The country eh, life hard and to survive cef con hard join. People just believe say, as a young guy, you no suppose get money, you no suppose dey drive. Something way oyibo cef dey drive enter college, na watin dem dey outlaw for we naija, e no dey okay na. Dem just make people way dey try utilise opportunities way dem see online dey difficult. Anyhow way you wan try explain am, na so dem go believe say, na fraud you dey do. Once e no be something way be say, the office dey visible and you dey live okay, them don tag am fraud. The matter just cast.
EFCC don forget politicians, them forget those way dey spend foreign currency for them country dey focus on these men them... e no soft at all. The just dey common these days for street and e dey drop there rep. Na so SARS been stat o, soon the street go cable cable for them.
We the youths don supposed understand by naw say these policies them wey we politicians the make for the country nah to make sure say it keep us under lock and key under poverty so that anytime Dem put calls to us for election mata we youths go ball out based on say nothing dey pocket so if them ball out for them something go enter their pocket at the end of the day.
No be say d politicians Dem no know wetin to do but the coco be say if them do am every youths go dey independent and no go dey answer their calls to d go do the uglies.
Smartvirus just imagine say as u get something u dey use hold ur side wey weigh u at all at all, if any politicians com call u make u go do uglies for am make him lap u 5k u no go gree go do am, bcos u get something wey the bread RBS but for those wey no get anything source Dem go rush that offer say na opportunity for them to get money.
So na just the game those men d use us play dey block block our channels Dem, but baba God pass Dem.