I don follow one police man wey I sabi talk about dis mattar before, and from d response wey him give me I felt bad. D man talk say guns wey most of those criminals dey use better pass their own, him say sometime if their gun don hot e go dey misbehave, and before dey commot for station, dem dey count bullet give them. All those criminals wey be say na new guns dem dey use with unlimited bullet, how u wan take fight people like that. D police man talk say if dem dey exchange bullet with d criminals, if d bullets wey dem give dem for station don finish, na die remain be that ooo.
Dis one na serious matter be dat oo, we go stop dey judge book by the cover now. Me never know say dem strict with police like dis when dey come to going out for duty to secure the people in the country. If na wetin really dey happen be dis, den where d insecurity wey we say we dey fight for dey now. When d people wey go help us fight too dey fear make dem no come kpai dem, our own lives go be like joke for their sides be dat now, dem fit do anything dem like for town since dem know say the people wey go stop dem no dey fully equipped like dem to fight dem. But dis matter really surprise me still o, you dey sure say na so dis matter still be till now and dem neva rectify am by now. For God’s sake, we dey 21st century, wetin dey sup with our country na.
In a society where there is law and order and citizens rights respected, even though what she said was bad and demoralizing to our security forces, she was not supposed to be arrested and detained rather, there should be a way to make her substantiate her claims. Two wrongs can never male a right.
Naso, two wrongs no fit make any right but e be like say na d condition wey dos officers dey dat night na him make dem react like dat to her. E for better as dem interrogate her come show her small pepper make dem allow her follow d rest passengers go, but as dem no do like dat, e mean say dem really mean d girl and dem go deal with her very well be that. But my fear with all dis road side security personnel’s na impersonation. I just pray say she no fall into the wrong hands as dem leave am come dey go their thing. Country hard, everybody dey vex base on say dem dey face one or two daily, but dat one no mean say make we dey run our mouths anyhow.