Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 271. (Read 1330513 times)

legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
So see wetin happen wey make thread don change. We Nigerians we sabi carry Africa for head but others no dey reasons us like dat. E come be like we dey waste our time for here as na only we we dey here. Some people come reason me say make we fight for our own first then we fit fight fight for odas and I come see sense for wetin dey talk na e make I sharp sharp change the thread to focus more us, Nigerians.

As e be now eh, the agenda never change as na to get our own local board be the priority, if we fit achieve am everywhere go strew for us. We just need to dey very active atleast once a week for the thread and contribute towards the matter wey we dey address.

NEW TOPIC: How we go fit end bad governance for we country, no be just to EndSARs.

Person wey e reply make sense die go recieve awoof merit from me. If you see reply wey interest you then follow encourage the person too.

You fit still add your voice here; EndSARs: The movement for police reformed as a result of police brutality in NiG. @Blackpussy thanks for dat update.
member
Activity: 70
Merit: 26
My people for Pitakwa abeg make we try shine eyes for ground our government no care about us make we try stay indoors and keep the online protest going they are nothing but losers and we go win dem.

Our Buhari don abandon us as we no know who even dey Aso rock de country na OYO.

Old picker go pick again.

#EndSars
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
I hope all of Una wey dey major cities across 9ja dey sef currently via this massacre carried out by the Nigerian government? God go see us through. E no easy.
hero member
Activity: 2660
Merit: 630
Vave.com - Crypto Casino
Pepo , I hang small copy on #endSars update. Mak we flow wit am here abeg https://bitcointalksearch.org/topic/m.55408579
member
Activity: 70
Merit: 26
Good evening my blood them wey dey here, I dey greet ona, how ona dey? I hope say everything dey go jeh jeh, make ona no vex for me say I never talk for here for sometimes now, the campaign wey I enter no dey count post from local board, so e dey make me dey far from here. Make ona forgive me.

I really like the fact say ona dey make here dey lively as e dey always be. As the matter of #Endsars and police brutality don dey for our country naija, so in order to let the forum know, Brainboss don talk say make we create awareness by putting "Join the fight to EndSARs/Police brutality in NIG." in our personal text or something similar to that, but no be compulsory something.

@blackpussy, I really like am as you put am for your signature spot already, but go make more sense if e dey for personal text.
baba no shaking i go do as you talk the awareness go dey everywhere
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
Good evening my blood them wey dey here, I dey greet ona, how ona dey? I hope say everything dey go jeh jeh, make ona no vex for me say I never talk for here for sometimes now, the campaign wey I enter no dey count post from local board, so e dey make me dey far from here. Make ona forgive me.

I really like the fact say ona dey make here dey lively as e dey always be. As the matter of #Endsars and police brutality don dey for our country naija, so in order to let the forum know, Brainboss don talk say make we create awareness by putting "Join the fight to EndSARs/Police brutality in NIG." in our personal text or something similar to that, but no be compulsory something.

@blackpussy, I really like am as you put am for your signature spot already, but go make more sense if e dey for personal text.
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
I greet Una for house. I beg make Una see this my book wey I publish.
Baba the book no get link? How we take read am

No too vex for me.

https://bitcointalksearch.org/topic/--5281840
i don see am we no too get no reason am our country na trash

Omo, no reason am the love massive and e Belefu me. Oga Boos, your doings the gimme joy.
member
Activity: 70
Merit: 26
I greet Una for house. I beg make Una see this my book wey I publish.
Baba the book no get link? How we take read am

No too vex for me.

https://bitcointalksearch.org/topic/--5281840
i don see am we no too get no reason am our country na trash
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
I greet Una for house. I beg make Una see this my book wey I publish.
Baba the book no get link? How we take read am

No too vex for me.

https://bitcointalksearch.org/topic/--5281840
member
Activity: 70
Merit: 26
I greet Una for house. I beg make Una see this my book wey I publish.
Baba the book no get link? How we take read am
legendary
Activity: 2422
Merit: 1083
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
 
Btw,.. Which platform you dey get your training materials from?? Me na udemy I dey use but am open to switch if I find any other platform wey better pass udemy

Quote
So far so good, Na udemy be my plug at the moment for web dev courses. But them no get much content on Vue Javascript framework so I dey use frontendmasters and scrimba for some content. I go suggest you check out freecodecamp too. Them get nice resources too.

ok, thank you very much, i go take out time to check out those platforms you mentioned, i don even hear about freecodecamp well well from many people, but i be no take the platform serious, but as you don tell me for here now, i go look their way as soon as possible , thank you ones again and i wish you and everyone else a great day today and every other days.
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
I greet Una for house. I beg make Una see this my book wey I publish.
hero member
Activity: 2212
Merit: 805
Top Crypto Casino
Speaking of this web development thing, me too na front-end I still focus on now, though I hope to enter backend programming soon, just say the thing no dey easy with the way nepa no dey gree bring light for my area, and no be everyday man dey get money to dey buy fuel pour for generator,

Yeah. Light issues na one of the major issues when it comes to coding. Right now, na only developers wey dey on steady paycheck don solve that problem. For people like us wey dey learn, we gats treasure our battery and make the most out of it whenever e get some charge. Na why programming get as e be for this country. You fit wan code but light no go dey to do am.

And that blockchain programming thing, na the next thing wey me self won enter if I finish my web development course, cus i no like to learn something half way, leave enter another, that's why I decide say I go just get patient, finish the web course, then gather money, buy blockchain programming course, then start the journey again.

If you dey check the services section, people dey request for such services from time to time and don't even get much responses/applications. I feel say the field dey untapped especially for the Nigerian market. And crypto go dey big soon so the demand for blockchain developers go increase. I want to be qualified when e increase sha.

Solidity and Javascript na the way forward.

Btw,.. Which platform you dey get your training materials from?? Me na udemy I dey use but am open to switch if I find any other platform wey better pass udemy

So far so good, Na udemy be my plug at the moment for web dev courses. But them no get much content on Vue Javascript framework so I dey use frontendmasters and scrimba for some content. I go suggest you check out freecodecamp too. Them get nice resources too.
legendary
Activity: 2422
Merit: 1083
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Username: Fivestar4everMVP
Gender: Male
Country and state of resident : Nigeria, Lagos resident
Skills: I be junior web developer ooo, (junior mean say, i still dey learn) but I hope to leave the junior level soon
Quote

Glad to meet another web developer in our community. Welcome bro. I'm also a web developer but I'm focused on Frontend technologies sha. Right now, I dey consider start blockchain programming coz e dey lucrative and e no dey saturated like the web dev space.
Thank you so much brother, I appreciate you and I dey wish you good luck on your exams.
Speaking of this web development thing, me too na front-end I still focus on now, though I hope to enter backend programming soon, just say the thing no dey easy with the way nepa no dey gree bring light for my area, and no be everyday man dey get money to dey buy fuel pour for generator, but i still believe country Sha, i no say one day, e go better, though I don dey hear this thing since when I dey 3 years old,..
And that blockchain programming thing, na the next thing wey me self won enter if I finish my web development course, cus i no like to learn something half way, leave enter another, that's why I decide say I go just get patient, finish the web course, then gather money, buy blockchain programming course, then start the journey again.
Btw,.. Which platform you dey get your training materials from?? Me na udemy I dey use but am open to switch if I find any other platform wey better pass udemy
hero member
Activity: 2212
Merit: 805
Top Crypto Casino
Good evening to all my brothers in this community. I hope una dey fine. The last time I post here na when I rank up to hero Member. Make una no vex say I never dey active on this thread coz I currently get semester exam to tackle since my school don resume so I dey try manage time here on forum.

Regards to the recent happening for Nigeria so, I know say we go win the fight to #EndPoliceBrutality. Abeg if you no dey protest, try dey retweet those tweets. Coz if the country better, na all of us go enjoy am.
So @Lordhermes na Pitaqua homeboy too like Duncan Mighty and even Brainboss? E good like that.

Lol. I also dey PH with oga Brainboss.

I also wan congratulate Posi and LordHermes for their rank up. This year, the Nigerian Bitcointalk community don see some nice rank up. Which is a good step, one taken in the right direction, very soon, we go get our very own local board. God willing. 🙏

Username: Fivestar4everMVP
Gender: Male
Country and state of resident : Nigeria, Lagos resident
Skills: I be junior web developer ooo, (junior mean say, i still dey learn) but I hope to leave the junior level soon

Glad to meet another web developer in our community. Welcome bro. I'm also a web developer but I'm focused on Frontend technologies sha. Right now, I dey consider start blockchain programming coz e dey lucrative and e no dey saturated like the web dev space.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
So @Lordhermes na Pitaqua homeboy too like Duncan Mighty and even Brainboss? E good like that. BTW, Brainboss I like your display of own flag for that your avatar. You be true Naija. We be better people, na only owa politicians dem dey make persin feel bad about we country. E sweet my belle well well as end this criminal SARS demonstration dey go on. Another thing we dey give me joy be as I dey see many of owa people dey enter campaigns wey dey fit pay with btc. I know as e be here for naija for peeps wey nor get work. And we dey try escape that frustration with this crypto thing. Una do well oh. @Smartvirus, nor feel bad for that competition thing. Keep trying. I welcome all owa newcomers too. Welcome, wey bread!
member
Activity: 70
Merit: 26
Congratulobia baba I tap into your blessing make baba God do am for me too
Make una jolly this poem from Port Harcourt First Son
(Crying Black Lives)
This your username no be chaise o but no worry, anyhow e be, you be my person and na lifting up we dey do for here. Though, you gay show say, you no go carry shit rub us for face. Na the matter be that.
I don view your poem and e go hard. Make your hand no tire as our hands no go tire too to show anybody way never see road the road. Me na still learner for here o and I go continue to dey learn from all of una especially our senior man @CryptoprenuerBrainboss, the man way anchor all of us for here, the man way carry one full country as flag #sig, the man way dey motivate me in every way and men like Charles-Tim, Nelson4luv, Lordhermes, Fivestar4everMVP just dey join the community but na man way I just get love for too. I respect una and every other person way dey here. Na we get ourselves, make we carry ourselves well.
Baba I dey see your hand work my name represent our continent me na traditional PHC boi I dey loyal to my oga @Lordhermes and all of una wey dey represent naija. @CrytoprenuerBrainboss I tuale baba you na highest I dey see your hand work
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Congratulobia baba I tap into your blessing make baba God do am for me too
Make una jolly this poem from Port Harcourt First Son
(Crying Black Lives)
This your username no be chaise o but no worry, anyhow e be, you be my person and na lifting up we dey do for here. Though, you gay show say, you no go carry shit rub us for face. Na the matter be that.
I don view your poem and e go hard. Make your hand no tire as our hands no go tire too to show anybody way never see road the road. Me na still learner for here o and I go continue to dey learn from all of una especially our senior man @CryptoprenuerBrainboss, the man way anchor all of us for here, the man way carry one full country as flag #sig, the man way dey motivate me in every way and men like Charles-Tim, Nelson4luv, Lordhermes, Fivestar4everMVP just dey join the community but na man way I just get love for too. I respect una and every other person way dey here. Na we get ourselves, make we carry ourselves well.
legendary
Activity: 2422
Merit: 1083
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Thank you a lot my brothers and sister wey dey this place. Me I happy wells as I come across this particular group my mind really come down badly Because I be very new person for this place and Dey believe say one day everywhere go really good and beside make we all put heads together and see Wetin we fit do wey go really move this group forward and una wey already Dey so much ahead of us make una try file complain so dem fit reduce the complexity of the site. But as e Dey be make una try carry me along this journey as me I ready bring my head down. Una thank you
I never change my name still remain @celebrityfarmer
I greet you my brother and welcome to the forum ooo, good thing say you locate your root here and congratulations on that one.
On the other hand, I go like to let you know say to come dey send compliant messages to thymos (Abi wetin be him name self) say make him and his team reduce the complexity of this forum go be like person wey look stone finish, come carry water dey pour on top hoping say e go desolve, you know say that one na fruitless journey, my only advice na, any thing wey you no understand for the forum, we dey here for you, just ask here, the first person wey see your query go surly help you out, and i also want make you know say no body know everything here ooo, we all na still leaner in one way or other, so the way forward na for us to always dey help each other...so welcome once again my brother,  hope you enjoy your stay here.
newbie
Activity: 10
Merit: 0
New thread is self moderated to prevent spam and scam like activities. Promise not to misuse this feature.

If you're a quality poster and you feel your post aren't recieving enough merit, apply for MERIT via List of Active Merit Giveaways threads. as you will get merited if you're truly a quality poster.

Hello my africa brothers and sisters, I decided to create this thread for we to hangout since we don't have a local boards were each and every one of us can communicate with our different language.

Username: celebrityfarmer
Gender: male
State of origin: rivers state
Skills;newbie
Feel free to discuss anything on this thread, if you have any questions, myself and others higher level members will be willing to help. You should qoute partially a previous reply if you want to reply to that comment as we try to keep the thread decent and spam free.

Lets try our best to obey every forum rules and regulations and only legal activities are encouraged on this thread.

IMPORTANT AFRICA RELATED THREADs ON FORUM

NOTE:
[1]: Don't trade with a user you just met on this thread unless you trust them and all trade related transaction should he carried out in the Marketplace board and child boards for transpiracy.

[2]: Official language (english and pidgin although you're free to communicate in your native languages).

[3]: First timers should introduce themselves in this manner;
  • Username:
  • Gender
  • Country and state of resident (optional)
  • Skills (Incase a project is looking for someone from your country for that particular job you get hired)
.
[4]:  All discussions are welcomed here and when you want to start a new discussion use this code
Code:
[b][color=red]NEW TOPIC[/color][/b]
followed by your topic subject.

Example: NEW TOPIC: What's your experience on forum so far?

Constructive suggestion are welcome in order to improve discussion on the thread.

If you'll be interested in promoting this thread indicated below (I'm thinking of creating a signature campaign for publicity of this thread to other africa citizens on forum).

Link to signature campaign: https://bitcointalksearch.org/topic/africa-bitcointalk-community-hangout-signature-campaign-5121541

Jump to: