Buhari as a person meant very well for Nigeria
I no gree this one at all. Shebi we saw how he started in 2015, at least before he got that sick. Which better thing weh him do to talk say him na better person? He immediately started by marginalizing the zones weh no vote for am. Abeg, Buhari na the problem of this country. He does not forgive, and he can defend anything north against any region and na wetin we deh see now.
2. Obi na one candidate wey never get stain of corruption for him body yet to Nigeria politics. If him be president e for make sense sha.
3. PDP dey want make Obi become running mate to Atiku again for this election and Obi no gree.
4. Obi never announce him new party yet, but him no get chances for Labour Party. If him wan be serious contender, make em consider NNPP, Kwankwaso go help him pull force for North.
Everything weh you talk here make sense well to me. And na better decision Peter Obi take by dumping PDP. Na jackals full there like them deh for APC. Na politicians for those two major parties keep this 9ja for this mess weh we deh.
You know why you no believe wetin I talk about Buhari say him initially get Nigeria for good mind? Because you sabi the politics wey play Buhari down.
You know why you believe say wetin I talk about Peter Obi dey correct because you sabi Peter Obi and you love him too.
Make I SHOCK you full time!
Even if Peter Obi succeed become Nigerian President, he will change NOTHING. Absolutely, he cannot do anything.
Make I clear you full time, Nigeria problem just be like a computer system. Even if the CPU good and the monitor no good, the computer no good, even if the monitor good but keyboard no good, the computer still bad.
If Obi becomes president, he will first fight the canals and defeat before he could apply his policies. But I bet you he will not win the cabals.
Well, the cut the story short, the only thing wet go correct this abnormalities, na #Ends EndSars Pro or Restructuring. Unless Obi go enter today and quickly restructure the government. But if you continue with the faulty foundation, men go loot you reach your dinning table.