Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 26. (Read 744351 times)

hero member
Activity: 1036
Merit: 860
Livecasino.io
~snip~
The two things wey I go like talk for this matter be say

1) There is no harm in trying. If we try am and e nor work, we change am, try another thing. We still dey learn all the things wey go make is achieve our goals.

2) If the ratio of  politics discussion to Bitcoin talk plenty, small wahala dey. So I support if Igehhh fit do am make him sieve the conversation.

I believe say very soon we go get our board and we fit create sub boards to yarn other matters but for now, I support anything wey go carry the ministry to the permanent site.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
We never even get our local board we don already dey discriminate some posts as low quality. We fit no understand wetin wan happen, but I don see am say e no go help us at all. E no compulsory say na bitcoin we go dey talk here.

If you check well Theymos himself no dey add anything wey go limit anybody. And I suggest say make we no suffocate here with rules.

Theymos self na politics and society him dey based, I understand everything wey you talk and e good as arguments like dis dey come out. Unfortunately one or two person no fit decide for all and majority go carry the vote although after we implement any rule wey we vote in and we see say e no work like e dey to decrease the activity for here, is obviously we go dissolve the rule. The idea here be say we dey get many spam of unwanted discussion wey no dey add anything positive to the thread and for now we need quality first for theymos to reason our matta.

When we get our local board, we go get sub boards wey go fit every discussions we want. Me personally self I for like dey discuss music (afrobeat) as na were I get more interest then even the politics but again to avoid low quality discussion I no dey bring am out. When it comes to the filtering out the political posts to determine the winners, I just dey wonder how Igehh go do am. Sha make we dey watch, na trying phase we dey like dis, no worries we go surely get am right one day
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
Now wey e b say government wan to adopt bitcoin and other cryptocurrency for we naija how far the mata be. i wan to ask question, how about the people  wey dem don already block their account, how about the others wey don don seize their money nko. How about the companies wey them don shot down as a result of cryptocurrency transaction. You see ehn this government just dey confused. The government no balance at all. Election don  wan reach na wey dem feel say dem go do things quick so that dem go gain the support of the masses. e no go work this time around come to talk of it, the youths don wise now be say dem no fit use them again. E good sha as federal government don see am verry   well
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Life's but a walking shadow!
New CNB 20k daily withdrawal limit
Well what i think most businesses are going to do as a result of this devopment is to ensure they have their own PoS machines so customers can pay directly to them with their ATM cards, i know every large scale business definitely has that already, but now even small scale businesses would have to get theirs, because you can no longer expect customers to have sufficient cash to cover what they want to buy.

Only denominations of 200 naira note and below will be loaded in ATM machines once this development takes effect oh (una see that one?), so even if you decide to go withdraw the stipulated 20,000 daily, na for 200 naira denomination or below you go hold am oh. Grin I feel this policy would greatly affect people who run PoS services as they would lack the funds to satisfy their customers, if they decide to use the ATM, they are limited to only 100,000 per week, and if they choose over the counter, they are limited to 100,000 and 500,000 with a fee to process such transactions amounting to 5% and 10% respectively, that is absolutely crazy; i can see quite a lot of people who are into PoS services shutting down from january 9, 2023, and we have many of them in our country, it means many people are soon to be jobless.

Having said that, i do not know what exactly the economic benefit of making cash scarce is, if you ask me that isn't our problem at all, me i believe say our main problem be say we no they produce anything locally, plus this men them wey they thief our oil, if we fit handle production in our country, fix refineries, come they export locally produced goods, plus enjoying the full benefit of the oil wey God bless us with, then i believe say our economy go wake up from sleep. Making cash scarce looks like compounding our problems, especially by making people jobless like i said in the second paragraph of my post.
hero member
Activity: 1036
Merit: 860
Livecasino.io
New CNB 20k daily withdrawal limit
~snip~
I read cbn letter 2 two financial institutions and all I can say is wow. I went on the internet to read the opinions of Nigerians and it's been mixed opinions. While some Nigerians have expressed support for this move others have also registered their displeasure. Have weighed both sides of the coin while some say that 20000 naira limit per day it's not good some others of the opinion that this would discourage corruption for example politicians would not be able to give out so much money as they used to do. All I can say for now is as long as it helps the economy as long as it helps the naira as long as it is going to reduce corruption I support this move. In the end we'll all be fine and would adapt so this new reality.
sr. member
Activity: 784
Merit: 366
Underestimate- nothing
Government wan begin dey tax crypto transactions

My people I listen to channels TV and them report say the government dey look into taxing crypto transactions and digital assets. Madam Zainab wey be finance minister say the go go through FEC before the president go forward am go Green and Red Chamber for approval. The way things they go recently he be like we government Don dey fall in love with crypto oo abi dem just dey feel say no matter watin dem do people no go leave the crypto so themselves they follow trend.

Abi them wan use this one take consol Nigerians base on election wey dey come? Since plenty youths dey into this stuff.

My people I wan here una view how una see this move?


Moreso he be like dem NITD Don shortlist people wey dem carry for this blockchain tutorial dem. If you apply just check your mail to see
Looking at waiting they happen currently for the world, seen countries like el Salvador and brazil wey don adopt bitcoin na good thing so I feel Nigeria government is already having a kind of interest or I don't even know, but if our government give it a try no be bad thing and deep down them ma know say them no fit stop boys from trading that one they sure , since the citizens done see am as a way of empowering their self, like the popular saying if you cant fight them you join them.
hero member
Activity: 728
Merit: 897

You see this our present government, no belief anything wey d sae until the implement am immediately. Shey you been see how the take ban trading crypto that year with banks. You also see how the take announce am that day for news, the next day d implement asap. Why don't they do the same with this one now? They wan try to follow the duo process to implement am. Wetin d showcase with this dia move, make em be sae dem no d against crypto.

It's remaining 2months to the end of their tenure, they wan to the try form good make people clap for them. Abegy make them shift one side, make we see wetin our next President go be gets in stock for Nigerians.

Me wey share the information about NITD I no get any email sha  Angry anyway congrats to people wey receive the email from them. I wish una luck for the training

Bros I see say u dey vex about this government but make that no make no reason things well. Banning of something no need that long approval. But this taxation matter no be something on crypto only but other digital assets. Moreover the stuff dey inside Finance bill so he must pass through FEC before president go relate am to House. So make we calm down, even if them Don do bad if them wan put new initiatives now wey go favour we no go mind at least the next president go know where to begin
hero member
Activity: 966
Merit: 609
BTC, a coin of today and tomorrow.

Top 30 active users in NOV 2022 extended.

1. Agbe [29] 5 Merits awarded
2. CryptopreneurBrainboss [24] 0 Merits awarded
3. Marykeller [24] 3 Merits awarded.
4. Maestro75 [22] 2 Merits awarded.

Congratulations to Agbe, CryptopreneurBrainboss and Marykeller. I also congratulate every person wey their name enter for the list. E good as here dey grow day by day and the whole community dey acknowledge say we dey try.

onward only 7 political posts will be counted per user for the Merit award

I just see poll wey dey ontop this our thread. I no just like that poll at all. This one or two rules we wan introduce no go help the growth of this our local board at all. Now wey the spirit don high, na em we wan come dull the spirit? Our page for this thread never even reach common 300pages, our activity still dey low and we wan introduce rule wey go discourage people to post.

We never even get our local board we don already dey discriminate some posts as low quality. We fit no understand wetin wan happen, but I don see am say e no go help us at all. E no compulsory say na bitcoin we go dey talk here.

INFACT, MAKE I CLEAR US, no bitcoin we go talk here wey go make sense pass wetin dey go on for bitcoin board. People wey dey take bitcoin serious for their local board na people wey no dey understand English.  We here dey understand English pass pidgin sef.

If you check well Theymos himself no dey add anything wey go limit anybody. And I suggest say make we no suffocate here with rules.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
New CNB 20k daily withdrawal limit

The central bank of Nigeria today announced a new monetary policy ahead of the general adoption of the new naira notes and fading off of the old naira notes, the limit of 20,000 nairas daily was placed on individual bank accounts and 100,000 nairas on cooperate bank accounts. This is inline with the central bank's intent to go digital and cashless, this move will help curb insecurity like kidnapping and terrorism financing as all transactions can be traced through the banks. I say make I bring the matter here make we put mouth check amm how e go be, and how e take affect us as the cryptocurrency community. To me we the cryptocurrency community in 9ja we are already used to digital life and at that, this cashless policies go help improve our privacy by making us to carry less cash even limiting the chances of point of sale private operators (POS). Because pos is also used by scammers to move limitless money around, if all this thing were CBN dey do work well, I think 9ja go make sense for everybody and I hope to see you guys contributions, observations, and criticism on this topic.
full member
Activity: 1190
Merit: 126
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Quote from: Majestic-milf
Congratulations to those wey receive the merits. This one go help encourage peeps for here to dey consistent and I believe say the more we dey grow this our small corner, we no go deviate from wetin cari us come here; which is to discuss mainly, matas wey consan d Bitcoin community and also tins wey dey affect we contri.

Dis a sign that we have a genuine leaders in dis community who can do things right to appreciate the most active in dis forum.  Those people that won d award really deserved it and it will encourage many to show themselves to be proud that they are members of dis community. And it will also make people to be more active in dis community to bring in more detail about Bitcoin and cryptocurrency news
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Life's but a walking shadow!
Abi them wan use this one take consol Nigerians base on election wey dey come? Since plenty youths dey into this stuff.
Many people are divided on the issue of tax generally, especially on how the money generated is put to use, i don't have any problem with paying taxes, as long as the government uses the money correctly. Crypto taxes cannot be a way to console Nigerians, nobody likes some part of their money taken away from them, even when it is necessary. Crypto is taxed in the U.S. and in some other countries too, i guess Nigeria is next to impose tax on crypto, we'd see how it pans out.
Nothing wey Nigerian government go do wey go surprise me again, e fit be say, dem see say people no wan live d cryptocurrency na why dem wan legalise am make dey get small money 4 people wey de involved in Bitcoin and cryptocurrency transactions
They are not legalising anything, crypto itself isn't illegal in Nigeria, only be say government don ban banks from running package with crypto exchanges. The Nigerian government do not even have to legalize crypto to impose taxes on it, it is within their jurisdiction to do so without legalising Bitcoin if that be the case.
Username: Sokani
Gender: Male
Welcome brother.
hero member
Activity: 700
Merit: 523
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Government wan begin dey tax crypto transactions

My people I listen to channels TV and them report say the government dey look into taxing crypto transactions and digital assets. Madam Zainab wey be finance minister say the go go through FEC before the president go forward am go Green and Red Chamber for approval. The way things they go recently he be like we government Don dey fall in love with crypto oo abi dem just dey feel say no matter watin dem do people no go leave the crypto so themselves they follow trend.

Abi them wan use this one take consol Nigerians base on election wey dey come? Since plenty youths dey into this stuff.

My people I wan here una view how una see this move?


Moreso he be like dem NITD Don shortlist people wey dem carry for this blockchain tutorial dem. If you apply just check your mail to see
You see this our present government, no belief anything wey d sae until the implement am immediately. Shey you been see how the take ban trading crypto that year with banks. You also see how the take announce am that day for news, the next day d implement asap. Why don't they do the same with this one now? They wan try to follow the duo process to implement am. Wetin d showcase with this dia move, make em be sae dem no d against crypto.

It's remaining 2months to the end of their tenure, they wan to the try form good make people clap for them. Abegy make them shift one side, make we see wetin our next President go be gets in stock for Nigerians.

Me wey share the information about NITD I no get any email sha  Angry anyway congrats to people wey receive the email from them. I wish una luck for the training
Nigeria government na them be scammers, na e make scam full Nigeria because the government dey promote scam. Them go lie give u so that make u do something wey go benefit dem and at the end wetin dem talk no e them go do. The difference between yahoo boys and them b say,government dey use authority dey scam you,and you no go fit do them anything because nobody fit win government.

If na yahoo boys, na still dem government go, go catch am becos e do wetin dem no go fit do without power, so dem go come envy. Just check out the bodi EFCC na dem be Nigeria legalize criminals. I no go believe everything wey this our government go tell me till I die only if good people come into power because e just be like say dem dey carry people play. All these wey dem dey talk or do now na election saga. Make dem cari their lie lie comot for sit make we see the next person wey go enter jor.
hero member
Activity: 742
Merit: 529
Di thing don enta politics.
Me just dey laugh una wey still dey carry mind face for Government and dia promises, see like dis my mind don strong and I no too reason government bicus dem be the biggest scammer we get for dis we country so e beta say una remove mind make we join hand put pesin wey go do us wella dan to dey see promise and fail everi 4 years to 8 years.

My broda  you see this our country anything wey concern government just know day politics must dey inside am, cos already na wetin dey government dey take live by. Just imagine how them use ASUU head take play politics telling them make them go back to classroom and start teaching say them go pay them all the money in arrears for the 7months sef wey Dem no work go work sake of dey strike. ASUU rush call off strike Las Las government change mouth say na month wey Dem work na Dem go collect salary based on no work no pay clause. People wey no get Masters/phD na com dey use/scam people head wey claim say Dem be Prof with PhD.

If u no fear this our country politicians den I wonder who person go fear again.their mouth na black and white person no fit knw wen Dem dey even talk truth again.

full member
Activity: 798
Merit: 134
Di thing don enta politics.
Me just dey laugh una wey still dey carry mind face for Government and dia promises, see like dis my mind don strong and I no too reason government bicus dem be the biggest scammer we get for dis we country so e beta say una remove mind make we join hand put pesin wey go do us wella dan to dey see promise and fail everi 4 years to 8 years.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Government wan begin dey tax crypto transactions

My people I listen to channels TV and them report say the government dey look into taxing crypto transactions and digital assets. Madam Zainab wey be finance minister say the go go through FEC before the president go forward am go Green and Red Chamber for approval. The way things they go recently he be like we government Don dey fall in love with crypto oo abi dem just dey feel say no matter watin dem do people no go leave the crypto so themselves they follow trend.

Abi them wan use this one take consol Nigerians base on election wey dey come? Since plenty youths dey into this stuff.

My people I wan here una view how una see this move?


Moreso he be like dem NITD Don shortlist people wey dem carry for this blockchain tutorial dem. If you apply just check your mail to see
You see this our present government, no belief anything wey d sae until the implement am immediately. Shey you been see how the take ban trading crypto that year with banks. You also see how the take announce am that day for news, the next day d implement asap. Why don't they do the same with this one now? They wan try to follow the duo process to implement am. Wetin d showcase with this dia move, make em be sae dem no d against crypto.

It's remaining 2months to the end of their tenure, they wan to the try form good make people clap for them. Abegy make them shift one side, make we see wetin our next President go be gets in stock for Nigerians.

Me wey share the information about NITD I no get any email sha  Angry anyway congrats to people wey receive the email from them. I wish una luck for the training
hero member
Activity: 644
Merit: 520
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Dis won na gud won bcos e bi like sae di Government have it in their mind even though dem neva approve am. But how dem wan do am wey bi sae dem won create jobs from crypto through taxation. Di mata tire me. Onli dis year dem don promise Nigerians on cryptocurrency plenty times but nothing don Happened. Di thing don enta politics.
Naija nai make i jus like dis countri. I tink say na dem ban crypto for the country e no end dear dem even block plenty people fiat bank account wey get any connection to do wit crpto, me sef i be victim of the block. Dem freeze ma bank for no reason during that time of the crypto ban and when i even reach bank to ask why dem talk say na account whey dey transact wit crypto. Now all of a sudden the same government don dey say dem wan train people for blockchain technology as dem don see the plenty moni wey dem get from taxin transaction with crypto ,and so many promises wey we don suppose dey use to by now for dis counkri.  As for politics e no suppose dey new na. na d normal trend for the counkri be dat even flood sef dem tun am to politics dey pack plenty moni wey dem suppose give people wey dey affected
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
Vave.com - Crypto Casino
Government wan begin dey tax crypto transactions

My people I listen to channels TV and them report say the government dey look into taxing crypto transactions and digital assets. Madam Zainab wey be finance minister say the go go through FEC before the president go forward am go Green and Red Chamber for approval. The way things they go recently he be like we government Don dey fall in love with crypto oo abi dem just dey feel say no matter watin dem do people no go leave the crypto so themselves they follow trend.

Abi them wan use this one take consol Nigerians base on election wey dey come? Since plenty youths dey into this stuff.

My people I wan here una view how una see this move?


Moreso he be like dem NITD Don shortlist people wey dem carry for this blockchain tutorial dem. If you apply just check your mail to see
Dis won na gud won bcos e bi like sae di Government have it in their mind even though dem neva approve am. But how dem wan do am wey bi sae dem won create jobs from crypto through taxation. Di mata tire me. Onli dis year dem don promise Nigerians on cryptocurrency plenty times but nothing don Happened. Di thing don enta politics.
sr. member
Activity: 588
Merit: 440
First timers abeg just introduced yourself so we fit relate weller
  • Username:
  • Gender
  • State of resident (optional)
  • Skills
Username: Sokani
Gender: Male
State:
Skill:
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Government wan begin dey tax crypto transactions

My people I listen to channels TV and them report say the government dey look into taxing crypto transactions and digital assets. Madam Zainab wey be finance minister say the go go through FEC before the president go forward am go Green and Red Chamber for approval. The way things they go recently he be like we government Don dey fall in love with crypto oo abi dem just dey feel say no matter watin dem do people no go leave the crypto so themselves they follow trend.

Abi them wan use this one take consol Nigerians base on election wey dey come? Since plenty youths dey into this stuff.

My people I wan here una view how una see this move?


Moreso he be like dem NITD Don shortlist people wey dem carry for this blockchain tutorial dem. If you apply just check your mail to see
All dis things wey dem dey tok, na because of the election, u know many cryptocurrency tok we Nigeria govt whether na di presidency e don tok. Dem say dem wan try pipo here nd there nd odas nd now dem wan tax cryptocurrency users from crypto transactions. If dem wan 2 adopt let dem do am no bi to bring different tories to come deceive pipo mind. Me I no believe am oo. To tax Crypto transaction is not easy oo. Mostly when the users use p2p and since di govt no fit control wallet.
member
Activity: 714
Merit: 30
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Government wan begin dey tax crypto transactions

My people I listen to channels TV and them report say the government dey look into taxing crypto transactions and digital assets. Madam Zainab wey be finance minister say the go go through FEC before the president go forward am go Green and Red Chamber for approval. The way things they go recently he be like we government Don dey fall in love with crypto oo abi dem just dey feel say no matter watin dem do people no go leave the crypto so themselves they follow trend.

Abi them wan use this one take consol Nigerians base on election wey dey come? Since plenty youths dey into this stuff.

My people I wan here una view how una see this move?
Nothing wey Nigerian government go do wey go surprise me again, e fit be say, dem see say people no wan live d cryptocurrency na why dem wan legalise am make dey get small money 4 people wey de involved in Bitcoin and cryptocurrency transactions, and e fit be say dis party wey de rule wan catch youth attention as dem see sa youths like Crypto wella.

Quote
Moreso he be like dem NITD Don shortlist people wey dem carry for this blockchain tutorial dem. If you apply just check your mail to see
Good luck 4 people wey dem carry, I hope say dat one na way to Bitcoin legalisation in Nigeria.
Pages:
Jump to: