I understand say we dun get plenty new members of recent and just looking at how una dey composed una post I understand say una never get everything sorted out. Well no look down on yourselves because some of us take us some months to understand how things dey work here and then we no get anybody to guide us but now una get us. I wan make we comot mind small for any other stuff and talk about self development.
Use this opportunity ask questions, on how to run things like writing formats etc, if you get any other challenge, no fear talk am here and we go try give you direct information on how to go about am and no be just generalized information wey no get any direction. Use this opportunity use understand the forum better and abeg if you no get idea about any questions asked just observe instead of misleading.
Thank you my Oga at the top, i beliv say wit una tins go pure for us wey be JJC.
make i tell you truth ehh e no easy at all like this na only here i hide myself so that i no go dey trapped down or get bad name so small tin wey bin dey boda me be say this forum too big and large and person no fit do any oda tin like post another board and tins never clear for my eyes na wetin make i say make i follow up here first maybe if i don stand small i fit push out go another place fit talk tins wit oda pipo. remember our pipo talk one proverbs say " person no dey carry two hand dey pack palm kernel for alter" so that if fall come him fit carry another hand wage himself.