Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 21. (Read 1332955 times)

hero member
Activity: 1008
Merit: 629
Na true you talk my brother. Just after dem implement dis policy I was reading a news of a newspaper screenshot posted on WhatsApp TV status that some politicians are already collecting people account details by luring dem with money. They’re doing it to bypass the daily withdrawal limit by funding dis people’s account to withdraw money for dem. If they really want dis policy to be very effective, they’ve to take strict measures with it, if not d reverse na him go still be d case again.

For them to do this one so e only mean say them plan this matter even before we hear am, anything they're doing are just for there own wayo interest.
As e be so, make we just wise up oh because this thief thief wey we dey see everyday or even hear for news no be new thing again, na to ready to kick those bad eggs off our face, make God help abeg.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
Collection of PVC for the 2023 general elections.
source:https://www.premiumtimesng.com/news/568710-inec-announces-dates-for-pvc-collection.html

The Independent Electoral Commission has commenced the issuance of the permanent voters card PVC for those individuals that did their registration in this year 2022, from today 12th December to January 22nd, 2023.  We're all encouraged to go the commission office in all our local government areas or wards to collect our cards through Mondays to Sunday's 9am to 3pm.

This na one thing wey I dey like Nigeria for, we no ever dey get deadline as new new deadline they always pop out at anytime to make sure the masses dey satisfy. This one na welcome development as plenty people never do their PVC and this new deadline go help bring out some new voters. We need the masses for this election or e no go go as we dey expect. Also make INEC also dey at alert as this opportunity wey dem open so fit dey used wrongly by politicians wey wan buy their way into position.

Make dem no go dey approved underage votes now or do wrong PVC for politicians as we dey normally hear the story after election wey we go see dozens of PVC wey dem throwaway. I been hear story for radio wey INEC people talk say politicians dey put them under pressure to make them rig this election. I hope this one no follow reason why them reopen the PVC mata so them fit use am achieved their rigging. Sha make we dey watch how things go play out but I belivyww go get an right this time.

Senior Comrade this matter wey you raise like this no be small one o. You see this issue of under age voting naim be the problem INEC need to look into because as the matter be now ehn na the strategy our northern politicians dey use very well dey  take win election. If you go remember the last general elections wey happen for Naija here na wetin dem use wella take win election even international observers wey dey ground too confirm to say na true say na wetin happen wey dem too witness. You see ehn this opening and reopening of voters registration and collection somehow too fit be strategy to confuse and distract the masses from knowing wetin dem dey upto. No be new thing o. E don happen before na same strategy dem use wey we no know and na same thing too dem want to do again. E go bad say we don know wetin dem dey do to take win election we no do anything about am. We just keep quiet  seat for fence dey look dem as dem take naija dey play football to their own satisfaction.
legendary
Activity: 1498
Merit: 1116
Top-tier crypto casino and sportsbook
Sha make we dey watch how things go play out but I believe go get an right this time.
I believe say we go get am right too, Make INEC just try their best make the election dey free and fair, make we see truly who Nigerians want to rule them. E sure me die say some candidates for Nigeria nor want free and fair elections and dem go try all their strategy wey we know including new ones wey we never see before to take try make sure say everything favor them.

 To get better election depends on us wey dey vote, make we nor just go vote then start to go house, you need to also defend your votes and ensure that the votes are collated correctly with any obvious mago mago. E go also depend on INEC say after people dun vote finish, stay to count am correctly, then dem cun dey do wayo later, I hope say dem go play their part well in ensuring a free and fair election.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Collection of PVC for the 2023 general elections.
source:https://www.premiumtimesng.com/news/568710-inec-announces-dates-for-pvc-collection.html

The Independent Electoral Commission has commenced the issuance of the permanent voters card PVC for those individuals that did their registration in this year 2022, from today 12th December to January 22nd, 2023.  We're all encouraged to go the commission office in all our local government areas or wards to collect our cards through Mondays to Sunday's 9am to 3pm.

This na one thing wey I dey like Nigeria for, we no ever dey get deadline as new new deadline they always pop out at anytime to make sure the masses dey satisfy. This one na welcome development as plenty people never do their PVC and this new deadline go help bring out some new voters. We need the masses for this election or e no go go as we dey expect. Also make INEC also dey at alert as this opportunity wey dem open so fit dey used wrongly by politicians wey wan buy their way into position.

Make dem no go dey approved underage votes now or do wrong PVC for politicians as we dey normally hear the story after election wey we go see dozens of PVC wey dem throwaway. I been hear story for radio wey INEC people talk say politicians dey put them under pressure to make them rig this election. I hope this one no follow reason why them reopen the PVC mata so them fit use am achieved their rigging. Sha make we dey watch how things go play out but I belivyww go get an right this time.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
If CBN no print N500 and N1000 plenty d plan go seriously help ooo and he go affect those politicians badly because too much cash dey no lik to ge carry am Waka for security purposes.now e go be sai if go 10million naira inside car everybody go kno sai you carry money. But are we  sure sai those politicians no go dey use dollars especially on c up coming elections to dey buy votes? I am sure dey 4 done buy dollars keep gain by now. Still all I no with dis withdrawal cash policy, I no sai it go help in one or two ways.
Any politician wey buy dollar wey em d save against election day, the buy am(dollar) on his own peril cos American government don give instruction sae make all man return old dollar currency wey d from 2020 downwards to bank cos by January dem no go accept old dollars again.

As for politicians side for this coming election, em go choke for their side cos FG don map out plans wey them go take curtain votes buying wey go happen next year. Check out nah the instructions wey dem d don pass for only our naira currency. The start with depositing of old naira notes to redesigning of new naira notes. Secondly, limiting daily and weekly withdraws from banks. You think sae, all this plans no be because of election d by the corner? I sae make I ask. This our government know wetin dem d do
member
Activity: 742
Merit: 30
Nigeria politicians na thieves dem be. Make I just say most of them, not all. Because e go get some weh still get conscience among them. Remember say the CBN new policy na on top withdrawal and no be on transfer o. Na weekly withdrawals. These politicians can move cash around to different accounts and then begin ask those people weh them use their accounts to withdraw am for them. We go see more of this type of something weh I described here from next year. Just watch.

Na true you talk my brother. Just after dem implement dis policy I was reading a news of a newspaper screenshot posted on WhatsApp TV status that some politicians are already collecting people account details by luring dem with money. They’re doing it to bypass the daily withdrawal limit by funding dis people’s account to withdraw money for dem. If they really want dis policy to be very effective, they’ve to take strict measures with it, if not d reverse na him go still be d case again.
My problem with them be say, na dem go still look 4 way to violate d rule. Some poor people no even get up to 10k to withdraw every day so e no go too affect DM at all, na people wey de run businesses d policy go touch unless if dem go all move go cashless transactions and e for make sense so dat any money wey plenty make dem run transfers. Me I de think say dis policy go give our Naira small value.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
Misplaced priority, wetin concern spraying of Naira to the price deprecating. When dem no go focus energy on wetin dey important na things like dis we go dey see. Them no know say dem dey destroy the job of minters. First na POS and now this, instead of carrying jobs them dey destroy the ones we been dey use hold body.
My broda man and my sister woman, dis our country way we dey so na big cruise. Where any body, make I no say anybody shah but the people way dey high places go just get up and do as them like. Imagine say person fit get up say, na en turn to rule the nation! That na to tell you say, this country way we dey so, e get people way dey run am. The only joy I get be say, the suffering way dem bring come, e don open so many people eyes to dey look for better.

I mean, dis people suppose dey think the problem of the common man way dem dey represent but, the matter way we dey see be say, th dey do the complete opposite. If you check am, na frm this same suffer most of them commot from breath air o but, them don forget say that kind condition dey exist or no just care. Maybe them feel say, as them take come out so, na so common man too suppose use fine e level.

I just hope say, them no go push person put for bad thing by closing all this opportunities way man dey take chop. I never still know how them want old women for village to survive with this there cashless policy because, e go had person buy goods for there hand. People way no get a count cef, how you wan con dey do transfer for them. Our wahala just too much.

Senior comrade you talk the matter as e sweet me for body. I no go lie you naija na big cruise wey our oga Dem at the top go just wake up one morning begin dance garala and everybody go follow Dem dey dance because Dem no get any option. I weep for my country Naija. I  believe say one day things go better but that better wey we fey find so na we go use our hand make am make e b so or else we go still dey for fence dey look where to jump enter. This time be say I for advice the youth and every other eligible voter make them no sell their vote, make them no allow any body intimidate them on the election day, make them no sell their vote right collect bag of rice and beans and chicken for say Dem dey want to chop for just wetin go finish for within one day sacrifice for  four years.  I pray make God give us the grace to stand up for the right thing and make the right decision come next general election.
hero member
Activity: 1008
Merit: 702
Nigeria politicians na thieves dem be. Make I just say most of them, not all. Because e go get some weh still get conscience among them. Remember say the CBN new policy na on top withdrawal and no be on transfer o. Na weekly withdrawals. These politicians can move cash around to different accounts and then begin ask those people weh them use their accounts to withdraw am for them. We go see more of this type of something weh I described here from next year. Just watch.

Na true you talk my brother. Just after dem implement dis policy I was reading a news of a newspaper screenshot posted on WhatsApp TV status that some politicians are already collecting people account details by luring dem with money. They’re doing it to bypass the daily withdrawal limit by funding dis people’s account to withdraw money for dem. If they really want dis policy to be very effective, they’ve to take strict measures with it, if not d reverse na him go still be d case again.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Misplaced priority, wetin concern spraying of Naira to the price deprecating. When dem no go focus energy on wetin dey important na things like dis we go dey see. Them no know say dem dey destroy the job of minters. First na POS and now this, instead of carrying jobs them dey destroy the ones we been dey use hold body.
My broda man and my sister woman, dis our country way we dey so na big cruise. Where any body, make I no say anybody shah but the people way dey high places go just get up and do as them like. Imagine say person fit get up say, na en turn to rule the nation! That na to tell you say, this country way we dey so, e get people way dey run am. The only joy I get be say, the suffering way dem bring come, e don open so many people eyes to dey look for better.

I mean, dis people suppose dey think the problem of the common man way dem dey represent but, the matter way we dey see be say, th dey do the complete opposite. If you check am, na frm this same suffer most of them commot from breath air o but, them don forget say that kind condition dey exist or no just care. Maybe them feel say, as them take come out so, na so common man too suppose use fine e level.

I just hope say, them no go push person put for bad thing by closing all this opportunities way man dey take chop. I never still know how them want old women for village to survive with this there cashless policy because, e go had person buy goods for there hand. People way no get a count cef, how you wan con dey do transfer for them. Our wahala just too much.
hero member
Activity: 644
Merit: 520
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
If CBN no print N500 and N1000 plenty d plan go seriously help ooo and he go affect those politicians badly because too much cash dey no lik to ge carry am Waka for security purposes.now e go be sai if go 10million naira inside car everybody go kno sai you carry money. But are we  sure sai those politicians no go dey use dollars especially on c up coming elections to dey buy votes? I am sure dey 4 done buy dollars keep gain by now. Still all I no with dis withdrawal cash policy, I no sai it go help in one or two ways.
Our politicians are the real Yahoo boys.
The best way na to put death-sentence as punishment for corrupt politicians. They set example with 3 of them and watch everything change.

Boss maybe that one na for olden days nai e for happen,  guy na this kind global world that kind shit no go fit happen again. as for this our country na only miracle nai go fit cleanse the whole Nigerian system and rid the country of this corruption wey deh the heart of every single Nigerian ,because the politicians were once like us and na still the same corrupted mindset dem carry grow go enta that political seats.

Our politicians truly na be the yahoo boys but the virus wey don spread don enta everyone wey deh for the country body and na only God and personal determination to stop very act dat involves corruption in your own way nai the country go fit better
hero member
Activity: 896
Merit: 586
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
If CBN no print N500 and N1000 plenty d plan go seriously help ooo and he go affect those politicians badly because too much cash dey no lik to ge carry am Waka for security purposes.now e go be sai if go 10million naira inside car everybody go kno sai you carry money. But are we  sure sai those politicians no go dey use dollars especially on c up coming elections to dey buy votes? I am sure dey 4 done buy dollars keep gain by now. Still all I no with dis withdrawal cash policy, I no sai it go help in one or two ways.
Our politicians are the real Yahoo boys. They all have a clever way of moving money. We only know the ones that they have allowed us to know. But do you know that this politicians no be one-man Mopol? Na people like you and me they help them run their parole. Dem don weaponize poverty so tey with even 10k some kind boys go fit move anything for them. See eh whether CBN no print N500 and N1000 our politicians go still dey siphon our money. The best way na to put death-sentence as punishment for corrupt politicians. They set example with 3 of them and watch everything change.
Boss wetin you talk na true o,na to kill all the corrupt politicians but who won judge the matter to make them guilty. Na the law or the court or who ? All of them plus politicians and judges all of them na e be politicians o,bcos judge dey pass judgment to favour the politicians wey go pay am well. Nigeria don corrupt to the extend wey be say the court no fit help the common man get justice.

Oya case study, I think Nigeria na federal constitution dem dey practice,wey state say  nobody is above the law,which is supremacy of the law,so that equality go dey in terms of human right between the poor and the rich but when court pass judgment make federal government release Nnamdi Kanu,how far Old Buhari wey no fit think well again no gree obey court order. If u even check am well Buhari fit no even know say Nnamdi Kanu still dey custody,na just some persons wey dey in charge of this mata no won listen to court order becos say dem be Buhari boys.
hero member
Activity: 1190
Merit: 901
Livecasino.io
If CBN no print N500 and N1000 plenty d plan go seriously help ooo and he go affect those politicians badly because too much cash dey no lik to ge carry am Waka for security purposes.now e go be sai if go 10million naira inside car everybody go kno sai you carry money. But are we  sure sai those politicians no go dey use dollars especially on c up coming elections to dey buy votes? I am sure dey 4 done buy dollars keep gain by now. Still all I no with dis withdrawal cash policy, I no sai it go help in one or two ways.
Our politicians are the real Yahoo boys. They all have a clever way of moving money. We only know the ones that they have allowed us to know. But do you know that this politicians no be one-man Mopol? Na people like you and me they help them run their parole. Dem don weaponize poverty so tey with even 10k some kind boys go fit move anything for them. See eh whether CBN no print N500 and N1000 our politicians go still dey siphon our money. The best way na to put death-sentence as punishment for corrupt politicians. They set example with 3 of them and watch everything change.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
If CBN no print N500 and N1000 plenty d plan go seriously help ooo and he go affect those politicians badly because too much cash dey no lik to ge carry am Waka for security purposes.now e go be sai if go 10million naira inside car everybody go kno sai you carry money. But are we  sure sai those politicians no go dey use dollars especially on c up coming elections to dey buy votes? I am sure dey 4 done buy dollars keep gain by now. Still all I no with dis withdrawal cash policy, I no sai it go help in one or two ways.

Nigeria politicians na thieves dem be. Make I just say most of them, not all. Because e go get some weh still get conscience among them. Remember say the CBN new policy na on top withdrawal and no be on transfer o. Na weekly withdrawals. These politicians can move cash around to different accounts and then begin ask those people weh them use their accounts to withdraw am for them. We go see more of this type of something weh I described here from next year. Just watch.
hero member
Activity: 882
Merit: 581
All Nigeria government does is to worsten things for the common man. All these ones wey dem dey do,e no go affect them o because if na cashless policy,them politicians go still dey spray money and go even dey carry large sum of money waka. If u check CBN rules,dem say anything above the daily limit, you go pay some percentage and these bastard politicians go pay all those charge fee becos money dey.

I know say dem talk so neh so that dem go fit dey task those big politicians join too but the thing no go affect dem at all because they’ve the money for it. But still d policy go limit them to the large amount of money denomination wey go dey their possession because dem CBN no go too print N500 and N1000 naira notes plenty like before. All dis na to make naira get value, make we hope say the aim go set achieve make e better for our country all.

If CBN no print N500 and N1000 plenty d plan go seriously help ooo and he go affect those politicians badly because too much cash dey no lik to ge carry am Waka for security purposes.now e go be sai if go 10million naira inside car everybody go kno sai you carry money. But are we  sure sai those politicians no go dey use dollars especially on c up coming elections to dey buy votes? I am sure dey 4 done buy dollars keep gain by now. Still all I no with dis withdrawal cash policy, I no sai it go help in one or two ways.
hero member
Activity: 1008
Merit: 629
Somtyms e dey be like say we contri no know wetin d wan use dia tym do and just like wetin @Cryptoprenuerbrainboss tok, did na misplaced priority. As d naira dey lose value so, e no go change anything if dem tok say make we stop to carry cash sef.
  We get the issue of insecurity and sori to digress a bit but recently our bubu go soon receive award on peace and security. I no lie say I shock. We get d problem of economic instability to solve amongst other things and yet wetin him fit choose to face na for pipo to no dey spray moni for occasion. Haba! We need wise up o!
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
Abegy my people make una take this news serious. CBN d do everything in their power to make our currency appreciate for value against dollar. First na changing of naira notes, limiting day and weekly transactions and now they don come up with this one. Just within 2months to the end of this present tenure. Anyway, dem don try. If this can make our naira come alive again. I support am

I no sure say na make naira appreciate make Government dey redesign naira. Redesign no go help naira appreciate. The redesign just help make people wey don too hoard money release am make money for enter circulation again. But the e been help redeem naira that time e fall reach upto N900 to $1.
The withdrawal limit I dey see am as tool wey Buhari wan use enforce this free and fair election him don dey promise this while. When the old money dom commot finish, no body go fit withdraw the new money full 10 Ghana must go back carry dey go polling units. Na the idea be that.

Comrade, this idea for make brain o but as it stands now the economy no ryhme for that policy though but anyhow Sha e go be as the government want am to be. See ehn me I for like am so because this policy go frustrate those politicians wey dey buy vote for election day. Dem no go see money to take buy vote at all no be only that one sef people wey hoard money for house too go bring am out then answer government  how e take happen wey Dem keep that kind money for house make e be say e no go back to the economy for people to smile well. But see o make we also talk the other side too. This new note sef wey Dem want to mint 5000 ehn na enough looting be this o. Na so alhaji Dem go dey carry millions for their babariga dey go their various houses nobody go know. That wan go make the looting get better head for them.
hero member
Activity: 1162
Merit: 643
BTC, a coin of today and tomorrow.
Abegy my people make una take this news serious. CBN d do everything in their power to make our currency appreciate for value against dollar. First na changing of naira notes, limiting day and weekly transactions and now they don come up with this one. Just within 2months to the end of this present tenure. Anyway, dem don try. If this can make our naira come alive again. I support am

I no sure say na make naira appreciate make Government dey redesign naira. Redesign no go help naira appreciate. The redesign just help make people wey don too hoard money release am make money for enter circulation again. But the e been help redeem naira that time e fall reach upto N900 to $1.
The withdrawal limit I dey see am as tool wey Buhari wan use enforce this free and fair election him don dey promise this while. When the old money dom commot finish, no body go fit withdraw the new money full 10 Ghana must go back carry dey go polling units. Na the idea be that.
full member
Activity: 303
Merit: 137
Defend Bitcoin and its PoW: bitcoincleanup.com
All Nigeria government does is to worsten things for the common man. All these ones wey dem dey do,e no go affect them o because if na cashless policy,them politicians go still dey spray money and go even dey carry large sum of money waka. If u check CBN rules,dem say anything above the daily limit, you go pay some percentage and these bastard politicians go pay all those charge fee becos money dey.

I know say dem talk so neh so that dem go fit dey task those big politicians join too but the thing no go affect dem at all because they’ve the money for it. But still d policy go limit them to the large amount of money denomination wey go dey their possession because dem CBN no go too print N500 and N1000 naira notes plenty like before. All dis na to make naira get value, make we hope say the aim go set achieve make e better for our country all.
hero member
Activity: 1190
Merit: 901
Livecasino.io
Quote
Could you imagine a better future using Bitcoin?

For those who actually own Bitcoin those who have seen two possibilities of Bitcoin would agree that there is a brighter future with Bitcoin. And he has no doubt about it.

-
Quote
Are there already plenty of people in Nigeria who use Bitcoin?

Are there plenty people using Bitcoin in Nigeria? I would see that Bitcoin is popular among the teeming youths in the country. What do I mean by this? 7 out of 10 youth have heard about Bitcoin while 5 out of 10 youth own Bitcoin or any other cryptocurrency. This is not from a pool but from my experience as a Nigerian living in Nigeria..

Quote
How is the Nigerian government responding to the increased Bitcoin use?
The only way the Nigerian government responded to the use of Bitcoin is by creating their own digital currency which flopped on arrival. They also ban Banks from transacting in  cryptocurrency.
legendary
Activity: 1106
Merit: 1372
I would be happy to answer these questions:

- How could Bitcoin help in your specific situation in Nigeria?
- Could Bitcoin give Nigerians a new way of life?
- What do you find particularly appealing regarding Bitcoin technology?
- Could you imagine a better future using Bitcoin?
- Are there already plenty of people in Nigeria who use Bitcoin?
- How is the Nigerian government responding to the increased Bitcoin use?

First of all you are welcome to naija. The bitcoin  dominating City in Africa. I don't know what kind of project you are embarking on. But there is harm in this research. These are my views on your questions
1. Bitcoin has helped me in particular to stabilize my life and cost of living. After the university education, the government could not provide job for the graduates so I key into bitcoin investment as a friend of mine introduced me to it. And I am doing well even in the bear market. And the future is brighter with bitcoin.

2. Of course, those who are serious and patient with bitcoin always have new life. Bitcoin is not a get quick rich investment but it is a long term system because of the bear markets, so those who can endure change their narratives.

3. Well bitcoin is a digital currency which is used to exchange goods (assets) and  services online that out of authorities control (decentralized payment system).

4. As it is stated in 1 and 2, the future with bitcoin is bright.

5. From my introduction, Nigeria is the bitcoin dominant city in Africa. Therefore the population of users of bitcoin in Nigeria is uncountable upon the ban.

6.well there are different propaganda circulating the media that Nigerian Government is planning to tran the youth on cryptocurrencies. That means there is a pre-planned adoption of bitcoin.

Thanks! This helps me quite a lot and that's how I am able to write an article about the situation in Nigeria  Smiley

- Which circumstances contributed to increased bitcoin usage in Nigeria?
- What do you think about the E-Naira?

2 more questions have emerged. I would be happy for another reply, but I'm already super grateful for what I have. There seems to be an awesome Bitcoin community in Nigeria! I am trying to onboard German people to Bitcoin technology, who care about sustainability and human rights. Those people should see what big implications money has and what Bitcoin could do for us. Would you mind sending me a private message?

1. The circumstances that increased the uses of bitcoin in Nigeria is the endsars protest, unemployment, and bitcointalk forum etc

2. E-naira was established after the ban of bitcoin in the country, and the youth didn't use it. And if this cashless policy finally established in Nigeria, the youth will still use bitcoin p2p more because the e-naira is centralized exchange system.
Pages:
Jump to: