Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 281. (Read 1328144 times)

hero member
Activity: 2660
Merit: 630
Vave.com - Crypto Casino
@Brainboss, your agility dey totori me well. You sharperly rush go do buy back. You nor wan hear story story... Lol.

How far the saga for twitter any body don see am, all high reputed cryptocurrency related twitter profile and some top celebrities account na hushpuppy brothers in work run dem street and I hear say dey don scam like $115,000 already. You think this event go affect price? Positively or negatively.
D whole thing be like sey na Twitter dem completely hack o and then tamper with some popular handles. So, you think sey na Hush boys dem? 🤔. Anyway, I nor believe sey that hack go affect crypto price since nor be exchange wey dem nack. But wait o, those ones wey fall victims come begin send Bitcoin to addresses wey claim sey dem dey do give away with "send one get two" nor be greed dey do dem? Well, everybody dey learn at their own pace sha. I remember when some doublers dem wayo me too in 2017 wen I just enter crypto new. I learn since then.

I don dey read for forum on some fud speculation on the expectation say the hack fit affect the price of bitcoin but me I no dey think like that oo. Btc dey funny oo. Sometimes the thing wey you expect say go pull price down, you go surprise how buy candle go fly up lol  Grin Grin Roll Eyes And you go dey watch ya money floating for river Niger, chai.... Abeg make traders no just go dey sell btc oo, just watch well and be sure it is a trade decision wey you see and not just expectation wey dey your mind.


Quote
I remember when some doublers dem wayo me too in 2017 wen I just enter crypto new. I learn since then.

About this.... I laugh because I also get that experience. I even buy coins they were already listed to be delisted from exchange (lol , how I want take know na. Person dey know wetin dem no sabi ?).

But, I don't know if @brainboss also get this kind of experience.
legendary
Activity: 1652
Merit: 1208
Gamble responsibly
I welcome you wella wella with correct cool water for ya body. E good as you enter this house. We go dey roll the thing dey go together. But Bros, we nor sabi book here o na im make we dey use pidgin dey yarn here. Your English dey knack my head too much
I don go through some of una posts e make sense, to correct say you be all learned and understand English even pass me self, na me be your pikin and need correction and thank you. I never write or speak pigin like that before but I go dey try small. You welcome me good and e make sense.

Welcome @Oshosondy
I respect sey you get rank, I go(went) check your profile, you don work here. Thank you for the welcome.

How far the saga for twitter any body don see am, all high reputed cryptocurrency related twitter profile and some top celebrities account na hushpuppy brothers in work run dem street and I hear say dey don scam like $115,000 already. You think this event go affect price? Positively or negatively.
This na just social media scams, bitcoin price dey well, nothing fit affect ham. If unto say na exchange get fault now, wahala go dey, people can fear convert their bitcoin to fiat and withdraw but the scam na phishing. No exchange dey at fault, this type of scam common for banks self and banks never run down.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
@Brainboss, your agility dey totori me well. You sharperly rush go do buy back. You nor wan hear story story... Lol.

How far the saga for twitter any body don see am, all high reputed cryptocurrency related twitter profile and some top celebrities account na hushpuppy brothers in work run dem street and I hear say dey don scam like $115,000 already. You think this event go affect price? Positively or negatively.
D whole thing be like sey na Twitter dem completely hack o and then tamper with some popular handles. So, you think sey na Hush boys dem? 🤔. Anyway, I nor believe sey that hack go affect crypto price since nor be exchange wey dem nack. But wait o, those ones wey fall victims come begin send Bitcoin to addresses wey claim sey dem dey do give away with "send one get two" nor be greed dey do dem? Well, everybody dey learn at their own pace sha. I remember when some doublers dem wayo me too in 2017 wen I just enter crypto new. I learn since then.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
DGTX too nor dey bad. I go try buy am by next week. Brainboss, e go good make you buy am back sharperly so you nor go ever regret not doing so now, the way I regret selling my 270 BNB coins @3 in 2017 or so before the thing go do $30 and then ATH of $40+ last year.

Na wah for you oh abi u no trust me, I don buy am back sharp sharp. First I buy ARPA for Binance come dey reason say make I just see how e go perform but after like some hours (later in the evening) I come view DGTX again for coinmarketcap, e don rise dey enta 7cents Broda I no think am twice go sell my ARPA (thank God I never withdraw am from Binance by then) then buy DGTX. For next 6months or so na the coin i go dey focus majority of my investment in. I believe the project die na just busy body make me go sell am.

How far the saga for twitter any body don see am, all high reputed cryptocurrency related twitter profile and some top celebrities account na hushpuppy brothers in work run dem street and I hear say dey don scam like $115,000 already. You think this event go affect price? Positively or negatively.

Welcome @Oshosondy
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!

I don already pack small ARPA keep on Binance. Since na Defi, e go suppose dey burn go down. Na around 1,450 billion e dey from the original 2billion. DGTX too nor dey bad. I go try buy am by next week. Brainboss, e go good make you buy am back sharperly so you nor go ever regret not doing so now, the way I regret selling my 270 BNB coins @3 in 2017 or so before the thing go do $30 and then ATH of $40+ last year.

The greatest risk for life as people wey sabi book dem dey talk, na to nor take risk at all.


Username: Oshosondy
Country: Nigeria
State of residence: Oyo
Skills: Trading
I welcome you wella wella with correct cool water for ya body. E good as you enter this house. We go dey roll the thing dey go together. But Bros, we nor sabi book here o na im make we dey use pidgin dey yarn here. Your English dey knack my head too much 🤡🤡
legendary
Activity: 1652
Merit: 1208
Gamble responsibly
Username: Oshosondy
Country: Nigeria
State of residence: Oyo
Skills: Trading

It took me long to make my first post here, I joined few weeks ago but unknown to me about how this forum works, getting acquainted daily and knowing more. At least I know few people now that are Africans which makes me happy like I am not lonely here. I had a good start but I will like more of your help in term of encouragement, advise and many more and I hope you will not let me down.

I have made few topics...
https://bitcointalksearch.org/topic/m.54796274
https://bitcointalksearch.org/topic/m.54657290
https://bitcointalksearch.org/topic/m.54650180

...and I want to improve more, I hope you can advise me on that. Thank you all.
hero member
Activity: 1666
Merit: 709
Playbet.io - Crypto Casino and Sportsbook
Username: Alobo Realer
Country: Nigeria
State of resident: Benue
Skills: Web Developer in View.

Samakpe for you, I get jolly for my Belle as I see my 9ja people interested in bitcoin, guy welcome.
I go advice make you reason wetin @upgrade don yarn e go help you for your stay here, baba the forum no hard Na many people soft, just do your thing in a right way.

Read rules if you never read am before
https://bitcointalk.org/index.php?topic=703657.860

Also read this one join
https://bitcointalksearch.org/topic/newbies-read-before-posting-1689727

Reading go help you for here well well.

Welcome my brother
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Welcomed @Maestro75 and @Alobo Realer
Make I go check all them altcoins wey una don recommend for here, my experiences with most of them don teach me say they no too dey reliable for the long-term, but better potential dey for the short period to hit better ROI.

Very true but sometimes the thing they go the other way. I if remember my 2017 experience with Binance tokens I get am like thousands but sell later after I noticed is no they rise again for sometime. Fast forward to today check prices see how far. Same with chainlink and most currently DGTX. This one own na him dey pain me pass. After all the patience I give am just sell am around 4cent and today e dey 6cent plus.

I dey reason buy am back as I believe in the project seriously but I dey fear correction anytime soon. That coin ARPACHAIN wey I suggest e don dey do me two two well the issue na my whole heart the bleed for my supposedly $DGTX lost, I fit pause by back my token anytime from now or wetin una think?

Person fit reason me how e see the project Digitex future exchange? and if na you among the two projects, which one you fit reason long term pass?
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
Important information: Nigeria Naira becomes first Fiat currencies to be listed on Binance.
Na dis thing make Binance exchange take dey pass other exchanges be dat. Once the CEO, CZ Binance, see anything wet go enhance im company, de guy no dey waste time to follow am up. Him realize dey so many Nigerian traders dey the Binance platform and to keep these people happy na im make am introduce naira enter Binance. Correct guy.

Abeg, make Una no reason am sey I be forget to introduce myself here even though e don tey wey I don dey this forum but I no too kukuma sabi this thread.

Username: Maestro75
Country and state of resident (optional) Nigeria
Skills: Student and school teacher, but I plan learning online stuff too
member
Activity: 127
Merit: 12
Becky666 and Mpamaegbu I gather courage take remove my Cap and shoe as I drop my chest for ground the take thank una for this ogbonge welcome. I pray say make the blessings Wei baba God don promise no go pass una by, and for this great opportunity una take give our dear people like this una reward go be for only heaven...

Mpamaegbu Hon Samuel Ortom dey very alright, Corona virus the only pass through him head but no the catch am, im the pay Salaries (im major achievement), im the travel and lots more...
legendary
Activity: 2254
Merit: 2406
Playgram - The Telegram Casino
Make I go check all them altcoins wey una don recommend for here, my experiences with most of them don teach me say they no too dey reliable for the long-term, but better potential dey for the short period to hit better ROI.

Welcome to all the new members dem wey don join the community, e go make sense if this thread stays active and those new members fit ask all their questions here and easily transition into the main forum.

• No copy any person work without source, and
• No engage in scam or share links wey fit steal person funds.
Asides this ones, just dey read and learn.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
My eyes dey on that ARPA stuff, and now I don add the new one wey BB throw out to us — DGTX, I go try buy some units this week. I thank all my guys here for throwing these ones out. One love!

Alobo Realer, I throw cool water for body to take welcome you, bro. How Samuel Ortum dey na? Anyway, just relax and keep making better posts. The merits go come when you nor even expect am. I sabi how the thing dey be, especially when you never begin dey get campaigns to dey put food for your table and pay for your data.

My people, una fit put eye for this thread on Africa proverbs wey I start here African Proverbs in Pidgin
full member
Activity: 756
Merit: 231
Username: Alobo Realer
Country: Nigeria
State of resident: Benue
Skills: Web Developer in View.

My experience in the Forum: my experience in the forum is quite interesting and educative. I've learned so many things from this community, I joined as a novice to cryptocurrency, had no ideal what Bitcoin was before I joined the forum, but after due follow up and research I discover this is the best place fo me, and at a point i regreted for not knowing it before the time I knew it.lol..
Welcome broda, u are highly welcome to b part of dis movement nd hope 2 see u doing well, don't get urself into trouble, b respectful 2 forum members.
Quote
Everyone here is friendly and kind, but make I no lie, e hard to get merit for this forum, my struggle to get merit don land me into knowing plenty things about Bitcoin and other cryptocurrencies wey I don fall in love with. That one na like killing two birds with one stone, even I never too get merits I don know much about cryptocurrencies and I don know how and where to invest my money..

Merit go com wen u dey do d right things, kip up d gud work. Advise: don't post becus u want to; but present facts nd also convince members.
member
Activity: 127
Merit: 12
Username: Alobo Realer
Country: Nigeria
State of resident: Benue
Skills: Web Developer in View.

My experience in the Forum: my experience in the forum is quite interesting and educative. I've learned so many things from this community, I joined as a novice to cryptocurrency, had no ideal what Bitcoin was before I joined the forum, but after due follow up and research I discover this is the best place fo me, and at a point i regreted for not knowing it before the time I knew it.lol..
Everyone here is friendly and kind, but make I no lie, e hard to get merit for this forum, my struggle to get merit don land me into knowing plenty things about Bitcoin and other cryptocurrencies wey I don fall in love with. That one na like killing two birds with one stone, even I never too get merits I don know much about cryptocurrencies and I don know how and where to invest my money..
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.

Alert! #ARPACHIN has done more than 50% correction and for those wish to enter can as well do. Personally I have already hold up some stash and hoping for a good time with #ARPA. Ensure you do your homework before leap into this trade. E go get as im b if una no dey check something wit 4 dis thread. My previous coins gave somtin gud shiaaa.

Exactly waiting dey hold me never buy na because my payout for 777coin and Bitvest for like four weeks now never come, immediately I recieve am I dey buy without hesitation and wait patiently for another massive run wey d coin go do. Brother dey put coinmarketcap for any project you suggest or link to anywhere person fit see how far the project.

I get another coin I dey follow for a very long time wey be DGTX e do impressive run last week due to Kucoin listing but I me self sell before den so I dey wait for correction too to buy back. I just say make I let una know whatsup.
full member
Activity: 756
Merit: 231

 Wetin I dey try talk be say I no get idea oh but my eye dey dis coin ARPACHAIN I hear say e dey shift focus go DeFi and the thing blow get 100% in 24hrs on Binance but I notice e don dey fall. I just dey observe as if e fall go around $0.02 or less, e go be my very first DeFi focus project wey I go invest in, never too sure what.
Alert! #ARPACHIN has done more than 50% correction and for those wish to enter can as well do. Personally I have already hold up some stash and hoping for a good time with #ARPA. Ensure you do your homework before leap into this trade. E go get as im b if una no dey check something wit 4 dis thread. My previous coins gave somtin gud shiaaa.
member
Activity: 127
Merit: 12
Each family will get the basic food items like Rice, Garri, Beans, Palm and Groundnut oil etc
@cryptopreneurbrainboss I will have to thank you for accepting to share those food items to the poor and needy in Port Harcourt but these people will not only need food during this hard time. Our old women and grand children need to be clean too, as i see alot of dirty children in the streets, I think they should also be a provision for Detergents, Soup, toothpaste and detols for them too. At least to wash and clean up their environments. My regards to Royse and Lauda also to @soldierswithlittlefaith your faith is very sufficient.

Wow! The world is dominated with good people, but stained with a little touch of bad minded people... Men that personally to do such charity are rare, how lucky is Africa to birth such selfless and great personality.. Someday everyone will know the advantages of giving and as well learn to give..

@CryptopreneurBrainboss you are a blessing to Africa..
full member
Activity: 756
Merit: 231

E b like say u dey my mind Boss, I b dey tink am say mak I tell u dis early dis week but tank God na u com talk am.

Na brain wave something, make we try send message to our brothers so dem for come contribute here, trust me once here dey active everywhere go stew.

Anybody eye dey for any DeFi token wey never enta mainstream?
Like as u talk, some of our peeps are now ready 2 join us 4 d movement tins, dem dey keep deir face make dem no know dem as naija peeps but dat I told dem will not help us here. Hope 2 see dem waka wit us on dis.

For d defi, we go dey update ourselves on de mata. For now, ur child dey observe.

Edit:
Dose who like am 4 altcoins trade or potential coins for long or short term can do their due diligence 4 dis coins:
#AST, #DREP..... I repeat!!! Do due diligence, bikonu.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
BB, na you go help us sharperly find this one. Even your job as a manager go make am very easy to spot too. Abi nor be so?

Na before altcoins dey reason me make I manage them and d funny thing be say den I dey hustle to get BTC paying campaign so I just ignore all of dem as I feel stress full there. Wetin I dey try talk be say I no get idea oh but my eye dey dis coin ARPACHAIN I hear say e dey shift focus go DeFi and the thing blow get 100% in 24hrs on Binance but I notice e don dey fall. I just dey observe as if e fall go around $0.02 or less, e go be my very first DeFi focus project wey I go invest in, never too sure what.

I think talent wise burnaboy is far above davido aka frog voice, only wizkid can come close. I hope burnaboy can give us the Grammy award some day

Abeg where e talent been dey when Wizkid and davido dey hold the industry down for 10 straight years. Burna belike all those self acclaimed ethereum killers, small attention dey don dey call demselfs odogwu abeg make e go rest abeg.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Dose two tokens wey u touchlight so eh dem enta eye but as I look am wetin discourage me small na the kind exchange dem dey although dat one no means say I no go keep dem close so I fit the observe dem ones once.
I agree sey Probit nor be the best of exchange. Me too reason am as I pursue that Curio token enter there. But na one of the risks wey we dey take for this crypto industry be dat. And the good thing be sey persin fit withdraw am put for MEW/Imtoken sharperly. As for ESH, check well. The coin dey for many better exchanges.


See eh this industry just funny carelessly imagine dogeccoin dey give impressive ROI of 500% and the DeFi related coins just dey scatter market. I believe choppings dey der.
Na that "to $1" challenge wey some American boys stage on top Doge head dey drive the price go up. I get like 10k units wey I buy three years ago. Make Oluwa help dem push am enter even $0.50 self, na hammer for my end be dat 🤑🤑


Anybody eye dey for any DeFi token wey never enta mainstream?
BB, na you go help us sharperly find this one. Even your job as a manager go make am very easy to spot too. Abi nor be so?
Jump to: