Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 20. (Read 732722 times)

hero member
Activity: 854
Merit: 597
Dem feel say our voice no sound, lai dis we be mugu wey no sabi wetin be dia plan for this election and "come and take your PVC" matter b. We hear of the issue of giving underage Pikin dem PVCs and now nah the polling units them go target when election reach cos some people don already collect dia own. no be everybody get conscience and we dey hear for news about thugs wey dey spoil things, but we know d truth.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Abuse of naira notes
In the fight of making our naira notes valuable again. The CBN don promise jail time for anybody wey d spread money, or step on am for any social gathering. Any person wey d found guilty of am go enter prison for six months or em go pay a fine of N50,000.
Link for information: https://gazettengr.com/cbn-promises-prison-time-for-nigerians-who-abuse-naira/

Abegy my people make una take this news serious. CBN d do everything in their power to make our currency appreciate for value against dollar. First na changing of naira notes, limiting day and weekly transactions and now they don come up with this one. Just within 2months to the end of this present tenure. Anyway, dem don try. If this can make our naira come alive again. I support am
hero member
Activity: 742
Merit: 529
Cashless Economy Wahala
The other day, I comot with my guys go one Lounge for we area to watch one of the world cup games. Normally, we buy some drinks as we dey watch the game. After the match end, e reach time to make  payment with our bank card, na so the waiter talk say if we wan make payment using their POS we go add N100 for charge. She talk say na so e be. Las las we nor wan talk too much, we pay the extra N100 charge o.

The whole thing come make me dey think say e be like say this cashless economy thing get as e be o. Because e just go against wetin I feel say na how cashless economy suppose be. How I go pay extra charge because say I wan use POS pay for wetin I buy?
How una see am. Anybody don experience this kind thing before?
I never actually get that experience before but if na like that they want to run it omo wahala they be that imaging say you go market you done buy your stuffs Finnish they come they ask for extra charges for the money omo the thing no go well at all, looking at it from a different direction na selfishness be that now you sell something finish you still chop charges you no wan loss, see greed abeg. That my problem with Nigerians' greed too much, and if na government now everybody go they complain.
The tin be say the pattern tire me towards the way dis kind tin be. Even wer I dey go fill gas na so the man go dey collect charge for him pos wey I go use to take payment to him for gas I fill from am, I com d wonder as a customer wey I be to him, wetin be the benefit I dey gain from am if him still dey collect POS charge from me. I reason that tin na I com change customer, now dis new person no dey take anything as charge. And this POS sef get him own wahala wey me sef the fear to the use am ever since I lost #7,500 through POS transaction around 27th december 2022, I waka for bank tire, fill forms for bank till today that money wasn't refunded. So this cashless economy wey we dey run for this our country I no go lie, the tin never mature at all
newbie
Activity: 22
Merit: 42
Boss just incase una still dey debate this matter see my bank don send me email and it's really disheartening how this people no dey even consider the common man

Na now I confirm say una get money for this country no be lie. If not how 100k weekly limitation go worry una. Me self I no deh do reach 100k weekly. Where the money even deh to withdraw self. How many people deh even earn up to that amount as salaries self for this country, even graduates? My concern na whether CBN and its partners go make the rule deh for everybody, no be only for the less privileged.
The truth be say even if the matter no concern you e definitely concern someone that is close to you my guy, wen we dey reason say some moves by the government no concern us na when them dey try dey do more.

In the pursuit for a better Nigeria we go gats dey selfless about the matter, I my self no get that kind money but there are some weeks like this way person fit use through me one run figures wey pass that amount.

Wetin I believe is that the country now they like kindergarten play ground them they focus on less important things we no go improve the economy like the new coloration of the naira because I no go call that one new design and now this one. Make them focus on things wey go at least give our currency value.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
Boss just incase una still dey debate this matter see my bank don send me email and it's really disheartening how this people no dey even consider the common man

Na now I confirm say una get money for this country no be lie. If not how 100k weekly limitation go worry una. Me self I no deh do reach 100k weekly. Where the money even deh to withdraw self. How many people deh even earn up to that amount as salaries self for this country, even graduates? My concern na whether CBN and its partners go make the rule deh for everybody, no be only for the less privileged.
full member
Activity: 1190
Merit: 126
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Quote from: Davidvictorson
Cashless Economy Wahala
The other day, I comot with my guys go one Lounge for we area to watch one of the world cup games. Normally, we buy some drinks as we dey watch the game. After the match end, e reach time to make  payment with our bank card, na so the waiter talk say if we wan make payment using their POS we go add N100 for charge. She talk say na so e be. Las las we nor wan talk too much, we pay the extra N100 charge o.

The whole thing come make me dey think say e be like say this cashless economy thing get as e be o. Because e just go against wetin I feel say na how cashless economy suppose be. How I go pay extra charge because say I wan use POS pay for wetin I buy?
How una see am. Anybody don experience this kind thing before?
Yes, I experienced d same tin in one super market in my area were I bought some goods to pay with my ATM card,  hoping that, there will not be charge over the goods but I discovered they charged me #100 for the #7000 goods I bought from Dem, that made me feel bad at the moment. Assume our banks are active in our country, i don't see what will make me to use ATM card in the supermarket because the supermarket owner suppose be the one to be responsible for the tools use in the supermarket.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Life's but a walking shadow!
The POS operators can withdraw more than the minimum and pay charges then continue their business.
I know that one boss, and if to say you find the post wey i bin quote you, you go see say i talk am there, but that charge no be here oh, imagine say person wan withdraw 600k for example, e go pay 10% tax on it, which is 60k, Grin no person go fit do that na, na business e they do, abi e come make loss Grin
By the time dey dun pay those charges wella, e go wey dem and them go increase withdrawal charges, this one go enforce people to go cashless since dem dey claim say dem get coconut head.
Lol, Grin this one they too, the charge go they mahd if they are to cover wetin them bin pay as charge for bank, so na wetin i they talk here since say PoS service go they affected, i don check am critically, the policy get advantages, especially in the long run, that post wey i quote you, i just bin wan correct wetin you talk say PoS no go they affected, na must, e go kick them out of business for sure, all of us fit agree on that one.
Personally I no fit remember when last I buy something with cash, all my activities this year has been cashless. E no hard to run am.
Me too, personally i no get any issues with the new policy oh, and long run e fit they beneficial for our economy if we fit begin produce stuffs locally, but that is btw; in the last two years me sev never hold like 50k or 100k cash for my hand, i never feel that kind amount in a very long time, meaning me sev don they cashless for a very long time now, i only leave my house with my TP to where i they go and my ATM card. Grin
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Cashless Economy Wahala
The whole thing come make me dey think say e be like say this cashless economy thing get as e be o. Because e just go against wetin I feel say na how cashless economy suppose be. How I go pay extra charge because say I wan use POS pay for wetin I buy?
How una see am. Anybody don experience this kind thing before?

Nothing dey wrong there with paying extra charge or na because say dem ask you na him make u dey reason am? Man must find way survive, na there own choppings be dat. You forget say you dey pay extra charge steady anything you use your bank do transfer or recieved transfer or na because bank no need your permission to collect that one na him make you no dey reason am?

Also @Coyster e get one reply you give me wey I dun forget where e dey to quote am but make I tell you. You can withdraw as much as you want but there's a charge. This POS businesses them need go register with government so them fit dey pay tax, we aren't paying taxes enough in Nigeria especially all this small small business wey government for use the hold body. All this policy go help enforce that. The POS operators can withdraw more than the minimum and pay charges then continue their business.

By the time dey dun pay those charges wella, e go wey dem and them go increase withdrawal charges, this one go enforce people to go cashless since dem dey claim say dem get coconut head. Personally I no fit remember when last I buy something with cash, all my activities this year has been cashless. E no hard to run am.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
I.e imagine you want to buy a car of one million naira, that means as an individual, you have to wait for good 10 weeks to complete a transfer of just only one million naira (#100k weekly).  Too bad.
Mate, the policy e no dey like dat. Na only cash withdrawal is limited to 20k on ATM while inside Bank is 100k or individuals but for organizations and companies can withdraw from 500-1m. Apart from the daily cash withdrawal limit. You can transfer any amount of money to another person through e-transaction.
My persn, e be like you no put eye down well for d image way Obari post o. I ho encourage you to look am again so, I I quite am for here. Yes na true say, daily withdrawal for pos or ATM machine na 20k but, even over the counter way be 100k, that na maximum for a week base. Person way withdrawal 20k for 5days in a week and person way go counter go withdraw 100k in a day, e don exhaust en weekly withdrawal chance as well. The target still carry say, you no gats pass 100k withdrawal in a week, either na pos o, ATM machine abi na for counter as far as na individual account you dey deal with.
I don repaste the image make we read am slowly to see the emphasis on weekly.


sr. member
Activity: 784
Merit: 366
Underestimate- nothing
Cashless Economy Wahala
The other day, I comot with my guys go one Lounge for we area to watch one of the world cup games. Normally, we buy some drinks as we dey watch the game. After the match end, e reach time to make  payment with our bank card, na so the waiter talk say if we wan make payment using their POS we go add N100 for charge. She talk say na so e be. Las las we nor wan talk too much, we pay the extra N100 charge o.

The whole thing come make me dey think say e be like say this cashless economy thing get as e be o. Because e just go against wetin I feel say na how cashless economy suppose be. How I go pay extra charge because say I wan use POS pay for wetin I buy?
How una see am. Anybody don experience this kind thing before?
I never actually get that experience before but if na like that they want to run it omo wahala they be that imaging say you go market you done buy your stuffs Finnish they come they ask for extra charges for the money omo the thing no go well at all, looking at it from a different direction na selfishness be that now you sell something finish you still chop charges you no wan loss, see greed abeg. That my problem with Nigerians' greed too much, and if na government now everybody go they complain.
hero member
Activity: 700
Merit: 523
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform


Thank you my brother for the update. Dem don too decieve us say our votes no go count and yet dem dey buy PVC. If vote no go count why dem dey buy PVC? Why dem dey share money for polling unit to carry influence our conscience.
Make everybody stand up for the truth.
Stand up against people wey think say na dem get this country.
Stand up against "my turn" people wey don already share the country positions without our consent.
Stand up for those who don dey thief and wan be president since 1993 till date and yet dem go talk say na youths be the leaders of tomorrow.
PVC na e sure pass but still manipulation dey coded, now some people day y get like 5 PVC for hand on that day of election wey be their own and dem go use all the five cards vote just because of to collect money five times,underage na another way to do am. Imagine say one same person dey do PVC every time wey national elections won come up

Anybody wey neva go collect him own wet e do make e quick go now o,because e get as e go tey before u know this INEC people go sell am out to party leaders for the ward so that e go be advantage for them to use am on election day vote without you the owner knowledge. Let's kick out bad government for naija and no be by talk but na by action.
hero member
Activity: 966
Merit: 609
BTC, a coin of today and tomorrow.

Collection of PVC for the 2023 general elections.

source:https://www.premiumtimesng.com/news/568710-inec-announces-dates-for-pvc-collection.html

The Independent Electoral Commission has commenced the issuance of the permanent voters card PVC for those individuals that did their registration in this year 2022, from today 12th December to January 22nd, 2023.  We're all encouraged to go the commission office in all our local government areas or wards to collect our cards through Mondays to Sunday's 9am to 3pm.

Please let's do well to go get our PVC as it is that only possibly legit means for us to elect the kind of good leaders we all hope for in our country. Don't exclude yourself from the process, come out even on the election day and cast your vote, "for bad men get into governance because good men sit down and do nothing". The 2023 is just about 74 days from now.

NAIJA go beta!

Thank you my brother for the update. Dem don too decieve us say our votes no go count and yet dem dey buy PVC. If vote no go count why dem dey buy PVC? Why dem dey share money for polling unit to carry influence our conscience.
Make everybody stand up for the truth.
Stand up against people wey think say na dem get this country.
Stand up against "my turn" people wey don already share the country positions without our consent.
Stand up for those who don dey thief and wan be president since 1993 till date and yet dem go talk say na youths be the leaders of tomorrow.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Life's but a walking shadow!
Nobody can predict the future but someone can tell how the future will be. Today we are celebrating because the thread is active. I am of the full support of the political discussion in the thread and I even voted for it. That doesn't mean that I should deviate from the core mandate of the thread. I was one of the number one novice in the forum. Dat is y I am trying my best to learn. But if I have offended u through my comments, sorry. But those who are really ready to learn might not come her or mute the thread till the main board comes.
You haven't offended me in anyway whatsoever, and we all have a right to air our opinions without fear, i do not have any problem with any sort of discussion that is brought up here, so long as it is on-topic and presented constructively, i must admit that some topics/subjects are unnecessary and unfit to be discussed here, but i think we might have to put up with it until we have our local board, if we tighten moderation here at this time we might dissuade people from here, that's why we are just trying to be diplomatic in all that we do.

Having said that, i do not think learning is in anyway being hindered in here, nor is questions or enquiries relating to Bitcoin being snubbed, it is just a matter of what users bring up for discussion, i'm ready to discuss on any subject that's on-topic, if a user here today stirs up a subject about Bitcoin, i don't think they are going to be snubbed, we are all going to react to it, and have our say/opinion.
Every transaction in POS just like bitcoin wallet transaction, there is a transaction fee paid to the machine. Just like transaction fee to the nods.
If i am not being nitpicky, transaction fees aren't paid to nodes per se, transaction fees as well as block rewards is paid to the particular miner who solves the complex 'puzzle' and creates a new block. Mind you that no be every node be miner, but every miner must to run a full node before e fit mine.
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
Vave.com - Crypto Casino
Cashless Economy Wahala
The other day, I comot with my guys go one Lounge for we area to watch one of the world cup games. Normally, we buy some drinks as we dey watch the game. After the match end, e reach time to make  payment with our bank card, na so the waiter talk say if we wan make payment using their POS we go add N100 for charge. She talk say na so e be. Las las we nor wan talk too much, we pay the extra N100 charge o.

The whole thing come make me dey think say e be like say this cashless economy thing get as e be o. Because e just go against wetin I feel say na how cashless economy suppose be. How I go pay extra charge because say I wan use POS pay for wetin I buy?
How una see am. Anybody don experience this kind thing before?
Every transaction in POS just like bitcoin wallet transaction, there is a transaction fee paid to the machine. Just like transaction fee to the nods. So the #100 transaction fee was not for the profit of the business owner but for the machine charges. Remember the machine is not for bot but for personal use in the sense that when person want to use card for payment that when it is used. The #100 charge is to fill the vacuum of the machine charged.

Dis thread is producing low and off topic discussions throough out this last week. There is nothing to discuss again, now I can see dat the thread was not moving for last two years plus. If you can see the activities of the thread is very low though I might be di only one noticing it in that way. Those who are good in bitcoin are quite, and politics will be remove from do the thread next month. As it is I am confused here. The free flow of discussion is...

Those who are good in bitcoin brought topics let discuss.
Where are you getting that idea from, that this thread is producing low and off-topic discussions, mind you that it is impossible to eradicate spam completely, even the forum generally hasn't been able to achieve that, thus there would definitely be spam and off-topic discussions from time to time in this our local community, i don't see it as a problem if the quality and constructive discussions outweigh them.

Having said that, this thread has grown tremendously in the past two years, what are your reasons for claiming it hasn't been progressing? Mind you that you can't compel someone to post here, if a user has decided to stop posting here for any reason whatsoever, then it is what it is, but do not undermine those who regularly make posts here by saying: "those who are good in Bitcoin are now quiet", there are quite a lot of active users here who are good in Bitcoin discussions and can help out in that area if the need arises. No user here can ban discussions on any particular subject, i guess the suggestion was only made for the monthly award stuff or so.

Nobody can predict the future but someone can tell how the future will be. Today we are celebrating because the thread is active. I am of the full support of the political discussion in the thread and I even voted for it. That doesn't mean that I should deviate from the core mandate of the thread. I was one of the number one novice in the forum. Dat is y I am trying my best to learn. But if I have offended u through my comments, sorry. But those who are really ready to learn might not come her or mute the thread till the main board comes.
hero member
Activity: 798
Merit: 547
Leo is resting.
Dis thread is producing low and off topic discussions throough out this last week. There is nothing to discuss again, now I can see dat the thread was not moving for last two years plus. If you can see the activities of the thread is very low though I might be di only one noticing it in that way. Those who are good in bitcoin are quite, and politics will be remove from do the thread next month. As it is I am confused here. The free flow of discussion is...

Those who are good in bitcoin brought topics let discuss.

@ Agbe, you dom talk wetin dey your mind base on say na wetin you observe but e get wetin I think say no dey right for some things wey you talk wey I wam try correct. First of all, the thread was created to discuss the things of cryptocurrency and how e take relate and concern us for we naija here so if the main reason wey make we create the thread no be wetin we dey discuss here then you dey correct and person no go blame you for anything but for you to come out say nothing day again to discuss here base on say maybe no body talk about crypto-related things last week e no make sense at all and you go need to do the needful.


Another thing wey dey there be say all of us dey here together you no need to feel bad or dey confused about wetin dey happen rather you fit still ginger men with your research then bring better topic wey be crypto related so that men go follow chuck mouth so that those off topic things go dey less abi how you see am?
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Cashless Economy Wahala
The other day, I comot with my guys go one Lounge for we area to watch one of the world cup games. Normally, we buy some drinks as we dey watch the game. After the match end, e reach time to make  payment with our bank card, na so the waiter talk say if we wan make payment using their POS we go add N100 for charge. She talk say na so e be. Las las we nor wan talk too much, we pay the extra N100 charge o.

The whole thing come make me dey think say e be like say this cashless economy thing get as e be o. Because e just go against wetin I feel say na how cashless economy suppose be. How I go pay extra charge because say I wan use POS pay for wetin I buy?
How una see am. Anybody don experience this kind thing before?
Bros make I ask you, your bill dey above #10k?
The answer is no, so why didn't any of you guys hold spear cash like 5k to 10k which is less than the daily withdraw of 20k which is way less than your bill for the day. The question we should ask ourselves, is how many Nigerians leave above #20,000 a day for daily needs, the answer is that inside 100% only 30% fall into this category, the remaining 70% fall into the category of those that spend less than #20,000 daily. With that we should know that this new monetary policy will check mate so many things in the economy, and even price of good will reduce because our currency will have value internally. Another thing I will like you to note is, this new monetary financial policy from CBN will eliminate the place of pos and replace it with e-payment such as scan and pay which can take any amount through electronic banking. So no body go need pos and even if there is need the fees will be less since there is less cash in the economy.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Life's but a walking shadow!
Dis thread is producing low and off topic discussions throough out this last week. There is nothing to discuss again, now I can see dat the thread was not moving for last two years plus. If you can see the activities of the thread is very low though I might be di only one noticing it in that way. Those who are good in bitcoin are quite, and politics will be remove from do the thread next month. As it is I am confused here. The free flow of discussion is...

Those who are good in bitcoin brought topics let discuss.
Where are you getting that idea from, that this thread is producing low and off-topic discussions, mind you that it is impossible to eradicate spam completely, even the forum generally hasn't been able to achieve that, thus there would definitely be spam and off-topic discussions from time to time in this our local community, i don't see it as a problem if the quality and constructive discussions outweigh them.

Having said that, this thread has grown tremendously in the past two years, what are your reasons for claiming it hasn't been progressing? Mind you that you can't compel someone to post here, if a user has decided to stop posting here for any reason whatsoever, then it is what it is, but do not undermine those who regularly make posts here by saying: "those who are good in Bitcoin are now quiet", there are quite a lot of active users here who are good in Bitcoin discussions and can help out in that area if the need arises. No user here can ban discussions on any particular subject, i guess the suggestion was only made for the monthly award stuff or so.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Cashless Economy Wahala
The other day, I comot with my guys go one Lounge for we area to watch one of the world cup games. Normally, we buy some drinks as we dey watch the game. After the match end, e reach time to make  payment with our bank card, na so the waiter talk say if we wan make payment using their POS we go add N100 for charge. She talk say na so e be. Las las we nor wan talk too much, we pay the extra N100 charge o.

The whole thing come make me dey think say e be like say this cashless economy thing get as e be o. Because e just go against wetin I feel say na how cashless economy suppose be. How I go pay extra charge because say I wan use POS pay for wetin I buy?
How una see am. Anybody don experience this kind thing before?
Which kind whining be that? To charge 100naira for POS transaction of drinks wey I buy from una. That's madness. It is not done anywhere. The only time wey a POS operator fit charge you money na when it is done outside and you are the one that called them. Not for a waitress to charge you for making use of their own business POS (Like am being charge of paying bill with una POS), Reason am that's to bad

I don't know why our country people like to take advantage of every small little thing wey happen for the country. It is very tiring and annoying, sae the FG never fully implement the new law and our people wan bring mago-mago into am.
hero member
Activity: 1036
Merit: 860
Livecasino.io
Cashless Economy Wahala
The other day, I comot with my guys go one Lounge for we area to watch one of the world cup games. Normally, we buy some drinks as we dey watch the game. After the match end, e reach time to make  payment with our bank card, na so the waiter talk say if we wan make payment using their POS we go add N100 for charge. She talk say na so e be. Las las we nor wan talk too much, we pay the extra N100 charge o.

The whole thing come make me dey think say e be like say this cashless economy thing get as e be o. Because e just go against wetin I feel say na how cashless economy suppose be. How I go pay extra charge because say I wan use POS pay for wetin I buy?
How una see am. Anybody don experience this kind thing before?
sr. member
Activity: 784
Merit: 366
Underestimate- nothing
You no need to bother yourself too much about this matter my guy, if dem implement dis then even the market people go improvise, na because dem never introduce am you dey reason say e go hard. Even person wey no go school now fit operate and use ATM machine. Before dem introduce am for even civil servants to dey collect money from bank instead of table payment dem been grumble but now dem prefer am like that. Anything wey person put head say him go do, e go definitely work out like that. Make we just dey watch see how the matter go be after dem implement am because I no see any reason wey dem go stop am now since e don reach dis stage like dis.
The thing be say for this our very country we like to jump into conclusions without proper investigation and analysis. We go just sit down for chambers dey talk I hear say this and that. If you really take out time to go through this new policy you go realize say CBN really try with this new policy. Is not that you can not spend more than 20k a day as majority of us dey think. You go fit spend millions or billions of naira a day but all transactions must be traceable na wetin CBN dey try achieve be that. Even the reps wey wan make dem reverse the policy na for their selfish interest and not for the interest of Nigerians.
my brother na true you talk the new policy actually make sense he go actually give the currency value and reduce the circulation of cash in general, so them try abeg make we look at the positive aspect of the policy, if you look am we get so many policy to amend and starting from the cbn I like this step them take, at least reformation done they come small small my brother.
Pages:
Jump to: