Pages:
Author

Topic: Why some newbies dey quick lose interest for the forum?? - page 5. (Read 1292 times)

sr. member
Activity: 504
Merit: 378
The great city of God 🔥
My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.
Lolz. This forum na place wey people brain dey work with 10G network. Some People don dey hear for over 5,6,7 to 10 years and e show say dem smart pass you for everything wey you dey do. Everything wey dey happen here everybody dey see am, and for you to succeed, as you just come just calm down make God use you. But if you come say you wan teach people some kind thing especially bitcoin for here, e just be like you dey play. Even say them come and them get knowledge about anything, dem need to calm down to see how the forum works. Most person go just jump enter, go to 9ja novice hangout go do introduction next thing na to create thread to educate people about bitcoin where as na learn dem come learn.

Although everybody get him own story for here, and me self wey dey talk I been don go teach people about bitcoin for bitcoin discussion and I no even know the caliba of men wey dey the forum. chai! Ignorant na disease but as I come dey go round I come dey understand say na house of crypto currency I dey. Naso I 🤐 my mouth. Dey try my best best to read more than creating thread. Sometimes the reaply for thread Naim dey dey interesting than the thread itself and most people dey learn and also get merit from am pas the topic itself.

So any newbie wey come, with the mindset say e wan jump in today and rank up tomorrow e go dey hard. except you study very well. And if any newbie make post and them yab am, make e no feel shy or even run, but take it as a learning process and put the very best in them and contribute because everyone's opinion is needed. Because your opinion fit save person life.
full member
Activity: 448
Merit: 163
Some people are lack of patience, and this forum requires sufficient incentive. That is why somes who comes to this forum are rapidly loses interest, and what some are taking this forum is not like that because all of their thoughts is that when they start, their successes will be sharply achieved they don't know that this place is not all about that. Let me simply state that this forum is a hub of learning because we all learned from each other, both senior and junior ranks.


This is why we should always invite people mostly to the forum to learn and not to make money. Most people leave the forum after weeks of being introduced to the forum because they aren't making money just as they were expecting.

To be honest, most people think that they can just visit the forum and start making money within a few months. They are unaware that while it may take several months or weeks to become an expert member of the forum, anyone can join and begin making money right away without having to elevate their account.  Because whatever a person wishes to undertake will not be created for him without a proper starting.
sr. member
Activity: 224
Merit: 195
The reason dey very simple,  na him be lack of proper mentorship because of anyone established member wan carry person come on board,  the first and most important advice na make the person develop a thick skin,  to be able to absorb all negative energy and still work hard to achieve their aims here in the forum,  and this is very important for a newbie.

But because some newbies found this forum on their own the missed such orientation will not be able to absorb any possible attacks from the forum and another online marketplace.
Nobody go talk say him no face this backlashes starting as a newbie for this forum we dey bound to make mistakes either in one way or the other, you no go just come here come turn expert over night. The thing be say as most newbies dey make this mistakes dem no dey always keep room for correction, some go feel say since dem dey criticize dem especially when dey create some kind thread and dey tell dem to lock am base on say another person don create am or dey suppose don read am from the pinned thread go make dem feel demoralized to attempt new ideas for the forum, this no suppose be so even some higher ranked members dey face same backlashes anytime dey fuck up

One thing i don like inside this our local board na the way we dey use ginger ourselves for here, even the weak go strong by force and e dey help us also for our Bitcoin accumulation and learning aspect.
full member
Activity: 588
Merit: 119
Some people are lack of patience, and this forum requires sufficient incentive. That is why somes who comes to this forum are rapidly loses interest, and what some are taking this forum is not like that because all of their thoughts is that when they start, their successes will be sharply achieved they don't know that this place is not all about that. Let me simply state that this forum is a hub of learning because we all learned from each other, both senior and junior ranks.


This is why we should always invite people mostly to the forum to learn and not to make money. Most people leave the forum after weeks of being introduced to the forum because they aren't making money just as they were expecting.
sr. member
Activity: 728
Merit: 354
So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.

Wetin they make newbies leave the forum, no hard oh. You too you know e be like say you just they ask question Nii oh, me wetin I think be say no be wetin you think wey you they talk say na criticism, no be dah one me I they think. Wetin I they think na how to grow and start getting money from this forum they no fit follow the process, like they no trust the process so na why most of they con give up be that. If not me I see many newcomers for here before but now they no they again. And I they sure say na because of merit wey they no get.

So anybody wey come and him no fit do am go con leave, they forget say na so everybody take start and reach some position for here, make them Sha understand say nobody carry merit come from house, or message anybody wey geh high rank, na hard work, make them understand na effort we put con get where we they now, so if them to go do am god go run am for them na just time e go take. Na my advice be that for them and anybody wey wan leave.
hero member
Activity: 644
Merit: 520
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.
Some of these users them na because of the kind of orientation wey dem give dem na dey cause am because if dem properly orient dem about the forum dem for know the forum na actually place wey if you no dey ready to learn and take correction then you go think say na war zone and this na the cause of many of these new users actually slowly and finally leaving because they no get the results wey dem dey find.
member
Activity: 168
Merit: 77
So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.

Na correct talk u talk, my brother. Normal we no say Bitcointalk no be for the weak and to grow from newbie accounts go high rank no be day job. For some parts of the forum u go see as some top oga Dem dey use mouth Tay finish some low rank account and person wey no get patience go fit vex talk back or just reduce e post for forum.

Lol, no be lie,  e just be like when I newly join the forum, the very first post wey I make as a newbie, one high ranked user tongue lash me wetin no nice, e tell me say because say I just join the forum, I no supposed rush start to post, say I suppose just dey look other people post dey read at least for some weeks before I go start to post, so I fit sabi wetin to post to avoid forum spamming.

On the other hand, wetin the man talk na actually true if you reason am the other way, but the way e take enter me, and the things wey e talk really vex me, lol I almost wan hala am but I just chill, the experience been dey enough to make me to dey comot body for the forum but then again, I no come here for anybody, I come here to improve myself and to learn for myself and no be for anybody, and na e make I no reason am at all.

These kind of things dey enough for newbies to just stop to dey participate for the forum, but then again, they gats realize and always the reason them dey here and if them do that, then all those kind of things no fit move them at all.
full member
Activity: 448
Merit: 163
Some people are lack of patience, and this forum requires sufficient incentive. That is why somes who comes to this forum are rapidly loses interest, and what some are taking this forum is not like that because all of their thoughts is that when they start, their successes will be sharply achieved they don't know that this place is not all about that. Let me simply state that this forum is a hub of learning because we all learned from each other, both senior and junior ranks.
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
Some newbie believe say working or contributing in the forum is something that is too hard and they don't give themselves the chance to get use to the forum instead they want everything fast without paying any price. It is only people who lack patience that sees the forum to be difficult place . But if you understand the forum their is nothing difficult to be here, the forum is place where people learn and it is expected that people will improve everyday.


Exactly, patient naim be the main Koko for anybody to grow for this forum. Dem say, the patient dog eat the fattest bone, though e get places for this life wey that phrase nor dey work oo, but for inside this forum,  you gats dey patient to succeed. Besides, for this forum na spoon feed Dem dey spoon feed us. For here naim Dem go still give you everything wey you need to use take study about wattin you want know about, and we nor dey even pay for directives or knowledge wey we dey get from other people, as you get freely na so you go share freely. After all minus crypto discussion sef we dey get very important information from topics like security, hack etc. so person wey no fit  relate for here, make try another wey of learning weda e go better pass this one wey we dey get for here.
full member
Activity: 560
Merit: 161
Some newbie believe say working or contributing in the forum is something that is too hard and they don't give themselves the chance to get use to the forum instead they want everything fast without paying any price. It is only people who lack patience that sees the forum to be difficult place . But if you understand the forum their is nothing difficult to be here, the forum is place where people learn and it is expected that people will improve everyday.
sr. member
Activity: 308
Merit: 256
Journey of a thousand miles begins with a step, for one to excel in certain perspective of life one has to pass
Through challenges, unlock doors and gates fighting good of faith and considering wining as the only option.
Asking questions where necessary, for person wey ask question no dey miss road.
Patient they said is a virtue, many lack patient and at such missed out, expectations not coming as per time
expected as regards to motive, and being stagnated in one level for too long is also one of the reasons for quick loss of interest in the forum.
sr. member
Activity: 532
Merit: 250
So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.

That wan na him fit bit truth of d matter o, dem no fit stand criticism and dey are not ready to learn by criticism. I no sure say dem go get person for dis forum wey go don move teach wey e reach now without receiving one or to backlash from d forum. If everybody wey dem criticize say dem no wan continue for here because of dat criticism, most of d people here today no go dey here.

One thing wey I notice for dis forum be say, when dey correct you and you follow the correction, you go for use dat correction learn and also correct oda people wey go make such mistake as you before. This forum na school of learning and criticism na part of the scopes of the school of learning the forum is. Only d strong survives here; I mean only dos willing to take correction and learn survives here.
legendary
Activity: 1498
Merit: 1116
Top-tier crypto casino and sportsbook
~
Many newbies who are introduced to this forum are introduced to the forum for wrong reasons. The people who introduced them to the forum did not tell them that the forum is also a place to learn. When they join this forum and discover that they cannot just start earning as they planned but need to still work hard, they get discouraged, loose interest and abandon the forum.

Another reason is that people start the forum, and then may get occupied with other activities that they do not have the time to spare. Since they have not been members of the forum before getting engaged in many activities, they find it difficult to find a way to fix the forum into their tight schedules.
hero member
Activity: 1190
Merit: 901
Livecasino.io
So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.
I don't know about you but in my early days on the forum, I knew why I quit for some months
- unfamiliarity with the forum interface on a mobile device.
- time was spent on work and other stuff
- a dearth of merits.
- strong criticism
- lack of topic ideas.
sr. member
Activity: 756
Merit: 454
For dis place no be everybody wey get d mind to withstand plenty pressure as we all know. Dis place be like jungle and inside jungle nah survival of the fittest so as I see am so no be everybody get d mind to dy take insults abi na blacklash you call am OP and e con be say nah from person you no sabi or know face to face, e dy pain oh.
And again I feel say any where wey you no dy get anything positive or make I say productive na to leave that place becos e be like waste of time, if no be patience wey some piple get I believe say all these our senior oga dem no go fit stay and get to this stage (base on rank), the weak no go fit survive this Forum at all.

Happy New Year
full member
Activity: 1414
Merit: 236
Catalog Websites
The reason b say d confident to argue with people here no dey their body in my own understanding, and d person wey introduce dem to dis Bitcointalk.org no mentor dem well. Well, every newbies dey always experience dis question wey u asked so , but those that escape it are those that refused to lose hope or lose interest on the platform because dey see bright future ahead of those that will maintain their confident till the end.

If I tell u say e easy with anybody to escape as a newbies here, I dey lie for u and d people here because, some time e look as if d person wey introduced u to dis forum play u, until u begin to use your eyes see some rules everybody is avoiding not to do good that will destroy their own.
sr. member
Activity: 658
Merit: 441
So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.
Normally, if you no fit stand the heat then u no go fit go close de kitchen. De forum no dey take am easy wen you make mistake, dem go come at you harshly and if you be that kind person wey no fit stand criticism, my brother na to take the easy way out and that is to tuwama. But if you go fit take the criticism with the correction and improve, na im better pass.

People dey come here mainly for the sig campaigns but forget say before you lick honey, you suppose ready to collect sting from bees. I dey hear when some go say nah for the Bitcoin knowledge dem register here but we know the Koko.
This one na de koko, de robbers na the number one motivational factor. Also, I believe say knowledge follow robbers for body, as we dey interact here, we dey also learn new things and improve ourselves.
hero member
Activity: 672
Merit: 546
The reason dey very simple,  na him be lack of proper mentorship because of anyone established member wan carry person come on board,  the first and most important advice na make the person develop a thick skin,  to be able to absorb all negative energy and still work hard to achieve their aims here in the forum,  and this is very important for a newbie.

Na true you talk, most newbies find it difficult to survive in the forum because of lack of proper mentorship about the forum. It takes a very strong mind to find their way around as a newbie and grow without any guidance. The forum is known for not tolerating newbie behaviors like showing any signs of unseriousness and mistakes due to not getting familiarized with the rules of the forum. It is really a tough space for newbies without any orientation and most of them get discouraged along the line.

user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.

This de happen and I believe most of us here went through the same thing but na just the dedication wey we get na him make us survive reach this level. For life to achieve success no easy no matter wetin you wan do so we need to be prepared to face challenges and na the same thing na him e be for here, we suppose use any backlash wey we face as a lesson instead no be to de give up easily because person de criticize us.

If Osimhen tell you wetin im go through you go cry for am, Footballers wey you see de make for this our country de receive alot of critics from friends, family members and even fans but they choose to ignore all the criticism and stand strong na wetin make dem turn wetin dem be today so the one wey de happen for forum here na just small thing.
sr. member
Activity: 476
Merit: 316
Get $2100 deposit bonuses & 60 FS
My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.

sometimes we wey be newbie dy post something wey deserve merit but we no dy get am, and you will be forced to ask yourself say make I first dance naked first before dem go know say this or dat post deserve merit?
To me the most discouraging is wen you even make the quality post, but dem no gree merit am, even wen you deserve am, but you go see post wey no better pass your own get merit.
My brother, I got your point shar, for here things they transparent, and nobody dey favor person for here. If you create a post wey people see the post as something wey they helpful to the forum they will give you merit. Secondly, you fit create a post wey deserves merit but the person wey sees that post as a quality post no fit gets sMerit at that time to use award your post merit. No dey discouraged, one-day idea go run enter your head wey you go make a post and the post go get plenty merit, you go believe say when person drops helpful post say merit go they follow like water.
hero member
Activity: 1008
Merit: 629
Lolz. Many of them dey come here because there mentors or instructors told them dat Dem go make money here and wen dem come dem go see another entirely different because many of dem never even hear di name Bitcoin before so for dem to learn dat kind thing for here before making di money dey tire dem. And some of them when dem dey try and encountered criticism, den dem go quick ma leave di forum. Den some of them na merit dey make dem run. Now their purpose na to grow di account fast fast and enter campaign wen merit no dey come for dem to enter campaign den dem go withdraw. While di last group of people wey I know, dem no fit write, dem no dey creative. And day is why any newbie wey dey come, and him or she really wants to stay in di forum, let dey focus on the learning side of Bitcoin and others, let dem remove demselves from the thinking dat dem dey here to make money or wants to get merits. Those things will definitely come if dem dey do well.

Even me sef almost give up after opening di account but I was encouraged to start all over again. I believed most of us had that sentiment at di beginning before pick up courage to continue the posting.
  My brother, this issue you point out nah big one and I no go lie. People dey come here mainly for the sig campaigns but forget say before you lick honey, you suppose ready to collect sting from bees. I dey hear when some go say nah for the Bitcoin knowledge dem register here but we know the Koko.
Sometimes I ask myself why people bother to open the account if them know say them no go get the patience to grow am. You go just see an influx of registered accounts today, after sometime, nah only few go remain.
Pages:
Jump to: