Welcome to the forum my brother. I dey hapi to see you here and I like as e be say you get beta hand work wey you dey do I believe dis one go make you no go channel all your energy for forum here.
No forget say oda men wey dey oda corner dey also see Wetin dey happen here e no make sense if you let men know say na person wey dey here already show you dis area no forget say every man here dey on guard base on privacy matters.
E good as you don jam men wey from ya area abeg no also forget to follow the forum rules make you no go fall our hands you no say na one hand wey oil touch dey affect oda hands, you go do well here if you follow how tins dey go here.