Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 253. (Read 1033065 times)

sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
Me self I never enta the market sha, I just dey observe how e go be so I pick some bag of NFT tokens soon.
Funds no too dey my hand na this paint be talking the town now.
https://www.coingecko.com/en/coins/murall
NFT tokens just dey para gan. You fit still stock am up sha. E get plenty many potentials to deliver.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Baba, you see as BTC dey fly dey go Baba dey para gan.

Wida dat manchi na, e just dey do do, btc own don too much self even me, I dey fear as if e fall now eh, all alts go bleed and me I dey trap for alts oh. Na this institutional investors oh dem dey play with the market, make una dey cautious oh, if you no get stop loss better put am because when the bloodbath go occur e go bloody die.

Within be ethereum problem self, e no dey see wetin e brother dey do. Ethereum just dey vexs me, I go soon sell dem off if e mumu for another one week. Anybody dey ride the NFT wave belike another Defi kind of madness they load for NFT.

Me self I never enta the market sha, I just dey observe how e go be so I pick some bag of NFT tokens soon.
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
Lol. Nobody fit advice this government to encourage anything that would aid the wellbeing of her citizens, just take a look at the regulation placed on crypto exchanges and banks. Omo, if person set mining equipments/firm for 9ja government go off him light I swear make we no use keyboards dey deceive ourselves. Mining no go work for 9ja.

No be lie oh, I no believe mining go fit work self, the challenges much. First you go need government approval so you fit get constant light on a low budget because if you wan run am yourself e go be for your head, dem go use bill kill you. You know say even the oyibo miners self dem no dey too profit like that immediately unless bitcoin just provoke run dey go up and e be say dem been dey hold the previous coins dem mine.

Make we just leave the mining matter as na dead end. If the OG's wey dey the game for nigeria never reason am, e must get why maybe dem don waka for am see say no way that side oh. If you noticed all of dem go trading and promotion like ambassador can of thing for projects wey relate to the industry. If you think say mining fit work for nigeria, air you own opinion, convince us wella.
I thank God say you sef dey reason the same way with me; if e truly go work, I believe many Nigerians go done dey do am. See other sectors sef wey no need power supply and much government approvals sef still dey suffer to blossom, talk more of mining wey involve plenty electricity consumptions.
Setting the firm up as a sole proprietorship go still hard you. Reasons plenty for ground, people for your backyard fit dey do amebo give government. Government too no come dey friendly with the crypto industry. The only thing wey go work properly na to find small money enter countries within Africa wey no too dey harsh to crypto with their policies and then get better electricity supply and crime rate low for there.


Person no need dey Nigeria to survive by all means, you fit dey anywhere dey make your money and our people talk say Anywhere you find peace, try make am your home
Na my own two cent be this, in case anybody dey plan set up the firm reason all these points wey just join together first.

Baba, you see as BTC dey fly dey go Baba dey para gan.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Lol. Nobody fit advice this government to encourage anything that would aid the wellbeing of her citizens, just take a look at the regulation placed on crypto exchanges and banks. Omo, if person set mining equipments/firm for 9ja government go off him light I swear make we no use keyboards dey deceive ourselves. Mining no go work for 9ja.

No be lie oh, I no believe mining go fit work self, the challenges much. First you go need government approval so you fit get constant light on a low budget because if you wan run am yourself e go be for your head, dem go use bill kill you. You know say even the oyibo miners self dem no dey too profit like that immediately unless bitcoin just provoke run dey go up and e be say dem been dey hold the previous coins dem mine.

Make we just leave the mining matter as na dead end. If the OG's wey dey the game for nigeria never reason am, e must get why maybe dem don waka for am see say no way that side oh. If you noticed all of dem go trading and promotion like ambassador can of thing for projects wey relate to the industry. If you think say mining fit work for nigeria, air you own opinion, convince us wella.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
Nigeria get the lowest electricity bill in the whole world we dey operate 0.07 per kilowatts hour for household so from de economical point of view e dey profitable to set a mining pool in this region. But De issues na be say the light is not steady, it's not reliable

Ya. The fact say na we get the lowest electricity bills no really mean much since the light sef, you go hardly see am. That's why e just be like say our bills high coz you go just dey reason say you dey pay bills for services you no receive.

Lol. Nobody fit advice this government to encourage anything that would aid the wellbeing of her citizens, just take a look at the regulation placed on crypto exchanges and banks. Omo, if person set mining equipments/firm for 9ja government go off him light I swear make we no use keyboards dey deceive ourselves. Mining no go work for 9ja.

Omo there's no need to still dey hope on this government especially since all government know na to dey concerned about anything wey go only benefit them. Mining for work for this country but government make the simple process turn into an overly complicated one. Mining fit still work but e go involve putting together many missing pieces.
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
Lol. Nobody fit advice this government to encourage anything that would aid the wellbeing of her citizens, just take a look at the regulation placed on crypto exchanges and banks. Omo, if person set mining equipments/firm for 9ja government go off him light I swear make we no use keyboards dey deceive ourselves. Mining no go work for 9ja.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
if by God grace I mistakenly get my hands on mining equipment e don be for all miners for oyibo oh. The electric something no go be problem, we go go illegal although for this side na indigene something nobody go reason you. Where problem fit dey na to learn am but we go still run am, abi no be just computer pressing something lol.
Na still this country go fight you indirectly. With the fact say, Mining require light wella and we know say, na Nepa light be the best if e for steady and the bill dey affordable o but, we naija no be like that for the light way. Na there you gat turn your own Nepa o and even as e be like that eh and with all the bitcoin catacata way dey the country, na once government go carry you do office o. Na to use you do side hustle fir government. Make you dey fund federal government wallet privately...

But then, e fir sure o, say one miner from here kwa.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Nigeria no be country for mining except the miner get another means to generate him personal electricity and security. That go even too dey expensive to maintain. Untill when government need make him improve electricity supply and availability of security personnels, a lot of things go still dey pass us by.

Any miner dey dis country self I doubt, me don reason am tayahh if by God grace I mistakenly get my hands on mining equipment e don be for all miners for oyibo oh. The electric something no go be problem, we go go illegal although for this side na indigene something nobody go reason you. Where problem fit dey na to learn am but we go still run am, abi no be just computer pressing something lol.
Nigeria get the lowest electricity bill in the whole world we dey operate 0.07 per kilowatts hour for household so from de economical point of view e dey profitable to set a mining pool in this region. But De issues na be say the light is not steady, it's not reliable
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
@Charles-Tim, Baba Which site person fit get the mining machines and how much on estimate using the current Dollar-Naira rate e fit cost person?
I have tested out some sites online to check for mining products, especially ASICs, specifically Bitmain Antminers. I found AliExpress looking more promising, the company is also owned by Alibaba Group which is based in China, I see the company to be one of the best sellers of such miners. You can check the site out, but ASIC are expensive, although the old ones like S9 are not that expensive, but consume more electricity than usual, it can be alternative forgo but I only see the new miners on the site.

You will need to check out the miners yourself on the site in which the hashrate generate are included
https://mbest.aliexpress.com/m/promote.htm

I have also heard that Antminers can be ordered directly from bitmain, but I do not see any product available on their site, you can in this case make use of their customer support for any solution.

Note: I have not ordered for any miners before, also you may like to purchase Graphic cards for altcoins, but for Bitcoin ASIC are better, try out AliExpress.
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
Any miner dey dis country self I doubt, me don reason am tayahh if by God grace I mistakenly get my hands on mining equipment e don be for all miners for oyibo oh. The electric something no go be problem, we go go illegal although for this side na indigene something nobody go reason you. Where problem fit dey na to learn am but we go still run am, abi no be just computer pressing something lol.

Wetin be bitcoin problem self, e no wan fall small make we use our useless naira wey dey bank buy, e dey pain me ehh. Now e dey $50k plus. E no dey even carry e brothers along well, e just dey show dem small small love no major rubbers.

Assuming the love been much Ethereum for don blow go far na, anyways other get any coins una eye set for make person do small waka for the coin head see if I fit buy small.

Plenty issues dey but this one be one of the major ones wey dey drag us down currently. Bitcoin no wan dey put body with all these amateur coins dem wey person for fit smile small.
See;
i. Bake
ii. TWT
iii. SFP
All these things suppose put person for track if bitisi allow BNB to follow body, but Baba say No. Tor, we no get options na we just dey buy mumu ones provide liquidity for 1inch aggregator as dem wan do airdrop but the allocation too small  sha.

@Charles-Tim, Baba Which site person fit get the mining machines and how much on estimate using the current Dollar-Naira rate e fit cost person?
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Nigeria no be country for mining except the miner get another means to generate him personal electricity and security. That go even too dey expensive to maintain. Untill when government need make him improve electricity supply and availability of security personnels, a lot of things go still dey pass us by.
Nigeria has issue of power generation and transmission, check these statistics


https://www.bbc.com/news/amp/technology-56012952

Nigeria is not even among the first 30 countries that generate most electricity in the world while South Africa and Egypt are still among.

Population estimate as of 2019 amount the three Africa countries

Country                 Population Estimate         Power generaion
Nigeria                         200,963,599                     11,165 MW
South Africa                58,558,270                       58,095 MW
Egypt                            100,388,073                     24,700 MW

I do not know how recent this is:
Any miner dey dis country self I doubt, me don reason am tayahh if by God grace I mistakenly get my hands on mining equipment e don be for all miners for oyibo oh. The electric something no go be problem, we go go illegal although for this side na indigene something nobody go reason you. Where problem fit dey na to learn am but we go still run am, abi no be just computer pressing something lol.
I think learning it is not that hard, but I think the problem na because Naija no know much about the mining aspect, and because no miners manufacturing in Nigeria that can bring exposure and easily making people go into thinking about mining. If having good electricity, I too go with your idea.

Wetin be bitcoin problem self, e no wan fall small make we use our useless naira wey dey bank buy, e dey pain me ehh. Now e dey $50k plus. E no dey even carry e brothers along well, e just dey show dem small small love no major rubbers.
E go dey hard for bitcoin to decrease. Recently (like almost two weeks or a week ago now) was a report about exchanges bitcoin volume decreasing and whales moving bitcoin to wallet, recently was a report the volume of exchanges decreased by 20% in 12 months
https://cointelegraph.com/news/the-number-of-btc-held-on-exchanges-crashed-20-in-12-months/amp

One of the biggest trends in recent months has seen Bitcoin flow out of exchanges into wallets. Generally, this is interpreted as a bullish sign — indicating that investors are optimistic about further growth in cryptocurrency prices.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Nigeria no be country for mining except the miner get another means to generate him personal electricity and security. That go even too dey expensive to maintain. Untill when government need make him improve electricity supply and availability of security personnels, a lot of things go still dey pass us by.

Any miner dey dis country self I doubt, me don reason am tayahh if by God grace I mistakenly get my hands on mining equipment e don be for all miners for oyibo oh. The electric something no go be problem, we go go illegal although for this side na indigene something nobody go reason you. Where problem fit dey na to learn am but we go still run am, abi no be just computer pressing something lol.

Wetin be bitcoin problem self, e no wan fall small make we use our useless naira wey dey bank buy, e dey pain me ehh. Now e dey $50k plus. E no dey even carry e brothers along well, e just dey show dem small small love no major rubbers.

Assuming the love been much Ethereum for don blow go far na, anyways other get any coins una eye set for make person do small waka for the coin head see if I fit buy small.
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
<...>
About the issue of electricity which is very important for miners to have access to cheap and constant electricity. In Nigeria, most regions do not have access to constant electricity, but there are some areas with constant electricity. I remembered the time I spent in Katsina, although not all areas have electricity, but there was a local government called Batagarawa where almost all tertiary institutions are located, they gave access to 23 hours electricity in a day or more. Also the Katsina town itself have constant electricity, in the GRA, if electricity is poor, there will still be 12 hours electricity in a day, but oftenly having access to more than 23 hours electricity. I chatted with our of our Nigerians that told me of 23 hours electricity in his area too. Although, in my area, electricity is very poor.

What comes to my mind is that, there are places there are constant electricity in Nigeria but few. But, the issue is to know if the electricity is cheap or not. But, there are two types of payment in Nigeria, the prepaid and the post paid. Using post paid, Electricity company in my state do not check Metre at all, thy calculate it based on how big companies and houses are, people can take advantage of this to mine Bitcoin or other crypto assets in Nigeria.

I am not sure about postpaid, it might not be cheap, but users have to calculate this on their own because the bills differ from state to state. I noticed we in my town paid less in electricity than people is another town. Because of this, it will be good for the person that want to mine bitcoin or any other crypto asset in Nigeria to calculate this on his own.

First by checking the watt the miners will consume
Also the watt others like cooling machines will consume during hot weather
Checking also the bitcoin paid by mining pool for the hashes generated for the miners he want to buy.

All thes will be used to calculate if mining is profitable in his area of location in Nigeria. Mining profitability will really differ from area to area.

About the issue if miners, I do not also think ordering from countries like China should be a barrier, but having retailers selling miners here in the Country will make them cheaper, getting it from abroad is not bad after the profitability calculation is made and positive.
The issues about poor electricity no be lie, some things dey very stable and commendable when you're using some parts of North as  case studies in Nigeria. Spent few days in a town in North not long a go. To tell you the truth of mining or any thing of such to happen in Nigeria, the person go actually prefer North to any other part of the country but there is something wey no dey well for North like insecurities and banditry and you know say na people wey dey do all these kind work wey get better thing na him dem dey target.

Nigeria no be country for mining except the miner get another means to generate him personal electricity and security. That go even too dey expensive to maintain. Untill when government need make him improve electricity supply and availability of security personnels, a lot of things go still dey pass us by.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
<>
Las-las eh, no where way there regulation reach. Highest na to place order on banks with threat and fee sanctions if not, nothing them fit do. The worst thing them for do na to make p2p transactions dey impossible and as them no fit do am, nothing them wan do or talk way go really make significant impact on this our joli joli currency.
Chaiii, if i no been dey into bitcoin or make i say crypto, e for really pain me! Crypto sweet, na the only thing way fit Nigerian government be this, something way there small muscle no fit carry. Abeg make them go gem. Them no go enter class learn book, na to dey control people way learn them sabi.
 
All the greedy men and women just join body decide say na politic them wan join because, them don hear and know say, na play them they play for there. The one them play when them small no do them, na advance and wicked play them don grow reach now. It's well, we go survive them finish.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Charles, I don't know about you or the opinion of others about the issue of regulating cryptocurrencies in Nigeria. I no just badu the idea. Wetin I dey try talk be say, we all got into crypto because of the the financial freedom along with privacy that was promised. Accepting to be regulated will make it look much more like traditional financial service providers like banks. Coz CBN go define limits, rules and even punish defaulters wey go against their regulations. Na why I just dey talk say e no too fresh. Well anyhow e be, we go still survive.
There is no better option than to regulate cryptocurrencies in Nigeria, else if not regulated, it will remain banned. Rugulating it does not mean we will not have the freedom you are implying, we can still make use of our wallet for such for privacy, also p2p can not be stopped because it is beyond the reach of any government to stop the use of p2p. All needed is to have the full ways to have the privacy we want, irrespective of the country we are, we can still privately make use of cryptocurrencies.

Like now, we using cryptocurrencies not need help to buy or sell irrespective of ban or no ban as p2p is difficult to deal with by governments, but we just need cryptocurrencies to be accepted in Nigeria for other reasons, like the boom in crypto ATM companies in Nigeria, while we will still find many ways around to have the privacy we want.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
So the TLDR be say, we fit no get crypto ATMs if CBN ban still dey active?
~~
I noticed only two Nigerians commented under the thread to Vice president speech about crypto assets, but it will be good to take a look at it as it encourages Nigeria to remain positive for bitcoin and other crypto assets to be legalized by CBN.
~Snipped

Charles, I don't know about you or the opinion of others about the issue of regulating cryptocurrencies in Nigeria. I no just badu the idea. Wetin I dey try talk be say, we all got into crypto because of the the financial freedom along with privacy that was promised. Accepting to be regulated will make it look much more like traditional financial service providers like banks. Coz CBN go define limits, rules and even punish defaulters wey go against their regulations. Na why I just dey talk say e no too fresh. Well anyhow e be, we go still survive.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
The truth be say, 'suffer don dey engraved on the name Nigeria and Nigerians'. Our government don put am to all there agencies and companies say, them gat stretch the life line finish for our body at every given chance. E con be like say, e get some kind advantage way them dey derive from stressing citizens. Who knows, maybe na to reduce our lifespan cef! Lol...

I bin dey talk with one of my soldier friend some days ago way just come in form the northern part of the country, the guy dey complain on how eh, to enjoy life just dey strange to ram. E say to suffer looked normal more than when you dey faji. Say if e faji small cef, na that time e dey feel like say, e dey suffer because, e don too dey used to suffering.
Suffer na the future way our government don plan for us, na just for us to use our own hand dey change am by doing things way no dey bonded by boundaries. Na why i just get joy for crypto and forum.
member
Activity: 239
Merit: 27
***Right now, i think the major concern/help to NIgerian in these forum should be  focus of foriegn conuntries towards installations of more ATM & issueing of prepaid card which can work effectively independent of the infeference of these financial agencies in in NIgeria!*****

We no reason am brotherly, no mata how u when write, whether na for oyibo man language or our own, you no get shaking and we gat ur back. I think you don talk better something here. Make I tell una something, so I go filling station go buy fuel play play my ATM card loss.

This one come make me go back, I spend nothing less then 4hours just to get card wey be say if this crypto firms get sense dey for done bring am come nigerian and na just order something we don recieve instead to go waste all our day for bank wey we no dey even reason except when the coins dem wey go Naira.

No be play oh, we need this ATM asap, assuming we get just one self for my ares I no for even dey near my bank again.



"....This one come make me go back, I spend nothing less then 4hours just to get card wey be say if this crypto firms get sense dey for done bring am come nigerian and na just order something we don recieve instead to go waste all our day for bank wey we no dey even reason except when the coins....."


@CryptopreneurBrainboss, hello #CryptopreneurBrainboss, i'm happy that you've finally contributed to this aspect of the discussion.

well, in the past years there have been several attempt by some foreign countries to provide Bct prepaid card specifically to most countries in Africa (nigeria,ghana...) to be precise but, this has not yield any positive result due to one or more challenges.

Now such project will be top priority of most prepaid card provider's in europe. before that, i think, there are some shortcut to bypass the current restrictions. Keep you posted!

Thanks
Soldierwitlittlefaith
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
So the TLDR be say, we fit no get crypto ATMs if CBN ban still dey active?
Yes exactly what I am talking about. The one we even have now will not be functional as it ought to be. But with the look of what is going on in the country, Nigerian SEC are in support but trying to convince CBN, also are learned people like the vice president in support of crypto assets in Nigeria, so let us expect the ban to be lifted.

I noticed only two Nigerians commented under the thread to Vice president speech about crypto assets, but it will be good to take a look at it as it encourages Nigeria to remain positive for bitcoin and other crypto assets to be legalized by CBN.

Nigeria’s vice president, Yemi Osinbajo speech at economic summit on Friday
https://bitcointalksearch.org/topic/m.56452813
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
~Snipped
NOTE : pls, i'm sorry for my other brother who had earlier contributed to this thread in pidgin english. i can read the pidgin english unfortunately, i'm unable to write in response to some of these comment(s) in a pidgin english.

Thanks

Haha. No reason am bro. The two accepted forms of community here na either pidgin or oyibo language. Coz no be everybody dey used to typing in pidgin so we allow for more community coverage and carry everybody along. Your case even better because you even dey understand typed pidgin so na big plus be that.  Communication is key in any community. So whether na pidgin or English, we dey with you.

~~
This leaves me not positive about this at all than to first expect CBN to legalize back financial institutions to be able to transact through Nigerian banks. Meself go wish if Naija get plenty ATMs.

So the TLDR be say, we fit no get crypto ATMs if CBN ban still dey active?
Jump to: