My country people, una well down o.
I go just dey straight forward with this post. this one na about the issue wey don dey our local board recently, this one na about the issue of members of our local board, creating low quality content they wey somehow no make any sense at all. this one come be like say Dem dey spam our local board, just to take fish for merit.
As oga Igebotz be don talk am here, even many of us go still don notice am and this one na true talk e talk.
una don finally turn the local board to Facebook.
The rate wey many off topic threads come take dey our local board now, e just come too much. person no fit find better thread talk put for local board again. As of September, I no too notice the matter, because them no too cast. but since the beginning of October, I don dey see many post, wey fit the off topic Wella. As we all know say e never too tay, wey Dem give us our local board and all of us dey play our part to make sure say the local board dey active. And if una check, una go see say we dey amongst the most active local boards for the forum.
That one na normal as we no Sabi carry last. but to keep our local board active, make we no come dey forget say here na Bitcointalk, no be
FACEBOOK, TWITTER,TIKTOK.the website original supposed dey about matter wey concern
Bitcoin, cryptocurrency, economy and many more thing wey concern money matter. when I observe other local board them, I come see say Dem too don get sub boards to take discuss other issues. their normal board jus dey for Bitcoin and cryptocurrencies alone. But for we board, we never get any
child board at all and many other request wey don de ground but Dem Admins Dem never still grant us any. the
OFF TOPIC board, na one board for now, wey I think say go clear if we get for now, but I no know how possible, e dey wey Dem go fit grant us this request. so I wan ask our oga them wey be senior men for we local board, make Dem still try as na only Dem know how to take run the matter.
if you check these topics
una go see say, them no fit anywhere but off topics and e no go sharp make we just dey spam board with all these kind low quality post maybe in hopes of earning merits.this one no be only newbies dey run am, but even higher members still dey do this matter.
This na why I bring this small suggestion, I no know if e make any sense since I'm not sure I'm in any position to make such suggestion, but I want make our people dem use one thread for now take dey post off topics, just like the ones wey I list for up. for now, we go just try dey discuss off topic matter for the thread, then leave main board with topics like
BITCOIN, CRYPTOCURRENCY, ECONOMY, POLITICS, MARKET AND ALL OTHER THREAD WEY FIT HELP PEOPLE FOR wey dey local board, navigate the forum Wella.this one na just my suggestions Sha, and I go like make we come together help our selves for now put head together talk for this matter. if majority agree with the idea, then make one of our oga Dem create the thread and As e go make sense Wella. Lastly, I go like make una still talk if we go just use this thread as the OFF TOPIC THREAD, instead of creating a new one.
(abeg no unessesary comment for this thread. if you no get watin to talk)