Pages:
Author

Topic: Why some newbies dey quick lose interest for the forum?? (Read 676 times)

jr. member
Activity: 98
Merit: 4

 
Normal if u no strong for here u no go fit grow na d truth just be dat. Again, some newbies fit don get wrong information about d forum, wey make Dem rush con register. Dem go don tell Dem say money dey here and if u fit grow account u go turn millionaire over night. all these many many wrong information na e dey give the newbies Dem wrong motive to tay join forum and u go see Dem just pop out, dey post things wey no make sense or some go come dey spam forum. Once Dem criticize that kind person, e go just rest and e interest fit just die like that.

I b living testimony to this one. My guy wey introduce me although I bin think say na Bitcoin trading en Dy do. En promise to teach me and carry me along. The first day wey I go meet am nay en come Dy tell me say the work no b any other thing but to Dy write "as simple as writing" but I go pay small money to register. Immediately I register e come Dy send me some beginners and help link wey I use like 3 days read, come proof myself worthy to write. My first account dem ban am due to plagiarism. I bin never too Dy grounded with  the forum rules. My evil fee to register this account now come b double due to the volatility of bitcoin price but I still get mind register because en tell me say after like 2-3 months I go begin earn money. Till now my merit still Dy 4 but my activity don reach 98. Na the 4th month b this.
That initial strength wey I use start the forum by Makin like 2-3 post daily don drop. Infact for 6 days now I never even visit the forum.
sr. member
Activity: 1316
Merit: 379
#SWGT PRE-SALE IS LIVE

Na correct talk u talk, my brother. Normal we no say Bitcointalk no be for the weak and to grow from newbie accounts go high rank no be day job.

This point wey you make really grab my attention, to be honest Bitcointalk no be for the weak. And despite the criticism and backlash wey be normal thing wey most newbies experience, to grow for this forum person go need patience with zeal and willingness to learn. Also person go need dey tolerative and overlook the criticism. Our people say who give up na em fuck up, so I believe say those wey give up no get patience and dem no dey willing to learn that's why them dey give up easily over small criticism and backlash by senior forum members. For the forum endurance matters a lot, if you notice na those wey get endurance, wey overlook the criticism and improve with the things they learn from this forum na them wey rank up and na them dey enjoy the benefits of the forum currently, that's why oyibo say, "patience is virtue".
newbie
Activity: 27
Merit: 1
My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.


I see am dat way too oo I know say me I be newbie too but I know weytin I find come here so I go get am, because me wen I first enter this forum I dun get orientation of how this matter be but some of all this newbie them think say e just deh quick to achieve something,not knowing say u go follow steps by step procedure,some go say them no get that kind time to deh type,do this and that for this caban.

Me I take am say e no make sense at all because anything weh u wan achieve for life nah Patience follow am,and u know say people go criticise you as u wan achieve something but u go know where u deh go so that u know go miss ur way.and another thing weh deh make them loose interest be say their mind no deh for the thing.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Reading would have been the best option for the newbies that coming to the forum newly but when dem come dem dey create threads dey find merits like elders. And when merit no come come before you know dem don tired and some even give up di forum and go and hustle physical cash jobs. And some of dem na impatient and can not endure insults. Dis forum if you can't wear thick skin then you can't stay because attacks here a d there go come. While di last group of people wey I know say dey give up na di people wey can't write and dem join di forum base friends initiative.but when dem discovered that dey can't write well then they give up.

Those are some of the people I discovered that they lose interest when they come here.
sr. member
Activity: 574
Merit: 308
The main reason why anyone would lose interest in the forum is because the person lacks the spirit of learning. The forum is all about reading, learning and building omes self, but anyone who is not ready to go through these process will not be successful in the forum.

This is how it is supposed to be but let be realistic for once. Majority of newbies joining this forum recently are not purposely joining for this benefits any more rather, they join purposely for the financial benefit. I don't blame them for that mentality thou I blame those who introduce them to the forum with such orientation. When you are being told that people are making money here and you joined with that mentality but you later realize that things are not as assumed, you'll definitely feel discourage. For those newbies, after facing the reality they give up instead of facing the challenge to equipped themselves with the knowledge and any other benefits that might come along the process but they lack patience. The truth is nothing easier if you can't be patient enough to follow the process.
full member
Activity: 588
Merit: 119
Epsiloan Protocol
The main reason why anyone would lose interest in the forum is because the person lacks the spirit of learning. The forum is all about reading, learning and building omes self, but anyone who is not ready to go through these process will not be successful in the forum.

Patience is another issue to discuss here. Some came to the forum to earn money as soon as possible. So they think of getting merit as they write and make post. But after a while of not getting merit on post which they believe are so good enough to be merited..They become discouraged expecially when such post received criticism from other members. They become discouraged and may later abandon the forum.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.
Honestly eh bross the kind backlash wey I see one newbie collect for this forum for one yeye post wey e make really reach for person to lose interest for the forum, e reach to even put person for depression and till now the newbie never reply. Na why I thank God say all of us dey anonymous for here so nothing fit move me comot for the forum because if you criticise me finish last last you no know who I be, you no fit see me for road dey point me say see that newbie wey no Sabi anything for bitcoinTalk forum and even if you know me e no comot anything for my body. (The patient dog eats the fattest bone) beginners need to use this proverb hold body for this forum, Las Las we go dey alright.
Omo, I understand how that newbie go don feel and I know say no be everybody sopoz Sabi everything like the next person but some of these noobs dey receive these backlashes because them no wan hear. E dey simple, before you make contribution for place you never enter before, nah to first study the place, see how things dey be before you drop your two cents but some of them no wan know this one; them dey expect say person go hold their hand, spoon feed them.
 Thank God for anonymity as e dey help the firing to reduce as you tok but that no mean say you go use that wan do any how, because at the end of the day, you no go want make them see you as that user wey dey post shit..
jr. member
Activity: 0
Merit: 0
My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.
Honestly eh bross the kind backlash wey I see one newbie collect for this forum for one yeye post wey e make really reach for person to lose interest for the forum, e reach to even put person for depression and till now the newbie never reply. Na why I thank God say all of us dey anonymous for here so nothing fit move me comot for the forum because if you criticise me finish last last you no know who I be, you no fit see me for road dey point me say see that newbie wey no Sabi anything for bitcoinTalk forum and even if you know me e no comot anything for my body. (The patient dog eats the fattest bone) beginners need to use this proverb hold body for this forum, Las Las we go dey alright.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
You might be right. Some persons might just be opportuned to be in this forum probably by chance of media trending also by recommendations which they may need some layman's orientations on how the forum is operated and also builds the individual with the knowledge to ignore criticism and lambasting of of forum users on them else they'd be fed up and depressed. Probably that'd build their immunity to overcome depressive responses while they're in the forum.

But otherwise, anyone coming to learn new thing in a strange environment should also understand that anything unfamiliar especially intolerance is possible to happen. So they the newbies too could stay fit and tolerance to nurture themselves believing that they're into this journey alone without anyone of a physicality to guide them through.
Atleast it should be popularly known that nothing good comes easy.
When you are in a public domain most especially on a social group and forums, there must be the likelihood that you will see a pattern of doing things, some people are not gentle with the use of words and can say whatever the wish without minding your feelings and other also behave in the most civil ways, so dont be surprised if you see diverse characters here in the forum and how unfriendly some comments could be but above all you need to kove beyond that and reaching a stage that you develop the thickness of skin to absorb them and not allowing the criticism to kill your motivation to learn as you move along the way in the forum.

So for that all I can tell newbies is never to allow whatever harsh words to take control rather let be the fuel to light up your desire to learn more new thing that will help you grow win knowledge to defend your self.
member
Activity: 378
Merit: 76
Eloncoin.org - Mars, here we come!
One part way person fit survive for this naija na to dey patient anything way u dey do for life and u no get patient u no fit move forward expecially the way the country be now our youth no want where go dey slow for the them need am hot hot, mk we always put am for mind say the waka of a thansand miles start with a step mk we know say for this life patient na the only way particularly for this forum.
The forum de really help us well well, we just go de bring positive news and holding on the system with good updates wey fit change person life one time. We go de patient but na with sense because any slight mistakes fit make person lose out on the significant profits wey de come our path. We go just continue to de learn everyday because if we no de learn, how person go take improve and know the updates circulating around the system?
member
Activity: 154
Merit: 33
Eloncoin.org - Mars, here we come!
The reason dey very simple,  na him be lack of proper mentorship because of anyone established member wan carry person come on board,  the first and most important advice na make the person develop a thick skin,  to be able to absorb all negative energy and still work hard to achieve their aims here in the forum,  and this is very important for a newbie.

But because some newbies found this forum on their own the missed such orientation will not be able to absorb any possible attacks from the forum and another online marketplace.

You might be right. Some persons might just be opportuned to be in this forum probably by chance of media trending also by recommendations which they may need some layman's orientations on how the forum is operated and also builds the individual with the knowledge to ignore criticism and lambasting of of forum users on them else they'd be fed up and depressed. Probably that'd build their immunity to overcome depressive responses while they're in the forum.

But otherwise, anyone coming to learn new thing in a strange environment should also understand that anything unfamiliar especially intolerance is possible to happen. So they the newbies too could stay fit and tolerance to nurture themselves believing that they're into this journey alone without anyone of a physicality to guide them through.
Atleast it should be popularly known that nothing good comes easy.
member
Activity: 196
Merit: 91
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
My observation on why some newbies lose interest in the forum is the awareness that was given to them before they joined the forum because since they have been told that they can earn money from the forum, they came with that mentality that earning through the forum is just something that will happen so fast therefore all their thinking is only based on that reasoning without knowing that they would pass through some stages before they get to that level. Another thing is earning merit, when they see that they have made some quite number of posts without gaining merit from them, they start to panic and lose interest along the line. The only problem we have in our society today is that almost every one want the easier way to wealth, they don't want to work hard before starting to see the fruit of their efforts.
member
Activity: 66
Merit: 5
Eloncoin.org - Mars, here we come!
The main reason why anyone would lose interest in the forum is because the person lacks the spirit of learning. The forum is all about reading, learning and building omes self, but anyone who is not ready to go through these process will not be successful in the forum.
Yes na true say person gays dey learn everything or dey open to learning before dem go dey successful for here, many times newbies dey complain say dem dey bully dem but na because then no get crypto knowledge and dem no want take lesson from any body, if you correct them na bully straight and that thing dey cause to comot for the forum fast fast.

Some people na because them think say na just come post one or two them go just rank up etc but when them come nd the game is not like that then begin dey vex they even want destroy the small opportunities wey them get. If person no fit learn from random people for here whether na their mate or not them no go waste time fall out.
sr. member
Activity: 266
Merit: 276
The main reason why anyone would lose interest in the forum is because the person lacks the spirit of learning. The forum is all about reading, learning and building omes self, but anyone who is not ready to go through these process will not be successful in the forum.

newbie
Activity: 56
Merit: 0
Let me chuke month for this matter small, newbies for this Bitcoin talk platform no be small ooo is not easy to grow at
all especially here,when I started some days ago I see some people and their merit I said God can I cope I wanted to run leave this platform but one thing I remember is courage.

And I also remember back in those days when I newly enter higher institution in my department alone we are more 300 thousand people,but I still finish my education,so being here is courage and determination,and also handle everything to the creator,no need to run.

I can never run till I see the end that is how I do my things,I will make sure I continue so to be part of people who use this platform to become somebody in future

Even if the platform didn't pay me,the knowledge am getting only is the best ever

Am very happy to be here , because many don't have the opportunity to be here so we that have the opportunity to be here how can we run,I can't to all the old people in the house I great you all ,is not easy to be where u are today,what am still asking from you people  that has last is to keep teaching us ,we the newbies so we can still stay I believe before u get to where u are today someone teach you, motivate us to keep going

Like a post i make ,one Senior member correct me and also put me in line ,I was so happy for correcting me ,here is a family a community,where good information and help are being rendered to each other ,pls the senior members ,keep on the good works of teaching and sporting out errors so we the newbies can still have more hope and courage on the platform
Thanks  Grin
newbie
Activity: 28
Merit: 0
One part way person fit survive for this naija na to dey patient anything way u dey do for life and u no get patient u no fit move forward expecially the way the country be now our youth no want where go dey slow for the them need am hot hot, mk we always put am for mind say the waka of a thansand miles start with a step mk we know say for this life patient na the only way particularly for this forum.
member
Activity: 168
Merit: 75
My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.
I go talk day the main reason wey dey make new members wey recently join the forum to loose interest na their reason for joining the forum. Some people get wrong information about the forum and na that information them dey work with, na the information wey don register for you mind go influence your behavior towards the forum.

Some people wey join the forum, people wey introduce them, tell them say, all they gats do na to register account and start to dey post correct correct things and them go start to give you merit and then when you don reach better rank, you go fyn one campaign join and then start to make cool cash. I know say na this thing them tell most of the people wey dey newly join this forum.

So when you don carry that kyn information for mind take join the forum, them start to dey post things wey them feel say e make sense ASAP then dey expect merit, and if the merit no come start to dey come the way them been expect or the way them been tell them, them go come loose interest for the forum go focus on other things wey go pay them money.

I always tell new members say this play na where people go learn and talk about Bitcoin, other tokens and some kyn general topics, so if you dey come that kyn place, your main motive na to learn as much as you for, and when you learn finish, you go come start to dey contribute wetin you don learn and then you get paid for your contribution. So if you never calm down learn, nothing you go fit contribute so rather prioritizing gaining merits, make we calm down learn first.
member
Activity: 154
Merit: 33
Eloncoin.org - Mars, here we come!
This is a lecturing forum where we are ought to consult, enquire and acquires knowledges in diverse of interests. So if there could be any member here be it newbie or old member who takes offense of having itself felt not Worth being talked to in one unpleasant way or the other just as OP said =back lash that means the individual is not ready to obtain the goal for being here and why this forum was formed.
We learn by all means of truly we wanted to learn. It is either we learn in the hard ways or the soft ways so, I don't think if I cares about them that lives just just back lashes. They must be unserious to learning.
sr. member
Activity: 504
Merit: 302
To me, I will say it is laziness, and some might think they can’t make it to rank up due to how hard it takes to get merit. That is just the main thing that discourages many newbies from losing interest in the forum. For instance, when you invite someone to join the forum and you show them links to read more and understand more about the forum, they will see that the context is very bulky. From there, they will start getting discouraged, and when it comes to posting, if you tell them that they can’t post just a few words, but they have to express and explain what they are trying to post, they will start wondering if you really want to help them or if you are only trying to make them suffer.

And showing them the part that is very hard for them to learn. For you to explain to a beginner or newbie, when it comes to merit and activity, that is what discourages them the most because, based on calculations, if they really want to rank up to full member rank, they have to spend approximately four months to get the activity, talk less of getting the merit to rank up. Many people here find it hard to cope with that to be sincere. To me, I think that is just the reason many newbies lose interest quickly.

Laziness is the one the things wey dey make newbie to feel discourage here and secondly na patient wey them no get, if you dey observe many newbie wey dey join this forum this days you will understand that many of them are here just to join campaign and get money, even from the way they are ask questions in forum you will understand that they are here for something else, the reason why I said all this is because many newbie will be complaining about having merit and how they are going to build their account, this forum Don become like something wey be say many people dey see am like place wey them go just come and make money, yes money dey forum but my brother you have to be patient enough and learn about forum, anything in this life have a step and have to be learn, so in my opinion the main thing wey dey affect newbie here na lack of patients and laziness.
full member
Activity: 294
Merit: 229
Let love lead
The reason dey very simple,  na him be lack of proper mentorship because of anyone established member wan carry person come on board,  the first and most important advice na make the person develop a thick skin,  to be able to absorb all negative energy and still work hard to achieve their aims here in the forum,  and this is very important for a newbie.

But because some newbies found this forum on their own the missed such orientation will not be able to absorb any possible attacks from the forum and another online marketplace.

The  orientation you received and motive of your joining the forum is very important. Continuous orientation is very important to succeed in the forum. During my early days, my mentor had me on close watch and even corrected me when I was quoting wrongly. He continued monitoring my account for flaws and even called me to inform me of an open slot in the signature campaign I work for till now. I'm really grateful to him. Myself on my part, I had the motive of learning everything that's learnable and the  hope of having rewards for my activities kept me going as I had my eyes fixed on the price.

I must confess that engaging in this forum until you rank up isn't easy at all, there are days you'll get very frustrated and think of giving up, everybody once felt that way, but its a choice to keep on track and focus on your target until you achieve success. In times of negative feelings, your mentor serves a very important role in motivating you to stay on track. This is what most mentors forget to do continuously. Your recruit remains under your guidance until he ranks up and starts working unless he chooses to stop listening to you.
Pages:
Jump to: