Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 278. (Read 1035251 times)

legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Username: Smartvirus
Gender: Male
Skills: Signature and Bounty

I identify with you, children from one womb of Africa. It was really thoughtful of you to create this forum @CryptoprenuerBrainboss, bringing us together in the spirit of togetherness. I welcome myself in mates.
I hail una way dey the room o. Men and women way sabi
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino

My name na George john
Are be male in gender
And I from Nigeria
Are be full son of africa.

Biko my people of Africa make we try dey help our begginers wey no no anything here so that dey go follow those people wey dey local board from another country dey compete.




George welcome to our tiny corner on bitcointalk (it's no longer tiny, lol).  I wan specially welcome you.  We dey long overdue to get our own board for this forum. I know say we go get am soon.


Welcome on board as you come join us here make sure say you dey represent us well avoid anything wey fit spoil our image here you no say Hushpuppi and co. don spoil naija image and these oyinbos go dey take one eye dey look us for any fuck-up.

The issue of trust na very big problem Oo especially for honest nigerians wey dey try hustle to help themselves and their families.  Na why e be say most recent opportunities dey limited from Nigerians. The only thing we fit do na to just try our best and stay true to ourselves. Coz e dey much harder now.

I see that coin oh even KEY all just dey blow dey no wan carry me along. Even chromia too. Infact all Binance coin just dey vex, all dey give two digits returns with very special ones giving three digit returns. They market dey very positive, any coin wey you buy fit turn u big boy in mata of weeks.


Bro no worry too much, That SYS coin don drop small. The news na in 2 days sha. I believe say e go resume pump soon. The surprising thing be say I miss out on those pumps. I been no wan jump in come catch falling knife. Even that MFT you talk about pump about 100%.
hero member
Activity: 1498
Merit: 711
"Play Poker on Telegram"
Welcome on board as you come join us here make sure say you dey represent us well avoid anything wey fit spoil our image here you no say Hushpuppi and co. don spoil naija image and these oyinbos go dey take one eye dey look us for any fuck-up.
make sure say you bring more country people come here so that we go push our local board up like others and to dey compete  with them as you talk am so that we too go dey help ourselves I dey always happi to come this board to come and feel at home na good talk you talk make we dey try and help others.

My brother thank you well well for the advice wey you  give me and the merit too you don give me
Because with una like this we go dey get merit  for this our Africa board.
For public board like this e dey hard before person go get 1merit.
Like these na I dey happy for the merit wey u don give me like these, my heart dey sweet me sugar sugar since are don see new merit
Biko are  dey beg other senior brothers make una dey help us here to dey grow like others.
This our board go help us well well.
Thanks brother are no fit forget you.

sr. member
Activity: 2590
Merit: 322
SOL.BIOKRIPT.COM
My name na George john
Are be male in gender
And I from Nigeria
Are be full son of africa.

Are dey hail everybody wey dey here,my brothers no be small thing for here ooh, i Thankgod well well for me to  see my africa people way I fit tell them my problem concerning bitcointalk forum wey we dey inside together
Waiting dey worry me well well be say some people for this forum wey we first register dey first us dey rank up because of their local board wey them dey

Biko my people of Africa make we try dey help our begginers wey no no anything here so that dey go follow those people wey dey local board from another country dey compete.

I dey happy well well todey to see myself here
And now I can identify my brothers and my people also can know me

My people say waiting wey don affect one person for group were dey belong don affect everybody wey dey the group.

Me are dey beg una make we dey try dey help our people here even when we go to public board make still help our people them.



Welcome on board as you come join us here make sure say you dey represent us well avoid anything wey fit spoil our image here you no say Hushpuppi and co. don spoil naija image and these oyinbos go dey take one eye dey look us for any fuck-up.
make sure say you bring more country people come here so that we go push our local board up like others and to dey compete  with them as you talk am so that we too go dey help ourselves I dey always happi to come this board to come and feel at home na good talk you talk make we dey try and help others.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Me are dey beg una make we dey try dey help our people here even when we go to public board make still help our people them.
Na true you talk about wetin dey happen for other people dem local board. I don notice tey tey how those ones dey take style rub body. We too wey dey here dey try too. I even get like three good posts wey I suppose merit since last week sef but I nor get merit to do am. Na small small bro. Just make sure sey your posts dey make sense and e go surprise you as merit go begin dey touch dem soon.

My people say waiting wey don affect one person for group were dey belong don affect everybody wey dey the group.
E bi like sey you dey like throw proverbs. O ya, make you join me for that my thread on African proverbs for the local board. https://bitcointalksearch.org/topic/m.54765222
Welcome BTW.

@CryptopreneurBrainboss, another round of distribution for CSTI na tomorrow. And na the third and final distribution be dat. I sure sey you be whale for that bounty 🤑🤑
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Mehn today just dey pain me like this. See SYScoin wey I suppose enter go pump 3x in 24 hours without me on the train. Their team yarn say big news dey come by 23rd July. If the news no leave up to people expectations, e go just dump massively. I no wan enter now coz e fit come get corrections.

I see that coin oh even KEY all just dey blow dey no wan carry me along. Even chromia too. Infact all Binance coin just dey vex, all dey give two digits returns with very special ones giving three digit returns. They market dey very positive, any coin wey you buy fit turn u big boy in mata of weeks.

You don check Cartesi wey I mention earlier. E dey Binance o.
Yes, That cartesi eh, I don dey hear as people dey talk about am of recent. E be like something go sup with am soon.

Yes few weeks back I been recieve my own share for the bounty I bi participate in. The project dey very active. Everybody wan create their own decentralized blockchain. The industry dey sweet me die

Welcome @GeorgeJohn
hero member
Activity: 1498
Merit: 711
"Play Poker on Telegram"
My name na George john
Are be male in gender
And I from Nigeria
Are be full son of africa.

Are dey hail everybody wey dey here,my brothers no be small thing for here ooh, i Thankgod well well for me to  see my africa people way I fit tell them my problem concerning bitcointalk forum wey we dey inside together
Waiting dey worry me well well be say some people for this forum wey we first register dey first us dey rank up because of their local board wey them dey

Biko my people of Africa make we try dey help our begginers wey no no anything here so that dey go follow those people wey dey local board from another country dey compete.

I dey happy well well todey to see myself here
And now I can identify my brothers and my people also can know me

My people say waiting wey don affect one person for group were dey belong don affect everybody wey dey the group.

Me are dey beg una make we dey try dey help our people here even when we go to public board make still help our people them.


hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
Mehn today just dey pain me like this. See SYScoin wey I suppose enter go pump 3x in 24 hours without me on the train. Their team yarn say big news dey come by 23rd July. If the news no leave up to people expectations, e go just dump massively. I no wan enter now coz e fit come get corrections.

You don check Cartesi wey I mention earlier. E dey Binance o.

Yes, That cartesi eh, I don dey hear as people dey talk about am of recent. E be like something go sup with am soon. But since them still dey distribute bounties, I go chill first, see if I fit get am a little cheaper.

E get another new one wey I dey shook eye put. Na Platincoin. E dey CMC already and I go like make una help me police am too.


Okay. I go check tge coin out though I never hear of am before. I dey mostly trade coins wey dey binance.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Becky and Brainboss – now wey both ARPA and DGTX don pump... Which coin we dey look into next? I go like join next train.
You don check Cartesi wey I mention earlier. E dey Binance o. And since wey dem start distribution to hunters like me, the coin never dump below IEO price. The last batch for distribution na July 23 and I expect small correction. After that, na to expect Towel of Babel height on top the coin head. Even Curio dey there too. Just 2 million supply. I never see any coin wey dey 2million wey nor pass $1. Anybody don see? Bull rum can take this coin to even $1k.

E get another new one wey I dey shook eye put. Na Platincoin. E dey CMC already and I go like make una help me police am too.

But this Becky (666) own fear me oo. Like, he abi she got it from the bible  Shocked. I no talk anything oo.
Lol... That Becky own fear me join sef. BTW, Becky na guy o 🤓

See this guy with nwa beke name... Lol. I think say you be one afin guy like that from that way  
Charles na one cool dude o. I bin done talk with am for phone sef.


I hail all owa new people for house. Una welcome, wey bread 😘
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
@gabbie2010 I sight u broda man, make we just dey come one by one, inform odas, the goal na to grow this thread into mage thread like 100+ reply once we grab dat numbers, dey must hear us when we apply for our own board. Also make we no forget to show each oda love both on and off this thread.
I be dey reason ham to post for here, but this great thread no dey active before unlike now, I don miss a lot but I go dey visit often now, make una no vex.

Becky666, Lordhermes, gabbie2010 and Gozie51. You be one of the few brothers I just dey know, the kind happy wey dey for my body say I know you plenty.

CryptopreneurBrainboss. Your name for btt no surprise me again, you too get brain. I happy die say you create this thread.


See this guy with nwa beke name... Lol. I think say you be one afin guy like that from that way  Grin. I dey hail all our people here and the once wey go still join too. I believe say we plenty pass as we don see , maybe some still dey form one thing one thing but we dey open our hands to welcome many more.
I think we go get plenty members in @brainboss level self.

@ brainboss, I believe say with time we go even arrange a physical gathering when this thread don begin represent wella. E no go funny. Grin Grin
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
I beg make una keep this thread going so that we no go carry last here.
True talk wey you throwey here but the thing na all of us hand e dey. Make wey make this thread owa own Nairaland. BTW, my conspiracy theory be sey any username wey get number join body for here na Nigerian get am, abi una too nor think so?
Examples like...
gabbie2010
Maestro75
Nelson4lov
Becky666
Dem plenty o... 😁😁And dem need to come identify with other Naija peeps here.


Lol  Roll Eyes Grin Grin. The number thing make me laugh as you line them. I believe say I no follow oo  Shocked. Maybe we like numbers and hoping it could be converted to pepper.
But this Becky (666) own fear me oo. Like, he abi she got it from the bible  Shocked. I no talk anything oo.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Una well done oo! I just the enjoy una discuss na him make I say una Doo!

Na shaking you no get probs but once once make u dey show face make we dey rub head together to achieve greatness for this industry but on and off the forum


Bros, na true you talk because I bin dey go off and on for this forum and na newly I take backlift enter this our thread. But na I wan to dey serious and na im make me wear your agbada for down so that I go begin think say I dey campaign. I try the avatar but the thing too heavy to upload and I no sabi how to resize things. I hail my people.

To resize just Google any resizing site used am, e go work wella. I just reviewed ur profile and you dey try meaning say I dey open to work with you. Just apply for any of my active campaign wey dey accepted full member and u go get am. I appreciate u creating awareness for me doe. tanku.

Becky and Brainboss – now wey both ARPA and DGTX don pump... Which coin we dey look into next? I go like join next train.

The market just get potential die but na how to enta before e start to dey rise na where the problem dey, I just the read through twitter jam dis coin Mainframe although before I fit research am finish, the coin don rise, I read say dey just shift enta DeFi so na wetin burst the price, and since they already dey Binance e make money easy enta. I no buy as the price don fear me but I just dey observe am.

Since I mentioned this project I just notice e do another 50% although me self no buy am. Well I just say me I drop alert say DGTX wey raise from around 5cent to 10cent don dey fall dat's some correction don dey happen so you fit pay attention to the coin see if you fit grab small before nexr bull run happen. Their public launched na 31st of dis month so potential still plenty.
member
Activity: 267
Merit: 11
Una well done oo! I just the enjoy una discuss na him make I say una Doo!
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
@Maestro75 I never see you before, welcome.
Bros, na true you talk because I bin dey go off and on for this forum and na newly I take backlift enter this our thread. But na I wan to dey serious and na im make me wear your agbada for down so that I go begin think say I dey campaign. I try the avatar but the thing too heavy to upload and I no sabi how to resize things. I hail my people.
newbie
Activity: 1
Merit: 0
~
@Nelson4lov where you lost go, well thank God we don dey come back small small

Omo Brainboss, Your man just dey like dele. Remember say I dey learn web development na? I participate for one internship like that – HNG internship. The stress been dey too much so tey I stop after sickness kick in. But I reach the point to get IT placement wey I fit use next year for their office.

That aside, you see this matter una dey yarn so? About falling/participating in scam? mehn me sef get story to tell Oo. The road no dey ever dey straightforward. I remember some hyip I join then, 3.14%  daily. Most of my friends then chop, but immediately I put my cash wey I earn from faucets then, them go maintenance till today, maintenence never finish. No be only that one sha but I want keep my story short. Since then I vow never to enter a ponzi/hyip or any scheme wey dey too good to be true. Na why this new stuffs like Ethereum Money and forsage, I dey frown when people talk about them coz all na to rub peter to pay paul.


Chaii, I feel your pain. It is well
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Becky and Brainboss – now wey both ARPA and DGTX don pump... Which coin we dey look into next? I go like join next train.

The market just get potential die but na how to enta before e start to dey rise na where the problem dey, I just the read through twitter jam dis coin Mainframe although before I fit research am finish, the coin don rise, I read say dey just shift enta DeFi so na wetin burst the price, and since they already dey Binance e make money easy enta. I no buy as the price don fear me but I just dey observe am.

Make una no fear to drop suggestion but try do small research to make people no loss money and always cashout in profit no dey greedy unless you plan to hold that coin for long-term. The project I highlight above me I never buy but just dey observe am, all this DeFi , profit dey am but na for short term oh no go buy dey hold for long as money dey move from one enta another. If you no fit keep up just relax than lose ur money for market. Na trading we dey nobi investing

I take this your observation serious ba add to de plan I don bin get for Ethereum I go buy am now and in time to come I go come back to give testimony

We dey wait, ur greatest challenge go be if you fit get patience because na the key to become a successful Investors. Trading needs smartness, investing needs patience.

@Maestro75 I never see you before, welcome.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
I been buy ARPA last night but I don sell off earlier this afternoon as profits enter coz now no be the kind of time to see profits and refuse to sell.

I reason am sey na fear make you sell am quickly. But you go regret if the price still continue to go up. Ask those people wey sell bitcoin when e dey around $3 and watch as dem go use cry tell you their story of life. Sometimes, life no need make we too dey fear things like that. Me my very sef go like check all the coins wey una don list here to see the one my small cash go reach buy.
member
Activity: 127
Merit: 12
Back in the early days I mumu die, na hyip, doublers, Ponzi abi matrix or wetin dem dey call am self, I no do? I do all but thank God today persin eye don open.

The matter don tey, Ponzi don run men down. Especially our innocent Nigerian youths wey de hustle for internet, them don fall for scam tey tey and still de fall. My self gon gather story for ponzi scheme, them don run me tire. So tey I package my self come go buy touchlight phone make I for no the surf internet again, but for where e no work out. After 3weeks I still jack another phone again, that time bitcoin come begin ring for my head, as I enter na so I take sabi about Cryptocurrency and I no gree leave am again. The funniest thing be say I never earn 1 kobo from crypto, since I start early 2019 but e get as e better pass those Ponzi wey I lost my money no still earn shishi.

The Koko be say, I happy as I don fashi those hyip and ponzi and i believe say everywhere go stew as we never give up the hustle.

The trick na be say instead of to patronize the ponzi, I buy the coin. Ethereum get future oh make I just highlight am. If any coin fit reach bitcoin (four/five digit price) while bitcoin increase more na ethereum especially as this der upgrade dey come. I always tell people say, buy bitcoin, ethereum then any nonsense coin wey u like but make sure u get some of this 2 coins because na dem dey control the industry. See DeFi na, na ethereum blockchain most or all of them dey use etc.

Ethereum get as the future bright reach, them the fight real hard for the market, we no expect less from them. I don follow updates and news to, I believe say them go wan keep the competition strong and in the process they price go rise to something more than as e be now.
Na why I de talk say ba CyptopreneurBrainboss e get as you be motivation for me, na the best the always come from you. I the take this your observation serious ba add to de plan I don bin get for Ethereum I go buy am now and in time to come I go come back to give testimony
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
As our elders talk say "no matter where piking go" when time reach him dey always find way go back home. Na reason I come greet my elders and everybody for house o. Una dò
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
The trick na be say instead of to patronize the ponzi, I buy the coin. Ethereum get future oh make I just highlight am.


This talk make sense. Instead of to join those ponzi schemes, na to buy ETH wey them dey hype, coz I dey sure say thousands of Nigerians wey participate in those schemes buy eth to use join.

E just remind me of when ICOs dey run on ETH, ETH been pump up to $1400 or so just because them dey buy eth to use invest. Nice idea 💡.

Maybe na real-world hustling tins, happy to see u back broda.

Lol. Na true sha. Man dey try improve skillset. Becky thanks Oo.


Becky and Brainboss – now wey both ARPA and DGTX don pump... Which coin we dey look into next? I go like join next train.

Username: Lordhermes
Gender: Male
Country and state of resident: Nigeria/Portharcourt
Developing Skills: Trading.

Before I forget, Lordhermes welcome to the community. I don dey suspect say you be Nigerian since. Me sef dey PH sha 😁
Jump to: