Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 137. (Read 1024792 times)

sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Theymos dey plan to talk to our leaders about the Board Creation. Na weti I see wey I dey sleep. So, I Dey believe say positive result go come out soon. Brainboss, Smartvirus, Igehh and others leaders make una ready well for us

May it be so o. Because this matter don tie wrapper come wear singlet on top face cap since last year reach now. Maybe na you go be our prophet here now if he thing happen quick quick.

All the money wey dem dey gather in the name of form, na money wey dem go use package their all the election runs, na osusu dem dey gather like this.

You get the whole plan, true true. Na real osusu o. This people don take us play well well like say we no know anything again. Country deh burn fire but them deh contribute that type of cash to buy form for election while universities are on strike. Chris Ngige failed woefully as labour and employment minister.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
... but people are buying N100m forms to govern a broke country.
You suppose dun know the matter say this thing na politics. Some people wey dey buy the form sef nor get the money, but them dey gather am round from people, some of them sef know say dem nor go fit win, but sake of say, for anybody wey buy the form, compensation go dey las las maybe in the form of political appointment, nai make people dey buy so.

All the money wey dem dey gather in the name of form, na money wey dem go use package their all the election runs, na osusu dem dey gather like this.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Theymos dey plan to talk to our leaders about the Board Creation. Na weti I see wey I dey sleep. So, I Dey believe say positive result go come out soon. Brainboss, Smartvirus, Igehh and others leaders make una ready well for us
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛

My point is, are you buying dipper or taking a loss in order to enjoy your life?

Me: I sold my ADA at a loss to enjoy life because it's been a difficult year!!
Baba you go feel bad about selling your ADA in loss o in few months to come when everything stew again. Na so we deh see this type of thing, no be today e deh happen. I still deh hold. I no want to sell now.

It's crypto, sometimes you take at loss, not every project will give you profit, you just have to know when to puff it off and when not to, I can assure you that selling my ADA at -20% loss was the best thing I ever did, ADA is a 5-10 years project which I won't advice anybody looking for a short term project to invest it.
hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
Toh ASUU don officially renew their strike bundle to original 12 weeks dem say the committee wey government put together never call dem even for once for meeting since February. Another thing wey dey pay them again be say politicians dey spend hundreds of millions for next forms and other things like say Na biscuit dem dey buy, and none of them don put mouth for any wey concern public universities. Dem fashe everything like say so dey exist for Naija again.
Personally for me ba this thing reach man make he cry. Imagine people wey suppose dey represent us dey carry us play ludo.

So my people how una take see this ASUU strike renewal

Make Nigeria Students body go close all the private Universities. So that the Politicians pickins sef no go go school. Nai be the best way. When the private Universities edon close. Den go answer ASUU. If not Politicians now dey concern only for their next year election.
Me and you no say students no get that kind mind to join body to close private universities for naija here, you wam make them kill all of them pretend like say no body die? Even if them even protest self for government to close all private universities for this country e no go affect politician children because most of them no dey allow their children to go school here so na people wey no dey go private university go always dey suffer this nonsense called strike for naija here.
member
Activity: 742
Merit: 30
Toh ASUU don officially renew their strike bundle to original 12 weeks dem say the committee wey government put together never call dem even for once for meeting since February. Another thing wey dey pay them again be say politicians dey spend hundreds of millions for next forms and other things like say Na biscuit dem dey buy, and none of them don put mouth for any wey concern public universities. Dem fashe everything like say so dey exist for Naija again.
Personally for me ba this thing reach man make he cry. Imagine people wey suppose dey represent us dey carry us play ludo.

So my people how una take see this ASUU strike renewal
This strike matter self they vex me, person no fit plan the exact years wey him go spend for university again, ASUU go add their own, and after we finally succeeded them go come talk say if you don pass 25 years make u no apply for job with your first degree, how they want make this country take better? Na them keep us for school above the years way we suppose spend and when we manage Wan see work, them go begin they talk say we don old. Na WA for this country oo, because this ASUU issue them fit just handle am for one week but na how their pukeet go take full them they hustle.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Toh ASUU don officially renew their strike bundle to original 12 weeks dem say the committee wey government put together never call dem even for once for meeting since February. Another thing wey dey pay them again be say politicians dey spend hundreds of millions for next forms and other things like say Na biscuit dem dey buy, and none of them don put mouth for any wey concern public universities. Dem fashe everything like say so dey exist for Naija again.
Personally for me ba this thing reach man make he cry. Imagine people wey suppose dey represent us dey carry us play ludo.

So my people how una take see this ASUU strike renewal

Make Nigeria Students body go close all the private Universities. So that the Politicians pickins sef no go go school. Nai be the best way. When the private Universities edon close. Den go answer ASUU. If not Politicians now dey concern only for their next year election.
newbie
Activity: 99
Merit: 0
Toh ASUU don officially renew their strike bundle to original 12 weeks dem say the committee wey government put together never call dem even for once for meeting since February. Another thing wey dey pay them again be say politicians dey spend hundreds of millions for next forms and other things like say Na biscuit dem dey buy, and none of them don put mouth for any wey concern public universities. Dem fashe everything like say so dey exist for Naija again.
Personally for me ba this thing reach man make he cry. Imagine people wey suppose dey represent us dey carry us play ludo.

So my people how una take see this ASUU strike renewal
newbie
Activity: 27
Merit: 4
Username: Sacrod
Gender: Female
State of resident: Kwara
Skills: Data analysis using STATA and SPSS

I just joined the forum last week, na person hint me sey make I scroll down, I go see this part of the forum where I fit relate with my country people. I never sabi plenty things as per JJC wey I be, but I dey ready to learn from people wey get experience pass me here. I'm happy to be here.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Our airline's operations don threaten sae d wan go on strike, Nigerian government don responded to them under a week.

The leaders of tomorrow don d at home for months, the Nigerian government d drag their feet, d campaign for election, the raise funds for presidential tickets.
 
Make una see how speedily them responded to airlines, they no d joke with their comfort at all. After now, person go talk sae this government mean well for us. Shey una don see where we land ourselves
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Is Nigeria now up for sale? Raising up to 3billon and above just for APC Presidential ticket within short period whereby Asuu d on strike up till now. If you hear the dollars these presidential candidate
of APC going up and down the country sharing to party members, delegates, traditional rulers, etc, you will feel sorry for this our dear nation called Nigeria. Yet our government d talk sae our country d broke but people are buying N100m forms to govern a broke country.
I dey hear say asuu strike go end tomorrow. I dey wait to see wetin dey sup for that side. The presidential ticket na one issue we need to tackle the money too big shuu 100 million naira for presidental form. Why them no go tiff money? Anybody wey fit pull that kind money for form go don borrow part of the funds from one or two people, promises go don dey ground nai dey make wen this people enter office them dey wan loot
ASUU is only ending warning strike today. Na warning strike ASUU d since ooohh. The real strike never commence sef. Na indefinite strike ASUU wan enter be so after today if the federal government no adhere to their agreement.
Nigerian leaders have failed us woefully, they have no regard for the educational system.
Nigeria is a failed state. Poor us that we find ourselves in this type of leader that has no tangible thing to offer to her youths other than siphoning money from all sectors
hero member
Activity: 1288
Merit: 504

I dey hear say asuu strike go end tomorrow. I dey wait to see wetin dey sup for that side. The presidential ticket na one issue we need to tackle the money too big shuu 100 million naira for presidental form. Why them no go tiff money? Anybody wey fit pull that kind money for form go don borrow part of the funds from one or two people, promises go don dey ground nai dey make wen this people enter office them dey wan loot
I follow hear the rumour but make we wait till tomorrow or this week to find out wetin deh sup. I asked myself when them come resolve the fight and why the press no deh there. Why e come be say na only rumour. Make we talk true self, if ASUU call off the strike now wetin be their achievement as nothing change abi some of their members don take bribe to compromise the struggle. No be small time again them go begin another strike. This matter as e don reach now suppose be once and for all.
Omo eh, this ASUU strike matters eh, e need be legit matters o via say, student dem don dey old for house I tell you. Some students cef don run commot for house to go short down for them student environment or house make them dey get the feeling say them dey school. Unfortunately, no be every body dey feel am so, then big belle men dem for the office no fit reason am and these ASUU people too like to rock this boat. E dey scratch for ear!

Meanwhile, the 100M way dey go via ticket them, na to tell you say, average man no fit come out las las for the presidential ticket o. This one no be quality by 40years of age again. Na quality by 100M above with plenty godfathers for your back. Las las, person way do business dey make profit, the profit must come after election. I go soon start learn Chinese.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co

I dey hear say asuu strike go end tomorrow. I dey wait to see wetin dey sup for that side. The presidential ticket na one issue we need to tackle the money too big shuu 100 million naira for presidental form. Why them no go tiff money? Anybody wey fit pull that kind money for form go don borrow part of the funds from one or two people, promises go don dey ground nai dey make wen this people enter office them dey wan loot

I follow hear the rumour but make we wait till tomorrow or this week to find out wetin deh sup. I asked myself when them come resolve the fight and why the press no deh there. Why e come be say na only rumour. Make we talk true self, if ASUU call off the strike now wetin be their achievement as nothing change abi some of their members don take bribe to compromise the struggle. No be small time again them go begin another strike. This matter as e don reach now suppose be once and for all.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Concerning the rumors of the strike, firstly we have to understand that Asuu is not on any social media handle. So, I don't know how the news came about. We have to understand that we are living in a country where the government has little or no concern for it's citizens, and we have seen that the Minister of Education bought a presidential ticket worth 100million naira while it's university are currently shutdown due to lack of funds to pay lectuers. So nothing can amaze me in this country and I really hope that Crypto-currency will be a gateway for many Nigerians to survive especially the youths.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
Is Nigeria now up for sale? Raising up to 3billon and above just for APC Presidential ticket within short period whereby Asuu d on strike up till now. If you hear the dollars these presidential candidate of APC going up and down the country sharing to party members, delegates, traditional rulers, etc, you will feel sorry for this our dear nation called Nigeria. Yet our government d talk sae our country d broke but people are buying N100m forms to govern a broke country.
I dey hear say asuu strike go end tomorrow. I dey wait to see wetin dey sup for that side. The presidential ticket na one issue we need to tackle the money too big shuu 100 million naira for presidental form. Why them no go tiff money? Anybody wey fit pull that kind money for form go don borrow part of the funds from one or two people, promises go don dey ground nai dey make wen this people enter office them dey wan loot
member
Activity: 742
Merit: 30
Topic: Old Nigeria Currencies Till date
This one na job weldone Cookdata, you take your time and arrange all those currencies wey person never even see before, na to just they here there names from our grand parents say they once exist. The way them tell us say the value with other European countries currencies na almost the same, but look now how our money don lose value completely, and I am sure these value way our money lose we ko fit get am back.
Na before we get leaders not now, all those once wey they lead now just use our head ne, the just they find way to make their family in good condition.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Topic: Old Nigeria Currencies Till date
Wehdone Cookdata for your efforts to put this topic together. I no get smerits, so I just drop the only one I get. The efforts wey you put to make this kind post for we local board, I like am.

Wise men understand everything British people do us;
1. Dem give us another version of Education
2. Dem give us another version of Christianity
3. Even when we use their pounds the value differ, so them give us another version of money.
Na true say dem develop us but still still dem exploit us join.

For me, the coin I don use buy groundnut, banana chewing gum, abiola milk na 50 kobo. I no witness the other currencies like Shilling and penny.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Is Nigeria now up for sale? Raising up to 3billon and above just for APC Presidential ticket within short period whereby Asuu d on strike up till now. If you hear the dollars these presidential candidate of APC going up and down the country sharing to party members, delegates, traditional rulers, etc, you will feel sorry for this our dear nation called Nigeria. Yet our government d talk sae our country d broke but people are buying N100m forms to govern a broke country.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Topic: Old Nigeria Currencies Till date

After our Independency, the west Africa old notes were removed form circulation and our first coins and bank notes were created , much didn't change till now except for the coins that were withdrawn from circulation and changes  in some of Nigeria Bank notes from paper to polymer(#5,#10, #20 and #50). I didn't include the New notes because everyone here should be familiar with the polymer currencies and there is much difference between the old and the New, its just the texture designed and size. The Nigeria coins were discarded and withdrwans because they lack value, they couldn't buy anything in the society due to inflation just like the way #5 is no longer doing anything good in circulation.

You don prove your name say you know how to cook data well well. Nice one baba. You do your research well. But I also know say there was a time when Central Bank of Nigeria bring back coins in the early 90s. I know of the N1 coin. Na paper note before government turn am to note. The thing heavy for pocket no be small and I believe say na wetin make the thing no last because people no deh like accept am. Na so the thing go they make noise for pocket if you carry am deh run as small pikin that time. Government quickly withdraw am.
member
Activity: 74
Merit: 18
Username: Proro
Gender: Male
State of resident: Delta (Warri)
Skills: graphic designing and printing

Area! I greet the house, I just dey see sey we sit-down for dis region and I happy sey we self still dey here. Make God bless the senior men Dem wen give us chance make we fit relate with our own people in our own language for here. I hail ooooo.

Welcome my brother. Hope you no follow for printers weh deh fall hand. Una too like to fall hand. If printers and tailors never fall your hand you no go sabi wetin tension be. Make I reason am say your own go deh different, abi no be so? As you land here make sure to read all the readables unto rules and laws guiding this forum so that nothing go stain you. No copy people work and claim am like your own. People full here weh go find out no matter how long weh it takes. No threaten anybody life here even when them irritate you. Just move and leave the matter. The laws plenty, take time read them all and be safe.
Another matter to add be say mk him the try make better thread/post wey mk sense for head and  no go around the beg beg for merit oh, dis forum no dey like am.

Just do your best and leave d rest to baba God.
Bros I grab way thing u talk,  I go try do my research well make I fit make quality post bcos na quality post they give quality merit as I don see with my small experience here. And I thank everybody for the warm welcome when them give me, I don see am say there is really no place like home.
Jump to: