Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 258. (Read 1033251 times)

legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
The skurskur people don start oh. I hope sey the gbenge nor rub anyone here potorpotor sha. Na anything to take bring common man down owa banks dey rush do. Ask dem for loans na, e go take dem forever to process your application. Idiots without a leader. GTBank and Access don already begin dem own closer too.

legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Nigeria's SEC suspends planned crypto regulations amid central bank ban

It was CBN before, now Nigera SEC. Although, crypto assets not yet banned. P2p still active.

Any pesi wey go or wey no go skool shuld know sey dem our leaders jakpa our kountry since b4 Bitcoin come, so, far-far-far-fowww, our leaders be our whahalas.
No be lie.
full member
Activity: 756
Merit: 231

Please, Bitcoin makes Naira useless? Or lack of capable leaders?
Even small pikin know sey dem our ogas at de top sold our kountry finish nd not dis deir accusations aganst Bitcoin, de question i dey ask som of my frinds be sey, wen Bitcoin came into Nigeria?, or how many years dis Bitcoin don dey spend with users? somtin wey neva reach 12years, why dem kountry don be 60+ years. Any pesi wey go or wey no go skool shuld know sey dem our leaders jakpa our kountry since b4 Bitcoin come, so, far-far-far-fowww, our leaders be our whahalas.
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
Senate don finally call CBN governor and him member about the crypto ban matter ,it just a matter of time b4 those ppl go unban their actions, but from my own point of view these ppl no Sabi say if them buy bitcoin for bulk them no Sabi say within 2yrs the country don cover all ihn debt and change go still dey.
No mind dem oh, dis pipo get plenti btc for their wallet, as you see dem so, dem dey poisonous, almost all of them politicians get btc wallet wey dem lute our money put inside, I fit remember pst Chris talk say "my bitcoin wal........",so you see Smiley The ones wey the news affect nae go meet CBN governor, na dem dem, all of dem wan cashout to deir pocket on a low, if you no know you no go know.

Edit:
You know say one tin one tin go cause one tin start to dey happen for naija, as dem ban crypto for kontri,  escrow service na de latest wey de happen for every corner of our WhatsApp group., make I draw our ears, make ona shine ona eyes, bad bad eggs dey for this escrow tins, Dem don scam persin wey wan buy crypto via escrow., Na you know oh.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
The thing be say, them no know say all this wahala na them. How can, each government way go come in go just dey focus on doing one new peoject or the other and yet, them no go fit focus on one finish am. NA so-so abandoned project here and there all because them wan chop Nigerian money through projects. Na the problem be that, na watin dey make them borrow and worst be say, we no dey produce anything. Na only our own thing cef we dey export for small money con import am for big money. If we wan build something, na so we go carry expert, pay them at their own rate in their own currency for our own country with borrowed money for that matter. Na why them need good image, to borrow more. Abi na our fault say grand mama and grand papa no gree commot online? I just thank God for P2P.
member
Activity: 123
Merit: 25
The matter don dey official , Senate don finally call CBN governor and him member about the crypto ban matter ,it just a matter of time b4 those ppl go unban their actions, but from my own point of view these ppl no Sabi say if them buy bitcoin for bulk them no Sabi say within 2yrs the country don cover all ihn debt and change go still dey . No wonder we are far behind revolution .some time I just dey wonder why we no get right to pick country were we for enter.this country for empty
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Naira no be good currency since 1960s. Naija dey only depend on oil while most of their refined oil na still imports. The country dey so unfortunate to have such leadership. The old papas wey don frastrate people's lives finish.
Our pipo say na prick know wetin him see 4 toto wey mak am vomit. Hand wey scratch nyash node be friend to nose oo. Dis pipo don rub us shit 4 mouth as dem like dme say make we dey do Cowtocurrency which kind wereyy country be dis na Satan go punish Adamu. Head big no means say sense full am ooo dis pipo don use der sense take pick itune cards
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Na u get data dey download picture of dis useless set of pipo me don disown dem teytey. De naira wey don useless since 1999 abi which one? Ghana and Kenye no dey crypto? Why der money no drop...una get time sha me na to find money, chop, fuck and sleep wait when God go reason my mata 4 heaven I answer present if na hell kwa I go sit down one place...
You dey mind them, although most senetors no support the ban if you read through the tweets. Naira no be good currency since 1960s. Naija dey only depend on oil while most of their refined oil na still imports. The country dey so unfortunate to have such leadership. The old papas wey don frastrate people's lives finish. You know this APC like to follow China, while China dey wiser and far we dey behind.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
The guy be like say e slow the way Igehhh dey reason am for my own eye o. When i start this journey eh, i bin fear the guy to talk true.

Me na prophet broda de aboki nodey active like bfore again de juju men dem 4 dis group don throw de abino stroke to keep am for house..me I see newbie wer avarta my head bust I go find way bring the link make una see am I come see anoda one wey get custom name newbie account with 6 activities notin I never see for this forum d past few days... Me dey waka ashawo 4 De forum now dey find who go help my ministry....


Bitcoin has made the Naira almost useless, says Nigerian Senator
Na u get data dey download picture of dis useless set of pipo me don disown dem teytey. De naira wey don useless since 1999 abi which one? Ghana and Kenye no dey crypto? Why der money no drop...una get time sha me na to find money, chop, fuck and sleep wait when God go reason my mata 4 heaven I answer present if na hell kwa I go sit down one place...
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Bitcoin has made the Naira almost useless, says Nigerian Senator

See some senators comments below:




Quote
For Senator Musa, Bitcoin (BTC) and not mounting foreign debt, decades of poor economic policies, and corruption are to blame for the naira’s decline. Meanwhile, Bitcoin adoption has been on the rise in the country amid questionable monetary policies adopted by the CBN.

Other senators who made their voices heard during the plenary session argued against the CBN ban. According to Sen. Biodun Olujimi of the Ekiti South Constituency, the goal of crypto regulation in Nigeria should be focused on preventing its use by rogue actors, adding:

“We didn’t create Cryptocurrency and so we cannot kill it and cannot also refuse to ensure it works for us. These children are doing great business with it and they are getting results and Nigeria cannot immune itself from this sort of business.”
The Nigerian Senate has resolved to invite the CBN governor to a hearing before the appropriate committees to discuss issues related to future crypto regulations in the country.
.

https://cointelegraph.com/news/bitcoin-has-made-the-naira-almost-useless-says-nigerian-senator

Please, Bitcoin makes Naira useless? Or lack of capable leaders?
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Una know sey theymos nor dey quick react to issues. I nor think sey e get any reason pass dat one. The guy dey like draw like ogbolo wey dey cold. Im dey like guage reactions on things from others before im go react and that na why e dey always look like im dey too slow. Make una nor reason am sey im don collect gala from Bubu not to give us greenlight for owa localboard creation.
The guy be like say e slow the way Igehhh dey reason am for my own eye o. When i start this journey eh, i bin fear the guy to talk true. The guy been just dey ban accounts anyhow then, talk for meta been be wahala for me but, i gat build confidence before my liver con mature for me to talk there. So, e dey natural say, that activeness way en been use follow matter up then, e for still dey en body but, they way e be for my eye now eh, e no dey again.
Except say e go be as you talk say e dey gauge am but then, me no beleive say them chipping am anything via say, watin you wan really give am cef? Na just talk from people way dey work with am and we kwa never do things reach anywhere.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
plenty pepuls dey afraid to come join us becus dey no wan bear dat name Naija becus of our name wey don caste 4 dem abino.
Na base on say naija don cast na, dem no want make people start to see them as frauadsters or something, if you go check ranking for the country way scammers plenty, omo naija come out on top as number 1,the kin bad reputation naija get ehn they make some people deny their father land, but anyhow we go still survive na  just the bad leaders way we get na cause all this rubbish, like this sef I no even understand the country again whether we dey go back or abi na front e dey go🤷‍♂️, the country na wa.
No be lie una talk, na as e be b that. The scamming for naija na on another level o, so tayyyy e don enter to scam fellow naija men and woman way no wise using the same pattern but, how man go do in a bad country na? Country way our fathers don betray us finish! Boys don see scamming as the easiest way to escape poverty way don be trade mark our government wan carry brand us so, them get very little choice and e con worst as them dey use something run am make e sure for them.
That being that, you no fit deny where you from, even if cef, you born outside abi you use legal means. You go still get the naija blood inside you and e go show in one way or the other. Denying your people no go add anything to you, even cef, e fit reduce you. If you check am well, we dey do well for the forum, most of us dey campaigns so, e no matter much to the forum. Make we identify and dey try redefine ourselves small-small.
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
plenty pepuls dey afraid to come join us becus dey no wan bear dat name Naija becus of our name wey don caste 4 dem abino.
Na base on say naija don cast na, dem no want make people start to see them as frauadsters or something, if you go check ranking for the country way scammers plenty, omo naija come out on top as number 1,the kin bad reputation naija get ehn they make some people deny their father land, but anyhow we go still survive na  just the bad leaders way we get na cause all this rubbish, like this sef I no even understand the country again whether we dey go back or abi na front e dey go🤷‍♂️, the country na wa.
full member
Activity: 756
Merit: 231

If u be naija and all dis while u dey hide cus of fear wen dem giv us board no cum ooo drag space cus de kind juju I go do bend person prick ehh no wahala.

igehhh! igehhh!!, ow manytim i call ur name? Grin dia is God oooo, dis forum eh noby dey wey u de dey se am na im b, plenty pepuls dey afraid to come join us becus dey no wan bear dat name Naija becus of our name wey don caste 4 dem abino. Wen u check de first page nd second page of dis thread den u go undersand sey i com wit fear until BrainBoss and Mpanmaegbu gav me courage. Wetin we hear mattas as dey can kill or raise us, so, mak we embrac dem wey go com afta.  Cheesy igehhh make juju wey go mak person prick big nd not bend bikonu.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
U see dat thread so we go dey bump am till thou kingdom com till dem giv us wetin we dey find cos dis time around na so so positive reaction dey de thread. All De abino dem know say we deserve am dey don see our activities nobe lie. Almost all de crypto forum get 9ja board cus dem sabi our force. 2secs wi fit shut down.
If u be naija and all dis while u dey hide cus of fear wen dem giv us board no cum ooo drag space cus de kind juju I go do bend person prick ehh no wahala.

@Mpanmaegbu dis ur ogoni name nobi dsame app u delete put porn hub?
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
E go get reason theymos never give us local board, as we dey increase the activity for here, and for other Nigeria matter, the chances they increase. theymos will later consider wetin we dey ask.
Una know sey theymos nor dey quick react to issues. I nor think sey e get any reason pass dat one. The guy dey like draw like ogbolo wey dey cold. Im dey like guage reactions on things from others before im go react and that na why e dey always look like im dey too slow. Make una nor reason am sey im don collect gala from Bubu not to give us greenlight for owa localboard creation.

Igeh, you and your troubles be like Lai Mohammed and lies or Mallams and their kettles. Kontinue oh. Me wey don dey on discord since 2017 sef.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
But as de thread dey go, we just need more of our pepuls 2 join dis race 2 be given our board. Abeg som of us wey dey outside dis place shuld help tel odars about dis matta becus we need more hands and leg now.
If the matter bin end for people joining this our small corner, i sure say e for be small something, e no for be watin go keep us for that small place on the chat but then, na say, people way don even find their road come here cef dey act like say, e hard to speak pigin abi na waste of time... My people, i dey slam my language anyhow when i jam my tribe men o, talk more of on a foreign soil way we don try get corner and na to hustle make we for get board way remain. Na to loud am be that na! But our people no dey even wan touch leg for the ground or shuck mouth for the tori way dey the town. Na there e tire me. E no go go-hard say, you talk finish con dey reply yourself. Na to spam the board be that na... people need dey respond make e be proper discussion. I sure say most of us dey whatsapp groups way be say, na so 321 messages we dey see when we say make we just view watin sup for that way. Na that spirit we fit carry boost for here. Anytime person dey online, na to just branch make we for see wtain we fit shuck mouth.

Still on the matter eh, e go shock you say, non of us, even me inclusive never throw-way anything to anybody for the board since o. Except Brainboss, the only G way don dey try for us since. Na all this thing we need to change from make we too dey enjoy watin forum get to give us.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1167
Gamble responsibly
Baba I dey suspect u oo u be like person wey go uninstalled bible download porn...na also every day African queen porn pages dey increase in number......

Make un try oo
Everybody na Jesus boy na. No way to holiness than serving Jesus na. How you know African queen porn pages? Me never hear that before oh. Wink

Dat thread wey Charley create na awereness, we go come in full force and na Brainboss go lead dat time, anywr wey theymos hide we go worry am.,dey kpor wetin go happen.
E go get reason theymos never give us local board, as we dey increase the activity for here, and for other Nigeria matter, the chances they increase. theymos will later consider wetin we dey ask.
full member
Activity: 756
Merit: 231

Dat thread wey Charley create na awereness, we go come in full force and na Brainboss go lead dat time, anywr wey theymos hide we go worry am.,dey kpor wetin go happen.
I tink sey dem oyibo lik progrex, na now de tin dey convince me say dem no lik am at all, de record shown sey atleast we need am but dem wey no dey talk maybe dem hav dia reservasion. But as de thread dey go, we just need more of our pepuls 2 join dis race 2 be given our board. Abeg som of us wey dey outside dis place shuld help tel odars about dis matta becus we need more hands and leg now.

Sickness na bad tin and God go continue saving us all, Iseh.
sr. member
Activity: 1232
Merit: 379
Abeg we 4 cari d same energy go Bitcointalk discord:( na der we fit get Cyrus attention well na him be 2nd in command anytin wey him tell thymos na sure copy..
No b lie you yarn 4 yarn, you wey your face don show for the discord group, you fit run am for us e no bad keh.

As for the local board mata, wetin we just need na to make this page enter about 1000+ pages, Lol, I no say e no go easy shah, but we go run am. Ona never notice sey we beta pass oyibo dem, for oda local board dem still dey struggle like, e.g Vietnam, becos of Brainboss arrange dis hangout, nae mak dat statistic man(no wan cal name) run go create him own 4 him kontri pipo, check am, howfar dem don reach, our papa born us wit pressure.

Dat thread wey Charley create na awereness, we go come in full force and na Brainboss go lead dat time, anywr wey theymos hide we go worry am.,dey kpor wetin go happen.
Jump to: