Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 146. (Read 1025315 times)

hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Rotimi Chibuike Amaechi

As we been dey talk about the declaration of Nyeso Wike, him brother CRA from the ruling party come declare interest for the office of the presidency. As na my man wey I like, e get two things wey happen yesterday wey I like.
1.The multitude wey storm Ph yesterday.
2. CRA speech, the closing side. He said "I thank president Buhari for this great opportunity "
That statement wey him make na wise statement, the thing show say na Buhari anoint him say make him declare interest.
Make we dey one side dey watch because the bigger drama wan unfold.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Finally, I don find a way to be at peace with everybody. Once I don speak wetin dey everybody’s mind, I can never go wrong.

If na by that one you think say you don make peace with everybody, like this weh I deh I no happy with you self. How you go say all of them win? Your rigging pass how Buhari and his people take deh ring poverty into our ears. Na joke sha. But make I tell you wetin sup, just be yourself and say wetin deh your mind as you think am because if you think say you go make everybody happy the same time na pure lie be that. You sabi say even as Buhari deh bad reach e get people weh deh ready to die for am? Na so o. This people go tell you say Buhari na the best president.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

So far, I have counted 14 persons who have already declared interest to be Nigeria's next president. They include:

1. Anyim Pius Anyim
2. Yahaya Bello
3. Orji Uzor Kalu
4. Kingsley Moghalu
5. Dele Momodu
6. Chukwuka Monye
7. Bola Ahmed Tinubu
8. Rochas Okorocha
9. Khadija Okunnu-Lamidi
10. Sam Ohuabunwa
11. Doyin Okupe
12. Bukola Saraki
13. Atiku Abubakar
14. David Umahi
The list go long pass so shortly, e be like you ho need to update am....and the truth na say some of them just dey talk say dem wan be president so that las las something or one political appointment go reach their side. Even all the ones wey we feel say go support crypto for 9ja fit shock us finally, e nor mean say make you nor vote ooo, but wetin i dey talk na say we dun dey disappointed, we need  performance not plenty talk.
If I tell you say eh, my mind dey for any of these men there matter eh, that one go be big lie. We no be pikin again way be say, them go dey carry empty promises they turn our head around. If no be say, na so politics just be eh, I for prefer cef say, make them just declare there interest then, them go for the pulls and our judgement on them go be based on formal office way them don hold before, how them perform. If na person way never hold office before, e go sure get watin e dey involved in and that na one good place to start too.

All these there promise of carry crypto along, e fit turn scam las las via say, them just wan be like say them dey for the youth and not the system. You and me know say, these men no dey like fight the system to dey on ground for the people. The. Prefer fight the people and work with the system. Imagine young senator like Desmond Eliot. Way don act several movies way be say, some dey talk about how the system cast and e for be full critic of the system. As e join big belle men, e turn big belle man. Youth like me and you for that matter o. Make them carry the country dey go where hungry them abeg, with crypto, we move!
hero member
Activity: 1064
Merit: 501

So far, I have counted 14 persons who have already declared interest to be Nigeria's next president. They include:

1. Anyim Pius Anyim
2. Yahaya Bello
3. Orji Uzor Kalu
4. Kingsley Moghalu
5. Dele Momodu
6. Chukwuka Monye
7. Bola Ahmed Tinubu
8. Rochas Okorocha
9. Khadija Okunnu-Lamidi
10. Sam Ohuabunwa
11. Doyin Okupe
12. Bukola Saraki
13. Atiku Abubakar
14. David Umahi
The list go long pass so shortly, e be like you ho need to update am....and the truth na say some of them just dey talk say dem wan be president so that las las something or one political appointment go reach their side. Even all the ones wey we feel say go support crypto for 9ja fit shock us finally, e nor mean say make you nor vote ooo, but wetin i dey talk na say we dun dey disappointed, we need  performance not plenty talk.
Peter OBi go win
ATIKU go win
Osinbajo go win
Amaechi go win
Saraki go win
Wike go win
Tinubu go win
Sowore go win
Moghalu go win
Yahaya Bello go win.
Dave Umahi go win.
Pastor Bakare go win.
Finally, I don find a way to be at peace with everybody. Once I don speak wetin dey everybody’s mind, I can never go wrong.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
imagine say him post dis kind thing for general forum, dey celebrate Binance weh accept BVN for KYC, e for cast us be that.

Anybody weh deh celebrate Binance bvn for Nigerians no really understand wetin deh at stake o. No be for our own good o.

Now we Don dey submit our bvn just to verify a Crypto Exchange which is supposed to be decentralized, now I ask Dem don throway the decentralized qualities?

Any day any exchange I deh make am force say we must submit bvn, na train speed I go take japa from there. I deh joke no be when e reach that level o. Am sure na to respect regulations make them begin put all KYC things but it is now becoming too much for these exchanges.

Rruchi man no worry yourself for those people weh deh that list. Some deh tell me say none of them go smell that seat, even Tinubu. Una deh see how him want shift enter another party now because he is sensing that APC fit deny am slot for primaries.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013

So far, I have counted 14 persons who have already declared interest to be Nigeria's next president. They include:

1. Anyim Pius Anyim
2. Yahaya Bello
3. Orji Uzor Kalu
4. Kingsley Moghalu
5. Dele Momodu
6. Chukwuka Monye
7. Bola Ahmed Tinubu
8. Rochas Okorocha
9. Khadija Okunnu-Lamidi
10. Sam Ohuabunwa
11. Doyin Okupe
12. Bukola Saraki
13. Atiku Abubakar
14. David Umahi
The list go long pass so shortly, e be like you ho need to update am....and the truth na say some of them just dey talk say dem wan be president so that las las something or one political appointment go reach their side. Even all the ones wey we feel say go support crypto for 9ja fit shock us finally, e nor mean say make you nor vote ooo, but wetin i dey talk na say we dun dey disappointed, we need  performance not plenty talk.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.

Honestly guys should this be good news, I no know how una dey feel. When I first joined Crypto, then the main topic na crypto-currency is decentralized, this was a core value of crypto-currency one that even got many governments scared, but as e dey go now I feel say the decentralized qualities/nature of crypto-currency done dey fade. Now we Don dey submit our bvn just to verify a Crypto Exchange which is supposed to be decentralized, now I ask Dem don throway the decentralized qualities?
Senior man, this your talk too go well. And me sef don think this thing tire. You see many of us for this side never still believe this bitcoin money, an average Nigerian dey find wey to convert to fiat anytime. Our oyibo mates dem dey practice this privacy well pass us by far. We just dey read theory for this our side.
Another truth be say, based on the kind country we fall out from, before you go begin talk about privacy, in one way or the other, your privacy go done cast.

But I like as him come make this post here. Him try wella, e better pass those ones wey go enter B/H thread open multiple threads wey no go well. imagine say him post dis kind thing for general forum, dey celebrate Binance weh accept BVN for KYC, e for cast us be that.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504

Honestly guys should this be good news, I no know how una dey feel. When I first joined Crypto, then the main topic na crypto-currency is decentralized, this was a core value of crypto-currency one that even got many governments scared, but as e dey go now I feel say the decentralized qualities/nature of crypto-currency done dey fade. Now we Don dey submit our bvn just to verify a Crypto Exchange which is supposed to be decentralized, now I ask Dem don throway the decentralized qualities?
The truth be say say, nothing done really change about crypto. E still dey as e been dey right from time except say, e get some other projects way von fa in for the system. Crypto na decentralized system way dey operate in a centralized system. Las las, if I wire you something from my wallet, nobody go know say, na me run you the least except people way sabi say, I don identify say, na me get the public address.

Na when I go used exchange way dey centralized, na there con be matter. Binance hands don too clap way be say, e ey very rear before you go see people way no wan dey use there platform dey run matters. As such, them no con dey fear say, them go loose customers again. I no like the BVN idea like that shah via say, before them go con dey get access to that kind data, e fit get terms way them go don bridge with government and imagine as e be now, way CBN dey fine some banks over crypto matter... na this kind thing dey cause the traces. Na fuck up way we go still manage shah.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702

Honestly guys should this be good news, I no know how una dey feel. When I first joined Crypto, then the main topic na crypto-currency is decentralized, this was a core value of crypto-currency one that even got many governments scared, but as e dey go now I feel say the decentralized qualities/nature of crypto-currency done dey fade. Now we Don dey submit our bvn just to verify a Crypto Exchange which is supposed to be decentralized, now I ask Dem don throway the decentralized qualities?
hero member
Activity: 966
Merit: 701
Kyc no be better thing for me to celebrate. Crypto exchanges dey do to make sure say everybody complete kyc for their platform. Binance approve nin for verification last year, from there many Nigerians complete their verification. I no like the idea of linking my bank details to third party.

Aswr but Binance shall get savings to use compensate anybody's wey hacking go affect their funds although if e happen your details dun go be that. Infact immediately you put your details for KYC just know say you dun sell out. Unfortunately majority of Nigerian gaz do am to enable a smooth use of the Binance platform. Complains been dey come ofr nin mata so it's understandable why dem introduced BVN immediately as NIN been dey get small issue.

Binance fit get the money to pay but how sure say e go reach everybody. Binance users still dey sue the platform say them no get access to their trades at one point na so them take lose money way they their trading account. That matter still dey court unresolved. I no be the kind of person way dey put many trust for wetin my hand no fit control.


Na the main thing be this oh, date traffickers go chop welle, before you go run the verification something with your BVN, just know say everything about your life they inside that number. Your house address, face oh, bank details, phone number even your NIN etc all dey inside that BVN number.
E be like US social security number. Na one thing them no dey use play for there coz their existence dey linked to am. All your records dey connected to that number.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Kyc no be better thing for me to celebrate. Crypto exchanges dey do to make sure say everybody complete kyc for their platform. Binance approve nin for verification last year, from there many Nigerians complete their verification. I no like the idea of linking my bank details to third party.
Snip
I no think say greater risk dey if you use your bvn than if you use your nin. All na the same thing. For people wey get international passport, you go see say nin dey there too, all the information link together.
And I feel say binance no get the whole access to the bvn and the database, the service them dey use na the same service wey website they use know say password wey you put correct or not. Them scrap the bvn data, so if you input your bvn and e match with the data wey government get, e go automatically verify, knowing too well that your details already dey with banks.

My real talk be say, no option of verification for binance dey more risky or less risky, all na same Kyc.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
The northern governors are making a lot of money from these terrorism business.

That thing Abacha talk na true and Buhari and his friends no go fit deny am say them no get hand for this insecurity matter. The thing don grow pass their control now and them no fit stop am again. Make them continue. The bandits go soon reach all of them. Shebi that dwarf for Kaduna don begin deh cry out now. Governor weh no get single sense.

Binance users can now use their Bank Verification Number BVN for verification.

I go beg our people make them never try use this method for verification o. I deh always avoid anything weh get anything to do with BVN. You never fit tell which person hand weh the thing go fall into. And as 9ja government and CBN problem deh affect us go, you no go fit know if them go use am track account go block or ban am. E go better to avoid am completely o. Na my one cent for this matter be that.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Kyc no be better thing for me to celebrate. Crypto exchanges dey do to make sure say everybody complete kyc for their platform. Binance approve nin for verification last year, from there many Nigerians complete their verification. I no like the idea of linking my bank details to third party.

Aswr but Binance shall get savings to use compensate anybody's wey hacking go affect their funds although if e happen your details dun go be that. Infact immediately you put your details for KYC just know say you dun sell out. Unfortunately majority of Nigerian gaz do am to enable a smooth use of the Binance platform. Complains been dey come ofr nin mata so it's understandable why dem introduced BVN immediately as NIN been dey get small issue.

Na the main thing be this oh, date traffickers go chop welle, before you go run the verification something with your BVN, just know say everything about your life they inside that number. Your house address, face oh, bank details, phone number even your NIN etc all dey inside that BVN number.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
Binance users can now use their Bank Verification Number BVN for verification.


Good morning my Nija people, I am new in Bitcoin talk forum and this is my first time of saying hi to my great brothers and sisters we they here. I Don they follow all the conversations, and I Don go through some of the posts wey our great pioneers they drop, this is indeed a remarkable one, I hope we all succeed together.

Many of us wey they here dey find am difficult to verify their Binance Using the requirements wey Binance list, and we no fit they use Binance until we are fully verified. I was finding it difficult to verify even after I Don submit my verification request, them they reject am.
Right now I just see say Binance don Add Bank Verification Number BVN as a means of verification, so I tried it and it was verified successfully. Na why I talk say make I share this news with my people because I know say some of us they here wey get the same issue as me.

This is the link to the image wey I see BVN as an option for verification, I no fit upload am because of my Activity and Rank pls you can view it and see through the link.
https://ibb.co/G9X8xpQ

Kyc no be better thing for me to celebrate. Crypto exchanges dey do to make sure say everybody complete kyc for their platform. Binance approve nin for verification last year, from there many Nigerians complete their verification. I no like the idea of linking my bank details to third party. Why? Recently them hack popular betting site Bet9ja I no dey use the platform so I no go fit talk how their t&c be. If them require mandatory kyc nai be say all their users info dey the hand of the hackers.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
One more thing, it's high time we stop protesting and start signing petitions against them!

Petition no dey work in an uncivilized country like Nigeria, if the protests no dey no work up on all the force e carry, wetin make you think petition go work. We no get better leader dem wey get shame. Infact at a time we ones had a convicted individual as president. Assuming say we get politician wey go use their own hand stepdown if they failed on their promises inorder to keep their integrity (reputation as well) in intact then the petition of a thing go fit work.

For the blockchain voting something, dat one na dream wey no go fit come to pass. U no see wetin dem do with electronical voting system dem been first introduced. Our politicians needs ways dem fit cheat and blockchain no dey allow am unless dem introduced centralized blockchain dem wey dem go fit manipulate to decieve us na when dat kind thing go work for Nigeria.

For this blockchain mata, other countries dun try am sha you fit read; Top Countries That Conducted Elections On The Blockchain
hero member
Activity: 952
Merit: 742
Binance users can now use their Bank Verification Number BVN for verification.


Good morning my Nija people, I am new in Bitcoin talk forum and this is my first time of saying hi to my great brothers and sisters we they here. I Don they follow all the conversations, and I Don go through some of the posts wey our great pioneers they drop, this is indeed a remarkable one, I hope we all succeed together.

Many of us wey they here dey find am difficult to verify their Binance Using the requirements wey Binance list, and we no fit they use Binance until we are fully verified. I was finding it difficult to verify even after I Don submit my verification request, them they reject am.
Right now I just see say Binance don Add Bank Verification Number BVN as a means of verification, so I tried it and it was verified successfully. Na why I talk say make I share this news with my people because I know say some of us they here wey get the same issue as me.

This is the link to the image wey I see BVN as an option for verification, I no fit upload am because of my Activity and Rank pls you can view it and see through the link.
https://ibb.co/G9X8xpQ
hero member
Activity: 910
Merit: 574
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
NEW TOPIC

With The General Elections fast Approaching, I was entrenched in my thoughts thinking about how we can make the voting system better.
Can the Application of Blockchain Technology make any possible/positive impact in our Voting system?
Like everyone in the country will use a little amount of currency to vote, since Blockchain is very accurate, fast and highly secured.

If I should score it 2/10 this won't be accepted by our old  grown, sniffing scumbags and old-fashioned and centered political representatives.
But can this be done in the future ?

One more thing, it's high time we stop protesting and start signing petitions against them!
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
CBN still maintain it stand by insinuating on crypto as an element used to perpetrates illegal acts such as money laundering, scam, and any form of fraudulent act due to it anonymity.
CBN is anti-bitcoin critic, bitcoin is money and an asset, it is normal if criminals are using it as they are using fiat but just that fiat are mostly used by criminals.

i still look forward to when our government will wake up to see the number of Nigerian youth trooping for cryptocurrency neglecting their ineffective E-Naira.
CBN knows that Nigerians are effectively trading cryptocurrencies through the P2P means of exchange. Never regard the CBN as the government, CBN is a governmental organization that deals with monetary policy, CBN are not government, just like a family that has a company, calling the company the family is not right.

CBN did not fine the bank because people are trading using p2p (but also if not stated in the purpose of making a bank transfer to be about cryptocurrency) because other banks like GTBank and Kuda Microfinance bank that most crypto traders in Nigeria are using were not fined.

But, we need to be careful, especially people that are into frequent buying and selling of cryptocurrencies, making it to becoming just like an organization for them that can be detected by CBN.

I see this move as a good move from the CBN most especially when we want to deal with money launderers who have seen cryptocurrency as their save heaven.
The fine is not because of money laundering, it is because some accounts of users were used in crypto transactions and failure to close customer crypto accounts as directed by the CBN. Although, I was confused about this because court ordered the banks to unfreeze people's bank account, but maybe this happened after the ban.

It is fair that the CBN fined the defaulting financial institutions. They already stated that digital currencies  are largely used in terrorism financing and money laundering of which there is a point.
No crypto transaction yet linked with Boko Haram, but I am not saying cryptocurrencies can not be used in financing terrorism or money laundering just like fiat, if fiat can be used, then crypto as a money can also be used. Check this interesting news about six Nigerians that US sanctioned for financing Boko Haram.

Full list: US sanctions six individuals for supporting Boko Haram

When I talk am say there is bitcoin ban in Nigeria some people talk say nothing like that, say na partial ban or say na only Buhari fit do am. Wetin come be this now where CBN begin sanction banks? We deh forget say na Buhari get CBN.
Not partial ban? It is partial ban.

Nigerians are still able to access centralized exchanges that is very easy for the government to make sure no Nigerian would be able to access any centralized exchange in a way decentralized means of exchange would be the only option left.

This is old already, but I do not like to refer to it because even CBN do not have the power to place total ban on cryptocurrencies. This is what CBN made clear after the 5th, February 2020 crypto ban:

According to a report on Sunday, bank officials have said the directive is not to be mistaken for an outright ban. Instead, the bank said it has reiterated an already imposed 2017 ban on institutions facilitating cryptocurrency transactions.

Speaking on behalf of the bank's chief, Godwin Emefiele, Deputy Governor Adamu Lamtek said the bank had never banned cryptocurrency activity in the country.

The CBN did not place restrictions from use of cryptocurrencies and we are not discouraging people from trading in them, said Lamtek. "What we have just done was to prohibit transactions on cryptocurrencies in the banking sector."

But, even, the CBN do not have the power for total ban, CBN can only propose more ban to the government, the government may accept it or reject it.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Na this one deh make me shock. Government no fit deny am say them no know who the sponsors of this bandits be. If na any other part of the country this thing deh happen military for don run go there and begin assault innocent citizens. But a whole Kaduna and military presence and equipment yet bandits deh play them scores.
Everything wey dey happen for this country just dey show that the insecurity we dey experience dey sponsored by the state (government).

How else wey terrorism go dey since 2010 or even earlier, and yet there has been no solution to it with all the military force and even support from other countries.
You no fit travel by road or train safely and no he everybody fit afford flight. It's just a failed state at this point.
This country mata tire everyone. Na government be bandit, na government be insecurity and, na dem be unknown gun men, na dem be herdsmen and na dem be government. Wetin I discover be say, the head of different security prastatal dem dey hold am hostage. Everyone dey capitalise for our problem dey r*pe us.
Imagine say our president na former General, yet him no fit stop terrorism for going to 8 years now.
E good make we comot mind for Nigerian leaders, dem no fit help us, because as long as the system bad, even if good person enter seat, e go still bad.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Any insurgency that lasted for more than 24 hrs is sponsored by the government that was the statement wey Abacha made while he was in office

When dem been dey start this violence, e be like person no warn dem. Nobi Boko Haram dem take use discredit goodluck administration. Buhari come say him go finish dem but up til today nothing very person fit use hold body dun happen based on the insecurities levels. Me too I follow believe say this bandits and all other groups wey dey disturb the country is been sponsored.

Make we reason am now, assuming na Boko Haram dey sponsor demselfs, dey for dun surrender since na but dem get somebody or organization wey dey benefits from all this. I hear say the equipment this terrorist dem get better pass our Nigeria forces own. How dem wan go wan fight that kind war when they no ready for am.
Jump to: