Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 255. (Read 1033251 times)

legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
This list them cef dey fear me o, we way never get better stand for the forum or chop money for the forum, this guy don dey make the place look too challenging. Make e no motivate person to over do then them go ban the person o. I no want wahala. Me way still dey suffer to build my account.
Nor just let the thing para you. Do eye like sey you nor even dey see the guy or any oda ones wey dey do anyhow and form galadima. Avoid dem like where lion see grass. Just make sure you dey code yasef wella. Avoid them if your mouth neva dey strong for any mata wey dem dey yarn. Na d simple mericine be dat. And nothing go do you. Kontinue dey read and improve wetin dey inside you.
member
Activity: 70
Merit: 19
This list them cef dey fear me o, we way never get better stand for the forum or chop money for the forum, this guy don dey make the place look too challenging. Make e no motivate person to over do then them go ban the person o. I no want wahala. Me way still dey suffer to build my account.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
That guy na wahala i no go lie you. Na why the other one be en better halve. The guy policy be as e get. E no dey make brain at all but, anyhow e be, so long as e go pay, we gat do well with am too though, me no fit chop that kind grass en dey offer person. Na man i be no be cow. Na when i never open eye for fit dey apply for that kind thing. Na to degrade my account be that na, e con dey like say we dey beg. I kukuma no apply, make people way never taste fries for the forum know how e dey be. Very dirty somethin g na em en do so, e be like e no dey use en head.

Steady on code o, make e no be wahala for anybody, na still senior man e be for the forum so, wida your eyes!
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Dis life na God dey give persin chance dat guy for 2017/2018 season na him rein pass for that service section
Bros, ya head dey dia! Kai! Nothing wey persin nor see for im hand oh but unto sey we dey find wetin we dey chop we just coolele dat time. As you yarn dis thing na im I rush enta your profile make I check because anybodi wey throw dis kain comment sabi wetin im dey talk unto don dey here tey. Na so I com see sey na d same month dem even born me & you for here sef. Una see as life dey be onto dat guy mata? Dem sey life bi like barber chair, na so e dey turn turn. I tuale for my current manager. D guy sabi talk to people wen you get gbenge. But d other guy nor be am at all. E sabi carry shoulder up like mosquito wey jus do abortion.


Lol baba leave dat guy mata de kind pride wey him get nobe here ooo and naso him dey pay peanut nain make anytime anoda campaign showcash nigass dey tuama shapaly comot for him campaign and edey pain am well well..
So, ya eyes too sabi see wella. Na im even start dis 5 coolele water thing to take enta campaigns. And dem take am gbab many guys dat year wey rush sama demselves with coolele something to take enta. Nor be small thing oh. But see where d guy dey na. Life na cruise jor.
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
Most of these managers no just get joy most shit posters for the forum no make the unhelpful list, lol. No be by who Sabi post pass I done see legit posters wey make the list. But as the day passes make we try improve on our daily activities and post level here. As per na one of the only work wey dey put food for table currently be this. Offline jobs too difficult with rigorous schedule and intolerant bosses.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Never mind to bring this up here, but I think it is very important as some Nigerians are concerned, make we please double our hustle. I do not know how true this is, but we need to increase the quality of the way we post.

https://bitcointalksearch.org/topic/m.56447596
Lol baba leave dat guy mata de kind pride wey him get nobe here ooo and naso him dey pay peanut nain make anytime anoda campaign showcash nigass dey tuama shapaly comot for him campaign and edey pain am well well..u no see him new campaign wey him dey pay Sr.Member $21? Na him papa buy me phone ni, a bi na from $21 I go take give ashawo urgent 2k ni.... His dad.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Make una no reason watin Charli bring. Na say make we improve on ourside e mean via that manager view, i no wan mention en name but na the matter be that. No be say we no dey post well o abi we no dey try o but then e no go, go well say them misrepresent you for anywhere for the forum. That na wahala because, people way go believe in the thing go dey watch from one side and na fk be that. So, we gat wise up and do our best to avoid in fact both list cef. If you no make the good one, at least make you no make the bad one kwa. Real matter o.
sr. member
Activity: 2590
Merit: 322
SOL.BIOKRIPT.COM
Never mind to bring this up here, but I think it is very important as some Nigerians are concerned, make we please double our hustle. I do not know how true this is, but we need to increase the quality of the way we post.

https://bitcointalksearch.org/topic/m.56447596

Lol my guy dey tak chill pil somtims oo. Nothing concern wetin u bring com with post. D guy dey para as men waka comot. I sabi say bible say e beta make we dey show 4 where dem dey bury persin pass where bash dey but no be so dis place be. If u check am well , u go see him real vex , men waka plenty.

Mak we try 2 dey code d tin wey we dey print here abeg. Ur own na pure Elizabeth way. If u no u no.
Dis life na God dey give persin chance dat guy for 2017/2018 season na him rein pass for that service section but see dey persin wey rein now, this guy dey dominate that forum now both bounty and signature campaigns everi bodi just day take off from the other guy side dis life no be one way traffic if it swerve go one persin side e go swerve to another persin.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Never mind to bring this up here, but I think it is very important as some Nigerians are concerned, make we please double our hustle. I do not know how true this is, but we need to increase the quality of the way we post.

https://bitcointalksearch.org/topic/m.56447596

Lol my guy dey tak chill pil somtims oo. Nothing concern wetin u bring com with post. D guy dey para as men waka comot. I sabi say bible say e beta make we dey show 4 where dem dey bury persin pass where bash dey but no be so dis place be. If u check am well , u go see him real vex , men waka plenty.

Mak we try 2 dey code d tin wey we dey print here abeg. Ur own na pure Elizabeth way. If u no u no.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Never mind to bring this up here, but I think it is very important as some Nigerians are concerned, make we please double our hustle. I do not know how true this is, but we need to increase the quality of the way we post.

https://bitcointalksearch.org/topic/m.56447596
My guy, relax. I see dat thread too yesterday na so I scatter laugh on top the matta. So, you think sey na bc of quality dey make people get merits abi? Abegi, make we nor deceive owaselves on top that matta jor. And about d thread topic wey you post here, nor be cause of quality make that dude (I nor want mention im name) blacklist those people. Na pepper body dey do that guy as people dey take leave im campaign once other campaigns catwalk enter arena. People want campaigns wey stand wey unto to put food for table na. How you go enter campaign and to pay for data na wahala bc keshi dey small. Ok, if you carry am go quality side. You nor see Lordhermes and Gozie names there? Those guys even get better merit pass me within 120days. So?
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Never mind to bring this up here, but I think it is very important as some Nigerians are concerned, make we please double our hustle. I do not know how true this is, but we need to increase the quality of the way we post.

https://bitcointalksearch.org/topic/m.56447596

Abegi no mind anyone categorizing nigerian as spammers, brother na lie abeg no be the nigerian wey I know for the forum eh. We dey try abeg infact we better pass most local board. See eh I dey manage Campaign (if not the highest number self) if you see as my eye they pain my every week eh from reading all other guys (no wan call local board name) but their english no be here talk more of their quality.

For nigerian na only bounty hunters they spoil our name if not we dey show working abeg. Make una just keep am up, improve more for the quality wey we dey deliver and in the right time we go all rank up. That e new blacklist fit be as a result of say e see my talk wey make me add someone new to my black maybe d tin just refresh e memories and e decide to update e own blacklist.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1167
Gamble responsibly
Never mind to bring this up here, but I think it is very important as some Nigerians are concerned, make we please double our hustle. I do not know how true this is, but we need to increase the quality of the way we post.

https://bitcointalksearch.org/topic/m.56447596
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I no really take that Osinbajo video too seriously sha. My own be say, at least we get person in higher places for government wey don try come talk something wey make sense on top the matter coz I no see why cbn go get mind ban crypto for the country. I no know whether na by force to invest for those nonsense bank investment markets like fixed deposits etc. I dey expect them to resolve am soon because them go only cause more and more problems for themselves.
CBN no fit do pass him capability, CBN fit make the bank not provide services for crypto businesses but crypto can be p2p, na why we still dey enjoy the benefit of bitcoin and other crypto. E funny me when senate talk say they wan invite CBN governor wey no know anything about crypto but carrying false information around. Waiting senators know about crypto? Nothing. Na false information CBN go pour down wey senate go gree. I no even do much follow up again about leaders wey no know anything about crypto. Waiting Osinbajo talk is true and realistic, na regulation we need.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
Sure say that talk, no be en mouth them just talk put because, all this men them, na so so written speech them dey read for us o. Watin them dey sabi na to fine favor with the public wen them get interior motives. Anyway, e just good say we get person on our side based on the crypto ban matter and tre-true, people way getb power for Nigeria no dey take time evaluate something before them take any decision. E just dey too simple to them, them forget say, the decisions them dey take, say e dey affect common man wella and not just the targeted few. Since i hear this there ban matter come up, i never hear say e end or reduce the scam. Niggas way dey run am still dey faji so, make them calm down, accept fault and revert that thing.

I no really take that Osinbajo video too seriously sha. My own be say, at least we get person in higher places for government wey don try come talk something wey make sense on top the matter coz I no see why cbn go get mind ban crypto for the country. I no know whether na by force to invest for those nonsense bank investment markets like fixed deposits etc. I dey expect them to resolve am soon because them go only cause more and more problems for themselves.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Sure say that talk, no be en mouth them just talk put because, all this men them, na so so written speech them dey read for us o. Watin them dey sabi na to fine favor with the public wen them get interior motives. Anyway, e just good say we get person on our side based on the crypto ban matter and tre-true, people way getb power for Nigeria no dey take time evaluate something before them take any decision. E just dey too simple to them, them forget say, the decisions them dey take, say e dey affect common man wella and not just the targeted few. Since i hear this there ban matter come up, i never hear say e end or reduce the scam. Niggas way dey run am still dey faji so, make them calm down, accept fault and revert that thing.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
I no know if any of una been see this news but I just say make I drop update for una. Osinbajo been post one video like that this afternoon. For the video him dey talk say cryptocurrency and blockchain na new evolution wey fit replace traditional financial systems and instead of acting on them with fear (like wetin cbn do to ban crypto for we country) say na to embrace am just like the rest of the world don do so we no go lack behind.



Since CBN ban crypto more and more news don come out wey suggests say them no take careful consideration and get opinions of other knowledgeable men in government before them make that decision wey dey affect crypto traders in Nigeria today. I believe say them go revert that rule soonest.

https://twitter.com/ProfOsinbajo/status/1365300799535009793
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Watin concern the government with our matter of unemployment. Government way never fit pay pensioners na em wan employ more labour. Infact cef, watin person wan work cef for the country eay cast like this. Everybody now na to fine small skill get o if not, to see food chop go be big wahala like this. Imagine country way be say, we get everything, we no for need to import anything way no be technology but then, e con be say even food to chop cef na very big challenge. That no mean say people way dey enjoy am no dey o because them plenty but the cost high.
Day by day instead of us to dey see positive things na only negative things, the government dey owe so many people no be small wahala, every government with their own agenda na dey cuz dis tins, A go start to build bridge if him comot for sit when B enter, B no go even care to complete am him go start him own, the cost of living don increase even minimum wage no reach person to use for better 2 weeks, omo na to find small skill learn oh, since the schooling system for Nigeria don fail,na to learn good skill make your money, no time to wait for government oh, even to block sim way no do NIN dem fail us Cheesy.
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
Smart Virus, Baba you too get talk for mouth. You done Yan plenty full ground. We go try dey amend our ways nobody truly Sabi finish na why we gather dey be this. We go try dey here, aside the forum paroles some other work still dey wey dey keep man pikin busy offline and other platforms. Mostly na to come fill the min required posts per week dey dey person mind. As we dey agitate for this creat course, we go try by all means to dey very active. Sometimes dey way the merits sef hard to collect the discourage person but we go try strive more and keep here busy.

Baba, harmattan no really dey our area sha. Na only money no just dey.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Still on the matter, all of us way dey here know say, here pass reach out, na where we go carry get one on one talk, make we fit know ourselves wella then push people for yash make we kwa get mouth for the forum too, na why e be say, we dey fight for this local board matter. Charles bin don create thread https://bitcointalksearch.org/topic/request-for-nigeria-local-board-5315340 for meta via say make them for give us watin we dey fine but then, if we no active here, na when them give us local board we go dey active? That na lie o. We gat show working for here first, at least, we dey try but, the matter still be say, some persons no dey talk. Na only when e get something of interest inside. Even say cef, you fit carry here complete post, e be like the English too sweet we. Na fk be that. If you no fit dey wityh your country men then get comfort, na Oyibo man wan give you joy before, people way go see you con dey see beast to use work...

Abeg, make we no dull this our movement. If you no dey dey active for here, e go help us say, you dey come once-once to shuck mouth for matter way concern us. And the thread way Charles create for meta, i know say meta dey fear some of us to talk but, na small-small pussy cat use build courage to fight dog o. So any how e be, na just to talk as e pain you reach or affect you reach or how e for help our people and the forum. Nothing much there, you no go research am. The idea na say, amke the thread no commot for first page, anytime way e be like say the matter don dey die, make person talk something so that e go come up. Make them dey see am till e go wayh them then, maybe them fit give us watin we dey fine.

How e dey be una for your side of the naija na,,, e be like say na now for be december o. The amatan just too much this time, everywhere hot.
The climate change this time no be illegal bonkery and crude oil cause am. Na Egbo and AZ. The company don get too much customers. Hahahahahahaha

Make una faji, live government to dey mumu dey go.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Na true talk o, say here no be only when you want something, because you sabi say your people dey here and we fit carry soft mind for each other, we go just pull in then, commot again. Na f**k up and e no go well at all. Na why e be say we low on that stats way Charli bin paste here sometime ago. Because, if we make here busy for ourselves, no how way be say, we no go notice ourselves wella even without dm or invite via one or two forum matter way we nid person hand to push up. So, we just gat try to dey make here sup wella. We dey do am for Whatsapp group chart, make we do am here too. Na just talk i talk, nothing too much for there.
Jump to: