Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 273. (Read 1034533 times)

full member
Activity: 756
Merit: 231
Me kum-kuma dey use Trust wallet so I dey stake for dere.
Abeg, which other app (apart from Trust Wallet) persin fit take do staking? I dey interested but na the duration of the lockdown of tokens they always discourage me from involving myself.
Na trust wallet and Binance na me dey use but some others still dey like dis ones: Crypto apps that allow staking of coins , although me I neva use dem before except de two wey I mentioned above(Binance and Trust wallet). For me oooo, waitin I dey use na em I trust, so, use wit caution if u won use anyone among dem.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Me kum-kuma dey use Trust wallet so I dey stake for dere.
Abeg, which other app (apart from Trust Wallet) persin fit take do staking? I dey interested but na the duration of the lockdown of tokens they always discourage me from involving myself.

Make we just juggle our brain small. Anybody wey get am, I fit give am 1 thing  Grin

Tell me wetin beat husband for where the wife and children dey?  Grin

Na rain.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

I greet everyone for the house. I been wan come officially tell the house say local man been don finally reach hero rank and e for no dey possible without una support so I thank una. The reason I never dey active here much be say, I been dey seriously sick. I still dey try recover and I been get burnout from coding (burnout mean say I code till I lose motivation aka my fuel run dry) so I dey try recover from both my sickness and burnout at the moment.



O boy!!! How you come dey na  Huh I hope say the "burna boy"  Grin don rehearse your matter finish. Na God be ya muscle you hear....
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Make we just juggle our brain small. Anybody wey get am, I fit give am 1 thing  Grin

Tell me wetin beat husband for where the wife and children dey?  Grin
full member
Activity: 756
Merit: 231
STAKING AND ITS PROFITABILITY
Una gudmoni my people, I just want us to discus dis issue wey I tink many of us don dey do but some never start or hear am. De altcoins still dey down and dis is de time to get into staking, staking can earn u many many profit wey trading cannot give except dose wey sarbi well-well. So, if u never dey gud in trading abeg make u shift ur yash to staking of altcoins now.

Here are some few altcoins wey fit give gud profit in short-term: "KAVA 5.08% TRON 0.74%, ATOM 7.39%, TEZOS 6.09%" among others, why I chose dose ones bi sey, dey cheap for market now nd na opportunity for anybody to buy dem for staking. Me kum-kuma dey use Trust wallet so I dey stake for dere.

Tell us more about staking make we pinkins learn.
full member
Activity: 756
Merit: 231
For me, Gozie post dey try yarn say if those people him quote succeed regardless of the obstacles them been face, then we no suppose give up or feel bad whenever things no dey work out as planned. But that's by the way.
I understand my bros post but wen i read dis our own pensi's motivated talk for de list keep my laughing. Na u tell us sey u suffered nd we give u power to bring us change u can't change even ur state, wich can scam be dat ni.

Am not motivated by dose polithieves we have in our dear country but be motivated by dose of u here with sincerity in de delivery of assignments.
Quote
I greet everyone for the house. I been wan come officially tell the house say local man been don finally reach hero rank and e for no dey possible without una support so I thank una. The reason I never dey active here much be say, I been dey seriously sick. I still dey try recover and I been get burnout from coding (burnout mean say I code till I lose motivation aka my fuel run dry) so I dey try recover from both my sickness and burnout at the moment.
Congratulations bro, more higher we all prayed IJN.
Oh, sorry for dat, sickness no gud samsam becus me self fell sick nd was hospitalised but wit prayers offered am back again by his grace. My guy please small small ooo, wen I be regular wit PHP and MYSQL I hear my body nd soul, though as a family pensi wey i be now, I do limit myself to codes.
Quote
I hope say una dey safe from the market dumps wey happen offer the last couple of days.  Some blood stain me but na just another day in the market. Soon the market go get relief rally. The only problem be say, when e don dey get towards the end of the year, market dey usually go down as much people dey cash out to use the funds enjoy with their family so make we try dey vigilant.
Bloody market na we dey but we go pass dis time with strong holdings. As u don talk, we must be vigilant.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
* I got pregnant when I was in SS3 and was banned from singing in church choir: -Aituaje Iruobe (Waje)
Ehen na, before nko wetin dem suppose do for you for being wayward? Dem for fry egg, bake cake and clap for you on top the belle wey you carry, abi? Iranu oshi.

Jack Mai (the persin wey get Alibaba) own story too make sense but e bi like sey you forget to add am. Even Abraham Lincoln own too. All those owa polithieftians stories nor dey touch me shimkpan. Nothing nothing for them.

I greet everyone for the house. I been wan come officially tell the house say local man been don finally reach hero rank and e for no dey possible without una support so I thank una. The reason I never dey active here much be say, I been dey seriously sick.
Congratulobia Nelson for the new rank. Welludone. E remain me. But my own journey be like sey na crawl I dey crawl oh. Ehen, make I thank God for your recovery. Kpele, abeg nor sick oh, or sick but make you always recover 🤡🤡. God punish devil...
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
Lol becky. I understand the message wey gozie dey try pass across. No doubt say our chairman, Brainboss, don do very well. A lot of people do sleep for night with  happiness and a filled stomach because of am. For me, Gozie post dey try yarn say if those people him quote succeed regardless of the obstacles them been face, then we no suppose give up or feel bad whenever things no dey work out as planned. But that's by the way.

I greet everyone for the house. I been wan come officially tell the house say local man been don finally reach hero rank and e for no dey possible without una support so I thank una. The reason I never dey active here much be say, I been dey seriously sick. I still dey try recover and I been get burnout from coding (burnout mean say I code till I lose motivation aka my fuel run dry) so I dey try recover from both my sickness and burnout at the moment.


I hope say una dey safe from the market dumps wey happen offer the last couple of days.  Some blood stain me but na just another day in the market. Soon the market go get relief rally. The only problem be say, when e don dey get towards the end of the year, market dey usually go down as much people dey cash out to use the funds enjoy with their family so make we try dey vigilant.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
^°^ Gud one, I tink u don say plenty tins here which don motivate me now. But u see eh, dose our people names on dis list na scam dem be, no offense: bikonu. Pensi wey don pass trough dis deir acclaimed situations should don help fix our dear country becus most of dem don served our naija.


Shey you sabi say 2face been wan lead protest wey go shot the economy down sometime for this present administration? Later, he announced say him no do again lol. You fit research wetin make him stop ?

The country never dey practice democracy and so all the ingredients wey suppose dey for the administration, are missing.
Name them : equality, rule of law, supremacy of the constitution, respect for fundamental human right (na hear rally and peace protest fall put but your country go send DSS,Army etc follow people wey dey do rally.


Quote
See forum assignment wey our big brother @Brainboss do here for covid-19, him do am wit all transparency, una see eh, me am not motivated by dem samsam. Una happy Sunday.

@becky666 hmm.... Na when you enter that place you go know how dem dey operate there wey make dem dey change wen dem dey dere.
full member
Activity: 756
Merit: 231
^°^ Gud one, I tink u don say plenty tins here which don motivate me now. But u see eh, dose our people names on dis list na scam dem be, no offense: bikonu. Pensi wey don pass trough dis deir acclaimed situations should don help fix our dear country becus most of dem don served our naija.

Assume sey u and I wey dey hustle like dis see dis type opportunity to help fix our country, don't u see sey we go do am pass dem?. Some sey "I no get shoe, I contest many times nd I loss, I be sell firewood, dem be catch me for kirikiri" dose our pensi's own no just jijar me.

See forum assignment wey our big brother @Brainboss do here for covid-19, him do am wit all transparency, una see eh, me am not motivated by dem samsam. Una happy Sunday.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Make I drop this here. Na a kind of encouragement e go be for some to continue whatever hussle wey we dey struggle with.

We fit don here or know them before though


* I was raped at the age of 9: -Oprah Winfrey
* I was in prison for 27 years: -Nelson Mandela
* I got pregnant at 17, during my secondary school days: -Genevieve Nnaji
* I didn't even complete my university education: -Bill Gates
* I contested the presidential election 3 times and failed: -Muhammadu Buhari
* I once sold plantain: -Inetimi Odon (Timaya)
* I used to serve tea at a shop to support my football training: -Lionel Messi
* I slept under the bridge in lagos: -Ramsey Noah
* I sold rat poison : -Patrick Okorie (Patoranking)
* I started out as a firewood selling orphan, I have tasted poverty: -Atiku Abubakar
* I was once a prisoner: -Olusegun Obasanjo
* I was an unwanted baby, my mother almost aborted me: -Cristiano Ronaldo
* I was formerly a maid: -Mercy Johnson
* My family was so poor that even poor people called us poor: -Pastor E.A. Adeboye
* I was once a bus conductor: -Atunyota Akpobome (Ali Baba)
* When I remember my past, it was poverty. When I pass on the road, people usually laugh at me: -Duncan Okechukwu (Duncan Mighty)
* I was in the university for 9 years: -Ayo Makun (AY)
* I was a school dropout: -Mark Zuckerberg
* I grew up in a slum at Ajegunle: -John Asiemo (Daddy Showkey)
* I was rejected by facebook when I applied for a job there in 2009: -Brian Acton (WhatsApp co-founder)
* I begged for a chance to perform on stage for free for just 5 minutes, but I wasn't given the chance: -Francis Agoda (I Go Dye)
* I once had no shoes: -Goodluck Jonathan
* I was rejected from birth by my father because he didn't want a girl: -Chika Ike
* I got pregnant when I was in SS3 and was banned from singing in church choir: -Aituaje Iruobe (Waje)
* My family was the poorest in my village; I sold firewood, I was a butcher and also a hairdresser: -John Okafor (Mr Ibu)
* I used to live in an orphanage as a motherless baby: -Ali Bongo Ondimba
* I was once a corn seller: -Chisom Okoroji

WHAT'S YOUR STORY???

Believe that GOD can convert:
- Your discomforts to comforts
- Your pains to gains
- Your story to glory
- Your shame to fame
- Your losses to profits
- Your tears to smiles
- Your sorrows to joy
- Your debts to credits
- Your mess to message
- Your foes to friends
- Your dreams to realities.
Amen

REMAIN BLESSED
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Abeg anybody been take advantage to buy ARPA and DOCK when Becky and Brainboss been talk about am here? Them don craze sha. Solid 100% from the entry points mentioned here. ARPA in particular get hot DeFi news on the 18th  of this month.
Yes o! I buy small ARPA and the run dey sweet my belle die. Make I dey look wetin go happen after that date too. Whether e go fly enter $50 🤑🤑

Believe, e sweet me die for belle say people follow my advice. Personally I been get small challenge wey take me off been very active on the forum and this thread in particular. I been wan put my thoughts together so I fit bounce back after some very bad choices. I sell all my coins and come dey focus mainly on trading newly listed coins on Binance.  From $RSR, $IDEX to $TRB and currently $BZRX, just day day trade, e no easy sha.

All I do throughout na daily trading and I dun come to realize say although profit dey am but nothing sweet pass holding oh especially when you get better coins. I love the energy I dey see here e mean say even when I hang my boost the thread and struggle go still dey alive.

As for that thing @posi talk personally i no buy into am but if you get chance you fit try am if your spirit allow you. Una good night.

PS: no referrals link on thread, e dey against forum rules So I gaz delete your post. You fit rewrite am and ask people to reach out to you for referral link privately.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!

My wife (she's teacher) was in talk with her boss on WhatsApp about the pandemic issue, the time school will be open and he introduced her to an [url =https:// GramFree.world/?r=7888015]online venue called Gram Free[/url] with no investment or fee involve than doing max total 1hour task and get pay for it, of which I told my wife to ask him for an evidence (which what I posted above) because I'm kind of person that hardly believe in other online stuff due to what i have learn and read on this forum.
Abeg, anybody fit help me with wetin Posi dey talk for here? Grammar ti poju ni. Hah! Bros, you sabi sey we wey dey here na local people wey dey try write WAEC ni 🙄. We never even dey sure whether Bubu and dat Adamu guy go allow us pass the exam sef.


That onmyrise people and story na akawu oh. Na always 'Request Processing' we dey see but cash we nor see 😂
hero member
Activity: 2268
Merit: 579
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Disclaimer
I dont know much about the team involve but the video giving to me is a unique evidence and despite the evidence try it at your own risk.


My brother , you for no even put the thing here. Many of thes things na ponzi in different gimmick, strategy and style. As you never try am yourself or most times these multilevel marketing stuff go pay people wey first register and begin story with other people wey come register after the first people, and by then , them go don achieve the purpose them want or advert and hype.

See, e get one wey I do and I still dey wait for close to $5,000 from them. $5k no be beans na  Grin you sabi how much be that na..lol. With that kind money, vacation for Ashanti is sure my brother but since two months, the website just dey look me bad eye  Grin Roll Eyes Shocked

The people name na on myrise. There link https://on.myrise.net/

Them even dey advertise that gram for there website but I just no want know wetin dey happen there as onmyrise no pay.

No wonder them say birds wey get the same feather, na the same mama born them....lol

You make a good point. I was once a victim of ponzi scheme (MMM) then but i choose to share this one cause people dont need to put any money and the person that gave the information to my wife wont lie about it. Besides, the Youtube video is enough but in the end if the choose not pay as time goes on theres nothing to loose except for the time spent.

I have registered an account already but others can join at their own risk.
Note : I was scared for sharing this information but i decide to share it cause information is poser and if each and everyone of us was able to get the information about BTC potential since 2009 do you know what will happen now.

A friend of mine been tell me about this Gram free and it's about four months now, I asked him about am recently but the respond him give na something not encouraging. Him talk say na referral program them be, the more you refer the more money but the money small. I come research on more and noticed say na something wey do with time and watching videos, creating videos, playing and winning lottery, the money for playing lottery na from registration bonus of 5 Grams,. The withdrawal na until e reach 500 Grams but its real and not fake but take you courage and determination to perform all those activities.
You can read more here to understand am very well.
https://medium.com/@jonvansidinh/how-to-1000-dollar-with-gram-free-85bd7c33d102
You completely know every information about the site cause you just said everything i want told and its good youre aware of the site genuinely level.
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
A friend of mine been tell me about this Gram free and it's about four months now, I asked him about am recently but the respond him give na something not encouraging. Him talk say na referral program them be, the more you refer the more money but the money small. I come research on more and noticed say na something wey do with time and watching videos, creating videos, playing and winning lottery, the money for playing lottery na from registration bonus of 5 Grams,. The withdrawal na until e reach 500 Grams but its real and not fake but take you courage and determination to perform all those activities.
You can read more here to understand am very well.
https://medium.com/@jonvansidinh/how-to-1000-dollar-with-gram-free-85bd7c33d102
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Disclaimer
I dont know much about the team involve but the video giving to me is a unique evidence and despite the evidence try it at your own risk.


My brother , you for no even put the thing here. Many of thes things na ponzi in different gimmick, strategy and style. As you never try am yourself or most times these multilevel marketing stuff go pay people wey first register and begin story with other people wey come register after the first people, and by then , them go don achieve the purpose them want or advert and hype.

See, e get one wey I do and I still dey wait for close to $5,000 from them. $5k no be beans na  Grin you sabi how much be that na..lol. With that kind money, vacation for Ashanti is sure my brother but since two months, the website just dey look me bad eye  Grin Roll Eyes Shocked

The people name na on myrise. There link https://on.myrise.net/

Them even dey advertise that gram for there website but I just no want know wetin dey happen there as onmyrise no pay.

No wonder them say birds wey get the same feather, na the same mama born them....lol
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
My people, shey una dey see how Cartesi dey fall small small? E remain small before any reverse go happen there. But that nor mean sey the project nor good. This correction wey dey happen now dey give everybody the opportunity to buy the coin cheap oh.
Omoh, I no go miss this chance now as I miss before, Cartesi na better coin wey do wonders, wetin make believe them be say their team members dey active and them dey make sure them finalise their roadmap as them plan.
Good evening my fellow country men, I hope una dey fine like this, local man enter street so I come greet my chairmen, even though I no really dey active on this thread, I dey constantly follow up una discussions.
We dey camkpe as we dey kpor eye for any blessing on the forum, I really notice say the thread been first calm for some time but e no go well, here na our room for resting and yarn wetin dey your mind.

I believe say new members go soon come in as we dey wait.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
Good evening my fellow country men, I hope una dey fine like this, local man enter street so I come greet my chairmen, even though I no really dey active on this thread, I dey constantly follow up una discussions.


My people, shey una dey see how Cartesi dey fall small small? E remain small before any reverse go happen there. But that nor mean sey the project nor good.

I been no buy. I been remember when dip to 440 sometime last month abi early this month, I feel say e dey overbought at the moment but I never really take out time to view the chart. Bro, you know of the SXP (Swipe) people dey hype upandan for crypto twitter?
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
My people, shey una dey see how Cartesi dey fall small small? E remain small before any reverse go happen there. But that nor mean sey the project nor good. This correction wey dey happen now dey give everybody the opportunity to buy the coin cheap oh. Again, I believe sey una dey take one eye dey watch how Curio dey do with moon walk, abi? Abeg, anybody wey see project with small total supply like that make una nor hesitate to sound the alarm here. E jor.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Quote
@Lordhermes, Curio na magic coin na, but to invest for now no go make any sense. We no know where the price of cryptocurrencies dey go na, if the bull back continues, curio price go drop, and as the price dey increase abruptly na so it dey do too when decreasing.

Lol @ Charles-Tim but na so btc too be na... As e dey fly like kite, na so e dey nose dive like plane wey dey crash (As I imagine and read because I never see plane wen im dey crash unless for oyibo peopo film  Grin). Anyhow, if curio give a good entering, na good buy. The team dey active fit 4m wen julerz12 run dey bounty package.
Good day all our peopo here.
Jump to: