Pages:
Author

Topic: Is Dollar The Cause? (Read 487 times)

member
Activity: 378
Merit: 76
Eloncoin.org - Mars, here we come!
May 03, 2024, 05:22:46 PM
#56
Yes dollar has turned everything, like you said earlier a bag of cement used to be 4500 latest#5000 back then but now, is times2 of this amount to be honest,can a bag cement still come back to the normal price or is it still going to increase nawa for this country oo
Funny to see Nigerians blaming the hike in prices of commodities because of dollar. The exchange rate of dollar to the Nigeria currency is quite different and we should always know what's right on our ends. The government are trying their possible best to make things balance but greedy Nigerians doesn't want to give room to development but ready to stock themselves in massive profits and making life hard for the common man.
hero member
Activity: 798
Merit: 669
April 27, 2024, 04:25:24 PM
#55
Dis increment in price sef no be issue of dollar wey rise for the country, wey the matter originate from na from d increment in price of petroleum products. Every of dem, the dollar rise and fuel hike all contribute to the tin but even before dollar go rise, tins don already dey increase for the market. All dis government policies wey no dey favour us come be like say dem no dey look into the tin wella. For a petroleum price increase, every thing wey go involve the use of petroleum to get the goods to their destinations go immediately increase money because of cost of fuel consumption. Person wey dey buy the products to go resell go come add their own money too, na so d price go increase for everywhere.

Even person wey dey buy rice for 1mudu N800 come see say e don reach N1000, if him too get wetin him dey sell and na from their e dey get money to buy the rice, him go add him money too for him products so that him go meet up with the current price of goods for market, na so e dey be dey go. Some increments dem no really get choice but some people dey really take advantage of the tin dey make life worse for people. For such instances, I no dey too gbadu people like that, everywhere don hot for us all, make we dey try check dey look into tins for one another when it come too adding money to your price of goods.
newbie
Activity: 42
Merit: 0
April 27, 2024, 02:06:40 PM
#54
Nigeria is a country that is base on importation we import most of the goods we consume in Nigeria we import machinery also, and so when the dollar rate increases the cost of importing goods also increase there buy making every goods in the country high in price even house rent.
Now the reason house rent will also be affected is because if a landlord depends on his estate for finance in running his day to day activities and the money he gets from rent has been beaten very well by high cost of goods it will lead to increment in rent and also in the cause of running maintenance in the house they buy things which has already been affected by high price this also lead to increment in house rent.
So you see how high rate in dollar also affect house rent in Nigeria.
newbie
Activity: 27
Merit: 1
April 26, 2024, 05:55:01 PM
#53
D way things dey increase for dis contri surprise me well well, e get so many things wey we no suppose mention say na becos dollar don increase nai make.

Make I use this housing as the matter for ground, how piple dey take find house to rent but dem no see the one wey fit their pocket moni abi we go say dollar nai cos that one too? House rent don increase and before you go get house for this contri with this current situation e go hard.
So I dy ask if na becos of say dollar don increase nai make landlords and landladies get mind to increase everything wey concern their house; house rent don go high, agent fee don high, agreement fee don high lawyer fee self don add moni, no be say everything dy the house of toilet fit no make sense and other things wey no good dy the house, wey you fit pay up to 300k...
I dy ask nah Dollar cos this one too bcos plenty piple dy homeless becos them no fit afford wetin house owners dem dy call as price.

Wetin be the main reason for this particular one?

 I greet una oo..Abeg I deh new for here but I wan tell una my own opinion
This issue taya me as e taya anybody for here,d way things deh go yo these days and then go say nah because of dollars I know just know why.
The food aspect nah worst pass,u enter market today, tomorrow go dat same market everything dun increase and the price dun change just like that,and when u go ask one reasonable person,dem go say dollars dun increase oo nah why the price of things kuku increase but I come deh do rough check with myself how this kind thing take deh possible but I get to understand one thing,weh be say transportation nai be one Koko weh deh cause this thing but most people know wan see am like that.

The area weh I deh if I tell u the price of fuel,and dem know get much filling station weh get fuel like that,now as  e be so how do people,market men and women wan take market their goods or do business..so nah why d increase dey come from no be dollar anything.
And another thing I believe be say our money bo too get value again over dollars so nah why wen the dollars deh increase e deh worry our naira  deh make am deh depreciate as e be fiat money,so this one go urge us to put ourind for crypto currency Wella cause nah dat one be the way for now.
Nah so I see this thing oo
sr. member
Activity: 490
Merit: 308
April 26, 2024, 04:40:40 PM
#52
Upon say the dollar wey piple dy cry for don take style drop small, things no dy as if something happen to the dollar, today we go see dollar to naira at #1260 the next day e go be #1500, like wetin dey happen?
Prices of things no dy affected by this dollar matter as e dy vime down I no go lie. I still dy talk am say until fuel price drop to either #300 or #400 I no sure say prices of goods go drop. All these things dy make the common man to mind how him dy spend and piple no fit chop wetin go give them blood becos things dy high, I no know who go solve this problem for us like this...our government no follow at all.

Na waiting I dey reason be that know be dollar price they make things dey increase price because when dollar decrease to 1,100# still nothing drop he still dey as he be so they go get another issue where dy affect our foodstuffs that is making it to increase price is not dollar anymore. And I believe the your matter if know be say fuel reduced price I know dey show say things for market go decrease, our government just dey chop money dey go he know care about the youth since he be boss now nothing dey fit do am he will do what he like, na only God go only make price of goods drop down for this our country because if we say na government go decrease the stuff he go hard. How am seeing this government he know even shake body to solve the problems of increase price in the country he just stay with is family they enjoy without funding to solutions to make things good.
Omo the way this country dey now everyone don already tire for the country matter and na why most person sef no dey fit complain again. Dollar or no Dollar the problem if this country is still rooted at the top because if there is solid foundation at the top it will definitely reflect on the bottom too but since the top men dem just dey like people wey no send na so the matter sef be for people down infact this problem of Nigeria na virus and I bet you say e don actually affect every Nigerian staying in this country.
full member
Activity: 420
Merit: 152
April 26, 2024, 02:29:05 PM
#51
Upon say the dollar wey piple dy cry for don take style drop small, things no dy as if something happen to the dollar, today we go see dollar to naira at #1260 the next day e go be #1500, like wetin dey happen?
Prices of things no dy affected by this dollar matter as e dy vime down I no go lie. I still dy talk am say until fuel price drop to either #300 or #400 I no sure say prices of goods go drop. All these things dy make the common man to mind how him dy spend and piple no fit chop wetin go give them blood becos things dy high, I no know who go solve this problem for us like this...our government no follow at all.

Na waiting I dey reason be that know be dollar price they make things dey increase price because when dollar decrease to 1,100# still nothing drop he still dey as he be so they go get another issue where dy affect our foodstuffs that is making it to increase price is not dollar anymore. And I believe the your matter if know be say fuel reduced price I know dey show say things for market go decrease, our government just dey chop money dey go he know care about the youth since he be boss now nothing dey fit do am he will do what he like, na only God go only make price of goods drop down for this our country because if we say na government go decrease the stuff he go hard. How am seeing this government he know even shake body to solve the problems of increase price in the country he just stay with is family they enjoy without funding to solutions to make things good.
newbie
Activity: 7
Merit: 0
April 26, 2024, 09:02:46 AM
#50
Yes dollar has turned everything, like you said earlier a bag of cement used to be 4500 latest#5000 back then but now, is times2 of this amount to be honest,can a bag cement still come back to the normal price or is it still going to increase nawa for this country oo
brand new
Activity: 0
Merit: 0
April 26, 2024, 05:07:49 AM
#49
One thing we need to understand about the hike in prices in our country is that its cuts across all sectors, both feeding, commodities, housing, services rendered by skills men and transportation. The reason is that no service provider is autonomous, it still needs the other sectors to balance its activities and as such adjusts itself to meet with the pressure coming from other services that are provided to it and still make a living.

Take for example, the housing which is the bone of convention here, you pay rent to the landlord and that same landlord uses the funds to buy foodstuffs at the market which is very costly, he uses it to fuel his car with the hike in price there, used the same money to service his car, buy spare parts if necessary,  used the same funds to pay for his children school fees which almost every school increased their fees from last year.

 Basically the cost of living is high recently and every service provider has adjusted the pricing of their services to meet with the standards of living. I have some friends in the hardware repairs sector who didn't increase the pricing of their services, they always complained of the economy and running into loses instead of gains. I advised two of them on the negative effect of not increasing the prices because they're afraid to lose customers, but instead increase the prices accordingly and explain to the clients why its so. They took my advice and they're doing fine now.

Landlords and landlady are not to be blame for de high cost of rent neither is dollar the cost but rather the present economy situation.The country has being facing economy recession which has affected the cost of everything.
member
Activity: 153
Merit: 14
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
April 26, 2024, 04:43:59 AM
#48
D way things dey increase for dis contri surprise me well well, e get so many things wey we no suppose mention say na becos dollar don increase nai make.

Make I use this housing as the matter for ground, how piple dey take find house to rent but dem no see the one wey fit their pocket moni abi we go say dollar nai cos that one too? House rent don increase and before you go get house for this contri with this current situation e go hard.
So I dy ask if na becos of say dollar don increase nai make landlords and landladies get mind to increase everything wey concern their house; house rent don go high, agent fee don high, agreement fee don high lawyer fee self don add moni, no be say everything dy the house of toilet fit no make sense and other things wey no good dy the house, wey you fit pay up to 300k...
I dy ask nah Dollar cos this one too bcos plenty piple dy homeless becos them no fit afford wetin house owners dem dy call as price.

Wetin be the main reason for this particular one?
One thing wey me I see say na him dey cause all this increments of house rent and other stuff na the yahoo boys no be only Dollar wey make things they costly reach this extend because for my place now yahoo boys don make everything go high like mad just ordinary jeans wey will being dey always buy 5k now if you no hole 20k you no go fit buy am again wey be say the time wey them never come my place things just dey normal for everybody, but now people wey no get work dey find things difficult to pay house rent.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
April 25, 2024, 06:05:28 PM
#47
Upon say the dollar wey piple dy cry for don take style drop small, things no dy as if something happen to the dollar, today we go see dollar to naira at #1260 the next day e go be #1500, like wetin dey happen?
Prices of things no dy affected by this dollar matter as e dy vime down I no go lie. I still dy talk am say until fuel price drop to either #300 or #400 I no sure say prices of goods go drop. All these things dy make the common man to mind how him dy spend and piple no fit chop wetin go give them blood becos things dy high, I no know who go solve this problem for us like this...our government no follow at all.
full member
Activity: 392
Merit: 185
Play Bitcoin PVP Prediction Game
April 25, 2024, 05:23:43 PM
#46
D way things dey increase for dis contri surprise me well well, e get so many things wey we no suppose mention say na becos dollar don increase nai make.

Make I use this housing as the matter for ground, how piple dey take find house to rent but dem no see the one wey fit their pocket moni abi we go say dollar nai cos that one too? House rent don increase and before you go get house for this contri with this current situation e go hard.
So I dy ask if na becos of say dollar don increase nai make landlords and landladies get mind to increase everything wey concern their house; house rent don go high, agent fee don high, agreement fee don high lawyer fee self don add moni, no be say everything dy the house of toilet fit no make sense and other things wey no good dy the house, wey you fit pay up to 300k...
I dy ask nah Dollar cos this one too bcos plenty piple dy homeless becos them no fit afford wetin house owners dem dy call as price.

Wetin be the main reason for this particular one?

The thing is that dollar affected many things but Nigerians are increasing some goods extravagantly on their own, we know about building materials being costly be some of them are been imported into the country by the use of dollar for either purchase or import duty payment but one thing we should know for sure is that nigerians traders are another problem that we have in Nigeria, once there is a market speculation or any little hike in fuel price, they will just decide to increase even their old stocks without considering that even though the increase in it time 5 the government will still afford it but the common people will be meant to suffer for know reason.
The house you mentioned is because the government fail to do the right thing, in the land act government owns all the land, if they decide to solve housing deficit it won't take them anything, people are using the excuse that dollar is high to perpetrate evil just becsue the government decides not to monitor what is hppening in the system, if the government owns enough house i dont think all this fees and continuous hike of rent will be in existence, our problem is the government failure in all aspects.
full member
Activity: 1134
Merit: 154
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
April 25, 2024, 03:39:50 AM
#45
D way things dey increase for dis contri surprise me well well, e get so many things wey we no suppose mention say na becos dollar don increase nai make.

Make I use this housing as the matter for ground, how piple dey take find house to rent but dem no see the one wey fit their pocket moni abi we go say dollar nai cos that one too? House rent don increase and before you go get house for this contri with this current situation e go hard.
So I dy ask if na becos of say dollar don increase nai make landlords and landladies get mind to increase everything wey concern their house; house rent don go high, agent fee don high, agreement fee don high lawyer fee self don add moni, no be say everything dy the house of toilet fit no make sense and other things wey no good dy the house, wey you fit pay up to 300k...
I dy ask nah Dollar cos this one too bcos plenty piple dy homeless becos them no fit afford wetin house owners dem dy call as price.

Wetin be the main reason for this particular one?

Dollar no be the cause of anything wey dey happen for this country, anything wey dey happen for this country na we and the government dey do am, just imagine how things dey cause now, meanwhile dollar don come down well well o, yet the price of things still dey high, we just dey add price for things we dey sell just to take advantage of people knowing fully well say na suffer dem dey suffer us, even the government them self, to create job opportunities self na war, even some people wey still dey work office work or dey work for government, to pay them dem better salary na still big wahala for them, with all this how dollar be the cause rather for me I see dollar as the solution to the our current economic pressure self, because assuming say dollar dey high and things dey cost like this, person like me no go too reason am self, we dey country where God don bless yet we dey just dey suffer ourselves dey blame dollar.
full member
Activity: 182
Merit: 152
Never give up
April 20, 2024, 06:47:52 AM
#44
Make I use this housing as the matter for ground, how piple dey take find house to rent but dem no see the one wey fit their pocket moni abi we go say dollar nai cos that one too? House rent don increase and before you go get house for this contri with this current situation e go hard.

House matta pass dollars own but make you know say dollars dey affect everything for the country because we dey use dollars import fuel and na fuel dey control our movement through transportation and the rest. Dollar dey affect all our importation and the things wey we dey use build houses are mostly imported so dollars dey affect house but apart from the house na agents follow for this high costs of house. Make we first talk about landlords dem wey no dey Nigeria and dem dey hand over the house give house management companies, dem go come add their own price and plenty charges so dem for fit chop and the the landlord wey dey the country come dey see wetin people dey willing to pay for the other houses go come increase their own and from their houses around that area go come dey cost carelessly.
Housing mats is bigger than most things in Nigeria, in some places you can't afford the necessary bills for a comfortable environment because of how costly they are, I can recall when I wanted to reside in Lagos state because of some business movement so I have to pay for a house 1 year rent but I couldn't find any comfortable environment so I now have to rent a batcher house for over 150 thousand naira plus and agent fees is not included, no water and its also a public bathroom. I just have to pay because I have no other options. Landlords are also making things worse because if one do does not have a place we're he can put his/her head after every movement he made the person will not be okay. Housing is the first thing that one can have and stay comfortable before thinking of what will bring money to them. I have seen some people that have were to go and start working but they don't have house to stay there because of how costly rents are, and they can't afford they money as well (how can a House rent be bigger than ones 2 months salary?)
Quote
Yahoo boys/fraudsters follow too because those one dey rush house like water and dey willing to pay any amount which also motivate the other landlord to increase their own house rent to fit cash out too.
You are correct, and I don't think they only spoiled house rent's, other things are also involved, now one can not go to a boutique with 100k and buy up to 5 fine cloths and shorts. While I was growing up, I can remember when my uncle gave me 6500 naira to buy Christmas clothes, the money was very enough for me to buy everything I want but now 6500 can't afford 5 boxers  Grin , however I think the reasons why they are spending the way they do is because they didn't suffer to get the money.
Quote
Quote
I dy ask nah Dollar cos this one too bcos plenty piple dy homeless becos them no fit afford wetin house owners dem dy call as price.

We no dey homeless here oh, go America or other Western world and you go see wetin dem dey call homeless. House cost everywhere normally, e get people wey dey pay our yearly fee as monthly house rent like for American, Europe so no too complain but I dey understand because the house rent matters just come from no where and na agents we go blame mostly for that one because when we been just dey meet the landlord directly, house no been cost like this but since agents done enter na so everything begin they increase.
Housing is cost in most countries as their currency is already bigger than our own, people's yearly salary is just 2 or 3 months house rent. Some of our country people that travels to those countries don't stay alone, they pair with other people so that they can be able to afford the bills there. Over here in Nigeria we are leaving a free life as many of us are not paying taxes.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
April 20, 2024, 06:13:53 AM
#43
Make I use this housing as the matter for ground, how piple dey take find house to rent but dem no see the one wey fit their pocket moni abi we go say dollar nai cos that one too? House rent don increase and before you go get house for this contri with this current situation e go hard.

House matta pass dollars own but make you know say dollars dey affect everything for the country because we dey use dollars import fuel and na fuel dey control our movement through transportation and the rest. Dollar dey affect all our importation and the things wey we dey use build houses are mostly imported so dollars dey affect house but apart from the house na agents follow for this high costs of house. Make we first talk about landlords dem wey no dey Nigeria and dem dey hand over the house give house management companies, dem go come add their own price and plenty charges so dem for fit chop and the the landlord wey dey the country come dey see wetin people dey willing to pay for the other houses go come increase their own and from their houses around that area go come dey cost carelessly.

Yahoo boys/fraudsters follow too because those one dey rush house like water and dey willing to pay any amount which also motivate the other landlord to increase their own house rent to fit cash out too.

Quote
I dy ask nah Dollar cos this one too bcos plenty piple dy homeless becos them no fit afford wetin house owners dem dy call as price.

We no dey homeless here oh, go America or other Western world and you go see wetin dem dey call homeless. House cost everywhere normally, e get people wey dey pay our yearly fee as monthly house rent like for American, Europe so no too complain but I dey understand because the house rent matters just come from no where and na agents we go blame mostly for that one because when we been just dey meet the landlord directly, house no been cost like this but since agents done enter na so everything begin they increase.
newbie
Activity: 22
Merit: 0
April 20, 2024, 06:03:32 AM
#42
D way things dey increase for dis contri surprise me well well, e get so many things wey we no suppose mention say na becos dollar don increase nai make.

Make I use this housing as the matter for ground, how piple dey take find house to rent but dem no see the one wey fit their pocket moni abi we go say dollar nai cos that one too? House rent don increase and before you go get house for this contri with this current situation e go hard.
So I dy ask if na becos of say dollar don increase nai make landlords and landladies get mind to increase everything wey concern their house; house rent don go high, age
nt fee don high, agreement fee don high lawyer fee self don add moni, no be say everything dy the house of toilet fit no make sense and other things wey no good dy the house, wey you fit pay up to 300k...
I dy ask nah Dollar cos this one too bcos plenty piple dy homeless becos them no fit afford wetin house owners dem dy call as price.

Wetin be the main reason for this particular one?


It is not the fault of those landlord and they are not to be blame it is de economy of the country that cause it..if u evaluate the cost of building a house in 2020 and now u will notice that there has been a drastic increase in building.Just imagine u HV a house for rentage and that is ur source of income ,prices of commodity has gone up in de market, transportation, school fees and every other things including cement.will HV de mind to be renting out ur house at a lower?. Don't forget that it is de money u realised from this rentage that u will use in paying ur Ward fees, feeding , transportation, rice and every other need.so see that u don't HV to blame landlord for the high cost of rentage.
full member
Activity: 294
Merit: 229
Let love lead
April 20, 2024, 03:19:02 AM
#41
One thing we need to understand about the hike in prices in our country is that its cuts across all sectors, both feeding, commodities, housing, services rendered by skills men and transportation. The reason is that no service provider is autonomous, it still needs the other sectors to balance its activities and as such adjusts itself to meet with the pressure coming from other services that are provided to it and still make a living.

Take for example, the housing which is the bone of convention here, you pay rent to the landlord and that same landlord uses the funds to buy foodstuffs at the market which is very costly, he uses it to fuel his car with the hike in price there, used the same money to service his car, buy spare parts if necessary,  used the same funds to pay for his children school fees which almost every school increased their fees from last year.

 Basically the cost of living is high recently and every service provider has adjusted the pricing of their services to meet with the standards of living. I have some friends in the hardware repairs sector who didn't increase the pricing of their services, they always complained of the economy and running into loses instead of gains. I advised two of them on the negative effect of not increasing the prices because they're afraid to lose customers, but instead increase the prices accordingly and explain to the clients why its so. They took my advice and they're doing fine now.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
April 19, 2024, 07:07:57 PM
#40
Onto dis dollar mata I hear for radio say market piple don dey complain say things no still dey normal as dollar wey plenty plenty piple dey tok say e don com down but things still dey high say make government do something, say dis one don dey hunt even dem for market.
So as e be so where we wan put hand bcos everybody dey take dis dollar mata dey play and now e don dy wori everybody, if dem say dollar don reach #700, materials for building and oda market things and chop chop things go come back as normal?
One man say if dem no sell as dem tak buy am say na dem go lose so how dis one wan be for us?
hero member
Activity: 2478
Merit: 621
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
April 16, 2024, 05:25:02 AM
#39

Wetin be the main reason for this particular one?

Na inflation problem no be dollar. The government go try put hand take draw the price of fuel down. Na the price of transportation wey go make commodities wey dey for local consumption go down. Even when importers carry market come like building materials, custom dey charge no be small plus other costs wey you go run for corrupt offices before dem go gree release your market no be small money. To clear 40ft container now I hear say na around 14/15 million and so naturally dem go add am inside the products wey dem go sell. So before we go begin feel the impact of the current reduced exchange rate, the government go put hand for petroleum products and na that one go drop transportation cost wey local people go know and feel before dem too go drop price.
jr. member
Activity: 70
Merit: 3
April 16, 2024, 03:52:55 AM
#38
You do well, Lizzy to drop this kind thread. But first first make we know sey like this eh, no be everything wey go wey na dollar cause am. You dey get? I no dey talk sey dollar no dey affect everywhere o. Because when dollar go up, everything go follow because most raw material prices them dey very very tied to the exchange market. But our lovely Naija na place where anybody fit do anything. 😂To me, e no get any reason why egg go add price na. Wetin fowl dey chop?
Why garri go dey cost? Cassava, na we get am, wetin be the thing?
Even if a certain area, dollar no really affect, as the business owner see sey everything don dey cost, en go feel say he gats increase him own price to match.
Dollar na one reason for price increments, then there's fuel too. We know seyif fuel go up, we go hear sey pure water na 100, 150 per satchet😂
Well as e take concern the rent matter, make we understand sey first first, new building dey cost to rent, two, the maintainance and cost of the building too dey affect rent. As price of materials dey high for market, na so the maintenance too go cost and the landlords too they wan see their money , e suppose highif dollar high, but na the intensity of the highness na I'm be the thing. Some landlords fit dey inconsiderate for how them dey raise am
Another thing wey dey make house cost na the location.
If the house dey sited for well developed area, normal, e gats high but knack am that one, knack am fuel, knack am dollar, you go understand. But the funny thing there be say even if dollar fall, naira go up, we know the country, majority of these things no go drop price.
If you dey live for portHarcout, you go see am, even for the whole country.
Family loaf was about 350, 300, and dollar was less than 500 naira,about 300 there about. Oya dollar rise rise rise till before we know, fuel add ihim own, the bread reach 1k, now, e dey 2k. 300 naira bread o. Oya imagine house na. You get?
Sometimes even if the factor wey dey make things cost comot, these people no go gree drop price.
So, yes, dollar dey affect price. When you purchase materials at a certain price, then fuel high, transportation go high too, so when you produce the finished product, e gats high too.
member
Activity: 378
Merit: 76
Eloncoin.org - Mars, here we come!
April 16, 2024, 02:31:27 AM
#37
For me one of the things wey dey follow cause this slow reduction of price of things sef na the issue sef say Nigeria as a whole no really get this body of price regulation and control for the country and na why the cost of things dey go up anyhow anytime as if the country itself no really get government because I believe there ought to be some kind of body wey for dey in charge of regulating all these things.
The prices of goods go continue to increase based on Nigerians, them say dollar high na why things high well well, but now dollar don fall, why the prices of things never drop? This question de very concerning. If you ask them now, them go talk say na old stocks de available. Na we dey use our hand spoil the affairs of the country. Perhaps the government have failed us, that's all I could possibly say about the current status of the country. Make we just get better chance move from this country because to solve the problem wey de ground go really take enough time than possible. The country, we know say things no de organized at all, everything just de up side down.
Pages:
Jump to: