Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 272. (Read 1034533 times)

legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
@Becky, your suggestion make sense. And e easy to do sef. I don go adjust my own too.

I bin dey prepare one artwork via Roobet.com craft contest. I go soon post am make una view, tell me how e be and encourage me shah.
For the now,
How e dey be, make person yahn me what's sup
Oh really? So you too follow for the competition? Good one bro I hope you eon something. Roobet team dey try wella for helping people around with so many contests wey dem dey throw around and with better prices oh. I wish sey I sabi draw.

Still looking for partners and partnerships in Africa.
You've been told to specify what you want here. Not doing that won't get anyone interested in whatever partnership you want, especially as your account isn't a veteran account.
member
Activity: 1190
Merit: 10
Still looking for partners and partnerships in Africa.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
This room quite this days I. Watin sup na...
Na the way the cryptosphere dey be abi, e get something we dey prepare for. If na the matter be that, I bin dey prepare one artwork via Roobet.com craft contest. I go soon post am make una view, tell me how e be and encourage me shah.
For the now,
How e dey be, make person yahn me what's sup
full member
Activity: 756
Merit: 231
Help Create Awareness  

In quest for the exposure of this African bitcointalk community hangout, I want us to help spread this news to our brothers and sisters all over the forum. Believe me that, thousands of forum members viewed forum profiles to know who we are, this will probably help someone locate this community.
kindly follow these steps below:

1) Click Profile

2) Click Forum Profile Information

3) Copy and paste this text in quote(African bitcointalk community hangout) in 'website title':

4) Copy and paste this text in quote(https://bitcointalksearch.org/topic/naija-novice-hangout-newbies-introduction-orientation-thread-5121680) in 'Website URL':

legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Lol d revace fit be like molue wey dey turn 4 one small Ajegunle street. D molue fit take 5hours try 2 turn & enta gotta  Grin. If area bois push am come out, u go jus see d molue conductor advisin his driver say mak dem go anoda place go turn. Grin. Laf don finis me 4 dis ya xperiense. Mak nwa guy kol ur bori 4 u
I mean am o, na as e be me I dey tell una so. I know say the market get as e be, like when you dey expect am to buy, e fit turn against you almost, that one dey.
But then, na via the plenty lapses for your analysis but then, watin fit save you too na your account size. If you be man with large account size, you fit dey patient to hold the trade with hope say, e go reverse soon but that too na risky move o, via say, e fit turn against you con dey create new higher highs instead of lower lows.
If you analyze trade well to be oversold using RSI and you dey watch the kind of power candle stick, dragonfly doji, harmer, hanging man and all those signs of trend reversal them within a period of consolidation under four hour time frame though, you get to dey switch time frames to clarify yourself. Then, even when e still go against you, you get just hol small with your eye on the direction your moving average dey tell you, na the best way to ride or catch trend early be that. Your equity go sure.
Abi you never see am say, na plenty getting out of trade on loss dey chop you finish much much... And as you place trade ecf, na straight up minus you go dey see. Although, no be all trade you go hold shah, e get some way you just gat commot immediately but, na for you to know them be the matter.
But all na base on sabi shah and you way dey trade kwanu. You get find technique way go work for you.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

Most of us dey enter market without target and once we start to catch up with the trend, our greed go con carry us, before we know, the trend go push back against us. We go dey hope say e go reverse to our favour, the next thing we go know be say, we don dey loose.
My small experience for the market don teach me to get target, make my analysis on a higher time frame at least four hours observe the trade on a much laser like one hour.

Lol d revace fit be like molue wey dey turn 4 one small Ajegunle street. D molue fit take 5hours try 2 turn & enta gotta  Grin. If area bois push am come out, u go jus see d molue conductor advisin his driver say mak dem go anoda place go turn. Grin. Laf don finis me 4 dis ya xperiense. Mak nwa guy kol ur bori 4 u

Hello I'm looking for partnerships in the continent of Africa. If you have a business, skills, trade or connections and are in Africa please send me a message so we may talk. Thanks again.

You need to explain in details on what it is you are into with proves.
You have just made an open ended statement or request.
member
Activity: 1190
Merit: 10
Hello I'm looking for partnerships in the continent of Africa. If you have a business, skills, trade or connections and are in Africa please send me a message so we may talk. Thanks again.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
I still dey practice my trading skills shah but, the thing no easy at all. Placing a trade and you don already dey lose right from that point. Na so the matter just be but, you gat dey try and try to learn something from every mistake you make.
Most of us dey enter market without target and once we start to catch up with the trend, our greed go con carry us, before we know, the trend go push back against us. We go dey hope say e go reverse to our favour, the next thing we go know be say, we don dey loose.
My small experience for the market don teach me to get target, make my analysis on a higher time frame at least four hours observe the trade on a much laser like one hour.
Like that eh, once trend for market start to change, you go notice am on time then, commot body.
full member
Activity: 756
Merit: 231
@Mpamaegbu tanku, u don talk plenty tins wey sweet my belle, dis exchange tokens na gud talk nd u deserve one bottle of 'anointing' broda. Mak I gadar myself togedar nd hodl some wey dey my mind.

@awawo, I b tink sey na only me get d red card last month, d fire burned me shaoo but na lesson em b to me, I no regret am. Staking na gud tin but many persin here don talk sey dat level too na shit like trade. But mak I test dis one(staking) to know d gud one to follow.
member
Activity: 406
Merit: 13
STAKING AND ITS PROFITABILITY
Una gudmoni my people, I just want us to discus dis issue wey I tink many of us don dey do but some never start or hear am. De altcoins still dey down and dis is de time to get into staking, staking can earn u many many profit wey trading cannot give except dose wey sarbi well-well. So, if u never dey gud in trading abeg make u shift ur yash to staking of altcoins now.

Here are some few altcoins wey fit give gud profit in short-term: "KAVA 5.08% TRON 0.74%, ATOM 7.39%, TEZOS 6.09%" among others, why I chose dose ones bi sey, dey cheap for market now nd na opportunity for anybody to buy dem for staking. Me kum-kuma dey use Trust wallet so I dey stake for dere.

Tell us more about staking make we pinkins learn.

Me i still dey check amm like this, as staking new for my face. I been buy some coin like that and i just start taking now. I wan see how the thing go be before i put more money inside. I been try trade last month i nearly fent because of lose.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
smilex12, welcome once again. E bi like sey I don even sight you for that my thread on African Proverbs sef. But na now I sabi sey you be lady according to your confession for here.

How una dey my honorable men nd women? De market don turn bloody nd how una tak see de future of dis blood, e gud mak person buy nd hodl but which one gor-gor u go want mak person hodl?. We know sey ur talk no b investment advise, biko.
Make you or any other persin for here nor let this red wey the market dey see na bother you. Now na be the right time to even buy more of any coin wey you dey eye before. Buy dem cheap and no panic but make sure sey any coin or token wey you dey buy na one wey get utility. Na this utility be the only way wey go make dem come up again after them stone for ground. On this, we all sabi sey nobody for sure know the crypto wey go give us plenty riches except the persin wan just lie. But I go like tell us sey "Exchange Tokens" dem dey go to buy. Just look for the cheap ones and buy. Me I get some cheap exchange tokens like Tidex and Bitrue. Abeg, if you never still buy Cartesi (CTSI), make you try buy that coin. Na good project be dat.
full member
Activity: 756
Merit: 231
STATE OF CRYPTO MARKET  
How una dey my honorable men nd women? De market don turn bloody nd how una tak see de future of dis blood, e gud mak person buy nd hodl but which one gor-gor u go want mak person hodl?. We know sey ur talk no b investment advise, biko.

@Smilex12, we welcome u nd hope to see u doing well as everyone dey do. Don't forgets to read rules nd understand dem, I welcome u again.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Quote
E b like sey theory na em  people dey use pass practical for trading: e shock u abi? Me self I sabi theory well-well but dey fuckup during practicals

For bible, them say spiritual things go teach us physical things but;

For trading, me think say na practical go confirm your theory for you enugo, you don hear. Lol
Make we no go carry bible put untop laptop dey pray to revive a losing trade....lol

Fuckup   Roll Eyes Shocked

you no sabi say small pikin fit dey this ile? Abi wetin make you think say we get many levels here, from legend to small stout  Grin Grin

As @Smilex12 be our small stout as e dey go.

Nwa, u don show  Huh. How the tins  Grin
I join muscle with all man and human take salute ur elbow.

Abeg, make u reach ground to our levels for this ile, make some pesin no go stay for domot dey video dido our parole for this ile

E go make too much sense like dat. I hail you no be small.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
My broda, many tins dey happen for dis market, hope sey no b me d negative ones dey happen only? Trade eh, na scam Cheesy I see am, especially wen u no get otumopor. E b like sey theory na em  people dey use pass practical for trading: e shock u abi? Me self I sabi theory well-well but dey fuckup during practicals Cheesy I don lose some dollars now.
Chaiii! E just be like say you dey my mind. The trading eh, e be like say na you(we) them dey wait for. Like say one man just dey wan side dey move the wave and as e dey move am, e dey watch you. Once you say make you place trade, na once you go begin see consolidation or the trend go just go against you.
E con be like say, the theory way person know don dey out dated. The matter tire me just now.
full member
Activity: 756
Merit: 231

This na secret wey I been dey find since, as the market dey red everywhere, na the best option be this I swear down, among these coins you list down, me I prefer ATOM not because of the high ROI percentage but because of the project itself, I watched ATOM at $1.5 price but now na around $5.6, also them get tiny withdrawal fee and high volume and volatility, I never stake before so I go use trust wallet as you talk make I partake.
I like ur muscles bros, dis one na sense u giv oooo. Me dey follow KAVA shaoo becus of deir project and network in cryptospace, I will add dis ATOM now tank u.

among these coins you list down, me I prefer ATOM not because of the high ROI percentage but because of the project itself, I watched ATOM at $1.5 price but now na around $5.6
I hope sey you manage to pack small when e dey cheap abi you escort the price go up because of fear fear 😂. Trading na the easiest way to increase any unit of coin wet you get. But you must know the game wella to do am well. Otherwise, na sorry by the end.
My broda, many tins dey happen for dis market, hope sey no b me d negative ones dey happen only? Trade eh, na scam Cheesy I see am, especially wen u no get otumopor. E b like sey theory na em  people dey use pass practical for trading: e shock u abi? Me self I sabi theory well-well but dey fuckup during practicals Cheesy I don lose some dollars now.
newbie
Activity: 12
Merit: 3

Username: Smilex12

Gender: Female ( yes! We have quality female traders in Nigeria too. LOL)

Country and state of resident: Nigeria, Lagos

Skills: Marketing, Education and community management (Blockchain &crypto)

It's nice seeing and knowing that we have a place on this forum where we can express ourselves and relate in mother tongue.

Make i drop small words of wisdom before I waka-

Escort me, Escort me, na im slave trade take start.
meaning -Serious things sometimes start like joke.

Twale for una.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Na hunger
But that one na constant H na 😢. Na the way wey you take put the question confuse me (and I believe other guys too)

among these coins you list down, me I prefer ATOM not because of the high ROI percentage but because of the project itself, I watched ATOM at $1.5 price but now na around $5.6
I hope sey you manage to pack small when e dey cheap abi you escort the price go up because of fear fear 😂. Trading na the easiest way to increase any unit of coin wet you get. But you must know the game wella to do am well. Otherwise, na sorry by the end.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Make we just juggle our brain small. Anybody wey get am, I fit give am 1 thing  Grin

Tell me wetin beat husband for where the wife and children dey?  Grin

Na rain.

Lol... Nope. I go wait for like two more response.

Na hunger
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
I greet everyone for the house. I been wan come officially tell the house say local man been don finally reach hero rank and e for no dey possible without una support so I thank una. The reason I never dey active here much be say, I been dey seriously sick. I still dey try recover and I been get burnout from coding (burnout mean say I code till I lose motivation aka my fuel run dry) so I dey try recover from both my sickness and burnout at the moment.
You be one person I dread on this reputable forum wey know ways, I dey try hard to work up to you as baba wey don dey here for long, omoh, nelson4lov you try major, congrats on your Hero rank Boss, you too much, well done,I dey proud of you and this show say any thing you air out for here say make we do and follow, na the thing I go do.  
<...>

Jump to: