Pages:
Author

Topic: Is Dollar The Cause? - page 3. (Read 614 times)

member
Activity: 66
Merit: 5
Eloncoin.org - Mars, here we come!
April 10, 2024, 05:35:07 PM
#16
The inflation dey affect everything including house rent. Don't be surprised as things will keep increasing to some extent before it will make a price correct then inflation go drop small. As it stands now the people wey get house (landlords and landladies) dem too dey the country so things don dey tight for them and most na the house rent be their salaries and investments so if things hard them go add money to the house in order for them too to survive.

Just as we took dey experience the situation of things them too dey experience am, so the circle of things continues. The way I dey see the suffer self fit never end now oo because everything dey go in circle, if this one increase the other one go increase too and so on. It takes only Gods grace to revive the country because the law of gravity no dey function for Nigeria economy, as things go up e don remain there for life.
Make we no feel say na wickedness this landlords and landladies dey do but make we see am as the cause of inflation or hard economy.
sr. member
Activity: 476
Merit: 230
God is All
April 10, 2024, 04:23:25 PM
#15
The price of things for the country don increase and wetin really cause this increment na fuel subsidy removal and the rise of dollar. We been dey battle with the fuel subsidy removal before dollar come join body with the problem wey dey on ground already.

Me I no too blame landlord wey increase rent, when landlord go market to go buy goods or foodstuffs dem don add price, landlord enter bus or keke dem don add price, landlord fall sick go hospital, medical bills also don increase. Him house too na business so wetin you expect? That being said, some of dem dey very wicked.
Omo I dey surprised when you talk about increment of house rent because na watin dey like this wey dey happen for ma side. The funny thing be say you no fit even blame them sef as you talk am because the whole matter just dey revolve around this whole increment if foodstuffs and other commodities like gadgets and accessories. The naira dey gain on dollar well well but the cost of things still dey high it's just so crazy that things dey skyrocket so easily but to come down na big indian film.
sr. member
Activity: 602
Merit: 291
Bitcoin in Niger State💯
April 10, 2024, 04:00:41 PM
#14
D way things dey increase for dis contri surprise me well well, e get so many things wey we no suppose mention say na becos dollar don increase nai make.

Make I use this housing as the matter for ground, how piple dey take find house to rent but dem no see the one wey fit their pocket moni abi we go say dollar nai cos that one too? House rent don increase and before you go get house for this contri with this current situation e go hard.
So I dy ask if na becos of say dollar don increase nai make landlords and landladies get mind to increase everything wey concern their house; house rent don go high, agent fee don high, agreement fee don high lawyer fee self don add moni, no be say everything dy the house of toilet fit no make sense and other things wey no good dy the house, wey you fit pay up to 300k...
I dy ask nah Dollar cos this one too bcos plenty piple dy homeless becos them no fit afford wetin house owners dem dy call as price.

Wetin be the main reason for this particular one?

I dey reason say, the house rent aspect wey you talk about dey go too far, because at least to build house, you go need blocks, cement, and other building materials, some of dem fit dey import or get connection with exports, wey fit be one of the reasons why house rent dey cost pass before.

But that by the way, you go wan discuss things like rice, local rice, paddy rice wey we dey buy for our local markets, and you dey wonder why these items dey very expensive, and you fit hear common marketer talk say, dollar don rise, and na why their own products too dey cost pass. You go begin wonder how dollar take affect product wey dey inside the state, no be even across states or the whole nation, but just within one state, but e don affect am, but dollar na just one factor.

The second one na fuel. Fuel don dey one of the major determinants for market. Plenty things dey cost now because of fuel hike, so e make sense if marketer or seller mention fuel as their main reason why things dey cost, I fit understand, but when person dey talk about dollar rise, when all the production and value chain dey inside the state, na then you go ask why e cost because of dollar.
hero member
Activity: 1162
Merit: 643
BTC, a coin of today and tomorrow.
April 10, 2024, 02:27:25 PM
#13
Is Dollar The Cause?
As you use pidgin create this topic, you for also try make the title to be pidgin. Something like this for make more sense. Na dollar cause am?

But that one na by the way. To chuk mouth for the matter you raise, Nigeria na country where everybody dey do wetin dem like. Some people dey abuse opportunities we surface and many other people wicked. Some landlords wey don build house more than 10yrs ago don break even for the house (as in dem don collect money tire), but still dem high rent price anyhow. I no actually blame people wey build recently because price of things done high high for market. Nigerians too dey take small advantage to suffocate their fellow Nigerians.
sr. member
Activity: 756
Merit: 454
April 10, 2024, 01:26:58 PM
#12
The price of things for the country don increase and wetin really cause this increment na fuel subsidy removal and the rise of dollar. We been dey battle with the fuel subsidy removal before dollar come join body with the problem wey dey on ground already.

Me I no too blame landlord wey increase rent, when landlord go market to go buy goods or foodstuffs dem don add price, landlord enter bus or keke dem don add price, landlord fall sick go hospital, medical bills also don increase. Him house too na business so wetin you expect? That being said, some of dem dey very wicked.

My broda na over do dey worry some piple for this contri, wetin concern fuel and house rent? Unless them wan renovate am oh. This subsidy removal suppose affect moto piple, goods but e no suppose affect reach landlord their side. Na house human being go stay oh so wetin d contri give us e affect us so make them no take am too personal.
So you say if landlord spend like 250k for hospital bill the next day him go increase house rent becos him wan gain back? no nah e no suppose be so. Me I still dy talk am say wen dis fuel matter come back to normal things go set well and dollar no go do anything about am, abi na today we start to hear say dollar high but we still dy live ok, make the fuel fit go back to the main price or even lesser changes go dy.
sr. member
Activity: 742
Merit: 349
April 10, 2024, 12:52:39 PM
#11
D way things dey increase for dis contri surprise me well well, e get so many things wey we no suppose mention say na becos dollar don increase nai make.

Make I use this housing as the matter for ground, how piple dey take find house to rent but dem no see the one wey fit their pocket moni abi we go say dollar nai cos that one too? House rent don increase and before you go get house for this contri with this current situation e go hard.
So I dy ask if na becos of say dollar don increase nai make landlords and landladies get mind to increase everything wey concern their house; house rent don go high, agent fee don high, agreement fee don high lawyer fee self don add moni, no be say everything dy the house of toilet fit no make sense and other things wey no good dy the house, wey you fit pay up to 300k...
I dy ask nah Dollar cos this one too bcos plenty piple dy homeless becos them no fit afford wetin house owners dem dy call as price.

Wetin be the main reason for this particular one?

Any time wey be say we Dey talk about thiings wey Dey rise we suppose remember say na Naija we Dey, in Nigeria both living non living things price Dey rise, nothing wey dollar no Dey affect for Naija, even electricity for Naija dollar Dey affect because if you look at light for Naija this days he no Dey too stay, I don’t know for your area but for my area even electricity don matter don tired us, and about the house rent my brother, house rent suppose rise up too because building material price too get money, even cement now to buy am no be joke.

But the price of dollar Dey decrease everyday and i no see any changes for up to now , na the matter sef Dey pain me pass, dollar price don decrease to the extent wey be say many people wey buy dollar keep now Dey regret but things no still come down, that thing don already Dey Nigeria body, because nothing in Nigeria that the price go up and later come down that even the poor people can afford it.
sr. member
Activity: 602
Merit: 260
April 10, 2024, 12:45:57 PM
#10

The funny thing is that the price of dollar dun drop recently but things just Still dey increase like mad. Normally as dollar come decrease now things suppose to still calm down . But things just still remain the way dey still dey even dey worst the more , the thing is that most people are taken  dollar increment of back then as an opportunity to make more profits , just imagine person wey nor even know the price if dollars go dey tell you say dollar dun rise because dey hear am from other marketers mouth.

Now I even prefer then where Dollar even dey 1600/1$ , because despite things dey expensive we wey dey earn in dollars anytime we still make small thing from things space wey go give some dolls , if you run p2p you go see the kind nice thing wey go come out. Something wey go out smile for person face . But now dollar rate around 1144/1$ and things still damn expensive  Undecided
sr. member
Activity: 602
Merit: 306
April 10, 2024, 10:28:26 AM
#9
D way things dey increase for dis contri surprise me well well, e get so many things wey we no suppose mention say na becos dollar don increase nai make.

Make I use this housing as the matter for ground, how piple dey take find house to rent but dem no see the one wey fit their pocket moni abi we go say dollar nai cos that one too? House rent don increase and before you go get house for this contri with this current situation e go hard.
So I dy ask if na becos of say dollar don increase nai make landlords and landladies get mind to increase everything wey concern their house; house rent don go high, agent fee don high, agreement fee don high lawyer fee self don add moni, no be say everything dy the house of toilet fit no make sense and other things wey no good dy the house, wey you fit pay up to 300k...
I dy ask nah Dollar cos this one too bcos plenty piple dy homeless becos them no fit afford wetin house owners dem dy call as price.

Wetin be the main reason for this particular one?

The matter don tired everybody, we no understand where we are heading to at all. We know say dollar price dey affect everything for this naija but no be the way everyone dey put the matter for head, any small thing everybody dey increase the price of their goods, you no fit buy something today and expect to see am buy at the same price tomorrow. You forget say na small opportunity everybody dey look for now to make money, you even dey talk about house rent, but i don't know how dollar price take affect the water wey we dey drink. When dey started subsidy matter common pure no get money reach like this, but as dollar come join am we start to dey see different shege.

Since we started to dey complain about dollar price, the price has reduced to 1000 naira now, did you see any changes for your side. No be today dollar price started to dey come down and nothing gree reduce for this country. The matter go touch everybody even though you dey earn in dollar the products we are buying too dey expensive. People wey dey shout that time say try dey earn in dollar don finally calm. Grin
sr. member
Activity: 658
Merit: 441
April 10, 2024, 09:50:23 AM
#8
The price of things for the country don increase and wetin really cause this increment na fuel subsidy removal and the rise of dollar. We been dey battle with the fuel subsidy removal before dollar come join body with the problem wey dey on ground already.

Me I no too blame landlord wey increase rent, when landlord go market to go buy goods or foodstuffs dem don add price, landlord enter bus or keke dem don add price, landlord fall sick go hospital, medical bills also don increase. Him house too na business so wetin you expect? That being said, some of dem dey very wicked.
hero member
Activity: 896
Merit: 654
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
April 10, 2024, 09:04:56 AM
#7
-snip-
Wetin be the main reason for this particular one?
This one shoke everybody, my brother, I was pondering about the whole situation a few hours ago, I don't just understand, especially the manner in which the Naira has risen but the inflation refuses to subside. Fine, at the start of this whole thing, the forex played a major role in this hyperinflation and economic woe since we are a consuming nation but the fact remains that our people aggravated it unnecessarily. Every sector of the economy started using the inflation excuse to increase prices. No one in the business can be exonerated from this, be it the manufacturers, the wholesalers down the retailers. They were just driving the market as if it is their birthright and the government is just clueless about the whole situation. They are never prepared for anything.

What I expected to be strongly affected by the FX-made inflation are the imported goods and services, while the locally made goods and rendered services should increase a little bit. But Nigerians used that opportunity to earn more which triggered the hyperinflation. And since there is no viable competition due to the border closure and the discouragement caused by the low naira value, it continues unabated. I wonder if the pepper sellers sort for FX as well to sow and harvest it to the point that N200 now was the value sold for about N50 in less than a year. Sugar moved up by about x10 in 3 years. These are abominations and can only happen in Nigeria.

Now, about the housing, we can't entirely blame the landlords but they contributed as well. The high cost of building materials should be considered also. However, the wickedness here is that the house that was built 5-10 years ago without any renovation is reflecting the inflation to the point that the house of N250,000 a few years back is now about $750,000. All these are too much and show the wickedness of Nigerians. Nigerians are all just selfish and the blame is not on FX and the government alone but on everybody.
full member
Activity: 1414
Merit: 236
Catalog Websites
April 10, 2024, 08:10:11 AM
#6
No forget say landlords dey use cement to build d house and d chemicals dey are using to miss other things dat will bring out d cement, is b imported from other country which it will involve dollar before raw materials can b import to Nigeria before people will use it to make blocks landlords and landlady's are using to build houses all over d country.

 Nor b say I dey happy for Wetin dey happen for our country, and d reason why all those things dey happen b say our government is not ready to put an end to it in the country because dey have d power to force manufacturers and wholesalers to do d right thing, before dey will see another side of d government.

 Look at d sallah celebration dat is going on in d country today, and many Muslims that wish to celebrate d sallah in a bigger way but d high cost of living is not allow dem to celebrate it d way dey want it
sr. member
Activity: 392
Merit: 277
April 10, 2024, 07:35:17 AM
#5
One of the main reason why you see this increase in amount you pay for house is because of the 10% agent fee what that's a function of how much a particular house cost. Most agent will go to the extent of telling landlords and house owners to increase the price of thier house just so the amount they will take as agent fee will increase. I have witness different cases when some agent will even advice house owners to remove old tenant from thier houses after the first year and then do smal renovation and take in new tenant so the rent can be increased and others fees can still be collected from tenant. This country is just somehow and most of the things we are complaining about, we are the primary causes of them all but we won't be plain to tell ourselves the truth.

Another factor is that in some areas, all the self contain have same price and once a particular landlord increase his rent, the next person will also increase his rent and chain continies like that putting tenant in a tight corner. To rent house. Ow is one of the most deficult thing to easily go about now and untill you decide to relocate into a new apartment you won't know what's up with house issue
sr. member
Activity: 546
Merit: 265
April 10, 2024, 07:20:27 AM
#4
This is just one advantage real estate investments has over economy situations. In anyway, the real estate investments would always protect its interests in relative to the economy situations but one thing is sure that they would never count losts unless either properties damages.

OP, if you are so anxious about the case of high cost of rent in relative with the dollar, the property owners can actually defend itself by also pointing that the dollar value to say.... The cost of materials used in building and maintaining the houses has also gone hike so in anyways they would need to increase the cost so they can also secure some profits and I bet you can not argue to that because it is obvious that everything in cost has increased too expensive.

But without being in support to say it is also with the increase of the dollar then I would say it is as a fact of inflation where everyone is fighting out to survive with the current economy that is the cause of such house renting and its related real estate businesses.

Business strategies of making profits is considering the economy rate and also the rate  of demands. Actually the high cost of house rent can not also be compromised to this strategy.
sr. member
Activity: 756
Merit: 454
April 10, 2024, 07:14:02 AM
#3
Dollar no only affect some areas leave some if we check am very well as dollar rate they high nah so the price of things way them they import they also increase, on the other hand the price of transportation they also increase, cost of building materials for those way they build and renovate newly go know say eh don double some self don triple, a carton of tiles way be say before I buy 4500 naira currently now no they below N6,000 the price of things increase all round.

I agree with you oh becos e affect everywhere but for this house own, you talk about to build say the materials go dy costly I agree, what about house wey dem don build since before all these high rate of dollar matter come to play, dem still dy high the price as if them wan renovate the whole compound. My broda piple wicked oh, something wey no get to do with high rate of dollar dem go say nah Dollar nai make, so we no go rent house again nah if so.

Quote
If nah new building or the ones way them just renovate eh they understandable say the landlord or landlady they use base on the cost way him or her carry build the house to increase him own rent, but for those people way be say them don already build and people still they inside yet them they increase the rent inside house way u already they inside and him no they spend any penny to renovate am that one nah their own concern, you fit say nah wickedness but if we look am from another side we go know say that rent also they like their income and as where you they earn from they carry feed family, as price of things increase you also need look for means to meet with the demand of things so eh fit be their reason to increase the rent.

Na true sometimes landlord them dy use becos if one person or two persons wey wan enter the compound take increase things make e be say them gain more and na so some piple wey see say e hard to get house outside na to stay endure am since them no get choice again. Anything wey make person leave em current place of stay say na new place him dy find na big wahala for spending.
hero member
Activity: 798
Merit: 702
April 10, 2024, 06:58:37 AM
#2
Dollar no only affect some areas leave some if we check am very well as dollar rate they high nah so the price of things way them they import they also increase, on the other hand the price of transportation they also increase, cost of building materials for those way they build and renovate newly go know say eh don double some self don triple, a carton of tiles way be say before I buy 4500 naira currently now no they below N6,000 the price of things increase all round.

If nah new building or the ones way them just renovate eh they understandable say the landlord or landlady they use base on the cost way him or her carry build the house to increase him own rent, but for those people way be say them don already build and people still they inside yet them they increase the rent inside house way u already they inside and him no they spend any penny to renovate am that one nah their own concern, you fit say nah wickedness but if we look am from another side we go know say that rent also they like their income and as where you they earn from they carry feed family, as price of things increase you also need look for means to meet with the demand of things so eh fit be their reason to increase the rent.
sr. member
Activity: 756
Merit: 454
April 10, 2024, 06:48:24 AM
#1

Jump to: