Pages:
Author

Topic: Why some newbies dey quick lose interest for the forum?? - page 2. (Read 676 times)

sr. member
Activity: 378
Merit: 259
My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.

We should not lie give each other, as a newbie we know say this forum no really dey easy, we no have the same thought while joining this forum, some people joined this forum because they want to learn more about bitcoin, while some joined as them hear from other people say money dey this forum. If some newbie just create account the first thing that come their mind be say they should start to go and drop post anywhere them like to rank up, when dey continue to dey post and dey did not receive any merits dem dey feel discourage, their body will become weak, as dem dey drop post anyhow if to say dem dey receive merit ni body go dey sweet them say they should keep it up.

One reason wey i take see say some newbie no dey active again be say laziness dey their body, some newbie immediately they hear about this forum they think is something easy you will just enter and start write whatever they want. You know say some people dey get one kind laziness for body from childhood, they won't like to dey read, any words that is too long they don't have time to read am and this forum no be to enter and start dropping memes  Grin
member
Activity: 213
Merit: 12
Well my dear,wetin you talk na true,e dey happen alot of newbies don go leave their account here on the social media,but every body get reasonable reason why him or her go leave em account,

Some people may be dem no get time to the fellow up and do the comments here on the thread, and some people na impatient because dem don comment maybe 10 to 20 comments and e feel say the things dey easy and e no go fit with stand am,
Again na because dey person wey tell about this forum no dey with am again to dey guard am and him never too understand am,so when e try to comment e no go fit and maybe dey person wey teach am no teach am well ,
Another na like say the newbies think say if you just create your account you go beginning to the get rank everytime and they think say every post wey them make them go get rank so that before One month them go become highest ranker,but wen dey wait for some time and them no get that rank they go give up say them no go fit continue this because them beginning to see am as something wey dey take time and them no go fit wait for that time..
member
Activity: 196
Merit: 25
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.

I go just go straight to the point answer you wetin I feel say be the major reasons why some people dey easily lose interest or get tired of the forum especially the newbies.

1) Wrong Orientation: First of all we understand say some people dey bring other people come here but Dem no dey open up tell them as the place be and how things take dey happen for here so when dem talk to them up up when Dem come enter as soon as wetin dem expect to see no be wetin Dem see Dem go just tire for everything.

2) Lack of adequate study time: some people wey enter forum no dey take time well to study this place before Dem begin posting, most people wey stand well here today go confirm say Dem been first learn from others wey dey here before Dem before dem start to dey hustle but lately new comes wam just dey do tins on dia own forgetting say e no easy like that. I foe like continue but for the sake of time and other things make I stop here make others also put mouth 👄.


I think you said all in my mind , this is nothing but the truth poor orientation and inadequate study or research by newbies. The mindset of getting merit or campaign that will fetched them money, get rich quick, not knowing that it takes patient and hard work to achieve it. Many has explained many courses which not far from the truth. When expectations is cut off through wrong and poor orientation you should know the result  is to run away.
member
Activity: 132
Merit: 14
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.
Well done op, the thing wey I wan talk be say make we no forget say newbies dey like apprentice and imagine after putting so much work creating something to impress your boss/teacher em come tell you say wetin you do no dey worthy, this one na complete emotional damage, no be everybody fit take criticism as human go always be human. I don Waka for this forum and I dey see plenty criticism for person (newbie) post and my take be say this place no be for the weak at heart.

Two things wey I know say dey make newbies run from this forum na impatient and the criticism wey dey come from high ranked members. It will be very hard for any newbie to survive if they don't have patience and can't take criticism.

 My advice to other newbies be say make una develop toff skin if you wan survive, criticism no go kill you, e go only make you better if you use am well, if person criticism your post e no mean say the person no like you em want make you learn from your mistake and take correction. Me self don collect my own share of criticism and e really enter me but as I don go through wetin cause the criticism I go make sure say I correct myself next time.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.

I go just go straight to the point answer you wetin I feel say be the major reasons why some people dey easily lose interest or get tired of the forum especially the newbies.

1) Wrong Orientation: First of all we understand say some people dey bring other people come here but Dem no dey open up tell them as the place be and how things take dey happen for here so when dem talk to them up up when Dem come enter as soon as wetin dem expect to see no be wetin Dem see Dem go just tire for everything.

2) Lack of adequate study time: some people wey enter forum no dey take time well to study this place before Dem begin posting, most people wey stand well here today go confirm say Dem been first learn from others wey dey here before Dem before dem start to dey hustle but lately new comes wam just dey do tins on dia own forgetting say e no easy like that. I foe like continue but for the sake of time and other things make I stop here make others also put mouth 👄.
full member
Activity: 756
Merit: 180
Eloncoin.org - Mars, here we come!
My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.
Firstly, not everyone sabi take criticism well that one true point wey you observe wey make sense.
Secondly, when the newbies reason say to get merit take hard, them go just discourage. That na one why wey e dey good make we dey try follow up on them mostly as them identify with our local board.
E no easy aswear, even me sef dey feel discouraged sometimes but because this community don become like second nature to me, I no fit just stop.
Make those of us wey get dey share with the newbies so as to encourage them till their hand strong or the tempo don embed into their DNA
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
This depends on your motive of joining the forum. If you are here to learn and contribute, you will definitely see criticism as nothing but most of this people were introduced to this forum as a way of making additional income. At first they think it's easy but after being criticize from their few post, they got discouraged and left. They have forgotten a post that someone criticize may be merited by someone else. This is because individuals comes with different though and opinions.

My broda some piple come to learn and contribute but the way some high ranked members (abi nah old members I go call them) dy take bad-mouth this newbies go worry them seriously, e com be like say them no get anything to offer to this community even for here and outside our LB.
You check am, if them begin treat you like say nah your own bad pass you sure say you go stay here? No and nah only 75% of the users wey get thick skin to take every okoko words nai dy here and some piple dy talk about lack of mentorship, e go help oh but who you wan rely on to help you nah? For me here nah jungle wey if you no take good care of yourself  and behave well them go yeye you full ground, as for d mentorship them dy but who ready to help the next man this one wey everybody nah oga madam😁.
full member
Activity: 280
Merit: 151
God is All
My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.

This depends on your motive of joining the forum. If you are here to learn and contribute, you will definitely see criticism as nothing but most of this people were introduced to this forum as a way of making additional income. At first they think it's easy but after being criticize from their few post, they got discouraged and left. They have forgotten a post that someone criticize may be merited by someone else. This is because individuals comes with different though and opinions.
Only someone who doesn't want to learn, feels criticism as something bad whereas it's a way to actually develop and evaluate your flaws and mistake so you can take it to correction and help yourself. Once you start seeing criticism from this angle then I guess you would glad when someone even criticize you. The people that came here to exploit the financial benefits were having their expectations too high and that's why they got disappointed because their expectations were reduced as they failed to understand how the community operates.
full member
Activity: 588
Merit: 119
Epsiloan Protocol
My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.

This depends on your motive of joining the forum. If you are here to learn and contribute, you will definitely see criticism as nothing but most of this people were introduced to this forum as a way of making additional income. At first they think it's easy but after being criticize from their few post, they got discouraged and left. They have forgotten a post that someone criticize may be merited by someone else. This is because individuals comes with different though and opinions.
sr. member
Activity: 350
Merit: 335
We must tell our selves the truth that it is not easy being new to a new technology like Bitcoin that involves complex coding, unpopular terminologies, and different concepts and with money at stake. Yes money is at stake because any little mistake you make can cost you money. Even scammers are on the other side looking for a way to steal your money. So it is not an easy thing summoning the courage to join Bitcoin hence, we must appreciate the efforts needed for a newbie to scale through the huddles of fear, confusion courage and dedication even as some of us passed through.

Another thing that is scary about being a newbie is the laborious process of growing in rank through the merit system. If not of the intervention of some merit sources, it was not really easy earning merits because a newbie that probably do not know anything about Bitcoin before and not too sound in Bitcoin technical will most likely not make sense to deserve merits. It will take a long time of reading, research and learning to be able to make sense and not many people are willing to go this route because reluctance is in human nature.   

Therefore, I'm not surprise when I see newbies run away after some weeks of joining the forum. However, those who persevere will always succeed and find things easier with time. They can benefit from the abundance of information opportunities the forum offers.
newbie
Activity: 28
Merit: 1
I greet everybody in this forum, well just like you said why some newbies dey quick loose interest for the forum.

Some of this newbies you say, okay, like Early entering make them to feel like they don't see any benefit yet, that is why they leave the forum so early, this forum is just like having some patient for you to achieve your goals
So many newbies feel so less concerned about this forum which makes them even more weaker to operate in.

My advice to all newbies is that they should never give up because they are making move to their fucture of becoming an investor or a Bitcoin trader. Remember that everything has there own time to manifest.

member
Activity: 224
Merit: 24
My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.
To me , the major reasons would be;

Finding some topics overwhelming. They're newbies, they don't know much and sometimes it feels like trying to write a comment would make them look like they're writing basic things that most people already know.

Secondly, would be finding it difficult to fit writing on the forum into their probably busy life. When I started out on the forum, I would sometimes spend 2-3 hours writing only about 2 posts and it made me always tired. Like even the ones that I would have written would still be basic stuff.

Thirdly, it's always difficult as a newbie to get merits, cause even when they write something smart, when you just look to the left and see it was written by a newbie, most would just tag it as something that wouldn't make that much sense.

They may be many other reasons, but if you're a newbie reading this then, you should know that all these things is just a phase. I use to be like that and I honestly almost gave up on the forum, then I realized that i'm not that weak, I just needed to study harder and know more. If others can do it, then I can definitely do it and do more and so can you.

So, don't give up. Fighting ...
full member
Activity: 182
Merit: 120
Cashback 15%
This backlash alone don reach for person to give up, and sometimes when I reason the backlash na to correct some people but the actual manner wey some people dey take put am dey sound somehow, sometimes when I dey read through some topics and the comment, the comment no even relate with wetin the op dey try ask or explain.
Correction dey good most especially for people wey dey find difficulties to understand but some people dey wey no dey take correction and na those people go quick give up for the forum because forum na place wey different opinion and criticism dey, with just the backlash sef e don reach to quit
legendary
Activity: 2226
Merit: 1049
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Well, newbies na newbies, and newbie for this forum no mean say the person wey dey behind the newbie account na new born for real life, many of them na matured adults with pride and ego, and this tell us say, we get wetin they fit take and e get wetin they no fit take.

So, for the newbie wey drop post for here, and wetin he or she receive as comments na backlash, to me, this one na very enough reason for some people to withdraw from the forum, this na one reason why I dey always advice make we wey don tey for here dey try to the dey more accommodating to the ones wey just dey join us, for without more people joining us and becoming established, how many are we the old ones here currently?.

And another reason again be say, some people dey join the forum with a mindset say immediately they enter here, they go immediately earn enough merit within some weeks, to enable them become high ranking members, so that they go join signature campaign and begin make money, but when they don dey here for several months and that rank they need to begin the earn from this forum never come their way, they easily lose interest and start distancing the self from the forum.

This na wetin me I think at the moment.
member
Activity: 154
Merit: 33
Eloncoin.org - Mars, here we come!
One major sensitive reason why newbies withdraws from here after couple of times of activeness is basically a point that they were told by their referers that this forum has the potential to acquire Bitcoin which is a means to enrichment. Meanwhile... These said newbies are eager to make quick money while their stays in the forum seems a time wasting because they couldn't find it easy to cope with the situation that it wasn't as it was preached by their referers. While some of them are the grievance kind of persons that doesn't tolerate with the term of being corrected at when made mistakes. They are basically quick to make quitting decisions without giving it a benefit chances of doubts.
hero member
Activity: 896
Merit: 645
I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
Like you don already observe, them dey affected or concerned about having it all positive but, no be so e be. No be everybody go dey on the same wavelength with you and people no go always agree with your ideas. At times, you go collect. Na world wide forum be this and people way sting for keyboard and screen plenty here.

As per why them quit, I go attribute am to their person and watin them bin wan archive. When you start to dey collect, e go build in you the idea say, you no belong, people no dey appreciate you for the efforts you dey put in and your goals go con far for your eye.
Omo, the lashes you receive na em go shape you o, na em go ensure say, you no dey spoilt. You gats endure and no allow plenty things reach you but, that no mean say, you no go accept correction or follow the truth when you see am.
The matter still remain say, na only you waka come, if you commot, you will not be missed.
member
Activity: 154
Merit: 44
Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Gud evening my people this feels so directly to me,  when I messed up a certain time  my acc was reported, and then I was reading comments and other stuff I just feels like crying some people criticize people too much in this forum at least consider us we are still human it not always about patience sometimes the way people talk or comment on ur post when u lose guard u will know if they love u or not. Most people in the forum don’t like other for goodness sake how can u be jealous of someone u don’t know it not fair so many Newbie’s are trying hard to understand the forum the rate the Hugo rank criticize them make them loose hope most times I just feels am not loved or welcome in this forums am saying my mind ooo. I know we are here to learn pls always encourage the newbie’s the rule and regulations should always be reminded to them  thank u
newbie
Activity: 17
Merit: 1
I be new member for this forum, wetin carry me enter this forum na the testimony I don dey hear about how the forum they help in some certain ways, most especially that of the income side, but with the little experience wey I don gather, you gats get patience and also you gats they intellectually creative survive for this forum. E get some certain things about cryptocurrency wey I been Neva hear about, but with the help of these forum I don understand most of them and wetin them entails. Most of us wey be newbie fit nor get better orientation about this forum, but as we don enter for those wey still get patience, we go try our best to survive the masses.
member
Activity: 155
Merit: 79
E get the way some people dey do for here wey me sef no like. When person make post, some people na to bash the person just because say them won increase their activity. Some topic no even deserve some kind of criticism but e get some people wey their work for here na to criticize people post without first understanding wetin the person dey talk.
As for the newbie wey dey vex leave the forum because of criticism, dem no serious in the first place. I believe if they have a solid reason for joining this forum which is to learn about bitcoin, to gain exclusive knowledge, you no supposed vex because we are all here to learn from one another.
hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.
Wetin be the first reason is the mindset wey carry dem enter the forum. If the mindset na to grow quick and make money, when backlash come, dem go reason am say no be wetin carry them come. But dem forget say for the body of rose na thorns wey full am. But anybody wey understand wetin the world dey about, understand say nothing good comes easily, dem go prepare for worse and make it.

If your guy carry you come here and you see say that your guy dey successful, you no suppose joke with this space. Every newbie has their own story to tell only if dem dey successful for the forum. Person wey run leave here no get any better story to tell.
Pages:
Jump to: