 AM
#39
Make we talk true, people fit dey spend bitcoin for other countries, just the way dem dey spend their normal paper money but I just dey reason how that kind thing fit Happen for Nigeria, because people wey no sabi about bitcoin still plenty ooo, see the high level of illiteracy in this country, na just young guys wey dey come up and dem dey educated sabi bitcoin, and some of them go just tell you say dem dey hear about bitcoin but dey no get interest, but some wey get interest self immediately dey hear say na money you go use start am, they go just free am because person wey never see money chop go invest in bitcoin.

I understand wattin you dey try talk oo, but I go still like to remind you say e no get anything wey our country people no go fit do, weda na illiterate of learned person, we sabi adapt to things easily, just remember the time wey Dem been change the new naira note new and Dem come create policy say dem no wan see old note for our hand, within a short period of time. That time both market women come start to dey accept transfer wey we know say for life dem no go try am, and till today many of them still dey accept transfer, so provided say e don dey legal for we country, I believe say em daily use and adoption no go be problem.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
December 07, 2023, 03:44:13 AM
#38
Even if no be only Bitcoin, make e just be say we fit use cryptocurrency dey pay for many things and more without stress but for where things for this country just dey tire person anyhow... Menhn I dey serious thinking and imagination wan kill me self. NA WA OH.

That one fit happen only if this our government go gree nah, becos to me e go fit work out fine oh either Bitcoin or only cryptocurrency as you talk am but the main thing nah network go be the major cos of wetin fit hold am hostage.
You know say we naija piple we no too get patient to wait for something, before you know you go hear "thief oh thief oh, this man no wan pay me for wetin him buy instead him say nah network" so nah the problem we go face if e come to play say we begin use am.
sr. member
Activity: 266
Merit: 217
November 18, 2023, 04:36:58 PM
#37
Wahala dey for this our country too planty if them go alow us use bitcoin do waiting we won use am do we for do done beta by now self, things for less for us well well. Oya just imagine am say we fit use BTC pay house rent, transportation, buy car, even use am marry wife from obodoyibo e for make sense.. But our government no go gree us use am because say make them dey see money chop from us. But e go still hard for some of us too. because no be everytime BTC dey do well and no be everybody sabi how the BTC market dey be.
If the government allows the fiat banks to dey carry out crypto currency transactions, things no go completely better but one of the good thing be say e go make our money dey under our own care because plenty pipo no go use the fiat bank again and this nah one of the major things way the government dem them fear nai make them restrict the bank to dey run crypto currency transaction.
If our government them legalize Bitcoin fir this we country, e go dey more easier for us to purchase Bitcoin directly from our fiat bank account and still we go get more privacy if we just put our funds for safe crypto wallets.
member
Activity: 784
Merit: 34
👉bit.ly/3QXp3oh | 🔥 Ultimate Launc
November 18, 2023, 04:15:58 PM
#36
Bitcoin no be like paper moni wey we go fit carry waka dy do some kind things too. So I con reason am say, what if as we dy find way for Bitcoin to dy acceptable for the world, wait ma use our contri, what if we dy accept Bitcoin for everything we dy do and e con be normal thing like paper moni for this our contri Naija.
I con imagine say we con dy use Bitcoin pay NEPA BILL, HOUSE RENT, TRANSPORT BILL (to pay conductor self) like do many things and the one wey make me talk about this one nah, we as Naija people con dy use Bitcoin dey pay Bride Prize for this contri?

How una see this one, to go marry then use Bitcoin pay the woman papa...

Even if no be only Bitcoin, make e just be say we fit use cryptocurrency dey pay for many things and more without stress but for where things for this country just dey tire person anyhow... Menhn I dey serious thinking and imagination wan kill me self. NA WA OH.
full member
Activity: 280
Merit: 205
The great city of God 🔥
November 17, 2023, 06:58:47 PM
#35
Bitcoin no be like paper moni wey we go fit carry waka dy do some kind things too. So I con reason am say, what if as we dy find way for Bitcoin to dy acceptable for the world, wait ma use our contri, what if we dy accept Bitcoin for everything we dy do and e con be normal thing like paper moni for this our contri Naija.
I con imagine say we con dy use Bitcoin pay NEPA BILL, HOUSE RENT, TRANSPORT BILL (to pay conductor self) like do many things and the one wey make me talk about this one nah, we as Naija people con dy use Bitcoin dey pay Bride Prize for this contri?

How una see this one, to go marry then use Bitcoin pay the woman papa...
Bitcoin no fit be paper money for any reason. Because bitcoin no be stable coin like USDT or USD. And even say them even print am as money which figure go fit Match the price? Because in volatility dey change everyday. Emagine bitcoin with the price of $35,000k one year e climb to $50,000 how them go do? Dem go print another paper bitcoin wey go Cary $50,000k as price.

Then for the house rent and Nepa bill mattee e go dey understandable, but for transportation I know think say e dey possible. Because our public transport system wey agbero eye dey red Dem no want hear say oga send me your bitcoin address make I pay you bitcoin. E go be like say you dey play. And one problem wey dey dere na the charges wey you go spend for the transaction. As we all know say bitcoin don grow wella to the extent of to dey get network conjestion due to high transaction and that thing dey make transaction fee dey high emerging person wey want send bitcoin of $4 for transportation and them charge you $4 to 6 for charges you no go like am now. So bitcoin is too expensive for mini transactions.

Me I no fit to advice anybody to collect bride price for anything online transfer, because as our network be for Nigeria, di money fit to enter pending. Abi you go hold your inlaws ransom until di money enter your account? Or if you allow dem carry your daughter go, what if di money come reverse to Inlaw account? Dat one na one chance, so I go prefer as dem de do am before before, good old fiat currency, I no fit shout. Na on a lighter note my people.

Yeah me self don reason am. Nigeria na one country wey believe on culture and tradition and no matter the technological advancement Dem no ft change some tradition. For Nigeria here no matter the amount you transfer to your in-laws in regards to your bride price e go just be like na insult to them. Say you Mary there daughter with transfer. And na big insult to there tradition. Even you self reason am as African man wet you be if them come marry your sister come tell ona to bring bitcoin wallet address make them pay ona bitcoin how you go feel? Even if you accept and elders in council no gree wetting you go do? So there are many things wey mo ft dey possible atol for Nigeria.
full member
Activity: 308
Merit: 197
November 17, 2023, 04:36:33 PM
#34
You know say for this contri we need dream of something before e happen, so as you talk nah true say make dem first legalize am but e hard oh.
Dis nah something wey dey for government hands and e dey do me like say e fit happen, the only thing be say our government neva reason am, ones panel think am dem go begin talk of to make use of Bitcoin for our contri.
And this one you talk of to put am for school learning scheme I no sure say e go work, nah only children and youths go sabi oh but our papa and mama no go see time to even learn am.
    At the moment, crypto as a whole na contraband for the country but how I wish, our leaders sabi the kain blessings wey the crypto trading dey bring to boys as Dem no fit create jobs for us. Bitcoin has fast risen to be notable and of great value. Frankly who get BTC now na the real boss because the worth of 1BTC alone carry power. Well regardless say the coin dey prohibited, boys still dey use am, and sincerely e dey help us survive through this time wey our currency don depreciate to it's nearest minimum.
    Like sale of 1BTC now fit do a whole lot of things for person pass who no get BTC. I just wish say e go dey legalized again. Though some reasons dey as to why Dem prohibit am o but still if we look at the brighter side, BTC get better future for where digital currencies dey and with time, when the world don evolve, na then we go con see say we been really for no prohibit am for the country. Everything dey change, revolution and evolution dey sup, make naija follow evolve with the technology happenings around us. We no gats dey behind all because of our selfish interests.
newbie
Activity: 13
Merit: 1
November 17, 2023, 12:10:42 PM
#33
Bitcoin no be like paper moni wey we go fit carry waka dy do some kind things too. So I con reason am say, what if as we dy find way for Bitcoin to dy acceptable for the world, wait ma use our contri, what if we dy accept Bitcoin for everything we dy do and e con be normal thing like paper moni for this our contri Naija.
I con imagine say we con dy use Bitcoin pay NEPA BILL, HOUSE RENT, TRANSPORT BILL (to pay conductor self) like do many things and the one wey make me talk about this one nah, we as Naija people con dy use Bitcoin dey pay Bride Prize for this contri?

How una see this one, to go marry then use Bitcoin pay the woman papa...
To me I see say everything is possible in as much say na human being they do am, I remember back than in my community way everybody gather they celebrate one man way graduate for school back than, but today everyone done open eye civilization done reach every where, as long as say people like u day and others way no the value of Bitcoin and how e dey work I believe say in time coming we go use am pay pride price.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
November 17, 2023, 09:42:34 AM
#32
All these imagination go fit happen, if them first legalize am here and the government add bitcoin learning to school curriculum e go help people understand wetin bitcoin be but many people no go still understand am because of the complexity of it but gradually people will understand when they their close pal use bitcoin to achieve the above things you mention.

You know say for this contri we need dream of something before e happen, so as you talk nah true say make dem first legalize am but e hard oh.
Dis nah something wey dey for government hands and e dey do me like say e fit happen, the only thing be say our government neva reason am, ones panel think am dem go begin talk of to make use of Bitcoin for our contri.
And this one you talk of to put am for school learning scheme I no sure say e go work, nah only children and youths go sabi oh but our papa and mama no go see time to even learn am.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
November 12, 2023, 01:44:44 AM
#31
Normally if them remove the restriction for bitcoin, our country economy go first boost pass like this, and e go nice well well if we don start to use bitcoin for daily transaction for our live, just reason am say as dem wan pay salary na Bitcoin dem use, e go just make many of us run from bank wahala because, the way bank take dey suffer some people en, if to say dem don create another method dem for don press am leave bank, as e stands like this now many people sef no dey gree use any bank wey no be microfinance bank/ online bank because those physical bank dem too get issue, and dem dey thief money. But Bitcoin wallet dem na only transaction fee you go need to pay, nothing else.
full member
Activity: 322
Merit: 166
November 11, 2023, 03:03:51 PM
#30
I con imagine say we con dy use Bitcoin pay NEPA BILL, HOUSE RENT, TRANSPORT BILL (to pay conductor self) like do many things and the one wey make me talk about this one nah, we as Naija people con dy use Bitcoin dey pay Bride Prize for this contri?

How una see this one, to go marry then use Bitcoin pay the woman papa...

E no go bad if dis kind thing happen o, but na d probability of the happening na him dey very much impossible. For something like dis to come to past, many sectors of the contri economy need to dey function very well to make dis thing work smoothly. Na network I dey talk about, even d fiat wey we dey use, when e reach electronic transfer sometimes glitch dey there wey dey delay transaction and dis no be good thing if we come dey use bitcoin generally just like the fiat currency. Everything for bitcoin dey digitalized, to make am paper money go hard but e go make sense make e dey as digital currency dey use am run transfer d way we want.
newbie
Activity: 15
Merit: 0
November 11, 2023, 07:12:21 AM
#29
Wahala dey for this our country too planty if them go alow us use bitcoin do waiting we won use am do we for do done beta by now self, things for less for us well well. Oya just imagine am say we fit use BTC pay house rent, transportation, buy car, even use am marry wife from obodoyibo e for make sense.. But our government no go gree us use am because say make them dey see money chop from us. But e go still hard for some of us too. because no be everytime BTC dey do well and no be everybody sabi how the BTC market dey be.
member
Activity: 155
Merit: 79
November 08, 2023, 09:15:42 AM
#28
All these imagination go fit happen, if them first legalize am here and the government add bitcoin learning to school curriculum e go help people understand wetin bitcoin be but many people no go still understand am because of the complexity of it but gradually people will understand when they their close pal use bitcoin to achieve the above things you mention.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
November 08, 2023, 04:13:21 AM
#27
Ahh.. this one na true talk oo. Even me sef I don imagine BTC as our money .. and e go nice gon.
But the thing be say ignorance wan finish this country. People weh no know plenty, people weh know no dey interested ( maybe until dey don see person cash out from am). To them, e hard to dey monitor Bitcoin market every time and risk dey plenty.

Imagine BTC as our money 😂 my brother no go dia oh, e go hard abeg, if you wan talk eh nah to say you imagine am as something wey we go dey use do things wey we dey use paper money dey do. But e for really nice oh.
And again you no go blame people wey ignorance wan injure, people believe say as long as dem no dey see as people dy collect or gain from BTC dem no go too put interest and nah where the teaching of Bitcoin go come in if not, just forget am.

Quote
Another thing is that our people still very much have faith in fiat currency. They either forget( or they don't even know) that money has gone through a lot of stages and has evolved with time. From trade by barter, precious metals,  receipts, fiat money, and bitcoin can be the future of our money system.
Make we just give am time, paper money go fall hands, and our people go begin look for other things weh Dem go fit hold as money. That time, you no go even tell person twice, them go use bitcoin.

Eh e no matter the stages paper money don pass, the thing be say people don dy too accustom to this paper money and e go hard to even leave am, because na the one them dey see compare to BTC wey be like audio money until you swap am. So for this one you talk about paper money to fall hands, my brother e go still dy strong for the contri, e no go just easily go like that.
jr. member
Activity: 50
Merit: 7
August 11, 2023, 08:46:52 AM
#26
Ahh.. this one na true talk oo. Even me sef I don imagine BTC as our money .. and e go nice gon.
But the thing be say ignorance wan finish this country. People weh no know plenty, people weh know no dey interested ( maybe until dey don see person cash out from am). To them, e hard to dey monitor Bitcoin market every time and risk dey plenty.

They don't want to be involved in all the stress, they just want to focus on whatever other method apart from BTC there is for earning and investing in.
Another thing is that our people still very much have faith in fiat currency. They either forget( or they don't even know) that money has gone through a lot of stages and has evolved with time. From trade by barter, precious metals,  receipts, fiat money, and bitcoin can be the future of our money system.
Make we just give am time, paper money go fall hands, and our people go begin look for other things weh Dem go fit hold as money. That time, you no go even tell person twice, them go use bitcoin.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
August 01, 2023, 12:38:56 PM
#25
Even though this thing go make plenty brain, I feel say we never reach there. If we wan dey honest with ourselves, plenty people for Nija never see Bitcoin as something wey dey legit and the other big percentage of our people never really hear or know how to use Bitcoin. So, if we go reach this level, it means say our government done come out open with their full chest to support Bitcoin like El Salvador.

My Oga this one go fit happen only if the education concerning Bitcoin don scatter full 70% of the contri people for Naija. But me I still dy reason how e go dey possible like this, because people wey no sabi about Bitcoin full well well. Government self no dy help matter oh.

Quote
Omo this one go sweet o. The kind respect wey this one go give you ehh...them fit dash you one other woman untop as a worthy inlaw.

Why e no go sweet nah, see everybody go stone you plenty respect like say you be one of the ministers for Naija... But no go happy for something wey no be your own oh.😁😁
sr. member
Activity: 322
Merit: 250
August 01, 2023, 06:31:55 AM
#24

Jump to: