Pages:
Author

Topic: Imagine wetin we fit use BITCOIN do - page 2. (Read 427 times)

newbie
Activity: 59
Merit: 0
August 01, 2023, 02:27:58 AM
#23
Bitcoin no be like paper moni wey we go fit carry waka dy do some kind things too. So I con reason am say, what if as we dy find way for Bitcoin to dy acceptable for the world, wait ma use our contri, what if we dy accept Bitcoin for everything we dy do and e con be normal thing like paper moni for this our contri Naija.
I con imagine say we con dy use Bitcoin pay NEPA BILL, HOUSE RENT, TRANSPORT BILL (to pay conductor self) like do many things and the one wey make me talk about this one nah, we as Naija people con dy use Bitcoin dey pay Bride Prize for this contri?

How una see this one, to go marry then use Bitcoin pay the woman papa...

guy with everything u don talk here, abeg make you no go use imagination kill persin oh, becus like this all this things wey you talk just dey make sense anyhow but like this few wey u mention here don already dey happen. But na our learders for naija here no go allow the poor to breathe, because ehh any loop hole wey be say the middle class man wan use survive them go find every means to block am.

No be lie you talk sha, any small loophole weh poor person see take de manage life jeje, the useless govt go wan block am, e sure me say very soon govt go resume de crack down on crypto related stuff again..

As for the bride price matter, some cultures sef no be money dem de collect, so if na btc man get, na to convert am sharperly to fiat take go buy wetin you go use take pay bride price
member
Activity: 784
Merit: 34
SOL.BIOKRIPT.COM
August 01, 2023, 01:52:33 AM
#22
Bitcoin no be like paper moni wey we go fit carry waka dy do some kind things too. So I con reason am say, what if as we dy find way for Bitcoin to dy acceptable for the world, wait ma use our contri, what if we dy accept Bitcoin for everything we dy do and e con be normal thing like paper moni for this our contri Naija.
I con imagine say we con dy use Bitcoin pay NEPA BILL, HOUSE RENT, TRANSPORT BILL (to pay conductor self) like do many things and the one wey make me talk about this one nah, we as Naija people con dy use Bitcoin dey pay Bride Prize for this contri?

How una see this one, to go marry then use Bitcoin pay the woman papa...

guy with everything u don talk here, abeg make you no go use imagination kill persin oh, becus like this all this things wey you talk just dey make sense anyhow but like this few wey u mention here don already dey happen. But na our learders for naija here no go allow the poor to breathe, because ehh any loop hole wey be say the middle class man wan use survive them go find every means to block am.
sr. member
Activity: 546
Merit: 334
July 31, 2023, 03:38:52 PM
#21
Bitcoin no be like paper moni wey we go fit carry waka dy do some kind things too. So I con reason am say, what if as we dy find way for Bitcoin to dy acceptable for the world, wait ma use our contri, what if we dy accept Bitcoin for everything we dy do and e con be normal thing like paper moni for this our contri Naija.

As you talk am now, e dey normal and e go make sense if bitcoin they accepted for naija make i know lie, but wetin you suppose understand be say no forget the kind of country wey you they. I still they repeat am say people wey they this our country, wey know no anything about bitcoin plenty pass us wey know about am, so I they sure say e go dey very hard make we convince millions of people to accept bitcoin.

Quote
I con imagine say we con dy use Bitcoin pay NEPA BILL, HOUSE RENT, TRANSPORT BILL (to pay conductor self) like do many things and the one wey make me talk about this one nah, we as Naija people con dy use Bitcoin dey pay Bride Prize for this contri?

This one they funny pass, e be like say you no Wan travel for this country again na why you they reason to pay drivers in bitcoin. Op dis one go they very hard make i no lie, how you wan do with driver wey no even geh phone or e get phone sef but him know no anything about am.

Quote
How una see this one, to go marry then use Bitcoin pay the woman papa...

dix one wey you talk pass my power, Grin
hero member
Activity: 434
Merit: 500
July 31, 2023, 06:41:38 AM
#20
Bitcoin no be like paper moni wey we go fit carry waka dy do some kind things too. So I con reason am say, what if as we dy find way for Bitcoin to dy acceptable for the world, wait ma use our contri, what if we dy accept Bitcoin for everything we dy do and e con be normal thing like paper moni for this our contri Naija.
I con imagine say we con dy use Bitcoin pay NEPA BILL, HOUSE RENT, TRANSPORT BILL (to pay conductor self) like do many things and the one wey make me talk about this one nah, we as Naija people con dy use Bitcoin dey pay Bride Prize for this contri?

How una see this one, to go marry then use Bitcoin pay the woman papa...
Normal normal e go sweet say we fit do all this things with bitcoin for naija but we still get plenty challenges. See our government, na only God know wen dem go believe bitcoin for this country talk more of say dem wan accept am as an alternative for payment for the country. Even if them accept am i no sure if people go plenty wey go sabi use am and people go de fear to use am because say if dem make mistake con misplace their keys or send money to wrong address dem no go fit lay complain anywhere and their money don go be dat. Plenty people go make dis mistake and e go pain dem if dem loose their money just like that so dem go prefer to de use banks because dem go if complain for bank if anything do their money

Even if dem no de fear to loose their money and dem gree to use bitcoin even as dem no get anywhere to complain in case of any problem i still feel say we get illiterates full ground and some people wey go de think say bitcoin na scam so i feel say e go take time before we gt plenty population wey go accept to use am as money but I know say gradually naija go reach that level wey bitcoin yapa full ground.
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
July 30, 2023, 06:43:55 PM
#19
Bitcoin go online be option to fiat for Nigeria, meaning say between two people wey want do P2P fit carry themselves go corner go arrange the transaction because nothing dey there wey no be understanding. For the pride own wey op dey talk, e still dey possible depending on the amount of bribe but no be like 100 naira wey driver dey give police, even driver wey dey for road and police fit know no stuffs about bitcoin or how to transact with am. The kind bribe wey student dey do for school like sorting go work well because student and lecturer dey likely to know what's up about bitcoin.
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
July 30, 2023, 03:50:22 PM
#18
I con imagine say we con dy use Bitcoin pay NEPA BILL, HOUSE RENT, TRANSPORT BILL (to pay conductor self) like do many things and the one wey make me talk about this one nah, we as Naija people con dy use Bitcoin dey pay Bride Prize for this contri?

How una see this one, to go marry then use Bitcoin pay the woman papa...
Wetin you talk na true. Bitcoin get many use cases for the abroad and we fit still replicate am here for Naija. From everything wey you list, I just want tell you say na only to use Bitcoin pay for transportation like local or inner city transport na that one go hard or dey almost impossible. Imagine say na Lagos, how you wan pay those danfon with Bitcoin.
full member
Activity: 322
Merit: 146
July 30, 2023, 09:52:32 AM
#17
Shey u don explain am finish and e sweet left with d 1 to pay bride price u ask abi? E go stil make sense as long e dey useable and welcomed 4 other exchanges of goods and services.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
July 30, 2023, 04:20:34 AM
#16
I con imagine say we con dy use Bitcoin pay NEPA BILL, HOUSE RENT, TRANSPORT BILL (to pay conductor self) like do many things and the one wey make me talk about this one nah, we as Naija people con dy use Bitcoin dey pay Bride Prize for this contri?

How una see this one, to go marry then use Bitcoin pay the woman papa...
It is possible, but Nigerian government will be an obstacle to that. It is possible now in countries like El Salvador and CAR that have made bitcoin legal tenders. Also there are some countries that are very bitcoin friendly like Slovenia and Switzerland which you can still be able to use bitcoin for some products and services. But Nigeria is not just like those countries. If bitcoin would be used like that in Nigeria, it has to become a legal tender and that is highly likely not possible.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
July 30, 2023, 02:52:43 AM
#15
Omen if we dey accept bitcoin to buy everything e go sweet die. Dat means bank go collapsed be dat oo. Because 90% of di youths go dey use bitcoin dey do their buying things. Many monetary businesses go collapsed and because of dat I sure sae government go accept dat kind thing for we country oo. Oboy u no go fit use bitcoin pay 4 conductor oo. Na for only big big businesses u go fit use bitcoin buy things and no be small small ones. Di part wey dey sweet me for belle na di bride price and NEPA  Grin. And now that things e dey cost bitcoin go do well for payment.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
July 29, 2023, 06:43:17 PM
#14
Me I no fit to advice anybody to collect bride price for anything inline transfer, because as our network be for Nigeria, di money fit to enter pending. Abi you go hold your inlaws ransom until di money enter your account? Or if you allow dem carry your daughter go, what if di money come reverse to Inlaw account? Dat one na one chance, so I go prefer as dem de do am before before, good old fiat currency, I no fit shout. Na on a lighter note my people.

Abi no be your in-law? If the money reverse him go re-send am na abi you dey go pay 1m bride price in cash? Lol you go use online transfer run am.

Bitcoin LN adoption go hard ooo because every business owners will have to create their own lightening nodes or create Channel with existed one.
full member
Activity: 434
Merit: 152
July 29, 2023, 03:49:53 PM
#13
Make we talk true, people fit dey spend bitcoin for other countries, just the way dem dey spend their normal paper money but I just dey reason how that kind thing fit Happen for Nigeria, because people wey no sabi about bitcoin still plenty ooo, see the high level of illiteracy in this country, na just young guys wey dey come up and dem dey educated sabi bitcoin, and some of them go just tell you say dem dey hear about bitcoin but dey no get interest, but some wey get interest self immediately dey hear say na money you go use start am, they go just free am because person wey never see money chop go invest in bitcoin.

I enter some villages for my side, I fit talk say 99% of people wey dey all those villages wey I go no even sabi wetin bitcoin be, dey no even get stable electricity, very poor internet connection, No education, everything wey dem dey do no pass farming, if you tell those people about bitcoin, they go think say you just wan scam them self. Na why I dey reason say e no go easy make we dey use bitcoin for transactions in Nigeria, e fit even dey happen for urban areas, but u see our rural areas, we get work to do for that side.

exactly Many people don't know anything about Bitcoin in our Naija, dey just dey hear the name, but dey don't know knowledge about it, even our government allowed Bitcoin function na only us go benefits Weller, because our elders no get any knowledge about Bitcoin before. even you tell them dey won't have interest on it. and now where everywhere done hot now, know money now everything dey increase price for our Naija everyday. even dey allowed Bitcoin now make him function for our country, he go add for many people to join and invest there money in Bitcoin for long time. because know be all of us go dey patient to invest for long.
hero member
Activity: 812
Merit: 675
July 29, 2023, 11:38:13 AM
#12
All dis your talk na matter of time and if d time reach e go shock you d way everybody go dey use am like normal fiat money. One tin wey I dey confident about na him be say we dey move go digital world daily and in d long run, everything go dey digital and na dat time bitcoin adoption and use go come dey easier for people for Naija.

If you look am now, we get many literate d same way wey we get plenty illiterates too wey no sabi operate even an android device. If we fit close dat big cap and reduce d number of people wey dey illiterate e go go a long way to increase d likelihood of bitcoin adoption.
We wey be bitcoin enthusiasts already go find am easy but we gatz dey patient to understand am too so dat when dat time come e no go dey one sided, like only some few people na him sabi use am for d whole country.
sr. member
Activity: 420
Merit: 273
July 29, 2023, 10:38:57 AM
#11
Bitcoin no be like paper moni wey we go fit carry waka dy do some kind things too. So I con reason am say, what if as we dy find way for Bitcoin to dy acceptable for the world, wait ma use our contri, what if we dy accept Bitcoin for everything we dy do and e con be normal thing like paper moni for this our contri Naija.
I con imagine say we con dy use Bitcoin pay NEPA BILL, HOUSE RENT, TRANSPORT BILL (to pay conductor self) like do many things and the one wey make me talk about this one nah, we as Naija people con dy use Bitcoin dey pay Bride Prize for this contri?

How una see this one, to go marry then use Bitcoin pay the woman papa...

Micropayments using Bitcoin will be feasible only on the Lightning network, which is currently unavailable in most Nigerian towns. Africa free routing is currently operating free Bitcoin LN in various parts of Africa, and they are currently in Lagos.they presently have 390 channels in Africa. It will take some time for LN to get adopted esp here in Africa.

Na true, adoption of di lightening network by especially small business owners for Nigeria, na im be di koko to consider, because of bitcoin high transaction fees. If all things being equal, our government come regulate crypto matter, enof publicity about di use of bitcoin, NEPA come de try, network come de fast, but small business owners come de transact business with bitcoin at a higher cost, den e no go work. So dis LN suppose de available and make e no de so complex to understand by buyers and sellers.

I believe say e de very possible say one day every business for Nigeria, go de make payments with bitcoin, because twenty years ago who fit to believe say we fit to de make payments for goods and services directly from our bank account, with ordinary phone.

Me I no fit to advice anybody to collect bride price for anything inline transfer, because as our network be for Nigeria, di money fit to enter pending. Abi you go hold your inlaws ransom until di money enter your account? Or if you allow dem carry your daughter go, what if di money come reverse to Inlaw account? Dat one na one chance, so I go prefer as dem de do am before before, good old fiat currency, I no fit shout. Na on a lighter note my people.
sr. member
Activity: 490
Merit: 311
Hope Jeremiah 17vs7
July 28, 2023, 10:59:08 PM
#10
Currently, this won't be possible in Nigeria and even when become a legal tender in Nigeria, its won't be feasible for small transactions because of its scaling problem though Lightening Network fix this problem but not completely.
But you should note that Bitcoin was not created to replace a currency but to fix some certain problem and since the scaling problem issues, we just have to use when it is feasible for us.
sr. member
Activity: 462
Merit: 414
July 28, 2023, 05:51:14 PM
#9
Even if Bitcoins become globally accepted, e no go fit dey use in some cases. When person dey hurry, and ihn con rush buy something, na paper dey easy pass. For the case of bride price, for our naija na mere dream as old ones do not know more about it or understand how bitcoins works. We still get long way to go for this Bitcoin matter
Bros na the koko you talk so. Na old people dey collect bride price and e no go fit dey possible for such thing to happen say we go fit use bitcoin for that side. Make OP take note say the people wey dey adamant to accept bitcoin na people wey dey the age of our papa and mama because them believe say anything internet na scam or say them no follow because during their time nothing like this dey. What if you won buy pepper, how you won use bitcoin pay when only transaction fee pass the pepper amount 3X. E get things wey them fit use bitcoin for no be everything. If that time come, I no think say I go fit use my btc o,when I know say the price go still pump. Before that time reach for Nigeria,to buy bitcoin go hard because e go dey expensive.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
July 28, 2023, 05:48:04 PM
#8
Bitcoin no be like paper moni wey we go fit carry waka dy do some kind things too. So I con reason am say, what if as we dy find way for Bitcoin to dy acceptable for the world, wait ma use our contri, what if we dy accept Bitcoin for everything we dy do and e con be normal thing like paper moni for this our contri Naija.
I con imagine say we con dy use Bitcoin pay NEPA BILL, HOUSE RENT, TRANSPORT BILL (to pay conductor self) like do many things and the one wey make me talk about this one nah, we as Naija people con dy use Bitcoin dey pay Bride Prize for this contri?

How una see this one, to go marry then use Bitcoin pay the woman papa...

Micropayments using Bitcoin will be feasible only on the Lightning network, which is currently unavailable in most Nigerian towns. Africa free routing is currently operating free Bitcoin LN in various parts of Africa, and they are currently in Lagos.they presently have 390 channels in Africa. It will take some time for LN to get adopted esp here in Africa.
sr. member
Activity: 588
Merit: 422
July 28, 2023, 05:24:44 PM
#7
Una dy see say nah our old grand grand parents dy collect the bride prize and e go shock una say very soon those set of people no go dy to collect those money again oh, things go change and believe me say with time ones them don make Bitcoin advance like to let am stand fit for our country things wey we no expect go happen but that poor network something wey one of our brother talk nah true, but we fit still do this GS for where network dy friendly. I just get that feeling say this thing fit happen.
member
Activity: 334
Merit: 27
July 28, 2023, 03:30:18 PM
#6
Even if Bitcoins become globally accepted, e no go fit dey use in some cases. When person dey hurry, and ihn con rush buy something, na paper dey easy pass. For the case of bride price, for our naija na mere dream as old ones do not know more about it or understand how bitcoins works. We still get long way to go for this Bitcoin matter
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
July 28, 2023, 11:06:39 AM
#5
In time to come I know bitcoin will scale through lots of places in our country but for now our country isn't that organized or do I say developed to that extent where everyone would starts using it that manner for everything they wanna do, but from my own point what I know would be more better is when we have solid network and stable light because this alone could foster the use of bitcoin.

Why because first for you to do anything bitcoin transactions your phone should at least  be on and have power inside because there are lot of people who could want to pay with bitcoin but if there is power and network failure I don't think such feature would be ideal in our country. As per the bride prize well, our people may not put that in consider as they would want physical cash and not digital or electronical money.
But whatever may the case bitcoin is young and with time we'll all have to use it as the way we uses our fiat without restrictions this could be only if it has been legalized and adopted globally.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
July 28, 2023, 08:48:43 AM
#4
E go make sense o but make you no forget say Naija we country na developing country. No be everybody wey Sabi use technology. E go good say such era go come o but even at then no be still everybody wey go find am very convenient. As you Sabi no be so others dey o. E get some people wey dey struggle to learn technology or to even dey acquainted with modern facilities not to talk of bitcoin technology.

Make I tell you the truth no be every settings wey fit in bitcoin payment for we country. E get some payment wey go just require you dey fast to bring out cash pay den go your way. Those na like the public commuters, old and elderly vendors with no technological knowledge and lots more.  

Another issue na internet connection. We country never really get to the point wey person fit use internet without interruption. Even for cities poor network connection dey talk less the villages them.  For my capital city, I go one hotel go visit my friend wey lodge there the first thing I noticed be say I no fit browse at all. It was very frustrating and the thing vex me be say we dey yet to upgrade for we country. So tell me how the matter wan take go through wey be say na full scale adoption when all these challenges dey ground.
Pages:
Jump to: