Pages:
Author

Topic: Why some newbies dey quick lose interest for the forum?? - page 6. (Read 1292 times)

jr. member
Activity: 73
Merit: 3
My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.

Op any person wey go live this forum, be like na person wey dey give up, not even here you know how many place him left after all, you gaz know how to endure ahm on any how e come just accept am, anything for life na time.
  If you see say person live ahm e be like that person is not really a hardworking person, this forum itself dey guide us newbies.
  Even now wey me just recently enter i really learn alot and am still learning till date. Thank you
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
Normally the forum no be small place wey person go just come dey feel like say e dey em papa palor, the forum no just be like other social media Dem. For you to survive for this forum, you need to dey very discipline, so here comes my answer, many of the newbies wey enter here don see am say no be the way wey Dem talk na so e be, Dem don see wattin their ear never hear. Aside that sef no be everybody get that discipline and patience, some persons dey find sharp sharp wey to take blow for this Bitcoin matter( # dos who can relate) and that kind thing no dey for anywhere, legit something comes with sacrifices.
sr. member
Activity: 588
Merit: 338
Most times na di mindsets wey newbies carry enter di forum na im de determine how dem go operate or last for di forum, so if a newbie take small maturity enter di forum, dem go de apply wisdom to de follow as di system be. If dem first understand say first thing first na to gain knowledge, den na to get tolerance to accept every criticism, despite dem best efforts, because dem wan to learn from people wey dem no pay shishi. Secondly make di thoughts of campaign and earning for di forum be motivation for dem to focus on improving demsef with quality posts, no be say dem go want am rush rush. I enter di forum with zero knowledge about cryptocurrency, so I focused on learning , despite whether I receive positive or negative remarks for my posts, because I reason say if I vex comot e no go affect dis people campaign rewards.

Aldo some of our senior ogas dem suppose to de correct newbies with love, no be for only our local board but for di entire forum, so di newbies go de encouraged to continue to de try.

Las las, merit matter na im be di Koko, infact na im be di main ingredient to take give newbies di greatest morale to de active and to de try to make quality posts. E no easy to de put efforts and nothing to show, e de kill morale, no matter di maturity of mind. So if members go de reward newbies with merit, like di boss @Cryptopreneuerbrainboss, e go de very good. I hope say make we get more merit sources for our board, e go encourage newbies to de active and do quality posts.
legendary
Activity: 1106
Merit: 1372
Lolz. Many of them dey come here because there mentors or instructors told them dat Dem go make money here and wen dem come dem go see another entirely different because many of dem never even hear di name Bitcoin before so for dem to learn dat kind thing for here before making di money dey tire dem. And some of them when dem dey try and encountered criticism, den dem go quick ma leave di forum. Den some of them na merit dey make dem run. Now their purpose na to grow di account fast fast and enter campaign wen merit no dey come for dem to enter campaign den dem go withdraw. While di last group of people wey I know, dem no fit write, dem no dey creative. And day is why any newbie wey dey come, and him or she really wants to stay in di forum, let dey focus on the learning side of Bitcoin and others, let dem remove demselves from the thinking dat dem dey here to make money or wants to get merits. Those things will definitely come if dem dey do well.

Even me sef almost give up after opening di account but I was encouraged to start all over again. I believed most of us had that sentiment at di beginning before pick up courage to continue the posting.
hero member
Activity: 1008
Merit: 629
The reason dey very simple,  na him be lack of proper mentorship because of anyone established member wan carry person come on board,  the first and most important advice na make the person develop a thick skin,  to be able to absorb all negative energy and still work hard to achieve their aims here in the forum,  and this is very important for a newbie.

But because some newbies found this forum on their own the missed such orientation will not be able to absorb any possible attacks from the forum and another online marketplace.
You get point for here because if person no show you how to operate for here, you fit loose guard or lose appetite but what if after being mentored, them still tire? Or you feel say despite the coaching them Japa because them no get wetin them find?
sr. member
Activity: 266
Merit: 205
My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.

My brother you really dy on point,  to tell you the truth, na road I don pass before, criticism na something wey no be everyone dy take lightly, e get on post I post during the first week wey I open this account, my brother if to say mouth dy kill person, I for don die, initially I been wan respond back with anger but I come reason am say since true true I dy wrong make I leave am, but I no post again, I just lose interest in the forum entirely.
I come dy vex  say people go just dy tlk anyhow for post wey I crack my brain arrange, dem no even know wey I go through go create dat post, even wen I been dy school I no crack my brain like dat, but person go just rubbish am without even any consideration.
Of a truth, e take me like 3 or 4 weeks for me to post again,but after den I learn, and wetin even bring me back na the small additional knowledge I dy get from the forum. Secondly e dy very difficult to keep on posting wen you no dy grow for the forum, e go just dy do you as if you dy waste ur time, sometimes we wey be newbie dy post something wey deserve merit but we no dy get am, and you will be forced to ask yourself say make I first dance naked first before dem go know say this or dat post deserve merit?
To me the most discouraging is wen you even make the quality post, but dem no gree merit am, even wen you deserve am, but you go see post wey no better pass your own get merit.
sr. member
Activity: 448
Merit: 351
Truth be say here no easy to survive and na only motivation and determination go fit dey push you through. Normally some people no get this patience wey we dey always talk for real life. People just want sharp sharp something for life and only few want to pay the price. I see am say miss information dey really cause this thing too just like @Hatchy talk am. Some come with the information that once they come here say money go dey come out so when them come here come see say no be watin them bin carry for mind dey happen them go just vex leave am. Some dey lack proper guidance too as e be say person wey bring them come no dey stand by them to grow for here. And when they discover the merit system, and dem don get like 100 activities without any merit e go come be like say the thing too hard, this one alone na something wey wey go discourage person.
hero member
Activity: 1260
Merit: 765
Top Crypto Casino
The reason dey very simple,  na him be lack of proper mentorship because of anyone established member wan carry person come on board,  the first and most important advice na make the person develop a thick skin,  to be able to absorb all negative energy and still work hard to achieve their aims here in the forum,  and this is very important for a newbie.

But because some newbies found this forum on their own the missed such orientation will not be able to absorb any possible attacks from the forum and another online marketplace.
sr. member
Activity: 336
Merit: 365
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.

Na correct talk u talk, my brother. Normal we no say Bitcointalk no be for the weak and to grow from newbie accounts go high rank no be day job. For some parts of the forum u go see as some top oga Dem dey use mouth Tay finish some low rank account and person wey no get patience go fit vex talk back or just reduce e post for forum.

Normal if u no strong for here u no go fit grow na d truth just be dat. Again, some newbies fit don get wrong information about d forum, wey make Dem rush con register. Dem go don tell Dem say money dey here and if u fit grow account u go turn millionaire over night. all these many many wrong information na e dey give the newbies Dem wrong motive to tay join forum and u go see Dem just pop out, dey post things wey no make sense or some go come dey spam forum. Once Dem criticize that kind person, e go just rest and e interest fit just die like that.

 As I dey grow from newbie, I don learn many way, to tay endure this forum and no one method na to over look nonsense talk from some members. If u see person wey talk black lash you for ur post, just leave the post or if u see say watin e talk correct but e still talk spoil wey be like insult, tell am thank you then commot from there. Nobody go fit kill you physically for here na internet we dey and even though e use mouth finish you, e no go fit affect you so make we try dey chill.

Jump to: