The more you people talking about not being sentimental, tribalistic and whatever, the more I see sentiment and all you mention in the statement. PDP has ruled, yes! But was it Atiku that ruled? No. APC also, it's not Tinubu that is ruling now. Obi was the part of the PDP that ruled before. He's not Saint as you all portray. Na sentiment sef dey make us support Obi all in name of na Igbo turn and nothing more. If we are to be fair to ourselves, kwankwaso and Sowore are better choice too but sentiment no go allow us to see.
If you believe say na Kwankwaso or Sowore be the better choice for you, then vote for them, nobody they compel you to vote for Peter Obi, it is your choice, anybody sev wey feel say na Atiku or Tinubu wey be their own better candidate, make them vote them too; but as una they do that make una leave obedient people make them campaign in the way they want to, una fes they talk say na only online Obi get mouth, now una don change am to tribal sentiment, deep down everybody know say Obi campaign no they based on tribe or ethnicity, it is based on his track record of excellence whilst in power, and his visions of a better Nigeria wey many people don believe say na him be the man to take us out of this current condition. Nobody they talk say Obi na saint, but if na onto corruption matters, nobody is yet to bring up anything against him in that regard, but as for Tinubu and Atiku, you know say you no fit talk the same thing about them. Every Nigerian knows what is right, but una they inure to sufferings, so we always do what's not right, 2023 fit no they any different.