Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 256. (Read 1033251 times)

sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
I beg make Una no too para say I no too dey active here
I just dropped something today make Una see am I beg
Your matta sef reach to para on top jor. Na when you want us to follow you go see Ummunna na im you dey rememba us here  Grin. Afta dat one na you go lost again. Haaba.
I swear my matter really reach to vex for I no too dey come here na Charles-tim dey ginger my swagger but hopefully things go soon fall in place, I go dey very very active from now henceforth. Our people talk say "If your pikin sh1t for your hand, you no go use vex cut the hand comot. So, make Una forgive me.

That bobo, just dey blow plenty English, he for be say na spy but him no really get much thing on us.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
I beg make Una no too para say I no too dey active here
I just dropped something today make Una see am I beg
Your matta sef reach to para on top jor. Na when you want us to follow you go see Ummunna na im you dey rememba us here  Grin. Afta dat one na you go lost again. Haaba.

Snip>
Una sure sey dis one nor come infiltrate us here as im nor sabi yarn owa local flavour. May be na Bubu and Emefiele send am come as monitoring spirit.
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
i was just wondering what is happening to people who are into bitcoin trading in Nigeria!

For real, do you trully think anybody at this point in time could place a ban on bitcoin?
Bitcoin is not contol by Nigeria govt. so how could they ban the use of bitcoin in NIgeria?

They can ONLY instruct financial agency in Africa (Nigeria) to freeze any transaction(s) that is associated to bitcoin trading!

there is a way around this. There is a way to bypass or go about this.
Actually, i see things working in favor of NIGERIA who are already into btc trading but, you need to think smartly.

I repeat, for the strategy which i'm going to unfold to you to work for you, you need to think smartly!

No more time to live in fear & limitation(s) of some illitrate govt.

Pls, watch out for my thread on how to go around this bullshit


Thanks
Soldierwitlittlefaith

We dey gallantly dey wait for the ogbonge info wey you carry to give us. Really people no truly understand the power of bitcoin and crypto. I been carry my time explain the meaning of am to my people make dem know say government no too get control over the movement and safety of the asset. But na with time everybody go learn. Make the thread juicy wella so that boys go fit dey jubilate with you.
member
Activity: 239
Merit: 27
i was just wondering what is happening to people who are into bitcoin trading in Nigeria!

For real, do you trully think anybody at this point in time could place a ban on bitcoin?
Bitcoin is not contol by Nigeria govt. so how could they ban the use of bitcoin in NIgeria?

They can ONLY instruct financial agency in Africa (Nigeria) to freeze any transaction(s) that is associated to bitcoin trading!

there is a way around this. There is a way to bypass or go about this.
Actually, i see things working in favor of NIGERIA who are already into btc trading but, you need to think smartly.

I repeat, for the strategy which i'm going to unfold to you to work for you, you need to think smartly!

No more time to live in fear & limitation(s) of some illitrate govt.

Pls, watch out for my thread on how to go around this bullshit


Thanks
Soldierwitlittlefaith
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I beg make Una no too para say I no too dey active here
I just dropped something today make Una see am I beg
Truly is a nice thread that can be helpful, nice one. It will be good if you continue like this, because it will really get you far on this forum to receive merits for quality posts you are making. Nice one.

hero member
Activity: 1288
Merit: 504
For government eh, e no get as e wan be. For there mind, them don do there worst on crypto matter as them say make person no see way outside politics because, na there be the real oil money abi enterprise way dey pay for the country, there bloody nonsense. E be them like say na ritualist life and godfatherism na good life and e dey sweet people. Okay o, as them dey claim say na the scam matter be the gbege way make them dey fight the crypto, make we dey watch na, weda the ban na em go stop am! Useless idiots, them no know say if them create jobs and make the country dey fair for standard of living, people go commot eye for outside and body for crime con face how to get money in a genuine way. Nigerian government mumu o!
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
I beg make Una no too para say I no too dey active here
I just dropped something today make Una see am I beg
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
It always dey come my mind when things still cheap for past time, our fathers and monthers go dey tell us say life still better pass before the time, say things dey cheaper for past. Nigeria na just country wey no be say the leaders dey only greedy, they dey incapable also to lead, make I no just dey talk the truth further but the fact is clear with waiting the country don turn to. As you dey see me, I go school for Nigeria but no work, na to gather money start business or na gbege. Nobody dey ready to help than for CBN to ban crypto wey dey feed someone, nothing just good wan come from them.

Like this, things just dey worse every day for this country. See how prices of food stuffs and other items don go at least twice or quadruple the price them been be some years ago. The funny thing be say, once price don pass one level for any commodity, e no dey ever go back to previous price. Similar to how Naira-to-Dollar rate dey high for years. Our leaders no dey even do anything to solve the problems of growing cost 9f food items. Very stupid government. Them just dey vex say with crypto in the mix, people no dey bother to save money for banks again via fixed deposits, bonds etc. Everybody now dey out their money into crypto.

Anyhow e be, them no fit stop the evolution.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Person way carry hope put on top government of Nigeria don ready to fail, in fact, e don fail already because eh, the government no be am at all. Imagine say today, #5 no get value again, nothing you fit use am buy, for country way 20years ago been dey use kobo well. We don lose this country to our forefathers, them odn fail us finish as them pass the government to this greedy set of people way corruption full for their eyebrow so.
It always dey come my mind when things still cheap for past time, our fathers and monthers go dey tell us say life still better pass before the time, say things dey cheaper for past. Nigeria na just country wey no be say the leaders dey only greedy, they dey incapable also to lead, make I no just dey talk the truth further but the fact is clear with waiting the country don turn to. As you dey see me, I go school for Nigeria but no work, na to gather money start business or na gbege. Nobody dey ready to help than for CBN to ban crypto wey dey feed someone, nothing just good wan come from them.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
This na the reason I dey advise people, especially graduates sey make dem nor dey look up to government for job. E nor go come, except de persin get connection. Most times de connections sef nor dey fit pass security office.
Hahahahahahaha, that security office part funny me. The matter no be today o and true true, e no dey pass that kind low grade jobs via say, them no dey like make e be say, you con later get money pass them. Na them be Odogwu and no go like one young star theive their title, na so them dey see am. Nigeria no believe in anything like say make boy for better pass oga, na lie o, na for you to remain under them dem like. One thing you gat know if you dey use connection plenty be say, when wahala come, na only connection fit save you kwa so, you na man way dey hang on one thread.

Person way carry hope put on top government of Nigeria don ready to fail, in fact, e don fail already because eh, the government no be am at all. Imagine say today, #5 no get value again, nothing you fit use am buy, for country way 20years ago been dey use kobo well. We don lose this country to our forefathers, them odn fail us finish as them pass the government to this greedy set of people way corruption full for their eyebrow so.
Na to dey do our thing on a soft o, na so e just be.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
I get a brother wey talk say some people go dey think say na him/her papa or mama enemy wey course him/her or say enemy dey wey dey follow him/her Shocked. My brother, Naija situation don go pass that o, leaders mistakes pass spirituality  Roll Eyes.
This na the reason I dey advise people, especially graduates sey make dem nor dey look up to government for job. E nor go come, except de persin get connection. Most times de connections sef nor dey fit pass security office. De juicy jobs na politicians' girlfriends and family friends dem dey reserve am for. People suppose dey take online biz serious and reason am but when you talk to dem dey go tell you sey na scam. I know the many stubborn people wey I preached to as I enter this forum but dem nor wan even reason with me at al. Dem prefer to dey line up for baffroom every morning all in de name of dem dey go work. Dem nor know sey no biz sweet reach online biz 😀😀. If you think sey I lie make you ask Brainboss, Igeeh and Charles 🤔
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Brodaly as you see me so the country don tire me, people no fit speak against the government again, because the next thing government go do na to arrest them
because we no fit talk and yet, we dey act like say we dey free. Na only government and there interest the armed forces dey protect shah.
Like this no be democratic country naija be again as the government Don decide to forcefully control the citizens, we no fit impeach am because him dey like untouchable there, this APC Party I been always know say them dey up to no good, the people no care about the citizens na only their belle matter, wetin or how the citizens feel no concern them.
And of recent dem shun the part of insecurity for the country especially for North side go enter NO BLEACHING CREAM🤣. I mean which country the do this kind thing🤣. Them shun insecurity go the fight against bleaching
Abeg make we do make d country wake up Small
My sister(s) my brothers e go end soon make we jst get hope😁
Omo this naija na cruise if you take am serious u fit go die for nothing, we dey live for failed  state, the people for power no care about the citizens.
Naija don tire people, we see how cost goods dey rise, although not surprising say e dey rise, but the rate it dey rise come worse. Naija economy enter recession again last year, we no dey recession again this year though but the inflation rate dey increase while unemployment na issue.
😀Since them say na my father's land, omo I Wan kukuma sell the thing carry my money go, anybody way born for Nigeria already life Don dey win u 1-0, the cost of living own dey weak me, the worst part as things dey rise e no dey come down again, no work sef, school Don turn scam, NOTHING DEY WORK FOR THE COUNTRY.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Na waiting leaders don turn the country into be that o, I get a brother wey talk say some people go dey think say na him/her papa or mama enemy wey course him/her or say enemy dey wey dey follow him/her Shocked. My brother, Naija situation don go pass that o, leaders mistakes pass spirituality  Roll Eyes.
Na the matter be that and na big lie. Na just the hardship way dey the country dey make people think like that, like say them dey insecure and as e be like that, e them just dey open to watin anybody tell them. Even when the matter clear fro there eye cef, them no go fit see am say, na them be there own wahala because, to accept fault hard too much. If the country been dey fair with people small, at least standard of living been dey alright way be say man go dey see money take buy watin en need, no be want o but need. E for better but as e no con be like that, na why we no fit dey see progress when we rely on the country as we no go fit think.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Watin concern the government with our matter of unemployment. Government way never fit pay pensioners na em wan employ more labour. Infact cef, watin person wan work cef for the country eay cast like this. Everybody now na to fine small skill get o if not, to see food chop go be big wahala like this. Imagine country way be say, we get everything, we no for need to import anything way no be technology but then, e con be say even food to chop cef na very big challenge. That no mean say people way dey enjoy am no dey o because them plenty but the cost high.
Na waiting leaders don turn the country into be that o, I get a brother wey talk say some people go dey think say na him/her papa or mama enemy wey course him/her or say enemy dey wey dey follow him/her Shocked. My brother, Naija situation don go pass that o, leaders mistakes pass spirituality  Roll Eyes.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Watin concern the government with our matter of unemployment. Government way never fit pay pensioners na em wan employ more labour. Infact cef, watin person wan work cef for the country eay cast like this. Everybody now na to fine small skill get o if not, to see food chop go be big wahala like this. Imagine country way be say, we get everything, we no for need to import anything way no be technology but then, e con be say even food to chop cef na very big challenge. That no mean say people way dey enjoy am no dey o because them plenty but the cost high.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Brodaly as you see me so the country don tire me, people no fit speak against the government again, because the next thing government go do na to arrest them like the lekki toll gate protesters, them no care about the youth at all, jobs no dey sef youths way try dey into crypto them still Wan block the road, them way dey thief money nobody dey talk, like the snake way swallow 36mil,or the monkey way carry money run or na that one way Lai Mohammed say dragon carry money dem go borrow fly, omo we don too endure rubbish for this current government, I just wonder when e go end cause we no fit continue like this Sad.
Naija don tire people, we see how cost goods dey rise, although not surprising say e dey rise, but the rate it dey rise come worse. Naija economy enter recession again last year, we no dey recession again this year though but the inflation rate dey increase while unemployment na issue. Graduates no dey see job, na Naija I hear say going to school na for exposure say no be for job employment because where the job dey, even the president talk ham for University of Maiduguri some years back, say no job. Naija leaders like politics, they no like economy. Naija no dey produce, only depending on crude oil, na wey Naija have a long way before e go better.
member
Activity: 62
Merit: 14
Brodaly as you see me so the country don tire me, people no fit speak against the government again, because the next thing government go do na to arrest them like the lekki toll gate protesters, them no care about the youth at all, jobs no dey sef youths way try dey into crypto them still Wan block the road, them way dey thief money nobody dey talk, like the snake way swallow 36mil,or the monkey way carry money run or na that one way Lai Mohammed say dragon carry money dem go borrow fly, omo we don too endure rubbish for this current government, I just wonder when e go end cause we no fit continue like this Sad.
[/quote]

Na confusion d do our country, ruled by ppl who old pass the kind country, people wey no want better thing for the country, people wey d steal our money, people wey d try suppress us to abject poverty, people wey the try kill us in silence, people wey the take some nonsense decisions. E too much for me to talk(una knw am na).
All this lies wey Dem lie about money even the one wey dem talk say 50 goats chop 50bill naira for office. E mean say the goats share the money chop 1 goat chop 1bill🤣.
And of recent dem shun the part of insecurity for the country especially for North side go enter NO BLEACHING CREAM🤣. I mean which country the do this kind thing🤣. Them shun insecurity go the fight against bleaching
Abeg make we do make d country wake up Small
My sister(s) my brothers e go end soon make we jst get hope😁
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Brodaly as you see me so the country don tire me, people no fit speak against the government again, because the next thing government go do na to arrest them
I swear, na the truth be that o! E sound like say the level of civilization and freewill way we don attain suppose earn us some right to question unjust policies or watin we no understand but then, government don shot down anything like that. I no know watin them want make person do again if no be protest when them take all this there radical steps way dey worry person. E dey very bad o, say, the armed forces way suppose protect the citizens con be watin government carry trap us as slaves to freewill. E sound somehow shah but, e be like na so e be because, we no fit talk and yet, we dey act like say we dey free. Na only government and there interest the armed forces dey protect shah.
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Brodaly as you see me so the country don tire me, people no fit speak against the government again, because the next thing government go do na to arrest them like the lekki toll gate protesters, them no care about the youth at all, jobs no dey sef youths way try dey into crypto them still Wan block the road, them way dey thief money nobody dey talk, like the snake way swallow 36mil,or the monkey way carry money run or na that one way Lai Mohammed say dragon carry money dem go borrow fly, omo we don too endure rubbish for this current government, I just wonder when e go end cause we no fit continue like this Sad.
full member
Activity: 756
Merit: 231
Even dou de tin dey affect us nd we talk am weitin de govament fit do aside dem puting fire 4 our body. Dis govament no want us ask quesions becus dem know sey dem don spoil everytin. Naija be lik prison my broda becus dem oga talk na im be truth nd gud for citizens. God go "#safu" our naija 4 us becus notin wey we fit do as pikins dem.


Username: Nicecrypto
Gender: Male
Country and State of resident: Nigeria/Kano
Skills: Customer Service Management

Was lost now am found, Ma people I salute and ma broda I sight you.

Signed Edo's Own  Wink
Hmmmmm!, wecom brodaly, tank God sey u don com, mak u tel odas 2 com out, mak u visit https://bitcointalksearch.org/topic/request-for-nigeria-local-board-5315340 bikonu.
Jump to: