Anyhow wey e b make we talk tins wey we don achieve since wey we join de forum no matter how little wey the achievement be becos na from small something dey take dey big and any little tin wey person achieve for him life make him dey grateful and thankful and hope say in go achieve greater results for future. At dis juncture, I rest my case.
i still remember when I become jnr member for the forum, e sweet me wetin no good oh, and seeing how far I have gone now de give me joy on a regular.
E make sense to celebrate yourself for any new rank when you enter my man, no be small feet when e de take oh, for person like me when no too sabi stuff about the crypto industry and had to combine learning some basics to using the small sense when God give me, na big feet I done accomplish like this oh, at some point you go de fear make them no burst your account and at some point e go appear as though you are stagnant and that nothing Id happening at alland after sometimes you go just see love coming from different angles.
Make I first rank up first na then I go pour out my own episode.
My brother, no be only you oo, on my own part, I no ever believe say I go fit reach full member in the space of 1 year, talkless of achieving it in five months, though to tell you the truth, I really dy grateful to my oga in this forum, na him just dy push me, make I post, even though to me, e too hard, and e dy very stressful to me then, him go dy say, bro, you don dy into cryptocurrency for some time now, so I believe say l, this forum no go too hard you like that, because you get the knowledge already, and sincerely speaking, na him I dedicate this achievement to, for pushing me this far and hard, I just no wan mention him name, but him know himself, na him I dedicate this achievement to.
So along the line, the job come be like normal thing, sometimes before him call me I don drop seven or eight post already, so in essence of wetin I dy talk is that I just thank God for using my oga to push me this far, and now I am a full member, something wey I no ever expect to achieve this year, even when I look at my post count, I still dy surprise say na me post all this post, me wey to post before them have to push me to do so, but see me now, na me dy even call my oga dy ask am if him don post today? I just thank God for my achieve this year in the forum.