Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 101. (Read 1022076 times)

hero member
Activity: 910
Merit: 686
Make we just wait until we get this board as others go begin jealous based on the kind activities we go dey arrange for the board. You know na Nigerians no dey carry last, we sabi show ourselves and I believe we go do well. Make oga Theymos consider us na, I just tire for the whole matter and it seems man dun dey tire too because even names I dey normally see dey very active here dun reduce activeness and it's not making sense.

Dis local board wey we dey fight for go really make sense if we get am as soon as possible oo. I no fit wait make we dey discuss dem serious matter wey go help we all for d country and thrive for beta tinz for dis forum. Seriously activeness don reduce wella for here because even me too neva show for here for some time now. But as you don draw am to our notice, we go dey active more frequently dan before.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Campaign dun make Gozie51 turn Charles-Tim for this last update hahah.
It is great, this has been what we ever wanted, for Nigerians to be more active on our local board. @Gozie51, you really make sense for that. But this has been happening like 2 or 3 months ago. After the last update or so, I stated the reason why I am not active on our local thread, unlike before, not that I am not only active on our local thread, I do have over 50 to 70 posts weekly before as well in total, unlike now which has reduced to like 30. The reason Charles-Tim is no more active like before is because my time is occupied with other things which I can not just disclose here. But I can see that our local board is now having more activities, what we lack before that we do talk about. Gozie51 and every active posters on this local thread, you na all weldone.
@Charles-Tim what @CryptopreneurBrainboss said is relatively true even me I don reason the same thing but I use myself as an example, true be say we dey occupy with real life activities as you know say my wafi born baby so for the past four months am on paternity duty, and that have slow down my activities generally on the forum. But then again the campaign I was in which is blackjack does not count local board/thread, so that one 2 effect my presence for here since I dey try manage the little time I get, so do not make much posts. But when parade change and I come dey for campaign were at list awards some posts to local board e come encourage me more and I must say thank you to@ CryptopreneurBrainboss for the privilege to work with him on this one. So @Gozie51 is not the only one in that category because even @CryptopreneurBrainboss is a party that him been dey blackjack too. I may be wrong though but to a large extent, all of you can attest to that fact with 80%+ true. I greet every body for we house how the evening, hope say e dey go well.
full member
Activity: 882
Merit: 207
Firstly ehn, Naija government go try ban watin dem no fit collect tax from. That na why dem come up with e-naira. Like this sef, I never see person wey dey use am or even champion the cause. Many of these government people, even many of the companies wey dey Naija dey use their Bitcoin do trade wey big well well. If to say dem dey too use bank, the exchange rate of dollar to naira right now go dey very huge o.
We never even talk dat one finish, some people dey say dem no want election to hold in 2023. Abeg which way Naija?
hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
    • Congratulobia to everybody wey make the list including Star men like Davidvictorson, Rruchi, Adbitco and hyphen(-). Abeg I wan see all of una for this table next month

    Gozie51 abeg comment for this post for your merit. Congrats.

    I dey give Salama to all the people wey their name show face for last month wey be July update, walahi all of una try weller as una take make our local board here be hot and very active last month. I dey also recognize our own person wey be @Gozie51 my brother your face show and your show shine as you take wear the cap so for last month keep the fire burning. @uchegod-21, you do well as you take dey active here too and as you take dey samma us dis update every month no stop and I believe say more oil go dey your head as you take dey do well here, una congratulobia.



    .
    Make I great una officially and welcome una to the Month of August as e be like na my first time I dey post here for the month of August be dis. This Month so, market fit rally up small so no fail to take position. This one na quick gain something no be long term hold as I no be dem big name speculators hahaha.

    Senior man I greet you specially too and I dey wish you a happy new month. Thank you for dis correct information wey you give us now I believe say dis kind things go help us make small profit take recharge our belle kingdom, you do well.


    legendary
    Activity: 1512
    Merit: 4795
    Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
    Campaign dun make Gozie51 turn Charles-Tim for this last update hahah.
    It is great, this has been what we ever wanted, for Nigerians to be more active on our local board. @Gozie51, you really make sense for that. But this has been happening like 2 or 3 months ago. After the last update or so, I stated the reason why I am not active on our local thread, unlike before, not that I am not only active on our local thread, I do have over 50 to 70 posts weekly before as well in total, unlike now which has reduced to like 30. The reason Charles-Tim is no more active like before is because my time is occupied with other things which I can not just disclose here. But I can see that our local board is now having more activities, what we lack before that we do talk about. Gozie51 and every active posters on this local thread, you na all weldone.
    legendary
    Activity: 2380
    Merit: 4265
    eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
    Campaign dun make Gozie51 turn Charles-Tim for this last update hahah. Well e goes well if motivation dey to encourage more activeness for our local board. Make we just wait until we get this board as others go begin jealous based on the kind activities we go dey arrange for the board. You know na Nigerians no dey carry last, we sabi show ourselves and I believe we go do well. Make oga Theymos consider us na, I just tire for the whole matter and it seems man dun dey tire too because even names I dey normally see dey very active here dun reduce activeness and it's not making sense.

    Make I great una officially and welcome una to the Month of August as e be like na my first time I dey post here for the month of August be dis. This Month so, market fit rally up small so no fail to take position. This one na quick gain something no be long term hold as I no be dem big name speculators hahaha.
    hero member
    Activity: 1022
    Merit: 667
    Top Crypto Casino

      • Congratulobia to everybody wey make the list including Star men like Davidvictorson, Rruchi, Adbitco and hyphen(-). Abeg I wan see all of una for this table next month

      Gozie51 abeg comment for this post for your merit. Congrats.
      I can see the list improve pass last month and some members are gradually recovering and activities on this thread is coming alive again, @uchegod-21 waiten you dey do so make sense and this go help encourage everybody to try put body small for this corner, make we follow put mouth for waiten concern all of us. Am really proud of the level of improvement and development that is happening on this thread recently and I go follow the top the merit for the winner of the month if I have, and that could come as a bonus merit for the top member of the month. I done return back from paternity break and my face go show for next month 📈 stats.
      legendary
      Activity: 2058
      Merit: 1270
      Play Poker on Telegram
      Star man like Coyster don enter top 3
      You no lie oh, i no know if i go fit ever carry first, cause the senior men them wey they my front so ehn, them gallant wella for this thread and i commend them no be small. Having said that, me i no go lie oh, this our local thread come they sweet well well pass before oh, na so so quality discussions and topics they pop up everyday and na so everybody they drop their own contribution wey make sense wella. Make we just continue this way, soon e no go be local thread again oh, e go be local board. I comot cap greet you Mr uchegod21 and everybody wey they active for here too.
      hero member
      Activity: 1036
      Merit: 625
      BTC, a coin of today and tomorrow.
      NIGERIAN LOCAL BOARD THREAD ACTIVITY UPDATE FOR JULY, 2022.

      I don carry update of how our waka be for last month come we local thread here. As e dey be, e go show us who steady here pass last month and e go make us to know our effort and decide to increase.
      I copy the data wey I use for this post for igehhh thread for Meta https://bitcointalksearch.org/topic/m.57824603

      Top 15 active users May 2022
      Code:
      1. Gozie51 [26]
      2. uchegod-21 [19]
      3. Coyster [18]
      4. Adbitco [15]
      5. Charles-Tim [14]
      6. Davidvictorson [13]
      7. Rruchi man [12]
      8. igehhh [12]
      9. BIT-BENDER [10]
      10. Mr.right85 [10]
      11. cytpoway121 [10]
      12. CryptopreneurBrainboss [8]
      13. Hyphen(-) [8]
      14. Maestro75 [8]
      15. RockBell [8]


      Comments/Observations
      • After some months wey Uchegod-21 don dey top of the table, finally,  Gozie51 don dethrone him. Gozie51 been talk say em go climb the top and him doam.  Congratulobia to him.
      • Uchegod-21 no go too far, e dey for second. But people like Maestro75 slide go down for the table
      • Star man like Coyster don enter top 3 as BIT-BENDER  and igehhh dey drag position for middle
      • Big names like Charles-Tim and CryptopreneurBrainboss made the list. Charles-Tim don improve, e be like him don recover him form. Who knows weda him go steady back for number 1 wey be him favorite position
      • New names don enter the list wela, like RockBell, Mr.right85 and cytpoway12.
      • Congratulobia to everybody wey make the list including Star men like Davidvictorson, Rruchi, Adbitco and hyphen(-). Abeg I wan see all of una for this table next month

      Gozie51 abeg comment for this post for your merit. Congrats.
      hero member
      Activity: 1022
      Merit: 667
      Top Crypto Casino
      What if crypto trading because illegal? I see say the only reason we dey carry shoulder up na because government never ban crypto trading for the country and before you think say dem no fit do am remember wetin happen to twitter. Websites are centralized as such dey fit ban access to them for the country although VPN go clear road but e no go easy as e been dey before. And if them ban the trading then the officer go get right to dey distrub people.

      E no get anyhow you go tell me say crypto trading no dey affect dollars price as well. I understand say the economy no good and na the major reason we Naira dey crash but we get other smaller factors and one of them na the unregulated crypto trading wey dey go on for the country.
      Bros just like others have stated even though the volume of daily crypto currency trading contribute to the dwindling naira exchange rate against the United States dollars, the truth still remains that crypto currency trading is a global activities just like other forest exchange commodities and even if their are not licensed in some situations their still given free hand to operate. I will not expect a total ban but I will much expect some for of regulation and taxation soon since centralized exchange like binance still operate within the a bird of the government's laws.
      E nor go easy like that to ban crypto trading for we naija. Sake of say even some kind top companies wey some of we government officials dey run for background don enter crypto trading (insider informate). To digress a little, even sef we go wake one day hear say dem don legalize Igbo sef. Of course for medical and recreational purposes because dem don see say na very lucrative market. Ok back to the main gist. E been dey easy for dem to ban twitter because say dem nor dey benefit from am and na SM. No vested interest. But you see crypto trading, lie-lie  baning am na future impossible tense be dat  Grin.
      @Davidvictorson no doubt am say one day weed 🌿 go dey legalized for 9Ja after all aside from the fact that that sector is a very lucrative sector for the economy, secondly Rastafaria an religion and if senior advocate fit dress like herbalist enter High Court, sake of say him believe in his traditional religion, then also a Rastafarian have equal right to go public and legal after all there all religions what differs is their followers.
      legendary
      Activity: 1414
      Merit: 1104
      Bitcoin Casino Est. 2013
      I know say we get undergraduates for here, i believe say una don hear the news, ASUU hold meeting today and them don reach agreement say the strike go continue indefinitely,
      If you be undergraduate for here wey dey affected by ASUU,  my best advice for you na for you to go find wetin you go dey do, most preferably like i dey always talk, go learn high income skill or learn more about crypto as e be say you dun dey here already. Nor dey wait for ASUU and government, their children either dun finish or dem dey private or obodoyibo. The strike fit nor end anytime soon, the matter tie wrapper. I been see where dem yan say "two years nor dey too much for nigerian students to  sacrifice unto the struggle" Grin...who see am?

      The people i dey reason for too na parents wey dun pay rent for their pikin dem like my aunt, school dun go strike... house rent dey count dey go...money dey waste. Pikin wey just enter school for year one, instead of am to dey learn, e dum turn vendor for WhatsApp, thanks to Government. We need a complete overhaul of the current system for things to get better.
      hero member
      Activity: 700
      Merit: 541
      Bitcoin Casino Est. 2013
      Senior man abeg off mic, make Buhari no come reason you now come implement complete ban. Na here man garri deh come from o.
      Eh nor get watin nor dey let bubu do   Grin
      sr. member
      Activity: 1960
      Merit: 329
      www.Artemis.co
      E no get anyhow you go tell me say crypto trading no dey affect dollars price as well. I understand say the economy no good and na the major reason we Naira dey crash but we get other smaller factors and one of them na the unregulated crypto trading wey dey go on for the country.

      Senior man abeg off mic, make Buhari no come reason you now come implement complete ban. Na here man garri deh come from o.
      hero member
      Activity: 742
      Merit: 529
      casinosblockchain.io
      As things be so, whether government welcome crypto trading or not, Nigerians go continue to they involved in am, it is legal in our country, the only thing wey them do na to ban Naija banks them from processing crypto transactions, but crypto/crypto trading they go on without any trouble for here, the government fit no like am, and them fit no they in support of am, but so long as say e they legal, e no concern anybody wey they into crypto/crypto trading.

      What if crypto trading because illegal? I see say the only reason we dey carry shoulder up na because government never ban crypto trading for the country and before you think say dem no fit do am remember wetin happen to twitter. Websites are centralized as such dey fit ban access to them for the country although VPN go clear road but e no go easy as e been dey before. And if them ban the trading then the officer go get right to dey distrub people.

      E no get anyhow you go tell me say crypto trading no dey affect dollars price as well. I understand say the economy no good and na the major reason we Naira dey crash but we get other smaller factors and one of them na the unregulated crypto trading wey dey go on for the country.

      This matter of the naira lossing weight for the market no really get better attachment with on how people the trade, the real coco nah we government wey don't totally  fail to do the right thing in the right way.

      Just imagine how many of them and their children and relatives the run go sch abroad, what about the issue of every big n small man only wanting to buy only things wey be foreign made, imagine how much we government don borrow borrow up and down, inside all this borrow borrow conditions dey ontop am wey no dey favourable to the naira which we know but still becos of their selfish interest them go still go on borrowing.

      As it stands like dis naija no follow for exporting countries except crude oil wey no be we sef the refine am despite how many refineries we gather get for the country. Oya just remember ajeokuta steel company  wey been the produce steel irons of any kinds how many years now it dey shutdown. That company alone go produce all the irons wey Nigeria need to take do anything weda na rail tracks, car panels and trucks but rather we dey import iron steel from China with the same  money with borrow from China. No be juju be that? So tell me how the dollar and other currencies no go continue to appreciate against the naira.

      Oya make I burst ur brain! Do you know that in the 70s and 80s from Lagos international airport to New York was  #17,430 but today just from Port Harcourt airport to Lagos even #50,000 never reach for flight. Just imagine , so why people no go try hustle through the available loophole for other higher currency so Dem fit meet up the hike in prices of domestic goods and services?

      This matter na only God fit give us the kind leader we dey look out for, cos everybody don really tire for this our FATHER LAND, but it is well shaa!

      hero member
      Activity: 1036
      Merit: 861
      Livecasino.io
      What if crypto trading because illegal? I see say the only reason we dey carry shoulder up na because government never ban crypto trading for the country and before you think say dem no fit do am remember wetin happen to twitter. Websites are centralized as such dey fit ban access to them for the country although VPN go clear road but e no go easy as e been dey before. And if them ban the trading then the officer go get right to dey distrub people.

      E no get anyhow you go tell me say crypto trading no dey affect dollars price as well. I understand say the economy no good and na the major reason we Naira dey crash but we get other smaller factors and one of them na the unregulated crypto trading wey dey go on for the country.
      E nor go easy like that to ban crypto trading for we naija. Sake of say even some kind top companies wey some of we government officials dey run for background don enter crypto trading (insider informate). To digress a little, even sef we go wake one day hear say dem don legalize Igbo sef. Of course for medical and recreational purposes because dem don see say na very lucrative market. Ok back to the main gist. E been dey easy for dem to ban twitter because say dem nor dey benefit from am and na SM. No vested interest. But you see crypto trading, lie-lie  baning am na future impossible tense be dat  Grin.
      hero member
      Activity: 1022
      Merit: 673
      Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
      As things be so, whether government welcome crypto trading or not, Nigerians go continue to they involved in am, it is legal in our country, the only thing wey them do na to ban Naija banks them from processing crypto transactions, but crypto/crypto trading they go on without any trouble for here, the government fit no like am, and them fit no they in support of am, but so long as say e they legal, e no concern anybody wey they into crypto/crypto trading.

      What if crypto trading because illegal? I see say the only reason we dey carry shoulder up na because government never ban crypto trading for the country and before you think say dem no fit do am remember wetin happen to twitter. Websites are centralized as such dey fit ban access to them for the country although VPN go clear road but e no go easy as e been dey before. And if them ban the trading then the officer go get right to dey distrub people.
      Na d real matter b dat shah. E shock you wth wayin happn wth twitter nd d truth be say, nothing persn ft do Dan 2 use VPN. D result as at den be say, most affiliate marketers nd people way be say, na Twitter dem dey use chop frm small small promotions nd evn trade for followers, e bin slow down tins too.
      Dis go be d same result way go happn if dem ban crypto trading. Las las, na banks we dey still use 4ward money, on escrow site nd d rate ft make person put eye or ask question.
      Some pple go out trade via d stress to dey use vpn nd u still get govment forces dem way dere eye dey shook to deal wth. Getting crypto app cef go be crime nd dat na real matters.
      staff
      Activity: 1316
      Merit: 1610
      The Naija & BSFL Sherrif 📛
      As things be so, whether government welcome crypto trading or not, Nigerians go continue to they involved in am, it is legal in our country, the only thing wey them do na to ban Naija banks them from processing crypto transactions, but crypto/crypto trading they go on without any trouble for here, the government fit no like am, and them fit no they in support of am, but so long as say e they legal, e no concern anybody wey they into crypto/crypto trading.

      What if crypto trading because illegal? I see say the only reason we dey carry shoulder up na because government never ban crypto trading for the country and before you think say dem no fit do am remember wetin happen to twitter. Websites are centralized as such dey fit ban access to them for the country although VPN go clear road but e no go easy as e been dey before. And if them ban the trading then the officer go get right to dey distrub people.
      VPN are not allowed on most of the centralized exchanges, not every country are allowed to trade on binnace, there are too many of them and that's why VPN is not allowed on all exchanges, if the government ban trading on centralized exchanges it would have a huge impart for those who don't know how to use use decentralized exchanges

      E no get anyhow you go tell me say crypto trading no dey affect dollars price as well. I understand say the economy no good and na the major reason we Naira dey crash but we get other smaller factors and one of them na the unregulated crypto trading wey dey go on for the country.

      It has nothing to do with the Naira crashing it's poor government, The US trade twice of what Nigerians trade on a regular basis yet their dollar keeps appreciating, the best way to improve the Naira is to cut down much importation and do more of exportation.
      member
      Activity: 421
      Merit: 47

      E no get anyhow you go tell me say crypto trading no dey affect dollars price as well. I understand say the economy no good and na the major reason we Naira dey crash but we get other smaller factors and one of them na the unregulated crypto trading wey dey go on for the country.


      For these case, na govt and the cbn been cause this wahala and then looking for someone to shift the blame to. first na aboki fx emefiele blame, then he blame bereau de change shops and now they are blaming crypto trading. For the past 3 years now, buhari govt and emefiele through banks have been hoarding usdt for naija. knowing fully well seh we get international students weh go need the dollars, and well as several imports weh the country de, instead dem close border weh de help country export naira well, ban imports, hoard usdt, dem con de find who weak weh dem fit blame. the country mata tire me aswear
      legendary
      Activity: 2380
      Merit: 4265
      eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
      As things be so, whether government welcome crypto trading or not, Nigerians go continue to they involved in am, it is legal in our country, the only thing wey them do na to ban Naija banks them from processing crypto transactions, but crypto/crypto trading they go on without any trouble for here, the government fit no like am, and them fit no they in support of am, but so long as say e they legal, e no concern anybody wey they into crypto/crypto trading.

      What if crypto trading because illegal? I see say the only reason we dey carry shoulder up na because government never ban crypto trading for the country and before you think say dem no fit do am remember wetin happen to twitter. Websites are centralized as such dey fit ban access to them for the country although VPN go clear road but e no go easy as e been dey before. And if them ban the trading then the officer go get right to dey distrub people.

      E no get anyhow you go tell me say crypto trading no dey affect dollars price as well. I understand say the economy no good and na the major reason we Naira dey crash but we get other smaller factors and one of them na the unregulated crypto trading wey dey go on for the country.
      legendary
      Activity: 2058
      Merit: 1270
      Play Poker on Telegram
      I know say we get undergraduates for here, i believe say una don hear the news, ASUU hold meeting today and them don reach agreement say the strike go continue indefinitely, this new week wey we enter so go make am two weeks now since Mr President give minister of education order say make the baba end the strike in two weeks, i see no sense in that though, instead of Mr President to attend to the demands of the union, the baba they give order to minister to end the strike, how is the minister going to make it possible, it just shows lack of desire and interest on the part of our government to do anything about this industrial action by ASUU even after many months of students sitting at home.

      Wetin una think about this matter so, you believe say this strike fit reach next year, abi our government no go like make students they for house as election they approach as e no go too speak well about yeye APC, as for our undergraduates here, how the strike take they affect you, abi most of una don put hand into other businesses, so tey una no even care about ASUU wahala again.
      Pages:
      Jump to: