Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 212. (Read 1030181 times)

full member
Activity: 140
Merit: 128
Welcome back @mpamaegbu... It was really a victory won battle, some were gone through this but God help sustain you and gat you restored, we are our brother's keeper here and I love the symphony within us.

Now that you're back bro na wetin you carry bring for members now, let's through party now!
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Hey hey hey Charles-Tim and Engineer, na fight una wan take welcome be back from the 🦁's den ba? Abeg, make una nor do dat wan here. Na true sey some people dey like use I dey busy dodge responsibility but I nor think sey na wetin happen for dat whitelisting matta. Charles gist me immediately where Upgrade dey but sey make im enroute am through anoda persin......]

Lol, leave Charles oo na my boss be that na so we dey disagree sometimes oo him be that kind good man wey dey like cover up him friends lapses but me in fact all of us for PH our head no correct oo even our Governor Wike dey mad we nodey keep things to our mind instead we pour it in public make fowl nyash open all of us here na brodas we be if we get small power make we dey use am well make we try dey learn from our oga Brainboss, the power wey him get for the forum na our community dey benefit pass and na so e supposed be. At this point me I dey okay where I am all my hustle na to lift our younger ones to reach our height. I'm not against UP...de but make him make him contributions visible to our community too.(1/10)

Na woman wey never suck prick dey talk say prick bitter
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Hey hey hey Charles-Tim and Engineer, na fight una wan take welcome be back from the 🦁's den ba? Abeg, make una nor do dat wan here. Na true sey some people dey like use I dey busy dodge responsibility but I nor think sey na wetin happen for dat whitelisting matta. Charles gist me immediately where Upgrade dey but sey make im enroute am through anoda persin. I believe sey im for do am without shaking. Even though I neva get any one on one chat with Upgrade I still see how im carry my ban matta for head too like gala. Wetin happen with me and how una rally round show us sey blood is thicker than water (I hope dem nor go sey dat expression wey I use na plagiarism too 🙄). See ehn, we supposed stick together here oh and na im be d only thing wey go save us when gbenge happen. Lion strong lion strong na because im nor dey waka alone oh. Those forks wey dey dodge dis owa arena, na dem dey lose oh. Here na home outside home. Igehhh, calm down. Go drink ice water.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
No it's very necessary Charles just leave am as I talk make I clear my mind I no dey hold grudge for mind me and you know say for this country " I'm busy" na reversing full time. ( I've cleared my mind )
Do not go into conclusion of what you do not know about, Upgrade messaging me back earlier asking me about the next step is a sign he wanted to whitelist the account. There are just some matters that shouldn't be brought up, if you know you have anything to clear your mind about Upgrade, you can send him pm which would have been respected instead of this.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Me I be person wey nodey hide mouth you see that whitlister wey dey among us? Nothing come out for him side make una nodey carry am for mind na LoyceV whitelist that appeal account thru Charles.
I got in touch with him but he was very busy (I do not want to tell you what he was doing, just to be private) and told me to give him one hour, he messaged me back less than 30 minutes or less than an hour (I couldn't recall but I remembered he messaged me back faster than the time he told me he would) about the matter, but I couldn't wait, I posted for the whitelisting under LoyceV's whitelisting thread and messaged him, everything was done less than 10 minutes. Everyone tried to help, and I think this statement is highly unnecessary.

No it's very necessary Charles just leave am as I talk make I clear my mind I no dey hold grudge for mind me and you know say for this country " I'm busy" na reversing full time. ( I've cleared my mind )

Service

Please I dey find a good Telegram bot creator abeg if una see anyone recommend to me.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Please, let us all the time be checking and re-checking our posts, most especially topics, to make sure we reference it when necessary, clearly obvious Mpamaegbu forgot to include link, not intentional.

---snipped---
Your account was unbanned as a reflection of your quality presence on this forum and the topic that does not worth your account to be banned as it is stale more than the quality time you are devoting to this forum. I am just happy that you are back.

Me I be person wey nodey hide mouth you see that whitlister wey dey among us? Nothing come out for him side make una nodey carry am for mind na LoyceV whitelist that appeal account thru Charles.
I got in touch with him but he was very busy (I do not want to tell you what he was doing, just to be private) and told me to give him one hour, he messaged me back less than 30 minutes or less than an hour (I couldn't recall but I remembered he messaged me back faster than the time he told me he would) about the matter, but I couldn't wait, I posted for the whitelisting under LoyceV's whitelisting thread and messaged him, everything was done less than 10 minutes. Everyone tried to help, and I think this statement is highly unnecessary.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
[.....]

Na me this one want carry problem come give you dey whine my papa ni  Cheesy by the way we happy to see you back, I don't normally add banned users to my statistics but I was very sure say your mata go stew las las. At least all of us don learn a thing or two from what happened my advice to people wey talk say den no need attention be say when matter go sub nobody go stand for you so make sense to know who sabi road na the only way to survive here.

Me I be person wey nodey hide mouth you see that whitlister wey dey among us? Nothing come out for him side make una nodey carry am for mind na LoyceV whitelist that appeal account thru Charles. All of us know how the country dey and na here most of us dey take small thing hold body, make we try dey help with the little power we have.. Our people talk say rain nodey fall unto one person roof

@Dragonfund I see you my brother, welcome abeg try dey come set with us here too.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

Abeg, later I go gist una wetin I learn from dat ordeal and how wey go take dey dodge wahala here. Na to sleep remain for me now.

Lol I believe say your eyes don see ya back amidst say ya mind don cut ontop dis new pepper wey knack you, somebody want take him reggae take scatter your praise and worship, see me see wahala oo. The thing tire me oo, pepo like us dey find a ground wey we fit take put mouth b4 the good news land. I been just wake up and immediately go check ur appeal thread and see say baba don do the thing, soft.
E remain our second man, hoping say pardon go land him front too. Oluwa no go shame us.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Who dey breeeeeet!

I sey I must enta here dis night before I go crash whether Bubu like am or not. E dey mandatory for me today. My joy for dey fullest if to sey Pokapoka too dey free. Nonetheless, I dey grateful to Baba God and all of una wey carry my matta for head. Wetin my eyes and mind pass through nor be here oh. I just wan thank all man for una solidarity. Even Charles wey dey worry me come dey worried too ontop my matta 😆. Brainboss! You na Foreman, simple and short! We dey lucky sey you dey owa midst. I appreciate you and all wey dey here. Na night, I nor wan begin call una names again make una nor go begin sneeze anyhow for where una dey.

Abeg, later I go gist una wetin I learn from dat ordeal and how wey go take dey dodge wahala here. Na to sleep remain for me now.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
How I wish we all live by what we study in Nigeria, education is not meant to only pass through and have a roughly experience, we work on what we learn in school and make application in the practical world.
This is Nigeria, unlike countries like US, Nigeria rate if unemployment is high, high is even an understatement because it is much more worse than what some people think, almost all university graduates have no offered job while many are underemployed. We need to be exposed than what we read in school in Nigeria if we want to stay in the country and survive.

Yet, most recovery services are scam, we must avoid them, this is one of the scammers den of this century.

In other news, what are Y'all busy with? Una dey busy dey collect NFTs up and down to resell? Which trends are you guys on board ma?

- NFTs
- DeFi
- IDOs, etc.
NFTs? No
DEFi? No
IDO? No

I hope you are holding, and hope Naira is not among  Roll Eyes
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Well @Dragonfond we and myself welcome you for this corner. You really try help your self collect kpali wey be certificate becos you need am 4 life.
As you carry yourself enta here, make you still believe ur self to grow at least small small. I no go say e no easy but you na pesin wey say you don gather small experience 4 the place. We see how one of us fall and rise by support and God's grace as God no shame us. The pepo wey we dey wrestle with dey always want make we fall (na the thing wey all of us go know be dat as I know since). I welcome you and congratulate our pesin wey still dey with us. I sabi say e no go be moimoi 4 am to show back. Na Baba do am 4 am.
full member
Activity: 546
Merit: 148
Una good morning from here my people!!! E don teh weh I dun dy hear of bitcointalk since 2018 when I been dy do some shit airdrop and luckily, I landed here not knowing how important this forum is, I do this forum strong things and e do me back, the mod no dy play at all, one second you misbehave, your account go just enter automatic ban, though no be perma ban as i no scam or plagirise but the way i been dy post get low quality.
I been dy 300 level wen I join this forum posting shit when I was looking for how to get small small legit $$ to survive with the harsh situation of campus, things been no balance at all weh even make me join bounties, sometimes we go see better bush meat and sometimes e go end up as scam and we dy always move on.  Undecided
School situation been no allow me to look the good part of the forum because I been dy try to graduate with first-class but during corona, two members come advice me to avoid making post weh i no get idea on, I come create this account strictly with no unnecessary proof of Authentication and I come gather liver create a thread and that was how I began to see the beauty of this forum, e fun die and the unending learning make me like am due to the collective experience and knowledge weh everybody they share for here.
Last month on the 10th of August, I completed my undergraduate after spending 6 years in Federal Uni due to unnecessary internal strikes and Asuu with 2.1 Chemical engineering and I'm now active with this account, the interaction and the feedback dy improve me every day.

I see you CryptopreneurBrainboss, my mentor, you dy inspire me say we no d carry last.
Charles-Tim I greet.
igehhh i dun dy follow you since.
CryptocurencyKing  Wink
Smartvirus and every other active naija users for this forum, I hail all of una.
legendary
Activity: 1876
Merit: 3132
I suppose the Lightning Network is the solution for tiny, fast transactions between buyers and sellers.

That's exactly what it was designed for - instantaneous micro-payments. You don't need to lock up a large amount of coins on the Lightning Network unless you want to earn money off payment routing (which is not as easy as it may sound).
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
This comes as a shock to me and am filled with sadness getting to know about the news of his ban. @mpamaegbu was a quality nigerian on the forum, who went about to give out his knowledge to the forum to the best of his knowledge, and I think we should uphold the spirit of support towards him in any little way we can, I think the next step for him is to appeal, and his contributions to the forum is loud and even non-nigerians can testify to this, so let all pledge our support to a compatriot at this time.
Further more as @cryptoprenurbrainboss has urged let always becareful especially now that we are beginning to get recognition.

That's the thing with the forum. One has to be very careful about these things. I don make few mistakes in the past and learnt the hard way. The thing we should know that majority of all of our posts are scraped within seconds and achieved so there's really no way to escape it. Best bet is to just jejely watch well before taking any move to avoid mistakes.

I just feel bad for MP because this was supposed to be the time for him to finally enjoy with other big boys in bestchange and just when it's about to start, this happened. I really hope he can get back 100% and still retain his spot at bestchange.

In other news, what are Y'all busy with? Una dey busy dey collect NFTs up and down to resell? Which trends are you guys on board ma?

- NFTs
- DeFi
- IDOs, etc.

Please share!
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
Our joy don cut short as one of our broda wey dey accept for bestchange don get ban for plagiarism wey e comit years back. Make una send una prayer give @Mpamaegbu because dis one na real village people mata.

Omo guy, i dey follow the thread since oooo, nor be chyse matter. I pray make God help am tidy this matter ooo, because nor be small situation be this. Hopefully by God's grace, his appeal will pull through with our support.

Anyways ma people how una Sunday dey go like dis, hope say una go go church oh. I dey hungry but I never Sabi within I wan chop, belle just tight for nothing meanwhile food dey hungry me lol.

Chop the normal Nigerian Sunday afternoon food (Rice). Carry one fowl leg decorate am for the top, then use one cold hollandia take press am down.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Omo, forum no get joy and I know. At least I don dey here for 2years con sabi say, e no get how e qan be way be say, something no fit skip person via the plenty post way person dey make. Imagine person dey make over 2-3000 post, even with sleep eye cef, something fit fly you easily and you no go know. That na to say, make we dey extra careful for watin we dey do hear. If your hand dey one thing or the other way be say, e no too sure for the forum I go beg you say, make you carry clear eye dey handle am.

Another thing be say, the kind fia way don carry us for the forum eh, e don take rapper wrap us for head way be say, we no sabi say, when knotry man dey for wahala, na we kwa dey the wahala and as e be so, we no fit join body to say make we elp am commot for katakata. I know say we kontry hard and person especially family person no go like lose en account fir person way e no too know but, try clean your house and then maintain better standing so, you fit dey put mouth make our canda for strong wella because, we need ourselves.

This matter as e be so eh, e too pain me and I hope say, Mpamaegbu no go live am to end like this, make e come talk something something if you see way or get watin you go talk way go help am, try put body. Una weldone.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
He has to appeal, although I was thinking mods saw more plagiarism might the reason for the ban, but he has to appeal for this to know why. I do not want to mention names, but he should know that if that only post is the only one known to be plagiarism, many reputed members will support him which are not Nigerians. Please, tell him to accept the fault as he did yesterday in the appeal, indicate the link in the appeal post and ask for pardon and let us see how it goes. We will be expecting his appeal post very soon.

The matter shocked me self na last night I see am I think the matter been don cover for reputation but as another busybody person come carry come Meta I still dey feel say na oga theymos carry the matter because him been dey very active der dis past days i no want point finger but una see that maga wey hm name be like( where we dey buy medicine) make una dey careful with am na two-phase sword him be him just dey bump the threads anyhow dey talk rubbish.

Abeg make una tell am to appeal as edey hot now wey people mind still dey make we know the real matter worse come to worse na 2 years sig ban but make him prove to the forum how useful he was ( providing links to important helpful topics) that's the proper way to appeal, the mistake has been done now the forum want to hear what they will miss if the account remains banned, from the cases I study the people wey theymos pardon na most people wey get active loan thread except Lovemay but she been provide her scam bursting links to prove a point...but God dey. We lost a fighter.

Wetin CB talk dey game oo make we try observe our previous doings, post when you dey newbies and now nofit be the same ooo make una comot anyone you nodey sure of ooo after all the forum nodey pay for how many posts you get... If possible comot all your newbies days no law dey against it. Lauda do plenty.
full member
Activity: 140
Merit: 128
Our joy don cut short as one of our broda wey dey accept for bestchange don get ban for plagiarism wey e comit years back. Make una send una prayer give @Mpamaegbu because dis one na real village people mata. Also make una dey try come interval for una people problem. Make we no jusyydey dey divided. Na only when we dey together we go fit go far oh  I remember when dey ban one person like dat for Russia board, e people come put mouth for her matta and den self she never become d Snr women she be now for forum.

I dey bring dis mata up as Incase Mpamaegbu wan appeal e go need our support. If you look d mata self you go see say na mistakes because no be user wey no dey put source link for e mata dem. Also as una dey post make una dey crosscheck oh to make sure everything dey in order. E no make sense say you go surfer build ur account finish, village people go just reason your mata one day den because of mistake you do, dem go just rubbish all your efforts, e no make say at all.

Anyways ma people how una Sunday dey go like dis, hope say una go go church oh. I dey hungry but I never Sabi within I wan chop, belle just tight for nothing meanwhile food dey hungry me lol.

This is disheartening, after several years of committed efforts and contributions to the forum and getting ban as a reward, this serve a lesson to us to always take heed in whatsoever thing we do because there are things we do secretly and we can never get away with, it is termed "Hunting Shadow" for the sake of those attending service today, let's put in prayer that God should rebuke the devourer for our sake whose main work is to look for loopholes to set our downfall, and may the spirit of plagiarism be cut off in it entirety.

I also pray for a reconsideration on his ban for a second chance, he should never give up, let him try appeal and we will all join the movement and mobilize on top the matter as una dey carry us along on the thread.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
This comes as a shock to me and am filled with sadness getting to know about the news of his ban. @mpamaegbu was a quality nigerian on the forum, who went about to give out his knowledge to the forum to the best of his knowledge, and I think we should uphold the spirit of support towards him in any little way we can, I think the next step for him is to appeal, and his contributions to the forum is loud and even non-nigerians can testify to this, so let all pledge our support to a compatriot at this time.
Further more as @cryptoprenurbrainboss has urged let always becareful especially now that we are beginning to get recognition.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.

Jump to: