Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 140. (Read 1024977 times)

hero member
Activity: 1498
Merit: 702

I joined the forum 3 months ago but I didn't find out about this part of the forum until yesterday, when I checked and saw that there is a group for Nigerians, the joy I felt within me ehn, omo no be small. After going through the group, read some comments, I felt at home here and I'm ready to learn from others (especially the higher rank members), make friend and contribute to the forum at large.
I welcome you to dis forum my broda, I believe say you don check out many things for the forum especially the rule wey concern forum and plenty board pinned messages. This na Naija board, wey we all dey gather to see how we go uphold Naija name for this forum.
Personally, I believe say your stay here go make sense, no fail to ask questions na why we all dey here for eachother
hero member
Activity: 616
Merit: 713
casinosblockchain.io
Username: Bamjos
Gender: Male
State of resident: Oyo (but presently in Akwa-ibom)
Skills: Graphic designing, Electrical Layout design (using AutoCAD)

I joined the forum 3 months ago but I didn't find out about this part of the forum until yesterday, when I checked and saw that there is a group for Nigerians, the joy I felt within me ehn, omo no be small. After going through the group, read some comments, I felt at home here and I'm ready to learn from others (especially the higher rank members), make friend and contribute to the forum at large.

my broda e no easy at all and no be small tin, na so e do me too.
anyway nice to have you onboard. no reason me at all i just dey sleep anyhow for this forum onto say pesin wey put me true no show me much love to understand many tin for the industry until i found here. like this i don get small roots onto say my pipo dey here and i feel very secured around here.

welcome again!
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
Nigeria need adopt bitcoin and they need to do am fast.
If we are to be honest with ourselves do you see that happening in the forseeable future? With what is actually happening on ground, such as: Nigeria has placed a ban on crypto (yeah, i know it it not a thorough ban), but a ban of any sort shows unreceptiveness to the network, again we have gone on to launch a CBDC (E-naira) that is regulated by the Central Bank of Nigeria, the handwriting is somewhat clear on the wall, and it is that this present administration doesn't want to have anything to do with decentralized digital currencies (as far as making it a legal tender is concerned).

Having said that, i would also like to bring another dimension to the discussion, our Nigerian Naira is losing value everyday as a result of inflation, the government would be seeking ways to improve the economy of the country which will reflect on the value of the Nigerian Naira, if we are to be honest with ourselves, Making Bitcoin a Legal Tender will not help that cause, instead it will further dampen it by bringing an alternative legal currency; because AFAIK Bitcoin can't help the general economy of a country. Do you really think with what is happening on ground in Nigeria what we need is Bitcoin adoption? If you ask me i think what we need first of all is a viable/stable currency/economy.
member
Activity: 71
Merit: 22
Username: Bamjos
Gender: Male
State of resident: Oyo (but presently in Akwa-ibom)
Skills: Graphic designing, Electrical Layout design (using AutoCAD)

I joined the forum 3 months ago but I didn't find out about this part of the forum until yesterday, when I checked and saw that there is a group for Nigerians, the joy I felt within me ehn, omo no be small.

Na so the joy deh big for body once you locate your own people. I feel you. Welcome, na correct chairman you be. After we go talk about the groundnuts and chinchin weh you carry enter house. Make I quickestly drop this one for you. Abeg whatever thing weh you deh do for this forum make you try to deh maintain law and order. No copy person post or article without acknowledging say na them get am. Na big offence for here o. We deh call am plagiarism, and na ban offence e bi o.

Big man! E no go spoil for una (kòní bàjé fún e), I no fit thank you enough for this advise, I no go fall your hand, I go make sure sey I dey follow the rules like sey I dey follow my dreams Cheesy.

Concerning the groundnut and chinchin, na una wey don tay for forum suppose do party for we JJC wey just join now Wink. So, I go dey wait for my fresher's package ooo Grin
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Username: Bamjos
Gender: Male
State of resident: Oyo (but presently in Akwa-ibom)
Skills: Graphic designing, Electrical Layout design (using AutoCAD)

I joined the forum 3 months ago but I didn't find out about this part of the forum until yesterday, when I checked and saw that there is a group for Nigerians, the joy I felt within me ehn, omo no be small.

Na so the joy deh big for body once you locate your own people. I feel you. Welcome, na correct chairman you be. After we go talk about the groundnuts and chinchin weh you carry enter house. Make I quickestly drop this one for you. Abeg whatever thing weh you deh do for this forum make you try to deh maintain law and order. No copy person post or article without acknowledging say na them get am. Na big offence for here o. We deh call am plagiarism, and na ban offence e bi o.
member
Activity: 71
Merit: 22
Username: Bamjos
Gender: Male
State of resident: Oyo (but presently in Akwa-ibom)
Skills: Graphic designing, Electrical Layout design (using AutoCAD)

I joined the forum 3 months ago but I didn't find out about this part of the forum until yesterday, when I checked and saw that there is a group for Nigerians, the joy I felt within me ehn, omo no be small. After going through the group, read some comments, I felt at home here and I'm ready to learn from others (especially the higher rank members), make friend and contribute to the forum at large.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Brainboss, tankiu for relating this CAR bitcoin adoption news to our ogbonge Naija.
And Wiwo, you don try as you to talk on the matter and state what you understood. You talk say u decide not to dey chuck mouth for Naija political matter because people no dey believe you and because of sentiments. Baba, you no dey correct here, you no go fit separate sentiments and politics or because we no believe you then you no go dey update us again.

But for this crypto adoption mata, make una no vex for me if I talk my mind, me I be realist and I dey talk something as I perceive it.
See upon say crypto no legalise for Naija, but the level wey G-guys and government join dey use crypto, dey alarming and damaging.
If you mistakenly legalise crypto, Nigerian will be number one crime centre of the whole world. Infact the country fit no dey governable again.
So, as no body legalise it, boys still no get restriction to use it.
So, wetin I dey clamour for na, make law enforcement people no dey intimate and extort people wey dey use crypto. Make dem allow anybody wey sabi way to follow. But for now make dem avoid  to make public announcement for crypto adoption, make we see whether the country go normalise small after 2023 before dem go announcement the informate.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Normally I no Dey like long talk, I no Dey like over do things, but baba I no understand Wetin you Dey reason, and I go give my two cent again, Newbies it is not possible for senior members to keep watch on your posts and carry out daily forum activities, this whole thing is simple, go in search of that senior members you fancy, seek knowledge and you would find it, a prevented mistake is better than curing an already made one. I am really glad this forum is growing and it’s all your for the taking and if you don’t or are shy to approach you can read up post made by senior members understand them be sure to to plagiarize them, build out of the raw material available to you.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
News reaching out today be sae the Central African Republic don adopted bitcoin as legal tender, em do become the second country in the world to do so behind El Salvador.

Firstly I go like congratulate our brother for that side for taking this bold steps. Nigeria just dey disappoint me, abi dem no understand the power of first mover advantage. We for dun seized this opportunity use bring attention to the county. Already company dey run away from nigeria to other African countries and if we no do something fast we fit lose our stand as the Africa giant.

We get plenty start up wey dey look for country wey dey friendly to the industry to based and this go definitely bring job opportunities and revenue. Also this go bring about enlightenment to the country and this now all Nigeria dey miss by not been friendly to the industry. With all this hostility to the industry in the country by law enforcement agency and government yet we still dey on top now imagine there was some friendly to the industry, just imagine where we for dey. Nigeria need adopt bitcoin and they need to do am fast.
Brainboss make I let you know something, the country go make sense very soon as I done write for here before after 2023 9ja go adopt crypto currency, I know wan mentioned why due to say I don make up my mind say I no go talk anything related to 9ja politics why because most of us our mind dey over clouded by sentiments were make us make we no see good for some candidate since them no from our political affiliation or party. But the look be say after this 2023 election things go balance and we go reclaim our position as the African giant and hubs for innovation and start up, and of the key factor for development na development of the small and medium sized enterprises (SMEs) and the present government try in that direction but since na office of the Vice President dey handle that matter their power dey limited for now but in 2024 and beyond that sector go receive presidential attention because the right person go don dey on seat. All those businesses were relocated from Nigeria go failback asap.
Make we no give up hope dey change dey come waiten we done see na lesson for us now we done wise up and me dey very sure say 9ja go adopt crypto currency in fact we done adopt am already the only thing be say na informal adoption since we're be say na we the citizens do e adopt crypto for now but very soon crypto adoption for 9ja go get constitutional backing.
I Greet una this morning from FCT.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
News reaching out today be sae the Central African Republic don adopted bitcoin as legal tender, em do become the second country in the world to do so behind El Salvador.

Firstly I go like congratulate our brother for that side for taking this bold steps. Nigeria just dey disappoint me, abi dem no understand the power of first mover advantage. We for dun seized this opportunity use bring attention to the county. Already company dey run away from nigeria to other African countries and if we no do something fast we fit lose our stand as the Africa giant.

We get plenty start up wey dey look for country wey dey friendly to the industry to based and this go definitely bring job opportunities and revenue. Also this go bring about enlightenment to the country and this now all Nigeria dey miss by not been friendly to the industry. With all this hostility to the industry in the country by law enforcement agency and government yet we still dey on top now imagine there was some friendly to the industry, just imagine where we for dey. Nigeria need adopt bitcoin and they need to do am fast.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I know say, I never sabi many things for the forum but  on the follow up matter, I dey try put head make things for clear for me.
If e get one thing way I don observe for forum, once you fit follow rules and avoid those things way be say forum no gbadu but them allow, then you fit survive here for long. You break one, na either ban or na tagging straight up and men dey to serve am for you 2sec.

Another thing to know be say, forum na something way dey grow with person. The more you dey come the forum, dey follow up on watin dey sup for the forum, na so the forum go dey follow you go too, e go dey enter you like say na AZ you lightup.

On the entitlement matter, e get some men way be say eh... them know or get idea say, this thing, na so e be but still, them go want make you tell them. I no know I'd e get impression way them wan give person say, e dey try and I fit tell them now say, e no still matter. If you know say, na so this way be, follow or short down. No stress person. E get why follow no dey run referrer package!

Las las, person way wan learn something, e dey seek the thing out and when the responses no be as you expect, learn by looking. The way apprentice for barbershop dey do. View other people post history, see how them dey write and coordinate there doings, emulate am and one day, e go sure for you. Na the idea!
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Sometimes I dey reason am say when me go grow for the industry.
Lol

Why not. E go happen as long as you continue to deh contribute constructive posts here. It can take a long time but e go happen one day. See me weh don deh here since 2017 and still deh Full member but I no shake. I go rank up one day and that one I sure of.

I just Dey read a post where someone they ask old members to day monitor newbies post, Omo this one na real entitlement speech, na you be the Newbie na you need guidance I think e Dey proper to find a mentor infact beg the mentor, ask for way in other to make better posting and so on, na you go they pursue am because it is beneficial for you, but you one wait make people they monitor your work for free

Baba no go think am like that. I sure say no be like that the writer mean am. Maybe wetin him mean be say make those of us weh don deh here before him to deh put one eye for posts of our own newbies so that if we see where them fumble we go alert them to correct themselves. And no be say make we deh roam the forum for them.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
Make we sef try understand say anything you dey do no forget wetin carry you come here, the signature campaign na just one shengele area of the forum nor carry all your mind put for there. If signature campaign end today wetin you don learn from this place where go fit help you for outside. Information dey here, people ready to answer your questions anytime you post am. The problem wey newbies dey face na say them no even dey practice wetin them dey read some nor even get any crypto for their wallet. Them dey hope to earn their first crypto from bounty or campaign.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Pls I get something to yarn, and the thing don Dey occur to much. Firstly I go like make every newbie know something there is nothing like entitlement here, directly or indirectly, that why if any newbies fall short of a rule they still pay for it, I just Dey read a post where someone they ask old members to day monitor newbies post, Omo this one na real entitlement speech, na you be the Newbie na you need guidance I think e Dey proper to find a mentor infact beg the mentor, ask for way in other to make better posting and so on, na you go they pursue am because it is beneficial for you, but you one wait make people they monitor your work for free, Omo come on. Pls stop the Newbie entitlement. We get many friendly guys way if you want make them mentor you they would do that whole heartedly.
True talk, nothing dey difficult for the forum. Na some people dey use their hand difficult things. Any person wey carry mind put for money no go carry head come down. All the senior men for here dey ready to help. No be only here, for anywhere for this forum.
E get wan adage wey talk say, person wey dey drown for water dey raise hand up make people no think say him dey swim.
BIT-BENDER don talkam, and I summarise say na person wey dey sick dey find doctor, no be the reverse.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Pls I get something to yarn, and the thing don Dey occur to much. Firstly I go like make every newbie know something there is nothing like entitlement here, directly or indirectly, that why if any newbies fall short of a rule they still pay for it, I just Dey read a post where someone they ask old members to day monitor newbies post, Omo this one na real entitlement speech, na you be the Newbie na you need guidance I think e Dey proper to find a mentor infact beg the mentor, ask for way in other to make better posting and so on, na you go they pursue am because it is beneficial for you, but you one wait make people they monitor your work for free, Omo come on. Pls stop the Newbie entitlement. We get many friendly guys way if you want make them mentor you they would do that whole heartedly.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
casinosblockchain.io
Person no supposed reason that kind tin for here na,no be say na meeting wey pipo go dey see you face to face

Na parable I throw there with that shyness thing. No be that kind of shyness weh deh happen when people see face to face. The shyness for the matter na the type of shying away from issues to avoid wetin people go talk. No be everybody deh like put mouth for talk because them no want make others bully them online. Na that type of shyness I deh talk about.

Okay no issues, anyhow all way na way so e better say make them relate so that from there too we wey never stand we'll go see tins begin to take correction because we no go wait make something happen to anyone here weh be newbie before we go learn at least make we learn before e go happened.

Sometimes I dey reason am say when me go grow for the industry.
Lol
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Person no supposed reason that kind tin for here na,no be say na meeting wey pipo go dey see you face to face

Na parable I throw there with that shyness thing. No be that kind of shyness weh deh happen when people see face to face. The shyness for the matter na the type of shying away from issues to avoid wetin people go talk. No be everybody deh like put mouth for talk because them no want make others bully them online. Na that type of shyness I deh talk about.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
casinosblockchain.io
You forget say no be everybody like to deh ask questions for public especially when them no even know how to take arrange mouth ask am so that people no go laugh them. Alot of new users for this place go get this type of problem. Na shyness deh disturb them, oga.
Anybody wey dey feel like that for here suppose drop that kind mindset. The man Koko why we get local thread na make we dey communicate in a way we do normally for day to day activities. Ask the question anyhow wey you fit and I sure say person go answer you for here.

If your shyness too much, you fit PM person for guidance too.

Person no supposed reason that kind tin for here na,no be say na meeting wey pipo go dey see you face to face naimake them bring chat for easiest communication but as e be say them no fit open dia heart to chat here na when we go call general meeting wey dem go fit talk or expressed dia selves? The tin na capital "NO". So any how make we try relate small, so shyness no fit limit us abi dem dey also shy inside room  Roll Eyes?
Una sabi the matter and I come in peace ✌️
hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
If your shyness too much, you fit PM person for guidance too.
No reason am abeg, na made up excuse, which kind shyness be that one?
Anybody dey see person face for here?
If person go shy reach that level, why the person no go shy to open thread for other parts of the forum. Why the person go dey reply threads?
Nobody dey shy here, na to develop confidence be the koko.

Secondly be say una wey don tee for here make una dey help us observe threads of newbies wey come from we country well well as una they read to help alarm and correct errors earlier wey them fit make..
This your talk no go well atol. How you go expect established members to dey roam about for forum dey observe thread wey newbies post, then dem go use juju know say the newbie na Nigerian and finally give corrections when the deed has already been done. Imagine say na the only duty old members has to do.
Abeg, the best approach na to direct every newbie wey be Nigerian to this locals we dey.
No be lie every newbie suppose know about this place and no be the work of senior men (old members) to dey waka dey  monitor wia newbie wey be naija person post anything. For example when I been enter forum, na this place I fumble and BrainBoss put me true sharp sharp, some senor men here also advice me say make I put eye for ground dey read back wetin other people dom post so that I go sabi wetin I dey do. I dey follow up and I obey that simple instruction, I never get wahala anywhere and I no go get. Make other newbies dem put eyes for ground,make dem no dey in a hurry even if water finish for tank e never finish for ground.

Jump to: