Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 100. (Read 1021699 times)

hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Abeg oh if e involves money disclosed am oh as we no dey shame, na hustle we dey.
It is personal stuff  Grin. I would have told people here if it is an opportunity to grab.
Since after the Bitcoin pizza contest, @Charles-Tim done turn baker him done enrol for baking classes on YouTube, even if you call amm now you go hear say hmmm dey bake cake, I done tell ammm say big men no dey bake but him no wan gree oooo. Grin Grin
When I was trying to make a transaction from Ramitano website last week, network was very bad and poor, it delayed my transaction. The worst part was, the price of bitcoin was 25k and in the process of struggling with the network and the site I finally sold it at the rate 22k
Baba I done experienced that problem on several occasions on Remitano before and most times, na your network dey cause ammmm, as Charles-Tim said try to use another available network to see which one work best for you, one thing I done notice with network be say every area get their own best performing network, I get all the whole network sims and if any fuck up on one network I quickly swap to another network. For the price of Bitcoin to dropped from 25k to 22k that means it took you a lot of time before carrying out your trade, any ways I believe say even with the 5G LTE we go still dey experience network problem because this na 9ja things no dey work for here the way e dey work for other part of the world so guide yourself with all the alternatives that could aid your faster transaction time to avoid future loses.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
The day I go see you for that top I go send you $100 BTC. You dey whine us ni  Grin
Engineer, na me you dey whine ba? I go do reverse CPA method now – Bottom to Top 😆

No worry sir, next month I go put your name for number 1.
Chai! You wan panic Engineer small like dat oh. Igehhh, you dey hear am now ba. I go knack myself enter here to top chart dis month.

@CryptopreneurBrainboss, smart manager and the CEO of Brainboss Xchange, I hail you, I don see where you talk say if them give us local board you go dey do btc giveaway. I don record am down boss... 9ja to the moon.
No doubt dat dude, him na big name oh. Im face show wella. Na small Don you dey see so oh 🧐
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Lol @ uchegod-21 and all of us wey mention me from last page to now plus all of us wey dey read, make una no kill me say I never say anything after the update wey my face show. I no even check or see anything like that when I enta here in the morning.

Na this night wey I login in e com be like say my merit count change, I come say make I check , I see uchegod-21 wey no dey bless me, I surprise. As I see am na, na dat one cari me com know wetin dey happen 4 here. Una thank you oo

Abeg I appreciate all d comments oo. Me I no even know how possible this one be say na me top the show, my mind no even dey there. How com I con make such gap with 7 post behind the second wey be uchegod-21 with 19 posts. Abeg make our big guys for the thread no go back oo like our boss CryptopreneurBrainboss, Charles-Tim, Mpamaegbu, igehhh etc. Me I still feel say I no suppose top with just 26 posts, make we check na  Grin


Campaign dun make Gozie51 turn Charles-Tim for this last update hahah. Well e goes well if motivation dey to encourage more activeness for our local board. Make we just wait until we get this board as others go begin jealous based on the kind activities we go dey arrange for the board.


No be lie. Your campaign dey help make our face dey show here and that one go still make us dey show face here even when dat kind package no show again but we believ say oluwa go still dey follow help mak e dey show.


It has nothing to do with the Naira crashing it's poor government, The US trade twice of what Nigerians trade on a regular basis yet their dollar keeps appreciating, the best way to improve the Naira is to cut down much importation and do more of exportation.

But for my own side,I believ say refinery wey no dey dis country be major challenge to naira. Abi other countries dey still trade crypto but dem still dey kamkpe.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Nice one Uchegod I must say I really like this one, lots of improvements has been made and I Dey see many people they pick more interest in the thread, now the board don Dey sweet like this I go also use this medium to let others way still never Dey active say make them try, a lot of knowledge but crypto-currency and other wise are being passed here in the best way every 9ja man go understand. I go try come first this month sha lol.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.

Gozie51 dis wan everybody congratulobia you finish for your last month 1st position you no even comment for the thing, you continue your life, hope say peace day Grin The Merit wey I drop no be for the post wey I give am, na for your first position. Next time, if you carry first again, try acknowledge and express gratitude so that other people fit still appreciate via coolu water.

Somebody like oga Mpamaegbu dey beg say make we smuggle him name enter. No worry sir, next month I go put your name for number 1.

Adbitco, sorry for the body wey worry you, upon that you still try, you no slide go far. Hope say you don well finish.

@CryptopreneurBrainboss, smart manager and the CEO of Brainboss Xchange, I hail you, I don see where you talk say if them give us local board you go dey do btc giveaway. I don record am down boss... 9ja to the moon.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Remitano with him yeye network. Last week I dey tried 2 send BTC give Person 4rom remitano, di network come dey worry me like tomorrow no dey. Me, I bilive say, di 5G network go good pass 4 di internet gbese dem.

U fit check di Ramitano logo here.

Na di English bi dis https://bitcointalksearch.org/topic/the-adoption-of-5g-network-in-nigeria-5408698
You've been here for some time now and you expected you to know how centralized exchanges works, transferring bitcoin from a centralized exchanges is a huge loss, the fees are ridiculously high and fixed. I know that of Remitano is $30 fixed fees for all bitcoin transactions. BTW nobe Remitano get poor network na your data server get poor network.
Na finishing you give this oga so o. I nearly wan laugh for here way I dey so but the truth be say, na lapses to dey send coin from exchange. E dey always high watin no good but the advantage be say, na tip tap delivery. E no go take better 5 minutes cef because, you don pay the lion price. Although, that $30 high o. I think say na like $20 before.

Una dey try for keeping dis place warm. Next time make somebody try smuggle my name enta here na, whether I show or not. Haaba 🤪. I salute una doggedness for dis owa local corner. Una too much!
The day I go see you for that top I go send you $100 BTC. You dey whine us ni  Grin
Person fit spam to chop this money o, lol...
Like my person Mpa, I dey wonder when my face go show for there too. Maybe na if them start to consider the top 50 most active members, hehehehehe.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Abeg oh if e involves money disclosed am oh as we no dey shame, na hustle we dey.
It is personal stuff  Grin. I would have told people here if it is an opportunity to grab.

When I was trying to make a transaction from Ramitano website last week, network was very bad and poor, it delayed my transaction. The worst part was, the price of bitcoin was 25k and in the process of struggling with the network and the site I finally sold it at the rate 22k as of yesterday, At first, I thought it was my device so used desktop, it was the same. So I believe the 5G network which is the fastest network as for now will help to solve the problem of the slow and poor network for transactions and connectivity with other users of the internet. 
With 4G here, I can see 8 to 13 mb/s and 6 to 8 mb/s of download on router and mobile device respectively at night, while the network in the day are not bad either, slower though but not bad at all. I have used all networks before, but I later have no option than to stay with MTN. (I am not marketing MTN but the best that I have used)

5G is not like 4G as it is very expensive to setup, you should have known as it is not yet in Africa. It is costly to setup and can only be in main towns, unlike 4G which even not well developed towns and some villages can access.

Your problem is not upgrading to 5G, it is either the areas you are living, or get a better service provider's sim card. Even 3G can provide you the internet connection needed to access exchanges.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Remitano with him yeye network. Last week I dey tried 2 send BTC give Person 4rom remitano, di network come dey worry me like tomorrow no dey. Me, I bilive say, di 5G network go good pass 4 di internet gbese dem.

U fit check di Ramitano logo here.

Na di English bi dis https://bitcointalksearch.org/topic/the-adoption-of-5g-network-in-nigeria-5408698
Please try and reduce the size if your images make person fit and read well, dey always make the text dey bigger than the images. Back to the matter for ground, yes it a welcome development at this age we shouldn't be having network problems, I'm also happy the Elon musk Starlink network will also be launched this year too.

You've been here for some time now and you expected you to know how centralized exchanges works, transferring bitcoin from a centralized exchanges is a huge loss, the fees are ridiculously high and fixed. I know that of Remitano is $30 fixed fees for all bitcoin transactions. BTW nobe Remitano get poor network na your data server get poor network.

Una dey try for keeping dis place warm. Next time make somebody try smuggle my name enta here na, whether I show or not. Haaba 🤪. I salute una doggedness for dis owa local corner. Una too much!
The day I go see you for that top I go send you $100 BTC. You dey whine us ni  Grin
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!

Top 15 active users May 2022
Code:
1. Gozie51 [26]
2. uchegod-21 [19]
3. Coyster [18]
4. Adbitco [15]
5. Charles-Tim [14]
6. Davidvictorson [13]
7. Rruchi man [12]
8. igehhh [12]
9. BIT-BENDER [10]
10. Mr.right85 [10]
11. cytpoway121 [10]
12. CryptopreneurBrainboss [8]
13. Hyphen(-) [8]
14. Maestro75 [8]
15. RockBell [8]

Una dey try for keeping dis place warm. Next time make somebody try smuggle my name enta here na, whether I show or not. Haaba 🤪. I salute una doggedness for dis owa local corner. Una too much!
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Our 9ja govment e don talk say, dey wan bring 5G network come we kwantri, Dem talk say, n 4 aviation industry Dem go 1st do am nd see 2 kno hw di network go bi. Dem talk am yestadi we bi 3rd of August, 2022 inside 9ja television commission (NTA) tori hour we bi 9:00pm. Me, I come say I like di tori bcos we dey suffer 4 network well well.





Ramitano we get mumu network

Remitano with him yeye network. Last week I dey tried 2 send BTC give Person 4rom remitano, di network come dey worry me like tomorrow no dey. Me, I bilive say, di 5G network go good pass 4 di internet gbese dem.

U fit check di Ramitano logo here.

Na di English bi dis https://bitcointalksearch.org/topic/the-adoption-of-5g-network-in-nigeria-5408698
hero member
Activity: 952
Merit: 742
NBC own self don too much. Na so them dey put eye for every content wey dem broadcast, no be only foreign TV stations dem dey worry self but local radio stations. If radio station make any move to talk about government policies wey no good, dem go come after them and if na killing them report, dem go shut dem down. The thing don too much. Na so dem do with twitter , how many we go talk for this government.
E no shock me say NBC they against some talks wey be true from many sources because na weting be their own work be that, them no go want make everybody talk bad about about the government because them they under government which mean say na Government they control them, so them go try they against any news wey they try dig weting government do wey they bad.

How much be sae Asuu d even ask for sef? But Buhwri get funds to send give another country to buy cars???

Funds we dey even borrow from China, na wetin Buhari d give Niger Republic

Me self the matter tire me oo, ASUU they strike for more than 5 months now and him as president no take any serious action about the matta, that mean say Nigar repoblic they more important than the Nigerian citizens. Federal Government need to solve this ASUU strike problem.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
NBC own self don too much. Na so them dey put eye for every content wey dem broadcast, no be only foreign TV stations dem dey worry self but local radio stations. If radio station make any move to talk about government policies wey no good, dem go come after them and if na killing them report, dem go shut dem down. The thing don too much. Na so dem do with twitter , how many we go talk for this government.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Nigeria Broadcasting Commission (NBC)
D above federal government agency took say, den go collect money 4rom Startime, GoTV, DSTV, MyTV, say dem go show BBC documentation 4 Boko Haram. Dem say weti Dem show dey promote terrorist groups activities. NBC come say dem go fine Dem 5 millions 4 each company.

Me I come say, weti NBC dey do na veri bad something, now Dem dey tell us say make we no dey hear tori 4 we contri. Na so Dem bi wan do 4 di #endsars gbege bt Nigeria pipo no come gree 4 di mata day time. Dis Buhari Government no bi 4 d pipo bt 4 demselve. Di Ministers we dey suffer dis Buhari Government na the Minister of information Lai Mohammed, Minister of Education Adamu Adamu nd di Minister of Disaster. na dis 3 pipo bi di problem 4 dis Government, Dem no dey give di president weti dey happened 4 we contri bt na fake things Dem dey give am.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
You see this APC government, em no go better for them. Nigeria students do stay for home almost 5months  because of the Asuu strike and Buhari get mind to approve funds for Niger republic..

How much be sae Asuu d even ask for sef? But Buhwri get funds to send give another country to buy cars???

Funds we dey even borrow from China, na wetin Buhari d give Niger Republic

You see ehnn em no go better for APC government mancha

hero member
Activity: 952
Merit: 742
    NIGERIAN LOCAL BOARD THREAD ACTIVITY UPDATE FOR JULY, 2022.

    • Congratulobia to everybody wey make the list including Star men like Davidvictorson, Rruchi, Adbitco and hyphen(-). Abeg I wan see all of una for this table next month

    Baba me I no expect say my name go enter this list for this month, the list always they encourage me though, I go try make we adjust and make our unofficial local thread great and i hope we go get verified and be given local board soon.
    sr. member
    Activity: 1036
    Merit: 311
    but I use myself as an example, true be say we dey occupy with real life activities as you know say my wafi born baby so for the past four months am on paternity duty, and that have slow down my activities generally on the forum.
    Congratulations manchi. as e be so e no easy now way pampers dey cost. Na true Man U be beg. I just day on the low the monitor activities for our local board make I for know how I go take come in. As Oluwa done bless ur bowl him go fund ur wallet with heavy Bitcoin so that funds to train the pike go day excess... Amen
    legendary
    Activity: 2380
    Merit: 4265
    eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
    but I use myself as an example, true be say we dey occupy with real life activities as you know say my wafi born baby so for the past four months am on paternity duty, and that have slow down my activities generally on the forum.

    Big congratulations my brother, I no know if you dun break the story here before regarding the birth of your child as I remember we dun celebrate one child birth before never I wan congratulate you again as e no easy to bring life come this earth with all the responsibility wey dey involved. I pray God go give you and your family the funds and strength to bring this child up in the way of the lord and Bitcoin so when him/she grow, no go depart from am. AMEN.

    The reason Charles-Tim is no more active like before is because my time is occupied with other things which I can not just disclose here.

    Abeg oh if e involves money disclosed am oh as we no dey shame, na hustle we dey. Well good luck in whatever you're doing. Your contribution to the thread is highly appreciated and to all men wey dey put head together to keep the thread going thank you. Also make una bring relatable topics for easy discussion so we put head together they reason for the matter
    hero member
    Activity: 1428
    Merit: 653
    Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
    E get somtin wey don dey wori me for chest and I say make I bring am make una folo put mouth for the matter.

    With the way country don choke man and sapa dey hold every bodi we know say 2023 elections dey show so, wey politicians go like wan use youths, dem fit wet their pockets with small change and dis one fit ginja Dem to cari kala, nai wan major celeb wey Dem dey call buju bnxn com dey cap careless say make we legalize egbo for the country. Why him brain no tell am to move for BTC adoption instead? Because as e be, naija dey 39th place amongst countries wey be BTC padi.

     For naija we get youths wey go fit take egbo and notin go happen,  but e get the ones wey head nor fit cari and some of these ones fit go dey do bad things. We dey hear of cases of rape, stealing and other kata kata movement.

     But if we as leaders of tomorrow fit use our influence, like Buju bnxn case, push BTC, the government fit reason am, because na wetin fit grow economy as wetin we need pass.



    Why them go legalized egbo for we country and by the way self him no get the power to talk such thing wey be say commissioner for health no fit accept that kind thing, we know say egbo na bad thing and if any of them don go smoke finish them go come out cap anyhow as them like wetin be the future wey him get for we country wey other countries their youth dey inside industry dey build things to help the growth of their country innovating things wey go help them balance for life our own na to carry kala, egbo, mgborumini, TM, and any kind of bad drugs the scatter we country.
    Abeg just leave those people wey no wan plan their lives well. At least we know say we don suffer both the Rich and poor dey cry for the government so make e no be like say e no affect anybody so na the right time for we to vote wisely no be to sell our vote because of small peanut and suffer for next 4 to 8 years again.
    hero member
    Activity: 896
    Merit: 612
     E get somtin wey don dey wori me for chest and I say make I bring am make una folo put mouth for the matter.

    With the way country don choke man and sapa dey hold every bodi we know say 2023 elections dey show so, wey politicians go like wan use youths, dem fit wet their pockets with small change and dis one fit ginja Dem to cari kala, nai wan major celeb wey Dem dey call buju bnxn com dey cap careless say make we legalize egbo for the country. Why him brain no tell am to move for BTC adoption instead? Because as e be, naija dey 39th place amongst countries wey be BTC padi.

     For naija we get youths wey go fit take egbo and notin go happen,  but e get the ones wey head nor fit cari and some of these ones fit go dey do bad things. We dey hear of cases of rape, stealing and other kata kata movement.

     But if we as leaders of tomorrow fit use our influence, like Buju bnxn case, push BTC, the government fit reason am, because na wetin fit grow economy as wetin we need pass.

    hero member
    Activity: 1428
    Merit: 653
    Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
    NIGERIAN LOCAL BOARD THREAD ACTIVITY UPDATE FOR JULY, 2022.

    I don carry update of how our waka be for last month come we local thread here. As e dey be, e go show us who steady here pass last month and e go make us to know our effort and decide to increase.
    I copy the data wey I use for this post for igehhh thread for Meta https://bitcointalksearch.org/topic/m.57824603

    Top 15 active users May 2022
    Code:
    1. Gozie51 [26]
    2. uchegod-21 [19]
    3. Coyster [18]
    4. Adbitco [15]
    5. Charles-Tim [14]
    6. Davidvictorson [13]
    7. Rruchi man [12]
    8. igehhh [12]
    9. BIT-BENDER [10]
    10. Mr.right85 [10]
    11. cytpoway121 [10]
    12. CryptopreneurBrainboss [8]
    13. Hyphen(-) [8]
    14. Maestro75 [8]
    15. RockBell [8]


    Comments/Observations
    • After some months wey Uchegod-21 don dey top of the table, finally,  Gozie51 don dethrone him. Gozie51 been talk say em go climb the top and him doam.  Congratulobia to him.
    • Uchegod-21 no go too far, e dey for second. But people like Maestro75 slide go down for the table
    • Star man like Coyster don enter top 3 as BIT-BENDER  and igehhh dey drag position for middle
    • Big names like Charles-Tim and CryptopreneurBrainboss made the list. Charles-Tim don improve, e be like him don recover him form. Who knows weda him go steady back for number 1 wey be him favorite position
    • New names don enter the list wela, like RockBell, Mr.right85 and cytpoway12.
    • Congratulobia to everybody wey make the list including Star men like Davidvictorson, Rruchi, Adbitco and hyphen(-). Abeg I wan see all of una for this table next month

    Gozie51 abeg comment for this post for your merit. Congrats.

    Omo no be joke me don come carry 4 position wey be say last time I follow top, Sha e no easy one or two been dey worry me but thank God today I m fully back to my feet. Sickness been tie me down although I notify one of our man @Wakate trust this month of August my name go enter number 1.
    Thank you all for the effort and time to grow the thread.
    Pages:
    Jump to: