Author

Topic: Nigeria (Naija) - page 159. (Read 554634 times)

legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
March 10, 2022, 03:30:03 AM
You come see that kind of people ehhnnn, after they don sell their products finish and come want to buy goods offline and they observed say price don go up, them go join other Nigerians they shout say everything don cost but them go forget say they do am too.
All what you have been saying is just existing in an open market operation, it is not a close market. If you think the price is too much, then go and buy from another person. But I understood you, there is no way people are not scammed this way, but this is not at all the cause of inflation in Nigeria, inflation starts from what declines naira purchasing power.

For example
It can begin from increase in petrol price
It can begin from increase in food stuff price
It can begin from government decreasing the purchasing power of naira directly

I dey beg una to try put body for politics for full or use money support candidate, make people wey hate bitcoin no become leaders come put laws wey go affect our wealth. Me and you fit still be government.
Don't you know we have politicians among us  Grin

You are right, but you know that Buhari government are full of illiterates that went to school. But in Africa, only four countries placed total ban on bitcoin and other cryptocurrencies, all the four countries are White (North) Africans while no Sub-sahara Africa that totally banned bitcoin yet. But you are right about what you said.

But the rumour weh deh ground be say America and EU fit take vex ban bitcoin so they can wicked Russia more.
Only regulation, never mind misconceptions that can cause FUD.
sr. member
Activity: 1890
Merit: 328
March 10, 2022, 02:46:56 AM
My broda me like this no put mind for 9ja politics again or even dey listen to them cock and bull mata wia dem dey promise pipo heaven on earth say dem go do dis and dat.

E no go too make sense if we no reason politics for 9ja completely o as young people. Na true say our country don park up somehow, especially this Buhari time but we go still deh watch and concern ourselves with matter for 9ja. Otherwise old people in diapers as we deh see them declare now go take over in 2023. Every person go get your PVC.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
March 09, 2022, 09:30:27 PM
NEW TOPIC: Politics and Cryptocurrency

For many countries like my own (Naija), general elections go happen next year (2023). Politicians don dey make their underground waka, some done dey jump from one party to another, some don dey talk the positions dem wan occupy. But, we wey sabi crypto, e be like politics no concern us. No mata sey we get brain pass dem, but we no gree join for politics.
9ja politics and politicians way b lyk watin I no sabi. There mata just be as e get nd u fit mad if na to understand dem b ur wahala. These people dey play politics like say, na only 4 we country d tin dey exist abi na we originate d tin. We dey sabi ova do shah bt, the fact say person no even ft dey query there pattern na em dey tire me nd na watin still dey giv dem mind 2 dey do us anyhow.

Na so dem ho just dey decamp 4rm 1 party 2 d orda 1ce e be lyk say, e no dey favour dem. I no dey wan reason there mata becus, e fit turn a very gud day 2 a worst day.

My broda me like this no put mind for 9ja politics again or even dey listen to them cock and bull mata wia dem dey promise pipo heaven on earth say dem go do dis and dat. E better say make pesin just put mind hia to know wetin him fit carry im life do we country dey carry last wella wella, afer everi tin dem go carry money put for pocket forget me an you.
hero member
Activity: 896
Merit: 645
March 09, 2022, 07:09:13 PM
NEW TOPIC: Politics and Cryptocurrency

For many countries like my own (Naija), general elections go happen next year (2023). Politicians don dey make their underground waka, some done dey jump from one party to another, some don dey talk the positions dem wan occupy. But, we wey sabi crypto, e be like politics no concern us. No mata sey we get brain pass dem, but we no gree join for politics.
9ja politics and politicians way b lyk watin I no sabi. There mata just be as e get nd u fit mad if na to understand dem b ur wahala. These people dey play politics like say, na only 4 we country d tin dey exist abi na we originate d tin. We dey sabi ova do shah bt, the fact say person no even ft dey query there pattern na em dey tire me nd na watin still dey giv dem mind 2 dey do us anyhow.

Na so dem ho just dey decamp 4rm 1 party 2 d orda 1ce e be lyk say, e no dey favour dem. I no dey wan reason there mata becus, e fit turn a very gud day 2 a worst day.
hero member
Activity: 812
Merit: 573
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
March 09, 2022, 06:42:52 PM
Becoz Mbappe pick morning, him go halla Madrid.
Bezema come pick to go buy three benz Grin
Ornah gud evening, I dey greet in akwa-ibom
hero member
Activity: 1050
Merit: 501
March 09, 2022, 05:42:18 PM
NEW TOPIC: Politics and Cryptocurrency

For many countries like my own (Naija), general elections go happen next year (2023). Politicians don dey make their underground waka, some done dey jump from one party to another, some don dey talk the positions dem wan occupy. But, we wey sabi crypto, e be like politics no concern us. No mata sey we get brain pass dem, but we no gree join for politics.

If elections finish, our eyes go clear when people wey hate bitcoin and crypto, wey no too sabi money mata go become our leaders. Them go begin sama law wey no go favour bitcoin, like to ban it. We go return here begin cap say government wan kee bitcoin. Na who be government? Na we, but we just leave am for others to run.

Me I don gather mind to run for my ward councillor, I dey popular and my people trust me but na money dey yarb man.
I dey beg una to try put body for politics for full or use money support candidate, make people wey hate bitcoin no become leaders come put laws wey go affect our wealth. Me and you fit still be government.

Translation: English
Anything concerning politics remove hand from am. Nigeria politics na big dirty game. No be the right people d win for Nigeria election. Na mago-mago wet all d take win. If you are not in the ruling party, you can't win in any ward for your community.
This country politics don tire me. How can high court order the removal of a sitting governor(Umahi) and his deputy based on sae em change party. Dey accused am sae no be him win Ebonyi state governorship election, sae na PDP.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
March 09, 2022, 05:20:45 PM
as banks fail and the hope of all Ukrainians depends on bitcoin, and the future of Russia's economy would also rely on bitcoin due to sanctions imposed by NATO and the EU, forcing them to legalize bitcoin as the only means of international trade.

But the rumour weh deh ground be say America and EU fit take vex ban bitcoin so they can wicked Russia more. This one fear me when I read about am and e fit happen. America fit do anything to rubbish Russia apart from wetin go affect their country. This war going on don begin to not make sense to me. Eh deh make me reason say so many things no deh the way news deh carry am. So many hidden secrets unexposed with all the parties weh deh involved for the war.
The koko be say no body fit ban Bitcoin, why you no ask yourself why Satoshi remains anonymous despite all the fame surrounding Bitcoin the koko be say na because of Bitcoin freedom that na why Satoshi remain faceless and that na the power behind Bitcoin decentralized nature nobody fit control Bitcoin. So nothing like America or EU ban on Bitcoin they don't have that capacity, the thing we're the happened be say America and EU don play they last card and Russia done prepared for anything were go happen. Russia done replace Swift with unicorn a china gateway which will connect Russia to the rest of world.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
March 09, 2022, 02:03:17 PM
If you wish to convert your coins to Naira Igehhh Xchange is at your service, my rates are better and faster, you also stand a chance to spend 1 night in Dubai,  Wink just DM me.
Hehe, this is serious mate.
is there any specific amount to qualify individual to spending a night over Dubai Like total amount to exchange with  Igehhh Xchange before hitting out the target?
A min of $500 transactions qualify you for a raffle draw tickets to win amazing gifts and if lucky enough you go win the ticket to travel to Dubai that's how I operate.

NEW TOPIC: Politics and Cryptocurrency
~snip~
With or without Nigeria, Bitcoin will gain the most adoption before the next halving in 2024, as the Ukraine&Russia war turns out to be the event Bitcoin needed to gain the most adoption, as banks fail and the hope of all Ukrainians depends on bitcoin, and the future of Russia's economy would also rely on bitcoin due to sanctions imposed by NATO and the EU, forcing them to legalize bitcoin as the only means of international trade. I don't care who wins the next election, but one thing is certain: Nigeria will not be left behind.

Na eye service we dey play just to please America once den legalize Bitcoin we go follow too.

Okay, thank you boss let see how it goes anyway.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
March 09, 2022, 01:57:43 PM
as banks fail and the hope of all Ukrainians depends on bitcoin, and the future of Russia's economy would also rely on bitcoin due to sanctions imposed by NATO and the EU, forcing them to legalize bitcoin as the only means of international trade.

But the rumour weh deh ground be say America and EU fit take vex ban bitcoin so they can wicked Russia more. This one fear me when I read about am and e fit happen. America fit do anything to rubbish Russia apart from wetin go affect their country. This war going on don begin to not make sense to me. Eh deh make me reason say so many things no deh the way news deh carry am. So many hidden secrets unexposed with all the parties weh deh involved for the war.
It's not conceivable; there is no control room for bitcoin; you can only impose restrictions on it; I don't see how that would effect Russia. I've said before that bitcoin is a freedom money that one has control over. The only bold step they took was to ask exchanges to ban Russian users, which they all declined. Bitcoin was made for a season like this and it's already serving its purpose. Also, keep in mind that Binance, OKX, and other top exchanges are owned by Asians and Americans are not allowed to trade on them, so why would they take orders from the EU or America?

Bro just relax nothing dey happen all these na initial gragra.
sr. member
Activity: 1890
Merit: 328
March 09, 2022, 01:35:13 PM
as banks fail and the hope of all Ukrainians depends on bitcoin, and the future of Russia's economy would also rely on bitcoin due to sanctions imposed by NATO and the EU, forcing them to legalize bitcoin as the only means of international trade.

But the rumour weh deh ground be say America and EU fit take vex ban bitcoin so they can wicked Russia more. This one fear me when I read about am and e fit happen. America fit do anything to rubbish Russia apart from wetin go affect their country. This war going on don begin to not make sense to me. Eh deh make me reason say so many things no deh the way news deh carry am. So many hidden secrets unexposed with all the parties weh deh involved for the war.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
March 09, 2022, 12:39:50 PM
If you wish to convert your coins to Naira Igehhh Xchange is at your service, my rates are better and faster, you also stand a chance to spend 1 night in Dubai,  Wink just DM me.
Hehe, this is serious mate.
is there any specific amount to qualify individual to spending a night over Dubai Like total amount to exchange with  Igehhh Xchange before hitting out the target?
A min of $500 transactions qualify you for a raffle draw tickets to win amazing gifts and if lucky enough you go win the ticket to travel to Dubai that's how I operate.

NEW TOPIC: Politics and Cryptocurrency
~snip~
With or without Nigeria, Bitcoin will gain the most adoption before the next halving in 2024, as the Ukraine&Russia war turns out to be the event Bitcoin needed to gain the most adoption, as banks fail and the hope of all Ukrainians depends on bitcoin, and the future of Russia's economy would also rely on bitcoin due to sanctions imposed by NATO and the EU, forcing them to legalize bitcoin as the only means of international trade. I don't care who wins the next election, but one thing is certain: Nigeria will not be left behind.

Na eye service we dey play just to please America once den legalize Bitcoin we go follow too.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
March 09, 2022, 11:48:19 AM

If you wish to convert your coins to Naira Igehhh Xchange is at your service, my rates are better and faster, you also stand a chance to spend 1 night in Dubai,  Wink just DM me.


Hehe, this is serious mate.
is there any specific amount to qualify individual to spending a night over Dubai Like total amount to exchange with  Igehhh Xchange before hitting out the target?

hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
March 09, 2022, 10:33:14 AM
NEW TOPIC: Politics and Cryptocurrency

For many countries like my own (Naija), general elections go happen next year (2023). Politicians don dey make their underground waka, some done dey jump from one party to another, some don dey talk the positions dem wan occupy. But, we wey sabi crypto, e be like politics no concern us. No mata sey we get brain pass dem, but we no gree join for politics.

If elections finish, our eyes go clear when people wey hate bitcoin and crypto, wey no too sabi money mata go become our leaders. Them go begin sama law wey no go favour bitcoin, like to ban it. We go return here begin cap say government wan kee bitcoin. Na who be government? Na we, but we just leave am for others to run.

Me I don gather mind to run for my ward councillor, I dey popular and my people trust me but na money dey yarb man.
I dey beg una to try put body for politics for full or use money support candidate, make people wey hate bitcoin no become leaders come put laws wey go affect our wealth. Me and you fit still be government.

Translation: English
hero member
Activity: 910
Merit: 875
Not Your Keys, Not Your Bitcoin
March 09, 2022, 09:46:41 AM
Increase in online sales price

My people, I greet senior men and brilliant ladies.
I don notice something way they bother me with Nigerians and I say make I discuss the matter with my people.
No be new thing say inflation don chop us but after looking at the main causes, I found out say we they among wetin they add to increase in price of goods and services.
You don notice how online people way they sell things for WhatsApp, IG, Twitter and Facebook they market their products?
I know say we get increase for price of goods and services but the way these guys they put price for things, you go think say na from Ebay you they order something.
Na so I see one shoe for IG way enter my eye oooh say make I price am, the guy say na 50k, I laughed because normal normal I go see that shoe buy for igbo man shop for 20k if the price too go up be that but when e reach online sellers, they go want to use you start 3 duplex foundation. This thing they very common for every online vendor and the thing no good. As a sure guy, I know say OG PRODUCT dy mad for price but make we they try calm down abeg, wetin na.

You come see that kind of people ehhnnn, after they don sell their products finish and come want to buy goods offline and they observed say price don go up, them go join other Nigerians they shout say everything don cost but them go forget say they do am too. Abeg make all of us they calm down, I  know say all of us want to put something for table but no go they over do things, you self they contribute to this things, no they blame govument for everything.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
March 08, 2022, 03:45:30 PM
If you’re not worried about your privacy cause the bank transaction will show your real name you can trade with CryptopreneurBrainboss. He is trusted member of the forum
The best way to maintain privacy is the use of noncustododial wallet and decentralized exchange, but while exchange to naira, you will most likely have no option than for the seller to know your bank details (unless you use bank account of someone you know, or you meet the person physically which can be far worse than giving out your account details). Even while using decentralized exchanges, most payment method do not favour Nigerians than to use bank account which are also accepted by other Nigerians that are making use of decentralized exchanges.

I can recommend CryptopreneurBrainboss, he is a reputed member on this forum. I also strongly recommend Igehhh that can provide such service too, he is a reputed member as well.

Yes you can deposit and withdraw Naira on Luno with the help of the new Implemented voucher, if your KYC is verified you are good to go, you can watch this video for more insights
https://youtu.be/n9mPjBX5uPE
Exactly. There is a link directly from Luno I came across few months ago when it started supporting naira withdrawal ending of last year:

Luno’s status in Nigeria (UPDATED)
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
March 08, 2022, 03:14:43 PM
Can I use Luno to exchange to naira?

I have used Luno before to exchange to naira but I stopped when central bank ban crypto and find another way I can convert to naira, you can not be able to convert to crypto that time because Luno make it impossible. I have a friend that told me that it is possible now to convert crypto to naira on Luno but I do not know how.true it is because I met him online for business and I have not trust for him.

Is anyone in Nigeria on this forum still using Luno? Can you convert your crypto to naira on Luno again now?
Yes you can deposit and withdraw Naira on Luno with the help of the new Implemented voucher, if your KYC is verified you are good to go, you can watch this video for more insights
https://youtu.be/n9mPjBX5uPE

If you wish to convert your coins to Naira Igehhh Xchange is at your service, my rates are better and faster, you also stand a chance to spend 1 night in Dubai,  Wink just DM me.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
March 08, 2022, 10:31:24 AM
Can I use Luno to exchange to naira?

I have used Luno before to exchange to naira but I stopped when central bank ban crypto and find another way I can convert to naira, you can not be able to convert to crypto that time because Luno make it impossible. I have a friend that told me that it is possible now to convert crypto to naira on Luno but I do not know how.true it is because I met him online for business and I have not trust for him.

Is anyone in Nigeria on this forum still using Luno? Can you convert your crypto to naira on Luno again now?
Luno na for scammers avoid am, I go dey use one one eye dey look you Sha, make u dey qame!
Na Binanace self make me para once and  i come swear say for my entire life i no fit ever try that exchange again. I no even no weither na so them dey operate for other countries abi na we govenment give them that hands

If you’re not worried about your privacy cause the bank transaction will show your real name you can trade with CryptopreneurBrainboss. He is trusted member of the forum. You can pm him to know his exchange rate. I think it’s good to trade with each other. If the trade goes terribly wrong you can create a scam accusation thread with proofs. Any foul play and the person loses his account.
hero member
Activity: 1050
Merit: 501
March 08, 2022, 09:43:13 AM
As person deh university make them go learn skill join am. No too rely on your university qualification alone, that university paper no mean much again.
Especially our naija own unfortunately, you know say other countries dey follow know wetin dey sup for this our country sometimes. If every every year ASUU dey go strike and dem dey talk am for news, people for outside still dey hear am, so even if you finally carry your certificate cun go there, dem know say nothing come out because nor be small strike you dun face so. Nigerian educational system is in a sorry state, it is not enough to just go to school (school is important) but nor go loose guard oooo, first class dey still find work for Nigeria, even after you get work, the work fit nor dey okay to sustain your expenses, focus!
skills dey very important naw as u talk coz nah him be the koko, since the university paper don cast and no dey put food for table for belle to dey hot wella. For our contri now, wetin persin read for university no dey pay for job matter, nah wetin u fit do.  E go gud to carry handiwork join body so that if the paper no bring moni, ur hand wey work go bring and tinz go dey go back to back.
Skills dey very important for person life, but who and who are ready to learn the skills? Nowadays our youths are all eager to make quick money, no one wan d under person to serve am for months or years as d case may be. Everyone wants to be his or her boss. Na why yahoo, prostitution, crimes and ritual full for the town. No one wants to serve the other.
In years to come, I don't know what will be of this our country with the level of social vices happening in the land
sr. member
Activity: 1890
Merit: 328
March 08, 2022, 09:28:59 AM
It was not a scam exchange when I use it, have Luno turn to scam exchange? Or there are many Nigerians on the exchange that scam others?

Your name na him deh make me laugh first. Oh boy which kind name be that weh you collect for yourself. Am sure you must always look am up for papaer every time you want to login. See wahala. Make I talk about the Luno matter small. E never too long when that South Africa owned company get issue with Nigerians and they freezed many accounts like that. No be small thing that time o, na like two years ago that thing shele. You go need to find out if Nigerians still deh use that app before you use am o.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
March 08, 2022, 09:18:01 AM
Can I use Luno to exchange to naira?

I have used Luno before to exchange to naira but I stopped when central bank ban crypto and find another way I can convert to naira, you can not be able to convert to crypto that time because Luno make it impossible. I have a friend that told me that it is possible now to convert crypto to naira on Luno but I do not know how.true it is because I met him online for business and I have not trust for him.

Is anyone in Nigeria on this forum still using Luno? Can you convert your crypto to naira on Luno again now?
I been dey use Luno b4 but when them block naira deposits and withdrawal I come stop to the use ammm but they been send me one email say the deposit and withdrawal of naira on the Luno have been restored but I never use amm since then. But I think they are back now but you go use your head with them since we're be say other users dey complain of scam from the exchange but me personally I never experience scam there b4 so I no fit talk on that matter unless person fit share evidence of scam from Luno here.
Jump to: