Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 15. (Read 1529142 times)

member
Activity: 130
Merit: 10
My Username na ‘Framelover’, I be guy man wey get interest for crypto. I wan learn more about Bitcoin and other digital money dem. I lyk to trade, invest n I wan explore d potential of blockchain technology. I get Joy say I fit to connect with una and learn from una.

My naija people I hail una. I de very happy say I enter for place like this, I don even feel at home before una welcome me. I still be newcomer for this bitcoin, abeg I humble my self to learn, I thank una well.
Framelover and Kelward, we take open hands welcome una two for owa midst. I like as una talk sey una dey ready to learn because na dat wan be d koko wey make everyone of us enta here and then we com realize sey honey dey here too. Betta honey oh. Make una go thru d rules and keep dem. Nor plagiarism other people articles or spam for forum. If you nor keep all these, see you see ban but if you keep dem, see you see Shiloh as one of owa ogbenge members go yarn.

Oya, una welcome, wey bread 🤗

Edited
Sorry iBaba, I nor sight you before. I welcome you too.
Omorr e just be like na celebrity reply me… as I de sight u so e just be like na wizkid reply me… u don too bam for dis forum no be chais.. ur merits de inspire me boss. I de loyal and local 🙌 I dey appreciate your warm welcome nd I know say learning nd following d rules be d main tin for dis forum. E good make I hear sey honey choke inside too but me I no de rush, na slow and steady I de move. I go read and follow the rules make I no chop ban. I dey look forward to engaging with the community. Thanks again Boss, Una plenty wey de inspire my for here.
Clear Road for senior men dem 🙌
Sharp 📌
hero member
Activity: 2660
Merit: 630
Username: Kelward
Gender : male
State of residence: Lagos
Skills:  singing, good salesmanship.

My naija people I hail una. I de very happy say I enter for place like this, I don even feel at home before una welcome me. I still be newcomer for this bitcoin, abeg I humble my self to learn, I thank una well.

I follow join muscle take welcome you and all other newbies here. Una dey lucky say small group like dis our naija hangout dey now wey una join, so una no com late but at a time wey e be say tins don smooth for una. Wen I join I no fit remember if something lik dis dey exist. Make una enjoy dis umbrella, read and learn the forum rules and keep dem so dey won't hurt una tomorrow.

Normally, as e dey go , make I just open small shower for two of una wey don reach 1 month but no capping so far. Make una enjoy the whole place  Grin
sr. member
Activity: 672
Merit: 355
Username: Belarge
Gender :Male
State of resident: Rivers State(Port-Harcourt)
Skills :Drumming and Singing,

My people I greet una oo, my name na belarge o, and I be new born baby for this forum o, I don too hear about the better better things una dey do for this forum, nai I say make I join una, abeg as I dey here I go dey ask questions oo, and abeg make una try dey reply me and dey direct me make I no go astray abeg,

I really get interest for Bitcoin normally, I dey even plan to invest when small money go enter my hand, but one of my friend say make I come join this forum so I fit learn and know more better about Bitcoin, na that my friend nai come direct me to this forum,
And I believe and know say una go hold my hand to direct me and my God go bless una the way en dey bless una already...

My bros, you no dey alone for this matter. Me self na newbie for here.  I dey ready to learn, because no time to check time, them say bitcoin, na the place to invest and some people wey I know wey dey trade am dey do well. So me I like where I go de progress. Na em carry me enter this forum. I dey hope to learn from experienced members. So far I don learn say, bitcoin na wetin you need to get patient learn. Because if you no take time to Learn and sabi the technicalities, you go loose your investment.

I thank the Oga them wey create this naija forum, una try no be small. As una dey guide us through to the top, I pray baba God, to dey elevate una higher.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
My Username na ‘Framelover’, I be guy man wey get interest for crypto. I wan learn more about Bitcoin and other digital money dem. I lyk to trade, invest n I wan explore d potential of blockchain technology. I get Joy say I fit to connect with una and learn from una.

My naija people I hail una. I de very happy say I enter for place like this, I don even feel at home before una welcome me. I still be newcomer for this bitcoin, abeg I humble my self to learn, I thank una well.
Framelover and Kelward, we take open hands welcome una two for owa midst. I like as una talk sey una dey ready to learn because na dat wan be d koko wey make everyone of us enta here and then we com realize sey honey dey here too. Betta honey oh. Make una go thru d rules and keep dem. Nor plagiarism other people articles or spam for forum. If you nor keep all these, see you see ban but if you keep dem, see you see Shiloh as one of owa ogbenge members go yarn.

Oya, una welcome, wey bread 🤗

Edited
Sorry iBaba, I nor sight you before. I welcome you too.
sr. member
Activity: 672
Merit: 355
Username: Kelward
Gender : male
State of residence: Lagos
Skills:  singing, good salesmanship.

My naija people I hail una. I de very happy say I enter for place like this, I don even feel at home before una welcome me. I still be newcomer for this bitcoin, abeg I humble my self to learn, I thank una well.
hero member
Activity: 1260
Merit: 765
Top Crypto Casino
Just commenting here after a long time from the hangout threads, this thread is the cradle of the Naija local board and is interesting how everything started from this thread, all thanks CryptopreneurBrainboss who was the pioneer member.

I will keep an eye on some of the posts of our newbies to see how we can encourage the few exceptional newbies and help them navigate the way through their cryptocurrency journey and how to properly secured themselves from intruders, cryptocurrency is no doubt a highly risky venture so at that everyone needs to have adequate knowledge on how to secure the coins and his to properly DCA while holding bitcoin as the less risky coins in the cryptocurrency market., knowledge can be easily transferred to constant contact with the source of the information.

So I urge all our newbies to always be active on the forum and also on the local board there are quite several motivating activities going on on the local board that is enough to keep our newbies actively motivated in their quest to gain knowledge and understand cryptocurrency better.
member
Activity: 130
Merit: 10
    Dis new thread dey self moderated to prevent spam and scam like activities. I promise say I no go misuse am, e go only come into use when na for the betterment of the community.

    To avoid newbie welcome thread spam, use this thread use introduced yourself. Ma people I greet una oh, this thread wey I create like dis na for we to come together and welcome every newbies from naija wey join us for this board. No shy here oh, just dey free discuss everything wey you get for mind for here, if you get any questions we dey for your mind, just ask.

    Make we just try our best to obey every forum rules read; Unofficial General Guidelines For Posting( Na de koko dem) by Igehhh

    NOTE:[1]: No go dey trade with another person you just meet for here unless you trust them and all trade related transaction, carry am go Marketplace board and child boards for transparency.

    [2]: Official language Pidgin & English.
    [3]: First timers (All newbies) abeg just introduced yourself so we fit relate weller
    • Username:
    • Gender (optional)
    • State of resident (optional)
    • Skills (Dis one dey important oh incase person dey find person like you we fit recommend)

    Note: This thread now serve the purpose of welcoming new members to the boards as all assistance and questions can be asked here. Avoid discussing off topic discussion or they'll be deleted. Only welcome users, guide them, answer their questions etc on this thread.

    Thread will be updated regularly and improved as new things are implemented.[/list]
    Weytin dey, fam?
    My Username na ‘Framelover’, I be guy man wey get interest for crypto. I wan learn more about Bitcoin and other digital money dem. I lyk to trade, invest n I wan explore d potential of blockchain technology. I get Joy say I fit to connect with una and learn from una. My major hustle na interior furniture making (wardrobe, kitchen cabinets, bed frames, TV stands, wall panels office partitioning, office tables/chairs, sitting room cushion chairs etc)Make we vibe!
    sr. member
    Activity: 630
    Merit: 291
    Bitcoin in Niger State💯
    Hello, my name is iBaba and I am from Nigeria. I am a digital marketer that is also highly interested in bitcoin. On my quest to learn more about bitcoin, I was recommended to this forum by a bitcoin advocate.  I've been a member of the forum for a few weeks and only recently discovered our Naija board. It's great to finally meet my people and engage as a family. I'm hoping for the greatest advice and guidelines about the forum here.
    member
    Activity: 77
    Merit: 10
    Username:Philpsticks
    Gender:Male
    State of resident:Niger state
    Skills:Health practitioner
    Am new and ready to learn from you guys, I hope I will be carried along thanks.
    Welcome on board chief,is a good thing to see someone from  the North Region to join the forum,me sef never too Tey here,but is been  a very educative ride,the key here na to dey open to learning ,find person wey go teach you things ,becaus the forum get rules, wey to succeed in,you gats keep,and to be honest you go need person wey don dey before to show you,all the same welcom and explore.
    jr. member
    Activity: 44
    Merit: 1
    Username:Philpsticks
    Gender:Male
    State of resident:Niger state
    Skills:Health practitioner
    Am new and ready to learn from you guys, I hope I will be carried along thanks.
    sr. member
    Activity: 392
    Merit: 262
    Lohamor Family
    The user name na Ambatman
    Na Lagos dey born me and na I dey reside
    The sex with 3 legs
    I dey draft business plan dabble on ehn coding(JavaScript, Python c &c+) and crypto analysis
    Bros welcome on board,I see say you get good tech skills,with this your skill you go do well for the forum. Take your time dey read higher rank threads and comment to learn fast. Navigate round the different boards to also see your board of interest,i.e the board wey you get many idea on to follow chuk mouth for the mata wey dem dey talk. If you get any question make you ask us here and also beware of 'plagiarism' this fit make remove you from the forum.
    Good luck.
    hero member
    Activity: 980
    Merit: 636
    Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
    Hello my naija people, how una dey? I dey interested in Bitcoin for a while now until I found this forum. I see say here go better to learn more about bitcoin since na d discussion full here. Na the reason wey make me join who na for this place. I go want make who na guide me better for this forum because I dey find many things hard for me since I join. Abeg I for want make who na help and direct me more for this forum.
    Thanks my people.
    Bros welcome to our one big Naija family for inside this community. He make sense say you locate your brothers,you dey house already and whatever issue or wetin you won know for this forum or bitcoin related yarns,feel free to ask so that life for the forum no go hard for you. Read more because na school you dey so. Pls no plagiarism is an offence that leads to ban from the forum

    Username :
    State of origin :
    Gender :
    You for use this format for your introduction so that we go know you proper.
    full member
    Activity: 714
    Merit: 225
    Hello my naija people, how una dey? I dey interested in Bitcoin for a while now until I found this forum. I see say here go better to learn more about bitcoin since na d discussion full here. Na the reason wey make me join who na for this place. I go want make who na guide me better for this forum because I dey find many things hard for me since I join. Abeg I for want make who na help and direct me more for this forum.
    Thanks my people.
    hero member
    Activity: 980
    Merit: 636
    Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
    Username Cassandra Robert
    State of origin niger
    Gender na better man 😁 I be oo
    Make we no think 😁
    Bros welcome to Naija board,this place na where we dey discuss our own Naija matter and crypto related issues for we country. As you see am so,u need to read more and learn how we dey do things for the forum so that you too go fit dey progress and you no go come fall for law. Spamming na one thing we dey very offensive,so beware and stay away from it. If you get any question wey dey bother you about the forum or crypto make u no hesitate to ask us for here,because we be our brother's keeper.
    hero member
    Activity: 854
    Merit: 554
    Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
    Snip

    Hello victorybit1, Welcome to the forum, ensure to stay positive-minded. If you need help, you can create a thread in this local board or in the beginners and help board, but before creating a thread, use the search icon on the home screen to make a search relating to the question you need answers to, and if you can't any satisfying result, you can then go ahead and create your thread. That's to reduce spam.

    You quoted reply was wrongly placed; see the image below, or you can edit edit and use the example on the code below.

    Delete the quote from there.

    Also delete quote from here.

    This is the correct place to add the quote.

    Code:
    [quote author=CryptopreneurBrainboss link=topic=5121680.msg50205374#msg50205374 date=1552853890]
    [list][i]Dis new thread dey self moderated to prevent spam and scam like activities. I promise say I no go misuse am, e go only come into use when na for the betterment of the community.
    [hr]

    To avoid newbie welcome thread spam, use this thread use introduced yourself. Ma people I greet una oh, this thread wey I create like dis na for we to come together and welcome every newbies from naija wey join us for this board. No shy here oh, just dey free discuss everything wey you get for mind for here, if you get any questions we dey for your mind, [/quote]

    username: victorybit1
    State of Origin: Bayelsa state
    Gender: Female
    Skill: I'm a medical practitioner.
    I'm a newbie here, just joined last month. So far, I've been learning from this forum, I most say, you all are doing great. I've gone through the rules of the community.  Will be creating my very first bitcoin wallet soon.😄 Thanks for the knowledge you all are impacting on us newbie.
    newbie
    Activity: 8
    Merit: 1
    Username Cassandra Robert
    State of origin niger
    Gender na better man 😁 I be oo
    Make we no think 😁
    sr. member
    Activity: 658
    Merit: 441
    Username: Hillakris
    State Of Origin: Rivers State
    Location: Port Harcourt

    Hello everyone, I must say that I'm pleased as pleasured of treasures without measures to be among this great platform stood as a wireless oneness family aim to bring the best out of us as a collective measure. I would say that I've missed to be here earlier before now but it's better late than never.
    I hope to see us all glowing mindedly and without audacity as a supreme urges everyone of us to be conscious at our endivoures.
    All the best fam ✌️♥️
    Welcome to bitcointalk and our local board. Here na our local joint for the forum where we dey talk many things wey concern our country. As u na newbie be ah go like make you get some orientation about the forum, i.e make you look at the rules and guidelines so that you no go land yourself inside any problem. Read forum's rules and guidelines.

    The beginners and help section na good place to start your journey, there u go get to ask questions and many strong hands always dey available to answer and guide you. Also, if you need our help here, we go dey more than happy to assist you in any way we can.
    hero member
    Activity: 980
    Merit: 636
    Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
    Username: Odohu
    State of origin/City: Rivers/Port Harcourt

      My people I say make I start my crypto journey as our country don be like this. As I dey go through the forum na so I notice say my people them full here come even get this big community. My joy plenty knowing say I go receive plenty help and guidance from my senior people them. My people Mbana, una doo o, Sanu,  Ndewo o, Nsong nesong, nagode, ekwushe. No vex if I no put your own or get it correctly.
    Welcome to our ogbonge board,na here all your brodas dey and you no miss road. The only advice wey I get for you na say u need to settle down dey read all the sticky thread,I mean all the thread wey u see something like screw driver ontop,that na pin for Meta and beginners and help and that also go read for meta pin thread too. Them go help you know more about wetin dey happen for here.

    If you come get any question to ask,make u ask here so that our strong hand go give you confirm answer ASAP. Reading na the key to success for this place,no go dey rush to post make you no go post carelessly, if not na only you don dey bring out your leg. Life easy just follow up.
    hero member
    Activity: 700
    Merit: 541
    Bitcoin Casino Est. 2013
    Username: Odohu
    State of origin/City: Rivers/Port Harcourt

      My people I say make I start my crypto journey as our country don be like this. As I dey go through the forum na so I notice say my people them full here come even get this big community. My joy plenty knowing say I go receive plenty help and guidance from my senior people them. My people Mbana, una doo o, Sanu,  Ndewo o, Nsong nesong, nagode, ekwushe. No vex if I no put your own or get it correctly.

    You're welcome onboard this Nah our Nigeria board and for here all of us nah one, Incase you get anything when dey bother you or when you nor understand well no fear to bring am come we get people for this board when go help you dichotomize am till you don fully understand am. But, before then I go like make you go through this thread Unofficial list of (official) Bitcointalk.org rules, guidelines, FAQ e contain things when dem nor dey accept for the forum, he nor go make sense say you register account kon later dey get issue sake of say you nor know rule when dey guide the forum nai make me throw the link give you so, try settle down read am. Once again welcome to naija board and Bitcointalk as a whole.
    hero member
    Activity: 658
    Merit: 603

    Jump to: