Hello I know I also did took time to bring this, I was trying to visualise these info but will try to do much better next month, also what other features should be added aside top merit earners, recievers and top posters ?
Congratulations once again for sharing these our monthly overview, and abeg the extra time wey you take to present this very colorful chart de worthwhile, infact dis na di best monthly overview chart wey I don see, thanks very much. E de very easy to see the hierarchy of the top posters, top merit givers and top merit receivers for dis local board, di innovation de very fantastic, keep it up.
Di only thing wey I go add be wetin Crytoprincess101, talk say make you de add top quality posters, so e go de motivate odas to de step up for dem quality posts. Aldo this one no go be easy task at all, because e no go easy to de navigate di forum de find people wey dem posts quality pass odas, so if dis one go be a herculean task for you, make you forget about am for now.