Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 29. (Read 784182 times)

hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Hello everyone how we Dey na, I see a post for Facebook wey person Dey talk say Binance na the reason wey dey make serious adoption for crypto-currency in Nigeria.

We all no say exchanges like Binance are centralized and no support or protect person privacy at all, so Wetin una think, personally I no go attribute the success of Crypto-currency in Nigeria to Binance.
hero member
Activity: 770
Merit: 548
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

Like dis I wan use this opportunity call on all my brodas and sista Dem inside the forum to join me celebrate as today na my convocation for the university of Port Harcourt wey mark am say true true all don really don and dusted. The journey be no easy but baba God make am possible

https://i.imgur.com/wxjJoXe.jpeg

As baba do am for me na so him go run am for every other person in their own different expectations.

My broda congratulations on your convocation oo. Omo e no easy for the our country at all. To enta school  na one thing anoda thing na to finish especially for people wey no get any body to back dem up. Omo as i dey see people dey graduate i just dey say na only God nai dey do am for person. Me too i dey hope to go round up my studies very soon, because of  bills and the struggle e no easy for the bele kingdom i had to pull back for my year three @M.A.U and try gather small funds to meet up, but as you talk na oluwa dey run am and i go finish am very soon one-day and my prayers too be say make we all change so that dis our country go good because na all of us follow dey spoil dis country , one man go only start the change but na we all go complete the race
@ Lida u don achieve one purpose of life and I congratulate u for this,e no easy with all ASUU strike and FG issues on settling ASUU,u still cross make u no go think say u don arrive o bcos na now d hustle don start for u as u dey on OYO now. Parents go hardly give u cash for your up keep,na u need to face and overcome the joblessness wey the country put us for.

To be a man no easy o,so put God first for your hustle and e go clear road for you. The highest work dey inside this forum if you code the code. Welcome to Nigeria Labour Congress
hero member
Activity: 1022
Merit: 667

Based on our discussion last month, the poll dun close and na the i'ss have it. At the end of the month like dis when this analysis dun come out by our brothers Igehh and uchegod-21. The top three quality posts go received an award of 10 merits to be shared as follows; 50% for 1st position, 30% for 2nd and 20% for third. Initial budget na 10 merits but e fit increase if enough smerit dey my hand by the time the stats come out. Others fit follow this same rewarding criteria and make all the meriting happened for the local board posts of the winners wey dem make that means you gas review the account. Hopefully this go increase the quality on this thread and more engagement.
Baba, I salute you for this outcome and the way and manner you use to arrange the rewards based on the quality of posts and not quantity at least that will eliminate spam and low-quality posts in the local thread. I agree with the fact that other forum members including myself who will have some merits to play around with will comply with this sharing formula so that the best quality poster will receive a reward higher than the rest on the table of the top 3 active members here. That being said I will like to ask, what criteria will you use to measure the quality of posts, and since our official language on this thread is Pigin-English how do we measure their quality? Oh sorry 💔  my bad what do I know Grin you are a professional campaign major so you should have all the relevant tools to measure the quality of posts for grading at the end of each month.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
Quote from: Majestic-milf
E dey pain me say up till dis time, we still get pipo wey dey sentimental about this election and d candidates
E good say we sopoz vote who go carry is jakpa from dis mess wey our past leaders and current leader keep us, but e no go make sense if we dey particular about a candidate, because if no be God wey help, we fit still go vote another wolf in sheep's clothing.
Wen, I no say Nigeria will definitely get it right this time because nobody is voting because of region like wat ur leaders used to deceive us those days that if d person win will convert everybody to christian or Muslim. If u no the population of people that came out few months ago to register for voter cards, you will no dat Nigeria is very ready to correct some bad things to good things in ur nation Nigeria so that ur leaders will start carry citizens like eggs.
Any how tins be for now, me I still get the hope say naija go beta cos gradually the level of political consciousness and participation among our young and old don the increase pass befor befor. And all we dey pray na make baba God hep us mk we get the beta leader wey really get naija development for heart.

Like dis I wan use this opportunity call on all my brodas and sista Dem inside the forum to join me celebrate as today na my convocation for the university of Port Harcourt wey mark am say true true all don really don and dusted. The journey be no easy but baba God make am possible
https://i.imgur.com/wxjJoXe.jpeg
As baba do am for me na so him go run am for every other person in their own different expectations.

Congratugloria!!!!!!  Baba God don do am for you. Bible say as you join others celebrate na so celebration for dey follow you yanfu yanfu. Make me too join you dey celebrate because I like good thing o. Good thing dey sweet for body Wella. Say me too I like am say you don graduate o because me too want to graduate from University too. Eno easy o say person go school for Naija as I get matter be now say education for we country hard like dis.
Any ways me too dey convocate this coming Saturday for 10th December for my own school. Me too thank God say na my Second acada degree I just round up like this so. My brothers and sisters the journey no easy o. As e dey be so I thank for my life.
To God be all the glory. Congratugloria once again.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
Unto tinubu matter sef kwa, the man don old too much to go for 001  office. That office no be only for the old men Dem wey don dey rule us for long. We need fresh vibrant leader in the government.

If our country na where people deh do things well and from their conscience, all the old politicians for don know say them no fit cheat anybody enter that seat. Leave Tinubu, him think say his bullion van go rescue am this one. His eyes go clear. Wetin happen for Osun go happen again for national level.

Like dis I wan use this opportunity call on all my brodas and sista Dem inside the forum to join me celebrate as today na my convocation for the university of Port Harcourt wey mark am say true true all don really don and dusted. The journey be no easy but baba God make am possible
https://i.imgur.com/wxjJoXe.jpeg

Congratulations my brother. But why you hide your face for that pix? Make you no loose guard sha by looking for job after service. Start from this forum and pursue your dream well. No expect any uncle or aunty to fix you someone. Jobs no deh but they will lie to you say dem deh do something. Crypto has been saving lives since 19 00.
hero member
Activity: 644
Merit: 520
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

Like dis I wan use this opportunity call on all my brodas and sista Dem inside the forum to join me celebrate as today na my convocation for the university of Port Harcourt wey mark am say true true all don really don and dusted. The journey be no easy but baba God make am possible

https://i.imgur.com/wxjJoXe.jpeg

As baba do am for me na so him go run am for every other person in their own different expectations.

My broda congratulations on your convocation oo. Omo e no easy for the our country at all. To enta school  na one thing anoda thing na to finish especially for people wey no get any body to back dem up. Omo as i dey see people dey graduate i just dey say na only God nai dey do am for person. Me too i dey hope to go round up my studies very soon, because of  bills and the struggle e no easy for the bele kingdom i had to pull back for my year three @M.A.U and try gather small funds to meet up, but as you talk na oluwa dey run am and i go finish am very soon one-day and my prayers too be say make we all change so that dis our country go good because na all of us follow dey spoil dis country , one man go only start the change but na we all go complete the race
hero member
Activity: 742
Merit: 529
Quote from: Majestic-milf
E dey pain me say up till dis time, we still get pipo wey dey sentimental about this election and d candidates
E good say we sopoz vote who go carry is jakpa from dis mess wey our past leaders and current leader keep us, but e no go make sense if we dey particular about a candidate, because if no be God wey help, we fit still go vote another wolf in sheep's clothing.
Wen, I no say Nigeria will definitely get it right this time because nobody is voting because of region like wat ur leaders used to deceive us those days that if d person win will convert everybody to christian or Muslim. If u no the population of people that came out few months ago to register for voter cards, you will no dat Nigeria is very ready to correct some bad things to good things in ur nation Nigeria so that ur leaders will start carry citizens like eggs.
Any how tins be for now, me I still get the hope say naija go beta cos gradually the level of political consciousness and participation among our young and old don the increase pass befor befor. And all we dey pray na make baba God hep us mk we get the beta leader wey really get naija development for heart.

Like dis I wan use this opportunity call on all my brodas and sista Dem inside the forum to join me celebrate as today na my convocation for the university of Port Harcourt wey mark am say true true all don really don and dusted. The journey be no easy but baba God make am possible

As baba do am for me na so him go run am for every other person in their own different expectations.

full member
Activity: 1190
Merit: 126
Catalog Websites
Quote from: Majestic-milf
E dey pain me say up till dis time, we still get pipo wey dey sentimental about this election and d candidates
E good say we sopoz vote who go carry is jakpa from dis mess wey our past leaders and current leader keep us, but e no go make sense if we dey particular about a candidate, because if no be God wey help, we fit still go vote another wolf in sheep's clothing.
Wen, I no say Nigeria will definitely get it right this time because nobody is voting because of region like wat ur leaders used to deceive us those days that if d person win will convert everybody to christian or Muslim. If u no the population of people that came out few months ago to register for voter cards, you will no dat Nigeria is very ready to correct some bad things to good things in ur nation Nigeria so that ur leaders will start carry citizens like eggs.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
The more you people talking about not being sentimental, tribalistic and whatever, the more I see sentiment and all you mention in the statement. PDP has ruled, yes! But was it Atiku that ruled? No. APC also, it's not Tinubu that is ruling now. Obi was the part of the PDP that ruled before. He's not Saint as you all portray. Na sentiment sef dey make us support Obi all in name of na Igbo turn and nothing more. If we are to be fair to ourselves, kwankwaso and Sowore are better choice too but sentiment no go allow us to see.

No be sentiment make me deh support Peter Obi unto say na Igbo person. Carry Orji Uzor Kalu or Dave Umahi put there and watch how many people from the east weh go support his candidature. Many people deh support PO because say na him deh transparent pass among others. Sowore also deh good but his ideas no go too work except if majority of those lazy legislators weh deh National Assembly na people weh support am, to allow his policies go through. We sabi how those NA members don cast this country because of greed and them no go want to support Sowore policies weh e go be say e go go against them. Tinubu weh you mention for deh ok to run in 1999, 2003, 2007, 2011. Then he was active and healthy. The Tinubu weh deh now deh very sick. He will make us laughing stock abroad in the midst of other presidents. The man has dementia already abi una no deh see am?

Unto tinubu matter sef kwa, the man don old too much to go for 001  office. That office no be only for the old men Dem wey don dey rule us for long. We need fresh vibrant leader in the government. Edon tey wey we dey sing we are the leaders of tommorow uptill this time na the men Dem wey dey for power that time still dey for the corridors of power. Na how Dem want us to take be the leaders to today na. Minus sentiment aside this has nothing to do with political party any more, we are looking at the caliber of persons involved. I think the national assembly needs to look into age factor this time around so as to prevent some certain occurrence in the next general election. His is not a joke we have to stand up to it.
hero member
Activity: 644
Merit: 520
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

But baba God e no go come down and vote na still we we go still vote the candidates. So you beta know whom you go vote from now. We should remove sentiment, tribalism, religion and nepotism, obi is beta than any other person  candidates in this presidential candidates. PDP has ruled but nothing come, APC has ruled but nothing come out. So let tried another person.

The more you people talking about not being sentimental, tribalistic and whatever, the more I see sentiment and all you mention in the statement. PDP has ruled, yes! But was it Atiku that ruled? No. APC also, it's not Tinubu that is ruling now. Obi was the part of the PDP that ruled before. He's not Saint as you all portray. Na sentiment sef dey make us support Obi all in name of na Igbo turn and nothing more. If we are to be fair to ourselves, kwankwaso and Sowore are better choice too but sentiment no go allow us to see.
My broda i dey get your point, because this our country na everybody nai be the country problem. Everybody is just been sentimental say APC don rule before and PDP sef don rule so make  another new party try out and say old men dem don too rule us but one thing wey we forget be say even this proposed obi sef na still the same parties him comot from and him too no be saint but the fact wey i just like about this time election be say Nigerians for once get choice to turn up to vote person wey dey their mind and the thing be say make e no be because of sentiment sey him na labour party or na igbo man or him dey younger than the other two candidates
member
Activity: 714
Merit: 30
If you believe say na Kwankwaso or Sowore be the better choice for you, then vote for them, nobody they compel you to vote for Peter Obi, it is your choice, anybody sev wey feel say na Atiku or Tinubu wey be their own better candidate, make them vote them too; but as una they do that make una leave obedient people make them campaign in the way they want to, una fes they talk say na only online Obi get mouth, now una don change am to tribal sentiment, deep down everybody know say Obi campaign no they based on tribe or ethnicity, it is based on his track record of excellence whilst in power, and his visions of a better Nigeria wey many people don believe say na him be the man to take us out of this current condition. Nobody they talk say Obi na saint, but if na onto corruption matters, nobody is yet to bring up anything against him in that regard, but as for Tinubu and Atiku, you know say you no fit talk the same thing about them. Every Nigerian knows what is right, but una they inure to sufferings, so we always do what's not right, 2023 fit no they any different.
Shey you dey whine me ni? Nobody dey compel anybody to vote for Obi? So why Obidient dey attack anybody wey get different opinion? I don't know how you see this your comment but I can tell you that it's in form of attack. Is only a biased person will say Obi campaign is not based on tribal sentiment. Check 70% of his supporters and come back here to delete this comment please. Talking of corruption, lol do you have any evidence of Tinubu and Atiku involved in corruption? Is pandora paper a joke to you? Is Obi not in that list? Shey that one no be corruption abi? Talking about track record oga nobody among the contenders can beat Tinubu when it comes to track record. Do your findings again. Tinubu is the perfect choice but his health conditions disqualified him IMO.

I'm Obidient but let truth be told.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Life's but a walking shadow!
The more you people talking about not being sentimental, tribalistic and whatever, the more I see sentiment and all you mention in the statement. PDP has ruled, yes! But was it Atiku that ruled? No. APC also, it's not Tinubu that is ruling now. Obi was the part of the PDP that ruled before. He's not Saint as you all portray. Na sentiment sef dey make us support Obi all in name of na Igbo turn and nothing more. If we are to be fair to ourselves, kwankwaso and Sowore are better choice too but sentiment no go allow us to see.
If you believe say na Kwankwaso or Sowore be the better choice for you, then vote for them, nobody they compel you to vote for Peter Obi, it is your choice, anybody sev wey feel say na Atiku or Tinubu wey be their own better candidate, make them vote them too; but as una they do that make una leave obedient people make them campaign in the way they want to, una fes they talk say na only online Obi get mouth, now una don change am to tribal sentiment, deep down everybody know say Obi campaign no they based on tribe or ethnicity, it is based on his track record of excellence whilst in power, and his visions of a better Nigeria wey many people don believe say na him be the man to take us out of this current condition. Nobody they talk say Obi na saint, but if na onto corruption matters, nobody is yet to bring up anything against him in that regard, but as for Tinubu and Atiku, you know say you no fit talk the same thing about them. Every Nigerian knows what is right, but una they inure to sufferings, so we always do what's not right, 2023 fit no they any different.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Abeg I wan ask anybody here don notice say Remitano dey freeze or e dey too slow? And which other alternative dey aside Binance wey person fit to use? Una Doh

If you no wan use a completely decentralized P2P due to the risk of getting scam and you wan dey use this centralized P2P wey we dey manage for Nigerian then try Kucoin, OKX, Houbi or paxful exchange or other centralized exchange wey get P2P option. Dem plenty oh no be only Binance and remitano dey offer such trading options. Another thing na to just run the  transaction with another merchant wey you know wey dey into P2P trading and e for save you all the stress of going through this centralized platforms.

Based on our discussion last month, the poll dun close and na the i'ss have it. At the end of the month like dis when this analysis dun come out by our brothers Igehh and uchegod-21. The top three quality posts go received an award of 10 merits to be shared as follows; 50% for 1st position, 30% for 2nd and 20% for third. Initial budget na 10 merits but e fit increase if enough smerit dey my hand by the time the stats come out. Others fit follow this same rewarding criteria and make all the meriting happened for the local board posts of the winners wey dem make that means you gas review the account. Hopefully this go increase the quality on this thread and more engagement.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
The more you people talking about not being sentimental, tribalistic and whatever, the more I see sentiment and all you mention in the statement. PDP has ruled, yes! But was it Atiku that ruled? No. APC also, it's not Tinubu that is ruling now. Obi was the part of the PDP that ruled before. He's not Saint as you all portray. Na sentiment sef dey make us support Obi all in name of na Igbo turn and nothing more. If we are to be fair to ourselves, kwankwaso and Sowore are better choice too but sentiment no go allow us to see.
Sentiment kwa? I no believe sae you go talk this kind thing. To you now, you think sae 2023 election na via you be Yoruba, Hausa or Igbo? Omo, this election no go be like that. All man wan vote for the right peso wey go make Nigeria great again. No one the try reason sae Obi na Igbo or not. We d fight to secure a better Nigeria where all man go live in peace and harmony. Nigeria as a country needs a savior as a president to restore our economy back. We no fit repeat the same mistake to vote for incompetent people to seat at the horns of the affairs of the nation. Make we try vote wisely for our future(em get why we suppose to)
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
Make we still talk about bitcoin and bitcoin development for Naija because whether na Peter Obi win or na Atiku or Tinubu, if we nor hustle hard nobody, not even their proposed policies go fit help us.

Abeg I wan ask anybody here don notice say Remitano dey freeze or e dey too slow? And which other alternative dey aside Binance wey person fit to use? Una Doh

If nothing don teach you anything, wetin happen during #endSARS supposed teach you small thing about these politicians in authority. You see how Buhari take order banks to freeze accounts weh get crypto trades on them or you don forget? Those weh we elect into office get so much to do with how we progress or not. If you elect a nonsense or weak leader it will affect us too. Is the choice of Buhari not affecting all of us now? If you like hustle reach tomorrow and the leaders make policies weh go affect you, there is nothing you can do. So we have to get it right. This politics get weight pass our economy self because na politics deh control economy. Make una no deh see as say any discussion on this election na distraction. It is not a distraction. Na the main thing be that.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
The more you people talking about not being sentimental, tribalistic and whatever, the more I see sentiment and all you mention in the statement. PDP has ruled, yes! But was it Atiku that ruled? No. APC also, it's not Tinubu that is ruling now. Obi was the part of the PDP that ruled before. He's not Saint as you all portray. Na sentiment sef dey make us support Obi all in name of na Igbo turn and nothing more. If we are to be fair to ourselves, kwankwaso and Sowore are better choice too but sentiment no go allow us to see.

No be sentiment make me deh support Peter Obi unto say na Igbo person. Carry Orji Uzor Kalu or Dave Umahi put there and watch how many people from the east weh go support his candidature. Many people deh support PO because say na him deh transparent pass among others. Sowore also deh good but his ideas no go too work except if majority of those lazy legislators weh deh National Assembly na people weh support am, to allow his policies go through. We sabi how those NA members don cast this country because of greed and them no go want to support Sowore policies weh e go be say e go go against them. Tinubu weh you mention for deh ok to run in 1999, 2003, 2007, 2011. Then he was active and healthy. The Tinubu weh deh now deh very sick. He will make us laughing stock abroad in the midst of other presidents. The man has dementia already abi una no deh see am?

I for like shook mouth for this matter but your reply don already do justice to wetin the user talk. Well done. Make we still talk about bitcoin and bitcoin development for Naija because whether na Peter Obi win or na Atiku or Tinubu, if we nor hustle hard nobody, not even their proposed policies go fit help us.

Abeg I wan ask anybody here don notice say Remitano dey freeze or e dey too slow? And which other alternative dey aside Binance wey person fit to use? Una Doh
hero member
Activity: 854
Merit: 597
 E dey pain me say up till dis time, we still get pipo wey dey sentimental about this election and d candidates
E good say we sopoz vote who go carry is jakpa from dis mess wey our past leaders and current leader keep us, but e no go make sense if we dey particular about a candidate, because if no be God wey help, we fit still go vote another wolf in sheep's clothing.

sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
The more you people talking about not being sentimental, tribalistic and whatever, the more I see sentiment and all you mention in the statement. PDP has ruled, yes! But was it Atiku that ruled? No. APC also, it's not Tinubu that is ruling now. Obi was the part of the PDP that ruled before. He's not Saint as you all portray. Na sentiment sef dey make us support Obi all in name of na Igbo turn and nothing more. If we are to be fair to ourselves, kwankwaso and Sowore are better choice too but sentiment no go allow us to see.

No be sentiment make me deh support Peter Obi unto say na Igbo person. Carry Orji Uzor Kalu or Dave Umahi put there and watch how many people from the east weh go support his candidature. Many people deh support PO because say na him deh transparent pass among others. Sowore also deh good but his ideas no go too work except if majority of those lazy legislators weh deh National Assembly na people weh support am, to allow his policies go through. We sabi how those NA members don cast this country because of greed and them no go want to support Sowore policies weh e go be say e go go against them. Tinubu weh you mention for deh ok to run in 1999, 2003, 2007, 2011. Then he was active and healthy. The Tinubu weh deh now deh very sick. He will make us laughing stock abroad in the midst of other presidents. The man has dementia already abi una no deh see am?
sr. member
Activity: 728
Merit: 421

Again, politics na very emotional something so make we no take anything too serious, make we just understand say na vote we dey go vote and no kill ourselves in the process. I just dey pray say anything wey make Obi win, I use Jesus beg God make him help am make him get positive impact because if Obi fuck up as Buhari dun fuck up after many youths support am then We go lose many interest of the youth in politics and Nigeria go come finish finally.

Politicians in Nigerian generally are evil, like na only their own interests they get at heart no mata how dem behavior, the end goal na to get themselves on the seat and that's all. Most of them, immediately they enter them dun forget everything dem promise but I hope this time around things go different. Actually if we dey fair, non or them deserve to rule this country but as we can only work with whatever we have, then we have to select one and hope for the best.

This talk na true about dis our country politicians all of them  just dey after their own interests, the Time wey dem Neva enter the seat na so dem go dey give empty promises about making things beta for this country but the moment dem enter every thing don change and the most interesting part of the time election be say ,OK everybody dey support obi but even if obi cum win now owna forget say na still the same set of  evil politians wey dey for the pdp and apc nai go still run come enta the labour party wey win and the same appointment of ministers and senators go still circulate round and this same problem of corrupt leaders go dey on . The fact be say only obi no go fit change everything for this country oo. everyone needs to change their mind set on things for this country

Comrade, the matter sef tire  person no be small but the truth be say ehn na we dey do ourselves all this wahala. You go see say the same youth wey dey shout say Dem no want again na the same youth go vote them out come election after d don collect money and rice. Until we stand up to say no make them carry their money and vote buying go we no want again Dem go still dey for corridors of power. E no go make sense say after over 18 years of democracy the matter still remain the same come even worst pass as edey before democracy. As edey so I  dey think say the previous pattern of government don better pass as the Democratic system of government be now. Na only God fit help us for we country.  Make the youths, elders, papa and mama Dem say no this time to shun vote buying. This one go show our politicians Dem say we mean business this time.

Jump to: