Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 279. (Read 1035251 times)

legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
@gabbie2010 I sight u broda man, make we just dey come one by one, inform odas, the goal na to grow this thread into mage thread like 100+ reply once we grab dat numbers, dey must hear us when we apply for our own board. Also make we no forget to show each oda love both on and off this thread.
I be dey reason ham to post for here, but this great thread no dey active before unlike now, I don miss a lot but I go dey visit often now, make una no vex.

Becky666, Lordhermes, gabbie2010 and Gozie51. You be one of the few brothers I just dey know, the kind happy wey dey for my body say I know you plenty.

CryptopreneurBrainboss. Your name for btt no surprise me again, you too get brain. I happy die say you create this thread.

full member
Activity: 756
Merit: 231
@Becky666 that coin don rise badly oh correction fit happen anytime soon so no go rush buy oh although the possibility say the coin go continue raising dey as public mainnet na 31st July. Just research well. Na that news make me rebuy afta I been done sell
Tank-u Boss, d coin don rise as u talk but ur boy go wait for anoda opportunity b4 him strike. potential dey d coin nd I will buy some few stash now nd wait after deir mainnet b4 I go buy again.

@Lordhermes welcome, many names u dey see may look like girls/women but dey are boys/men, make we dey follow d level shia becus na God get power pass. Now wey Boss don accept make we use dis place wella dan going off-topic. Once again welcome broda.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Welcome @Lordhermes wetin u just suggest go well although wetin make me no put am at first be say I no want any gender discrimination but I don put am. Just pass the message across any of our brothers/sisters u encounter tell dem about this thread.

@Mpamaegbu, I don reply ur telegram message since na, I no dey waste time reply message (na one thing people sabi me for) unless I no dey online but d minute I see ur message I dey replace before anything else.

@Becky666 that coin don rise badly oh correction fit happen anytime soon so no go rush buy oh although the possibility say the coin go continue raising dey as public mainnet na 31st July. Just research well. Na that news make me rebuy afta I been done sell
full member
Activity: 756
Merit: 231
Na wah oh e get persin wey never fall mumu to dose scams before? Take God self for some of them because if no be MMM I no sure una for don see me for dis forum. Back in the early days I mumu die, na hyip, doublers, Ponzi abi matrix or wetin dem dey call am self, I no do? I do all but thank God today persin eye don open. All na experience and we don grab am major.
Boss, im get as e b dat time wen MMM com to naija, almost all my Peep's fell yakata 4 dis but me escape dat plague. But, weti go mak person fall first time nd still fall again nd again if no b greediness? My big broda wey dey here fell some few days ago for dose Facebook investment packages again.
Quote
@Becky666 my eye still dey for that coin but small development been sure up so I get to sell sharp sharp to buy back my DGTX (thank God e don rise). I still go buy some of the ARPACHAIN before month end. This two coins na my major bags.
DGTX shud b my next target. im go gud we dey talk for dis house about possible coins wey go giv profit make we dey take profit small small.
Quote
@Nelson4lov where you lost go, well thank God we don dey come back small small
Maybe na real-world hustling tins, happy to see u back broda.
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
Username: Lordhermes
Gender: Male
Country and state of resident: Nigeria/Portharcourt
Developing Skills: Trading.

Omo, I dey hail every body for here oh, I just come across this thread now meh e make sense wella, I feel say I dey home dey yarn with people wey know the matters. You too much Brainboss.
E get wetin I for suggest for this introductory post, we no know weda we be male or female. Gender suppose dey make we know male and female, wonder fit happen for this forum say people marry from forum as e dey happen for facebook. LoL, abi no be so?
Abeg, Brainboss, no vex say I yarn something like this for wetin you been don create.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
True, wait make I tagged all of dem as alt and the onli way dey fit prove say dey no be alt na to comment and actively participate for this thread lol.
Lol... I sabi sey na joke you dey. Leave dem, I know sey with time most of them go show here. You nor go too blame them as dem dey avoid people knowing sey dem be Naija peeps. Owa politicians dem don too give us bad name outside sotey once you tell anybody sey you be Nigerian, dem go begin hold their wallets tight. But people forget sey good Nigerians full ground too. See the type of charity wey you even organize for PH, dat na better thing from a concerned heart.

No reason am like dat oh, dat coin na $1+ coin if you get am under 5cents you still dey in luck.
Bros, I want make the thing drop small na so I go fit pack enough with small money. I don enter prayer for that coin head wey go drag am down whether e like am or not 🤡🤡.

BTW, check your pm for telegram and give me reply, abeg.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.

Na true I remember when u tell me dat time about ur internship stuff, hope say e dey go wella. Just dey show face once once make we self know say u dey alive. About dat forsage and ethereum money nonsense, e get something wey I don notice each time a particular cryptocurrency don dey enta ponzi creators eye, d coin dey ready to rise in d nearest time possible same thing with when bitcoin na the talk of the town back den even lending coins dem.

The trick na be say instead of to patronize the ponzi, I buy the coin. Ethereum get future oh make I just highlight am. If any coin fit reach bitcoin (four/five digit price) while bitcoin increase more na ethereum especially as this der upgrade dey come. I always tell people say, buy bitcoin, ethereum then any nonsense coin wey u like but make sure u get some of this 2 coins because na dem dey control the industry. See DeFi na, na ethereum blockchain most or all of them dey use etc.

@gabbie2010 I sight u broda man, make we just dey come one by one, inform odas, the goal na to grow this thread into mage thread like 100+ reply once we grab dat numbers, dey must hear us when we apply for our own board. Also make we no forget to show each oda love both on and off this thread.

@Brainboss, you come tell your people to increase that DGTX after you buy, ba? You for wait make I enter na 🤓

True, wait make I tagged all of dem as alt and the onli way dey fit prove say dey no be alt na to comment and actively participate for this thread lol.

No reason am like dat oh, dat coin na $1+ coin if you get am under 5cents you still dey in luck.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
I beg make una keep this thread going so that we no go carry last here.
True talk wey you throwey here but the thing na all of us hand e dey. Make wey make this thread owa own Nairaland. BTW, my conspiracy theory be sey any username wey get number join body for here na Nigerian get am, abi una too nor think so?
Examples like...
gabbie2010
Maestro75
Nelson4lov
Becky666
Dem plenty o... 😁😁And dem need to come identify with other Naija peeps here.

@Brainboss, you come tell your people to increase that DGTX after you buy, ba? You for wait make I enter na 🤓
sr. member
Activity: 2590
Merit: 322
SOL.BIOKRIPT.COM
Na wah oh e get persin wey never fall mumu to dose scams before? Take God self for some of them because if no be MMM I no sure una for don see me for dis forum. Back in the early days I mumu die, na hyip, doublers, Ponzi abi matrix or wetin dem dey call am self, I no do? I do all but thank God today persin eye don open. All na experience and we don grab am major.

@Becky666 my eye still dey for that coin but small development been sure up so I get to sell sharp sharp to buy back my DGTX (thank God e don rise). I still go buy some of the ARPACHAIN before month end. This two coins na my major bags.

@Nelson4lov where you lost go, well thank God we don dey come back small small
I jam this thread and come explore am I dey gbadun una tory here well well na im I come pack here jejely make I make I dey learn how una dey buy all those coins wey una dey talk about, I no say you people na oga here in this forum CryptopreneurBrainboss and mpamaegbu una gramama na baba me wey bi say na science student I be learner.
Nigerians no dey dull themselves in these obodo oyinbo forum me self I don learn many things here and I don learn how to run commot for any Hyips and ponzi schemes MMM don teach many mumu lessons wey be unforgettable I no dey go near thing like that again.
I beg make una keep this thread going so that we no go carry last here.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
~
@Nelson4lov where you lost go, well thank God we don dey come back small small

Omo Brainboss, Your man just dey like dele. Remember say I dey learn web development na? I participate for one internship like that – HNG internship. The stress been dey too much so tey I stop after sickness kick in. But I reach the point to get IT placement wey I fit use next year for their office.

That aside, you see this matter una dey yarn so? About falling/participating in scam? mehn me sef get story to tell Oo. The road no dey ever dey straightforward. I remember some hyip I join then, 3.14%  daily. Most of my friends then chop, but immediately I put my cash wey I earn from faucets then, them go maintenance till today, maintenence never finish. No be only that one sha but I want keep my story short. Since then I vow never to enter a ponzi/hyip or any scheme wey dey too good to be true. Na why this new stuffs like Ethereum Money and forsage, I dey frown when people talk about them coz all na to rub peter to pay paul.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Na wah oh e get persin wey never fall mumu to dose scams before? Take God self for some of them because if no be MMM I no sure una for don see me for dis forum. Back in the early days I mumu die, na hyip, doublers, Ponzi abi matrix or wetin dem dey call am self, I no do? I do all but thank God today persin eye don open. All na experience and we don grab am major.

@Becky666 my eye still dey for that coin but small development been sure up so I get to sell sharp sharp to buy back my DGTX (thank God e don rise). I still go buy some of the ARPACHAIN before month end. This two coins na my major bags.

@Nelson4lov where you lost go, well thank God we don dey come back small small
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
Kai kai. I don miss out on the fun already. Make I quickly join in.  First one of all,  make I welcome new members to the Africa/Nigeria Bitcoin and Crypto community.  I don set notifications now for this thread so I no go miss out again 😋


Username: Maestro75
Country and state of resident (optional) Nigeria
Skills: Student and school teacher, but I plan learning online stuff too

Welcome to the community bro. As usual, If you need anything, we're all here to support one another. This is our corner here on the forum made possible by chairman, CryptopreneurBrainboss.

Username: Alobo Realer
Country: Nigeria
State of resident: Benue
Skills: Web Developer in View.


Alobo, Welcome Oo.  I be web developer too Oo. But mostly frontend for now. Happy to connect with you like this.

I been buy ARPA last night but I don sell off earlier this afternoon as profits enter coz now no be the kind of time to see profits and refuse to sell.
full member
Activity: 756
Merit: 231
How many were able to make this opportunity?
The coin don start im challenge nd if u dey among d lucky buyers in d dip den make we dance Atlanta becus we don harma. Dis market eh need patient  b4 tins go fall 4 gud, tank u Big Boss, am okay 4 d first stage of my sell, waiting for the next round around 350 or 400 SATs.   ARPA-CHAIN my folo-folo people, folo person wey know roads....@BrainBoss
legendary
Activity: 1554
Merit: 1167
Gamble responsibly
About this.... I laugh because I also get that experience. I even buy coins they were already listed to be delisted from exchange (lol , how I want take know na. Person dey know wetin dem no sabi ?).
Na ignorance be that, na like disease self. Though, the kind scam are old before I sabi crypto not long ago, but I no dey invest on weting I no sabi. I see doubler too, I see many scam type but that Nigerian blood dey my body, no scam work if I no go lie. But, I no greedy nor dey impatient, life na step by step, these helped me especially when I see doubler site.

But weting dey pain me be sey people wet no know about these scams still fall victim.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
@Brainboss, your agility dey totori me well. You sharperly rush go do buy back. You nor wan hear story story... Lol.

How far the saga for twitter any body don see am, all high reputed cryptocurrency related twitter profile and some top celebrities account na hushpuppy brothers in work run dem street and I hear say dey don scam like $115,000 already. You think this event go affect price? Positively or negatively.
D whole thing be like sey na Twitter dem completely hack o and then tamper with some popular handles. So, you think sey na Hush boys dem? 🤔. Anyway, I nor believe sey that hack go affect crypto price since nor be exchange wey dem nack. But wait o, those ones wey fall victims come begin send Bitcoin to addresses wey claim sey dem dey do give away with "send one get two" nor be greed dey do dem? Well, everybody dey learn at their own pace sha. I remember when some doublers dem wayo me too in 2017 wen I just enter crypto new. I learn since then.

I don dey read for forum on some fud speculation on the expectation say the hack fit affect the price of bitcoin but me I no dey think like that oo. Btc dey funny oo. Sometimes the thing wey you expect say go pull price down, you go surprise how buy candle go fly up lol  Grin Grin Roll Eyes And you go dey watch ya money floating for river Niger, chai.... Abeg make traders no just go dey sell btc oo, just watch well and be sure it is a trade decision wey you see and not just expectation wey dey your mind.


Quote
I remember when some doublers dem wayo me too in 2017 wen I just enter crypto new. I learn since then.

About this.... I laugh because I also get that experience. I even buy coins they were already listed to be delisted from exchange (lol , how I want take know na. Person dey know wetin dem no sabi ?).

But, I don't know if @brainboss also get this kind of experience.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1167
Gamble responsibly
I welcome you wella wella with correct cool water for ya body. E good as you enter this house. We go dey roll the thing dey go together. But Bros, we nor sabi book here o na im make we dey use pidgin dey yarn here. Your English dey knack my head too much
I don go through some of una posts e make sense, to correct say you be all learned and understand English even pass me self, na me be your pikin and need correction and thank you. I never write or speak pigin like that before but I go dey try small. You welcome me good and e make sense.

Welcome @Oshosondy
I respect sey you get rank, I go(went) check your profile, you don work here. Thank you for the welcome.

How far the saga for twitter any body don see am, all high reputed cryptocurrency related twitter profile and some top celebrities account na hushpuppy brothers in work run dem street and I hear say dey don scam like $115,000 already. You think this event go affect price? Positively or negatively.
This na just social media scams, bitcoin price dey well, nothing fit affect ham. If unto say na exchange get fault now, wahala go dey, people can fear convert their bitcoin to fiat and withdraw but the scam na phishing. No exchange dey at fault, this type of scam common for banks self and banks never run down.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
@Brainboss, your agility dey totori me well. You sharperly rush go do buy back. You nor wan hear story story... Lol.

How far the saga for twitter any body don see am, all high reputed cryptocurrency related twitter profile and some top celebrities account na hushpuppy brothers in work run dem street and I hear say dey don scam like $115,000 already. You think this event go affect price? Positively or negatively.
D whole thing be like sey na Twitter dem completely hack o and then tamper with some popular handles. So, you think sey na Hush boys dem? 🤔. Anyway, I nor believe sey that hack go affect crypto price since nor be exchange wey dem nack. But wait o, those ones wey fall victims come begin send Bitcoin to addresses wey claim sey dem dey do give away with "send one get two" nor be greed dey do dem? Well, everybody dey learn at their own pace sha. I remember when some doublers dem wayo me too in 2017 wen I just enter crypto new. I learn since then.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
DGTX too nor dey bad. I go try buy am by next week. Brainboss, e go good make you buy am back sharperly so you nor go ever regret not doing so now, the way I regret selling my 270 BNB coins @3 in 2017 or so before the thing go do $30 and then ATH of $40+ last year.

Na wah for you oh abi u no trust me, I don buy am back sharp sharp. First I buy ARPA for Binance come dey reason say make I just see how e go perform but after like some hours (later in the evening) I come view DGTX again for coinmarketcap, e don rise dey enta 7cents Broda I no think am twice go sell my ARPA (thank God I never withdraw am from Binance by then) then buy DGTX. For next 6months or so na the coin i go dey focus majority of my investment in. I believe the project die na just busy body make me go sell am.

How far the saga for twitter any body don see am, all high reputed cryptocurrency related twitter profile and some top celebrities account na hushpuppy brothers in work run dem street and I hear say dey don scam like $115,000 already. You think this event go affect price? Positively or negatively.

Welcome @Oshosondy
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!

I don already pack small ARPA keep on Binance. Since na Defi, e go suppose dey burn go down. Na around 1,450 billion e dey from the original 2billion. DGTX too nor dey bad. I go try buy am by next week. Brainboss, e go good make you buy am back sharperly so you nor go ever regret not doing so now, the way I regret selling my 270 BNB coins @3 in 2017 or so before the thing go do $30 and then ATH of $40+ last year.

The greatest risk for life as people wey sabi book dem dey talk, na to nor take risk at all.


Username: Oshosondy
Country: Nigeria
State of residence: Oyo
Skills: Trading
I welcome you wella wella with correct cool water for ya body. E good as you enter this house. We go dey roll the thing dey go together. But Bros, we nor sabi book here o na im make we dey use pidgin dey yarn here. Your English dey knack my head too much 🤡🤡
legendary
Activity: 1554
Merit: 1167
Gamble responsibly
Username: Oshosondy
Country: Nigeria
State of residence: Oyo
Skills: Trading

It took me long to make my first post here, I joined few weeks ago but unknown to me about how this forum works, getting acquainted daily and knowing more. At least I know few people now that are Africans which makes me happy like I am not lonely here. I had a good start but I will like more of your help in term of encouragement, advise and many more and I hope you will not let me down.

I have made few topics...
https://bitcointalksearch.org/topic/m.54796274
https://bitcointalksearch.org/topic/m.54657290
https://bitcointalksearch.org/topic/m.54650180

...and I want to improve more, I hope you can advise me on that. Thank you all.
Jump to: