Pages:
Author

Topic: To chop no be small wahala for the country - page 2. (Read 548 times)

full member
Activity: 392
Merit: 236
Bitcoin in Niger State💯
October 01, 2023, 06:01:37 PM
#31
The salary of an average Nigerian worker is about N150,000( $160) per month and this is for graduates that have put in some years of service.
Abegy which average Nigeria citizen wey dem d pay 150k per month? I wan see them cos this 150k wey you mention don mad me cos I never hear or I see any graduate wey d pay such amount of money at this time wey em d hard some state government to even pay the small minimum wage wey be 30k. Even the recent minimum wage wey NLC d ask of, FG no wan implement am into law.

Abeg help me ask am well o. This one sha shock me reach my bone marrow. Why this person dey talk like say e no know wetin dey sup for Naija. Make we even say dem born you inside sliver spoon, yet you supposed to know say average salary for Naija no be 150k na. For this one, me and you no need Google am.

If you dey on ground, you supposed sabi say na only Federal works dey even pay above 100K for a start at level 8. For state, some Directors wey I know no dey really collect pass that o. E go shock you self. Na why plenty civil servants wey no get heart dey fit still government money be that. As Director, person don dey near him pinnacle for him civil service career be that, yet see wetin dem dsy offer am. Something around what another person wey dey work NNPC or so go collect for a start. Because I forget to mention say, no be all federal works sef dey give 150k for start o.

We no dey talk about this because say we dey happy about the status quo but the last time wey I check, our minimum wage no pass 30k. That na just around 30-35 dollars. Abeg, as you dey comot house every morning of the week dey go work place come back by evening, your minimum wage na 30k. Wetin you get to come show for house and how you wan take handle your bills when fuel subsidy removal kasala don burst too.

For our information, FG been just announce this evening, after him meeting with the Labour, say em go increase the provisional minimum wage for all treasury-paid Federal Government workers to 35,000 naira for the next 6 months. Chai, na him someone dey call 150k as average? Dey calm down na bros.
full member
Activity: 252
Merit: 157
September 30, 2023, 04:14:37 PM
#30
The mata no be small thing ooh, the rate at which commodities food stuffs and other things are increasing everyday is not proper at all, how can as big as Nigeria nothing like price control and not even that government is not aware of all this increment on commodities but they choose to ignore it and watch people surfer, actually is expected of the government to make things on a equilibrium state by implementing price control and enforce it using agency that monitor all the selling activities, at least with that things would have been a bit chipper and affordable.
full member
Activity: 560
Merit: 161
September 30, 2023, 02:15:27 PM
#29
It is so painful that if you calculate the amount money wey they come into your hands for the month, you see say about 50-70 % of this money dey into feeding.  Things too dey expensive for market,  and the funniest thing about the price of food be say the price still dey go up. The things we plant by ourselves wey suppose dey cheap dey increase in price too, for me I feel this people wey dry sell food wey no suppose cost dey use the inflation as advantage just to make more money. I think things dey get worse instead of getting better, the price of food for market Don finish the poor since and now dealing with middle class people. People who are earning no fit afford food because of the high price.
newbie
Activity: 28
Merit: 6
September 23, 2023, 05:02:08 PM
#28
Sometimes when I reason how things dey add money for this country ehhn I dey weak. And nobody wants to do something about the inflation, bag of rice now is 49 thousand and the cost of fuel follow join. One thing have learnt this year is buy this thing now if not money go enter tomorrow, and that's very bad. Na only God fit save Nigerians oh
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
September 20, 2023, 01:56:32 PM
#27
The reason why our farm product d cost even though we d produce them na base on the increment of fuel price. The increment of fuel contribute highly on am, in the sense of na transportation wey d farmers d take transport their farm product from one city to another. You no expect the farmers to pay hugely on transporting the farm product to the city without adding the money spent in transporting to the farm product produce.

The salary of an average Nigerian worker is about N150,000( $160) per month and this is for graduates that have put in some years of service.
Abegy which average Nigeria citizen wey dem d pay 150k per month? I wan see them cos this 150k wey you mention don mad me cos I never hear or I see any graduate wey d pay such amount of money at this time wey em d hard some state government to even pay the small minimum wage wey be 30k. Even the recent minimum wage wey NLC d ask of, FG no wan implement am into law.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
September 20, 2023, 01:46:40 PM
#26
One major reason everything come dare like this  na the cost of transportation  and fuel increase drastically  and you go agree with me say this raw materials wey you dey talk but so, go still need transportation  to fit reach the needed and necessary place and you go agree with me say this commercial drivers no come to play at all, another thing na the very bad state of our roads as this they also contribute to major hike in prices of every other thing.

This topic the very similar  to topic i been read of recent for the local board and seriously,  cost of living wan truly kill the living.
sr. member
Activity: 560
Merit: 408
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
September 19, 2023, 07:20:51 PM
#25
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
Oga ooo dis matter wey you bring so dey comfuse me well well, di way wey tins dey go self na only God fit come help us for this matter ooo. Even the government dey comfuse too. I no worry my self again for  issue, my prayer now na to ask GOD make him dey give me food they chop,
sr. member
Activity: 1316
Merit: 379
#SWGT PRE-SALE IS LIVE
September 19, 2023, 04:54:11 PM
#24
This matta no be wetin man go kill himself for because i know say everyday by day na so tins dey increased in our country without any cause of it or something that stirs it up.. Make I say Garri wey me carry from home to ph i spend like 10k while the garri na just 1 bassen wey be say i buy am 5k then transportation make am reach that level, this come trigger something for my mind say reason why some food stuff dey expensive even though na we dey produce am na onto say transportation dey high and the reason for this transportation matta because of fuel dey on a higher amount so to carry something from Northern area to the Eastern region go almost take you 10x of worth of produces wey you carry by this the seller ( That is, whole seller go increase their prices then sell to the retailers, the retailers will increased their prices and sells to the final consumers) which e come be me and you.

Na wetin make food matta come dey tire pesin for the country, anything you wan buy now carry belle so as you dey touch am you dey high tension because immediately you touch am come price the price alone go shock you and you go drop as e dey hot. For now nothing we fit do and the only remedy be say make you try get small garden for your compounds so that you go plant some things like, pepper, scent leaf, ugu leaf, bitter leaf, also you plant cassava if possible add am cucumber make you know say you don reduce expenses entire. Some people dey even go far put small poultry farm for their compound wey be say any time them fit kpai one chicken take make food eat while some people dey put fish ponds inside their compound as well.
full member
Activity: 322
Merit: 146
September 19, 2023, 04:37:01 PM
#23
Diz kind agenda dey make lot of us talk pass ourselves oh... Sometimes beyond what is called for cuz the situation on ground is frustrating.

Those days 4 primary schools, we dey call flogging "tea without sugar" na him Odogwu Burner boy com bring up update say heart broken na "breakfast".

Now I fit just say we dey chop " tea without sugar for breakfasts" for this country as e be.
Bro, rejoice say u get #700-#1K for 2 time meal on cuz some families dey find that amount to make a general family food yet no way.

Well as u ask, fuel na the source of the hiking of goods and services for our society today.
Our govt say dem want elevate national economy dey boost say in just 100days in office dem don save over #100B. But I ask, on what essence dem dey realize all these funds for way citizens dey perish? No he say dem dey use am assist to lives oh but all aim to feed more of their pockets.

full member
Activity: 448
Merit: 117
September 19, 2023, 12:34:28 PM
#22
OP your talk really catch my attention no be small. This same question Na wetin I don dey ask myself for long now.  Fuel price increase no be say na all the products wey dey Naija wey dem dey import o. The locally made goods wey we dey produce here how far?  The garri wey we dey produce here how about am? The rice and other agricultural produce too nkor?
Me I believe say within this level, Na we Nigerians dey do ourselves. Where e dey very clear Na the very first dey Mr. President make him acceptance speech wey him talk about subsidy wey make all filling stations close down immediately Na there I know say Na we dey do ourselves for this country. You go imagine say any small rumour wey just circulate about strike or fuel the next thing you go hear be say marketers no go sell again. Them go begin hoard their products dey wait for price increase so that dem go begin sell that same product dem buy very cheap at a higher price. How the country wan take move forward with this kind of actions now.

Most of these food stuffs wey we dey consume here for Naija no be import we dey import dem. Na just be say vendors and marketers  dey take advantage of situations to the detriment of the masses. Wen you ask a vendor why the increase in price wetin you go hear Na fuel price even for market too Na same story you go hear for vegetable leaf wey dem dey plant here too.
sr. member
Activity: 378
Merit: 259
September 19, 2023, 11:38:58 AM
#21
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us

Anyway that we see in this country we dey live on it, if anything happens it will not be a new thing. Breakfast wey you dey spend up to 1k all the time in some places you can just spend like 5h for breakfast and e go do you, na every place things dey cost but who are we going to blame? People fit protest from today to tomorrow we go just dey shout nothing go change for this country because even rich people sef don dey complain this one no be for only poor people again everybody don dey see shege wey government dey show us but money still dey where e dey most of people no go even complain over this challenges that we are facing now.

All this issue na fuel subsidy cause am base on my view, because if fuel no cost food sef no go cost, but base on say fuel don cost it will touch prices of everything, i believe say we go dey keep on buying things like this till next year before we see any changes from this country if not now things has town down already make we sha just keep on with our hustling.
full member
Activity: 294
Merit: 168
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
September 19, 2023, 07:04:07 AM
#20
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase every month to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use to make process food we get am, how come everything cost like this. Watin we go say be the cause of this one now. E Don vex me all person money now dey go for food. Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
This 700 - 1000 naira to use chop breakfast na only if now one person wants to take the breakfast, and you no go chop belle full so that the 700 or 1000 naira go do you for the breakfast.

In my view, flooding and the high cost of fuel are the costs while some things do cost for this country.
For instance, if flood happens as e happened last year, e go make people way get farms in those areas where flood enters to harvest their produce when e never matured and sell it at a low price, when those people way flood no effect go harvest their farm produce to sell for market, them go sell their farm produce at a very high price because say e dy limited for that period

The high cost of fuel follow keeps our country like this, we know say anywhere way transportation cost standard of living goes dy high too. Even to visit  person from this country na war if you reason money way you go spend for transportation you go just say make you relax o. Before to go buy garri from village come city to sell go cost you small money for transportation but now to buy garri from village come city na war because only the money way drivers go take from the garri way you carry go almost come out the money way you used to buy the garri half. Na this thing cost if them done dy successfully bring garri  come city them go sell one custard 1700 naira to get gain for their business. Na all these tins I talk above na in me see dy cost why food items dy cost for this country so.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
September 19, 2023, 06:40:18 AM
#19
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us

Who tell you say we dey produce most raw materials wey we need to use arrange food, why the cost of foodstuffs dey high na our bad government. The bad government come dey affect the economy and when market woman dem go market things dun cost for that side because of importations and after them buy dem go need sell am costly too so dem fit make back their capitals and gains. No forget say dem no wake go buy this things, dey enter transport and due to the increase in fuel prices in the country, transportation dun add e own and when dey add all their expenses, to make small gain self dem need double the price of the goods wey dem dun buy or increase more than double just to get better gain. We also get some wey dey over greedy and dem dey add price without conscience.

The salary of an average Nigerian worker is about N150,000( $160) per month and this is for graduates that have put in some years of service. Unfortunately, base on the currenct economic realities of our country, 50% of this fund is spent on feeding. This is to say that many people are leaving from hand to mouth because the remaining 50% is not enough to cover to shelter, health, clothing, utilities and other basic amenities.

Where you dey get dat statistics from say dem dey pay average Nigeria #150k abi u dun forget say our minimum wage na #30k and no need to dey convert am to dollars, na we we dey hear so we understand ourselves. Na local board be dis and everything need dey local. Wetin me I know na say the average Nigeria salary na #50 +/- and I dey putt together all the official and jobs wey dem dey pay #70k, #80k, #90k etc and unofficial jobs wey dem dey pay less. The big jobs self go hard before dem pay you reach $100k and dat's if you see the job oh because wetin I know na say job no dey the country and now all this filling station attendant, super market attendant and other small small private companies jobs na him dey and those people dem no dey pay dem pass #60k.
hero member
Activity: 798
Merit: 546
September 19, 2023, 06:39:40 AM
#18
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase every month to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey they dey use to make process food we get am, how come everything cost like this. Watin we go say be the cause of this one now. E Don vex me all person money now dey go for food. Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
Concerning the current situation of things in Nigeria, E dey clear say the problem we get for we country na money inflation and price inflation join body,  as the dollar dey go up steady against the Naira ($1/960 current rate), Na so the cost of importation of goods and services, plus food prices will as well dey go up because Nigeria relies mostly on the important of goods to survive, hence making the country a consumer as supposed producer.

It is really annoying to witness the current skyrocketing and instability in the price of things in Nigeria, when you go to the market today to buy something, if you go the next day you find out that the price has dramatically increased, that's insane.

Our bad politicians contributed to this harsh situation in the country due to their selfishness and is affecting everyone, forgetting that both the poor, middle class, and rich go to the same market.
legendary
Activity: 2254
Merit: 1052
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
September 19, 2023, 05:47:58 AM
#17
Op abeg, try relax a bit, making more than one comment in a roll is considered spamming on this forum, and it could lead to ban, try go through the forum rules to get a better understanding of this ..

When you have more than one comment you want to reply to, what you need do is use the "insect quote" function, you can find this function on the top right corner of every comment posted on the thread when you are on the reply page..
See the screenshot below to better understand what I mean..



With the insect quote function, you can reply to as many posts/comments as possible in one comment, instead of having to reply one after the other in a roll; which is I forbidden.



member
Activity: 64
Merit: 32
September 18, 2023, 05:19:36 PM
#16
Nigeria has gone from worst to too bad, sometimes I see a good reason to say that our leaders has no conscience, how will you allow the people that you are leading to die in hunger, our leader doesn't like the idea of licensing more production companies or better still encouraging small firms that are into production, because most of them have share or quota in a particular man business that have decided to keep his people in the dark by inflating the price of everything through the help of the government, Nigeria has everything within her reach not to allow it's citizen suffer, removal of subsidy has been the major cause for the suffering of Nigerians, a government that wake up and announce the removal of the only thing the citizens benefit from, without putting things in place to caution the effects that may arise as a result of this, I think its time for the right thing to be done, because the current hunger in the land is so unbearable that, it takes God to control people not to do otherwise, Nigeria needs urgent revitalization, and that's the way we should go.
Yes this is true the major problem here is bad and over corrupt leaders. Imagine tinibu saying its his turn ,meaning say them wan dey suffer the citizens turn by turn as we dey elect new presidents suffer dey increase even comon water pure water the most common of them all Don cost now u no fit buy water for you and your friends without thinking the thing. Now fuel wey the crude just dey under our land here don dey so expensive.  Tinibu just come comot subsidy wey we dey benefit from . This country na wa oh

Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
All these high price of everything for Nigeria na because of fuel subsidy wey Tinubu remove. Ever since Tinubu took over power the rate of hardship is increasing day by day to the extend that a poor man might finf it difficult to feed. I notice that the price you buy something today will increase the next week when you want to buy that same stuff.

Feeding is a basic need but the government don't understand this and they want the masses to die in hunger strive. No be small money I dey use feed myself alone for this place wey I dey. If I want to cook I will spend up to 3k but when I visit mama put, 1K no dy reach me chop because the food go small and some places only meat or fish will consune upto 500 naira talk more of the food itself. Poverty is really a major challenge in this country because the government have chosen to kill the poor people with harsh economy. All our gals are now on the street because of what they want to eat and some have been killed by ritualist, only God knows when Nigeria will become a better place for people to live happily due to good economy.

The most painful part of it is that the unemployment rate is also high . To see work do so u fit buy that expensive food no easy ,as I dey you like this my guy wey finish school still dey streat na now en wan learn affiliate marketing from me. My advice to every Nigerian is to start earning in dollars if not this hardship go finish you
sr. member
Activity: 322
Merit: 274
Baba God Noni
September 18, 2023, 11:40:33 AM
#15
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
All these high price of everything for Nigeria na because of fuel subsidy wey Tinubu remove. Ever since Tinubu took over power the rate of hardship is increasing day by day to the extend that a poor man might finf it difficult to feed. I notice that the price you buy something today will increase the next week when you want to buy that same stuff.

Feeding is a basic need but the government don't understand this and they want the masses to die in hunger strive. No be small money I dey use feed myself alone for this place wey I dey. If I want to cook I will spend up to 3k but when I visit mama put, 1K no dy reach me chop because the food go small and some places only meat or fish will consune upto 500 naira talk more of the food itself. Poverty is really a major challenge in this country because the government have chosen to kill the poor people with harsh economy. All our gals are now on the street because of what they want to eat and some have been killed by ritualist, only God knows when Nigeria will become a better place for people to live happily due to good economy.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
September 18, 2023, 11:29:50 AM
#14
Omo my fellow Niger men and women how una dey see this thing wey dey happen for our country cost of food dey increase on a monthly basis to chop common breakfast fit cost you like 700 - 1000 for management oh. And we dey farm dey produce rice and garri, even most raw materials wey them dey use make process food we get am , how come everything cost like this . Watin we go say be the cause of this one now . E Don vex me all person money now dey go for food . Abeg make una contribute for this matter I know say e dey vex all of us
Na inflation cause everything,  because most time what Nigeria produce is raw materials and not finished goods because in most cases,  we still import almost all our basic necessities a d this have left us at the mercy of foreign exchange rate,  which now determine the price of basic goods in the market,  and that is the cause of the current economic downturn that we are witnessing today in the society.

Basic needs have become out of reach for the ordinary citizens and also the cost of living in general talking about housing and the rest of what have you have all gone so high that survival now is just by the grace and high calculations.
sr. member
Activity: 714
Merit: 358
Underestimate- nothing
September 18, 2023, 10:45:48 AM
#13
The salary of an average Nigerian worker is about N150,000( $160) per month and this is for graduates that have put in some years of service. Unfortunately, base on the currenct economic realities of our country, 50% of this fund is spent on feeding. This is to say that many people are leaving from hand to mouth because the remaining 50% is not enough to cover to shelter, health, clothing, utilities and other basic amenities.

If urgent steps are not taken, people will drift towards depression and that is not good for a country with population of 200 million people. 


Even earning 150k monthly relies on the industry you work in, and even gaining the money isn't helping much; the money can't even keep up with the bills because the person generating the money is still battling to stay up with the whole scenario.  And the government has refused to revise the minimum wage, at least because the price of things is not friendly to people at all, from the price of fuel to the price of food. Everyone is just trying to survive it is no longer about how well you are doing. because even housing is becoming ridiculously costly, because despair is terrible and leads to a slew of unpleasant outcomes, both mentally and physically.
full member
Activity: 266
Merit: 140
September 18, 2023, 07:24:27 AM
#12
The problem of this our country now don get worst seriously no be waiting we sleep with we go wake with how we poor go take survive wey everything just dey high every forking dey, I can blame the farmers because even they're working materials don cost no be wetin de bort it last season dey sell am this season. Especially fertilizer wey before 1bag no pass 15k to 20k and now it's almost 50 to 60k, all the course of the does problem is do to bad government that we have, my brother is only God that can Stand for us if not the course of living wan killed the living.
Pages:
Jump to: